To get transaction confirm in the fastest time dey cost reach like $200 last week as I dey see screenshots everywhere (like the screenshot above wey person been send me) even me self check am and confirm am.
The highest fee that I noticed at 500 sat/vbyte for 1 input 2 outputs for native segwit to native segwit addresses was around $23, if bitcoin is at $28000.
Belike you no follow news, people that were looking for very fast confirmation payed at some point more than above what's on the OP. Many people no get patience and dem no get time to dey find accelerators. We no dey use the bitcoin blockchain, e get people wey dey depend on am very well and any moment wasted fit affect their reputation. Take Hhampuz as example, he's known as a fast paying signature manager and to keep his reputation intact, una see the kind money wey him dey pour for transaction fees just to make sure there's no delay in transaction while other managers dey delay their participants payment and you no go blame them, dey no get reputation to protect.
Edit: I notice those wey dey use trustwallet dey get this over high fee issue as dem no get control over setting their fees
You can customize the fee on Trustwallet. When you want to make the transaction, after you click on 'continue', click on the settings icon at the upper right corner to customize the fee.
Nice I no get dat update oh, I think say trustwallet na still dat crazy wallet wey no dey allow their customers to set their own transaction fees. I know say dem sabi recommend fees to use and during the hike in transaction fee they recommended were outrageous as I confirm am myself.
How you see the idea to they hold stablecoin as you dey hold your BTC.
Stable coin na Idan now o. Na wetin I dey use and the transactions dey seamless as if say nothing dey happen. But e dey possible say we fit experience this kind congestion for stablecoin like say USDT if plenty people start to dey use am?
Practically E fit happen, any blockchain can get congested, the thing be say most blockchain for this industry no get better activities but their develops just they manufacture high numbers to push rubbish agenda so people go feel say the blockchain na coco but nothing dey dem. See Ethereum na, immediately better people start they use am, na so congestion wan kill the blockchain. Using USDT as example, make we just assume say USDT transaction on other blockchain was stopped and na only Ethereum wey people prefer pass or dem dey use, already Ethereum get problem with congestion wey dem dey try solve so e fit get similar issues too.