Author

Topic: How una see this new rules to pass captcha before you post (Read 102 times)

sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Omo no be small thing o. When I see the update I begin wonder wetin happen wey administrator go bring captcha come. I still think am twice to know but on the other hand na 1st of April him make the post so my thoughts go straight to April fool but I reason the matter again say admin no dey too post and when him make post na fast implementation omo na there I know say jungle don mature but me I no fear because I know say if na for real, members go appeal for change of captcha format because that game no go well at all.

Omo another thing wey give me mind na as  I begin see senior reputable ranks dey carry the red banner for their head dey Waka for platform na their my mora high say nothing spoil. I continue my work, not minding the captcha and outcome of it.

I know say for sure low quality post na problem for this platform but I believe say management know how to handle the situation of low quality post but this measures fit no urgur well here but at the entire end, na big April fool.
member
Activity: 308
Merit: 26
When I first read wetin Theymos I fear,because I know say low quality post na big headache for the forum. I say which kind problem be did especially me we no get any idea for computer programming or related stuff like that. I just feel say alternative way fit dey to jump and pass. Later when I come discover say na April fool,omo na e my mind rest because I think say na for real.
All my life I never see this kind of April fool wey keep person heart for up. I swear down this forum na fun.
You fear for the matter , this one you done realize say you no get any idea for programming stuffs you no go like learn? E for go well if you learn o, becos na waiting dey on board be rhat,.
 As in ehn I tire when i read am, but I come feel say e go help the group in one way of or the other to check mate low quality post and spammers, and e dey stressfull, make we see how e go be
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
When I first read wetin Theymos I fear,because I know say low quality post na big headache for the forum.
Lol,,, e say fear catch am! At least, e don clear for your eye say na April fool now shah.

E get somethings way be say, them for like put in place for the forum but, na just how to put am or system to use coordinate am and e go dey on point be the matter. Like, how playing game and collecting coins take relate post quality... e no come out normally na and post quality or spam na watin AI no go fit measure accurately. So, na just another classical April fool and come next year, another one go drop.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If you have not been up to a year in the forum what happened on April 1st could be strange to you but that is the administrator's own way of celebrating that remarkable day and everyone have the right to prank others on that day the same way you do in your environment.

-But also we must know that there should be a limit to what or how far anyone can go, if you must pull a prank it must not pause any form of physical or economic risk to anyone else, that is why the administrator never limits anyone posting yesterday so it will not affect anyone activities.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
When I first read wetin Theymos I fear,because I know say low quality post na big headache for the forum. I say which kind problem be did especially me we no get any idea for computer programming or related stuff like that. I just feel say alternative way fit dey to jump and pass. Later when I come discover say na April fool,omo na e my mind rest because I think say na for real.
All my life I never see this kind of April fool wey keep person heart for up. I swear down this forum na fun.
sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
When I see the CAPTCHA I was shock and was total afraid of posting yesterday, I try playing the game but I couldn't be able to play, I spent all of my day busy playing the game but couldn't win a peace. If this is not April fool Forum go dy stressfull, shey it was fun.
full member
Activity: 798
Merit: 134
See it gone at 12 am (1 am in our local time). It is just April fool.

Abeg oo this one don pass be careful o, because e dey hard for me to pass this captcha and e really make things hard for me.
De way i dey see activity don reduce for the platform if not of @TryNinja wey just go hacked this game wey we dey play since thinking we dey reduce spam. E no sweet at all for one day since morning here just tire me to stay wey be say i dey always enjoy this forum to read and post around but this one go like reduce our activities if our oga T no do something quickly.
full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Omo that thing better end for April fool, because the thing just they so annoying I spend almost 1hr just to pass 1 of the Captcha because the red flag for spamming way they show for that up no really look good at all. 

I have just managed to pass it twice 😃.
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
It's just some April fool's joke by Theymos.

Have you been able to collect 99 coins, or are you just waking up now?

I've been battling with it the whole day.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
See it gone at 12 am (1 am in our local time). It is just April fool.
full member
Activity: 798
Merit: 134
My pipo una weldon oo, for like somedays i never too put eyes for the forum since i travel go my LGA network no too allow me dey constantly dey flow for the forum. This morning as i wakeup i say make do small post i come see the new development way come out and like this anybody wey no fit pass am dey suspected as spammer.
my question now be say wetin this AI fit consider as spammer, is it because you no fit pass am or your writeups no dey organized or in words with wetin people dey discuss go make them take your post as spammer?

make i even tell you the truth, everybody for the forum dey suspected as spammer does this means that no is qualify enough to be a good quality poster? And about those people wey no post better thing and they pass CAPTCHA na dem the forum go now take as quality poster?

wetin you think say go dey possible to implement than just giving us a game to play while e dey delay our posting speed.

Right now the CAPTCHA is in beta testing, so it only shows a warning banner for likely spammers, but in 2 weeks everyone who fails the CAPTCHA will be immediately banned, so you'd better get used to it!


Above na our punishment if we fails to pass it for 2 weeks, una like am like this or na just April fool post be this.

make we yan here
Jump to: