in my own little opinion Bitcoin makes it money through mining process, its data of transactions and rewards computer operators.
Your little opinion dey wrong, Bitcoin na money himself so Bitcoin no need to make money. Your question just dey like how Naira dey make money, e make sense to you like dat? Wetin you go talk na how people dey make money with Bitcoin and na when different strategies go come on boards like;
- People make money from Bitcoin through investing
- People make money from Bitcoin through mining
- People make money from Bitcoin through trading
- People make money from Bitcoin through offering a service relating to Bitcoin.
- People make money from Bitcoin through lending and other ways wey you fit make money from any currency, assets and so on
You fit devlope your own means of making money from Bitcoin, some people dey wey dey work and get paid in Bitcoin. People dey wey dey combine the plenty ways of making money from Bitcoin, basically Bitcoin go give you money anyway wey naira or any other currency fit make you make money too. Bitcoin na a tools to use make money and the best way to make am na by buying and hodling as e better pass others means but if you be person wey dey very creative, you fit invent your own means and they get your choppings.