Author

Topic: How the reality of the country the affect ur business? (Read 227 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
Omo e don affect business badly in a way e go mk person look like say we no sabi business or say we lazy but dem no know say na the way our country dey now na e dey affect our businesses like as they never open bother now, e dey really worry dey traders to dey do importing and exporting freely, even the cost of things don dey high due to government inability to provide the essential things for the farmers, na e mk wen we go buy something, we no go know how to resell am back because e too cost, we no come know who we go blame, whether na manufacturer, wholesalers, retailers or consumers because if we check am well, e go see say e dey from somewhere come but we no know who and where so in that case if u no hold better money like 500k or 1m, person no fit open better business and now no be anyhow business person go open again because as our country be nah, unlike before wey be say any business person open e go move well but no e no dey like that again if not person go stay two days self, no customer so to avoid story that touch the heart, person go look for better business.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
This country don really frustrate plenty people and e come worste pass even now for this economy wey the present administration come put everybody . The economy don affect every body, be it good or bad because the current state of this economy even the so called business are not an escapist to this problem as it's clear say the dollar dey rise every day making things to be very cost and upon say them even open boarder now e come be like say e even worse pass the time wey the boarder been dey close.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
The hardship way dey we nation don change not just how people dey conduct business but also how people dey live life. People way no sabi apply caution on cost, dey learn am now. If you get 3 cars, you go pack 2 and use one. Na so the play just be for the country now and in many ways, e don change how people dey do business.

The thing dey reflect in management and how people dey try keep eye on every digit running in the books to avoid any funds from sleeping and how to transfer some of the expenses give the customers. Either to put an in the product or to come out by some means and tell the customers.

All these chain reactions is claimed by the hike in fuel price. This tells us where the chief source of the problem be and if we fit tackle am, things for better small.
hero member
Activity: 658
Merit: 562
Business no dey move well because if you observe,na to eat na e be the first thing wey people dey reason now. Na e make you see say na only those essential commodities na e dey move market presently. I don so many people we dey do well for their life and business before no dey do well again because of the hard economy. The worst thing na those people we rent shop, before you know shop rent don expire,how you won take pay when you no even get half of the money to use pay. E get some business wey be say you need to think twice before you go into am,if not before you know you don stop the business. For my side here I dey see people wey just dey change from one business to another to find the one wey them go use hold body because them find out say the previous one no dey profitable.
hero member
Activity: 1022
Merit: 600
A lot of people have gone out of business lately either because they are not meeting up to pay their shop rent or have no money to purchase more goods to service their customers and low customers turn up to buy goods because of skyrocketing prices and what you can afford before becomes difficult because things has doubled and tripled in price.

The problem for we country today be say we dey consume more than we dey produce, we wholly depend on imported goods thereby increasing the demand for dollar. Nigeria needs to move from consumption into production, that way it will bring down the price of things and reduce the high cost of living that we are experiencing today as a result of inflation.

hero member
Activity: 756
Merit: 508
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
Prayer is the only thing that can ease our burdens. By God's favor, everything that rises must eventually fall.
Dis statement if na food person no go find anything chop am because e don clear say no only prayer fit come us for dis matter wey we dey so. It seem our leader dey comfuse because dem say removing subsidy go easy the affairs of the nation but still the suffering continue to extend of dem borrowing money to feed us for six months. Truely I don't know ooo but still better for the government to be paying for subsidy so that thing will be cheap.
newbie
Activity: 22
Merit: 2
How i dey see things ba, if Petro done rise price for our country, everything go increase price na only God dey self us for this our Naija, because everything just dey somehow many people dey suffer dey are looking for want dey will eat, because foodstuffs done increase, money where you go use buy 3mudu you use am buy only one, i know understand this Tinibu, if him no put this subsidy back fuel no go come down. And many business as be affected because of the fuel increase, when bring some products from different states, now everyone just dey find money to chop because this our country is hard now, many things done get value. Something were person no dey chop done start dey chop because of the hardship on the country.
full member
Activity: 448
Merit: 163
This new reality in the country is really putting many businesses to a stand still. Shey nah when person don chop bellefull naim go think of buying better clothes to wear, shoe, visiting places of leisures or even flex join? For those of us that are not into foodstuffs and groceries that are necessities of life that no matter how hard and heightened the economic situations turns out  people go still buy food to stay alive.

Omor na true talk the way this country is heading now, I know just grasp how things dey cost just like that, my own thinking be said for does that have plenty of families how dey wan take to exist if not be God that stays on the intervene for us.

The only issue is that our nation is running out of strong leaders, and since the dollar isn't doing well, I don't anticipate a spike in food costs may come down soon. Prayer is the only thing that can ease our burdens. By God's favor, everything that rises must eventually fall.

sr. member
Activity: 658
Merit: 441
No be lie oh, na people wey dey into foodstuffs business dey benefit pass for this economy because man must chop, if man no chop life no continue. Another business wey dey go well dis period na transportation business because no matter how e be man must move form point A to B and people need go work to go hustle so transport business na sure plug for all weather. Personally I no get physical business but I dey see people wey get and the thing no easy again because na so so close down dey happen this days. Money no dey on ground and wetin God do for us wey get sure online plug no be small because I just dey see the way wey people dey struggle to meet work schedule and I dey thank God everyday.
Baba, no be small thing God do us for dis hustle here, na something wey be say we suppose dey thank God everyday. Di economic realities for our country na iphone 15 pro max. Pipu wey dey gainfully employed, wey dey collect like 40 - 50 kpali, afta dem comot di money pay transport go work, feed themselves and other expenses, I wonder wetin dey remain. Even di transportation business wey you talk, no be everybody dey benefit ooo, I no kno about long distances but people wey dey run town services dey talk say nothing really dey, say na to just comot for hauz. Even di one wey I dey take hustle sometimes, I just stop becuz afta I don calculate di fuel wey I dey blow, it's not worth it.
full member
Activity: 490
Merit: 209
This new reality in the country is really putting many businesses to a stand still. Shey nah when person don chop bellefull naim go think of buying better clothes to wear, shoe, visiting places of leisures or even flex join? For those of us that are not into foodstuffs and groceries that are necessities of life that no matter how hard and heightened the economic situations turns out  people go still buy food to stay alive.

For some of us wey dey into business like sales of products, materials and other services wey no be foodstuffs, how market nah? For my own area in the past months the patronage don really drop oh and I wan know wether na the same thing for unah too.
How the reality of the country the affect the patronage of your business?

That first statement off me but waiting person go do, survival now no easy at all and considering the fact say na who chop they think well self if you no chop my brother you no go understand your body at all talk more of thinking, one of the most important thing na food and na why we they work be that, and that is why if you wan start business make person check the demand, now wey everywhere done tight na him person go buy cloth, the demand of food is higher than that of cloths, bro this matter na everywhere oh when it comes to comparing the two.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
This new reality in the country is really putting many businesses to a stand still. Shey nah when person don chop bellefull naim go think of buying better clothes to wear, shoe, visiting places of leisures or even flex join? For those of us that are not into foodstuffs and groceries that are necessities of life that no matter how hard and heightened the economic situations turns out  people go still buy food to stay alive.

No be lie oh, na people wey dey into foodstuffs business dey benefit pass for this economy because man must chop, if man no chop life no continue. Another business wey dey go well dis period na transportation business because no matter how e be man must move form point A to B and people need go work to go hustle so transport business na sure plug for all weather. Personally I no get physical business but I dey see people wey get and the thing no easy again because na so so close down dey happen this days. Money no dey on ground and wetin God do for us wey get sure online plug no be small because I just dey see the way wey people dey struggle to meet work schedule and I dey thank God everyday.

For some of us wey dey into business like sales of products, materials and other services wey no be foodstuffs, how market nah? For my own area in the past months the patronage don really drop oh and I wan know wether na the same thing for unah too.
How the reality of the country the affect the patronage of your business?

Na one Nigeria all of us dey and things no different for any state, na all of us they follow see the shege wey tinubu government dey show us so things no go different for our side. Transportation dun go up, foodstuff dun go up and nothing man fit do but to they avoid some kind useless spending dem wey we been dey do before. Which day wey I enter fast food to go chop small and normally place wey be say they full and you go need wait for your turn dey almost empty because people dun dey cook for house and na so all this market women dem dey sell business because their own business no dey affected.
member
Activity: 181
Merit: 39

Seriously, if Nigeria doesn't protest this time, it's a horrible situation, and no one should complain. Can you please acknowledge that even with our money, we are still hustlers?

E be like you nor be naija person and you no know how the issue of protests dey be b for here. The thing be say our leaders don make the whole tin so difficult that if you dey run your own business, if you no increase am you fit no see profit and just like wetin op talk, nah who don see money chop nai fit check if he fit flex or buy clothes.
Wit the way tins don hard, nah who don eat belleful dey go do protests na..abi you no see am so?
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
All I can say now is that the inflation is a little high and the source of income is a little difficult since so many people are trying to get what they will eat, and the price of foodstuffs and other basic requirements has climbed as a result of the increase and the petrol price.

We must adjust to this circumstance because we have no other choice because the value of our currency is diminishing as the dollar rises.

The price of fuel was increased by the marketers due to the increase in naira to dollar price in the parallel market. Since Nigerians, the marketers still refine their fuel out of the country, they’ll have to convert their naira to dollar to buy those products. Naira was diminishing against dollar, hence the increase in the price of petrol. I hope when naira appreciates again against dollar, we’ll see a decrease in petrol prices.

Seriously, if Nigeria doesn't protest this time, it's a horrible situation, and no one should complain. Can you please acknowledge that even with our money, we are still hustlers?

After all, no matter how we protest, they won’t change anything. This is not the time for protest but time to double our hustle and look for means to earn for ourselves since the government can’t do that for us now, you can’t be waiting forever. Even the government workers are still hustling, do you think their pay will cover for their expenses in this current economic situation? Don’t snooze now, work hard and pray for better days ahead for the country.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino

How the reality of the country the affect the patronage of your business?

I know say many businesses don dey affected for this country because of the hard economic realities even down to mamaput self for road no dey too finish deir food again because men dey roost, na so dem go carry remaining one go house go do curing.

There is things particular business wey don dey suffer come from north because of insecurity and that because na night life businesses. The owners of this kind of business na so so complain you go dey hear because truly night crawlers self don dey hold them body. As money no dey, food no dey, everywhere cast.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
We must adjust to this circumstance because we have no other choice because the value of our currency is diminishing as the dollar rises.

Food prices will rise again very soon if the dollar continues to rise because the situation is out of control, the government must take action to rein it in.

Na that dollar increment aspect na em I d think of since everything wey we d use for the country is highly dependent on imported  goods, there are rumors sae dollar go fit reach 1k naira before December. Presently na 820naira, things the on increase with addition of fuel increase, you can imagine wetin go na happen when naira enter 1k naira per dollar. Na murder be that nah. The funniest of it all be sae, civil servant salary remains the same, no salary increment for them and the FG no get plan to increase minimum wage. How are we to survive in this kind situation, where work no d, insecurity d, corruption na call of the day and those in power no care for the masses except for their pocket and family
sr. member
Activity: 546
Merit: 265
We just dey feel say d country don tumble bt e gt pipo @ d top way dey feed fats on our public moni dem.

Some pipo no even fit go daily hustle again bcos of T.P high price cus dem no evn sur say d hustle go pay afta checking pokets & d current T.P chargs.
Dis alone don spoil T.P businez.

Services charge dey add moni bt salary no dey add.
D worse dia b say goods & services way add dis moni no give more moni to d businez piop.
Na stil pety incom dem dey gt evn dou as dem dey sell or offer high charges.

Me don cut cost of evrytin and suspend d 1 I ft suspend cuz if I no find myself food nobody go feed me cos food na most wanted for living.

hero member
Activity: 1022
Merit: 744
All I can say now is that the inflation is a little high and the source of income is a little difficult since so many people are trying to get what they will eat, and the price of foodstuffs and other basic requirements has climbed as a result of the increase and the petrol price.

We must adjust to this circumstance because we have no other choice because the value of our currency is diminishing as the dollar rises.

Food prices will rise again very soon if the dollar continues to rise because the situation is out of control, the government must take action to rein it in.
hero member
Activity: 938
Merit: 605

Jump to: