I understood the principle of setting goals before I invested on Bitcoin and I can tell you for real that it has helped me in this journey of long-term hodling, I don't think of anything else each time I see my Bitcoin apart from the goals I have set in place for it.
Sometimes e make sense to have short term plans while you still get long term plans because some long term plans dey feel Impossible to achieve but if you get other small small targets e fit make you achieve your goals quickly and you no go even feel am say na that impossible goals wey you been dey see so na wetin you dun achieve already.
Na true talk you talk, e go even better say as a starter you start with short term investment so you go confirm am well say true true this thing good and en go even better say person hodl for long. When you done confirm am with short term investment when you enter long term nothing person fit tell you way go make you pull out because you done see the good result before through the short term investment you been do.
Wetin you talk nah true, but while you set those short-term goals inside your long-term investment, you go try dey focused make your attention no go shift from the main goal wey be long-term because of the petty profits wey fit come from the short-term goals wey you don achieve, cos sometimes all these investments dey Sabi play tricks on person and you fit easily lose focus before you even know.
Let's say you plan to HODL BTC for the long-term ( maybe 5 to 7 years na e be the initial plan) and then along the line after a year or two, you come dey see the small small profits wey dey enter there, then you decide to shorten the goal by taking small profit while still determined to HODL for the long-term.
But all of a sudden when you don start to dey collect those small small profits, you come dey feel like say you don arrive and say na there the main thing dey, small small your attention go dey divert from the main goal and then you go start to pull out any small profit wey enter on top.
This thing don happen to so many investors wey enter bitcoin investment with long-term goals, due to this main reason them don fall by the roadside, forgetting say that thing wey dey sweet well well, dey also bitter too, because when some kind DIP go hit the market, DIPs wey your long-term goals supposed shield you from, fear go come enter your body then make you go take decisions wey go fit affect your investment and possibly incur even more losses wey go pass the small small profits wey you take initially.
Dem say make you no do pass yourself, make you no go invest inside Bitcoin with important money that'll be needed urgently. Na only spare money go well or money wey be say we dun keep aside say na for investment na wetin we suppose to dey use and the percentage from your salary no supposed too much. The thing be say Bitcoin investment no be cashflow investment unless na trading wey you dey do for here or other various means of receiving cashflow for the industry. If na strictly investment wey you dey do then you need to plan yourself well so you go always dey get urgently 2k dem wey go dey bail you out of problem because dem go always dey around as for you dey alive.
This na why the DCA strategy dey always dey come in handy for situations like this, because e just be like say you dey comot small money from your salary dey throw for saving box, saving box wey you no plan to break anytime soon, and by that time you go don get other mediums wey go dey sustain you, just incase the need for urgent 2k come, you go fit chest ambulance without even thinking about the investment wey you get.
Make we say for instance, person wey dey earn like 50k every month, as month finish and you collect your salary, you don drop like 10k for your investment knowing fully well say the remaining 40k go fit carry you till month finish again, na this one we dey call DCA.
To even make the whole matter easier for you, inside the 40k self wey remain, you fit dey keep like 10k for your emergency fund, then use 30k take guide till next salary show, you go see am say if emergency lap, instead of to run go meet your investment to collect money there, you get another alternative, wey be your emergency fund, the thimg go come make your investment safe and go dey steadily dey grow for you, and any awoof money wey enter your hand too, you fit split am, put some for investment and some for emergency fund.
E dey very important to take emergency fund seriously o, because na the only thing wey fit pose threat to person investment, so yes, emergency fund dey just as important as person investment because without am, the investment self fit no stand.