Una good morning oooo my country people. I dey new for Bitcoin talk so I say I come hail una. Since I take come,I just dey take my time to study the forum.
Recently I just dey observe our local board, I con see d good work wey our people dey do for this forum and dem dey help well,well. Out of all the local board, na only this our own na e dey active pass for the forum and e dey jolly me for body. I even dey see the good work wey some people like
Satoshi princess,
Igebotz,
cryptopreneurbrainboss and some others dey do to dey help make sure say this board dey active and with good quality posts. I too go do my best to make sure say I still contribute to make our board better.
Actually, I just noticed say we never get moderator unlike other local boards Dem get. I know say our board still dey new and e never reach one year since Dem give us local board. But abeg make Dem still try add moderator for us abeg make e for reduce some kind ugly post for this our board although I know say we dey try grow am Sha.
Another thing again we I observe na e be d matter wey
cryptopreneurbrainboss still talk early this year about our subthreads and childboard. I really like the idea,e go make sense and go dey very important. If una observe well now, our local board just dey mixed up with different thread everywhere and everything just dey mixed up. If newbies come here, them go just confuse and no know watin Dem dey fine at all. According to cryptopreneurbrainboss and from my own observation,some important subthreads and childboard wey we go need for our local board go include.
1.introduction (about our local board, newbies, and some important thing wey Dem go need to know)
2.polities( governments, elections)3.our Economy (Naira,market,food,school)
4.security(news, security update)
5. Bitcoin Nigeria (cryptocurrency,trading,the market)
All these one go make sense at least for now because I noticed say almost all the post wey Dem don create for this our local board, dey revolve round these matters. So abeg watin una talk about this matter. I no know how possible e go dey abeg make Dem help us correct d disorderliness for our local board. Thank una once again abeg make una drop comment watin una think.