Author

Topic: How to convert your NIN slip to plastic card (useful for xchange kyc and others) (Read 92 times)

legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Anyways, I just gotta say, thank you for the reminder, I've known about this process from long time ago, and I've planned to process my premium NIN since I need it for some verifications online as my drivers license have expired, and I am yet to renew it..

I need this to verify some of my account online, but I've always been forgetting, but coming across this post now, I remembered again and I've just downloaded the premium nin, will visit the Cafe later in the day to have it printed out..
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Thank you for bringing dis information to de local board. Since wey I run my own NIMC registration many years ago na de NIMC slip wey dem give me, I don wait to receive de ID Card and I don tire. So with dis information now I go try make I get my own ID CARD as de slip no dey presentable. But wen I see dis information I bin get some doubts about de authenticity of de news because I no dey comfortable inputting my details into any random app online. So I had to do some search and I don confirm say de information dey legit and I go advise you make you add dis link to your post from their official website so that many persons go take your post seriously, de tiktok link alone no too dey convincing.

Code:
https://nimc.gov.ng/how-to-print-your-improved-nin-slip/
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
You done try to bring to us this latest update about how to get our nin plastic ID, watin this nin matter do people for this we country few months back, e bad but e still good sha, because as a citizen of any country you must get your National ID card so that you self you go still remember were you from incase you forget Grin.
Nowadays, if you no get this nin you no go fit register for even junior weac or senior weac and you no go still fit register new sim card and to still verify some things for internet.
I no too like the green copy of this nin which is the pepper own because e dey easy to stain if you no keep am well, so I go do my own plastic nin with this app way you talk.

I done go through the app and I done dey download am, I dey see the app say e go dey easy for people to use and e legit.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
My people how we dey today? I believe we dey survive the country hardship jeje dey go. I bring this update come here for people wey need am including myself.

We know how incompetent our identity management commission dey be for this country if not e no suppose dey take years to get plastic NIN card after registration. Even for my school, e no dey take up to 3 days to get plastic ID card as a new student when you finish your registration. I no con know why NIMC dey take many years to provide us with plastic NIN despite government funding.

Thank God, you no need to wait for years again to get your plastic NIN. With the help of your phone and little money you go get am instantly. How? Just follow this steps:
1. Download NIMC app
2. Log in using your NIN
3. A code will be sent to the number linked with your NIN. (if you don't receive the code, dial *346*3# from the Sim that is linked to your NIN) you'll receive your user ID and OTP.
4. Input the user ID and OTP
You're almost there. Your dashboard will display showing your informations.
5. Proceed by clicking on print premium slip
6. Make payment using remita (approximately 1300 naira).
7. Download the soft copy after the payment
8. Take it to any nearby café for print out (it will cost around 2-3k)
Congratulations for having your plastic NIN without waiting for years again.

Wetin be the benefit of having plastic NIN? I believe some people go dey wonder say ahh wetin they wan use plastic NIN do wey go make dem pay money on top to obtain. Make I yarn you some benefit of having plastic NIN.
Plastic NIN na coloured in nature. As a student, you can use it during application for scholarship that require identity verification. You no fit japa without it too. For exchange traders here, you go use am do any exchange verification as well. E dey durable and no go easily damage. The benefits plenty but make I no make the post long.

The information and procedures is culled from this video and it's tested and verified.
Jump to: