Author

Topic: How you take dey dodge Ekelebe and EFCC? (Read 166 times)

hero member
Activity: 1064
Merit: 501
February 09, 2023, 01:43:28 PM
#18
Em d very heartbreaking sae the people wey suppose to the safeguard our lives and properties don become the real enemy of our lives. If na before the moment you see a military personnel for road or for anywhere, you go get rest of mind sae you are protected. But nowadays if you as young guy see a military officer your mind go jump first because you no know the kind harassment wey dem go give you.

I no know the kind intuition wey EFCC people d get towards young guys. Does it mean their major work na to the go about the arrest young guys wey d fresh and em d do well. I no know kind of reasoning wey their Oga ontop d give them for young guys matter.

Em d very annoying and tiring sae, EFCC no the target our corrupt politicians again, na young young guys they are after.

Na God save us all for this country cos the level of evil wey this people that are meant to guide and protect us don commit against the youths no be wetin my mouth go fit talk
full member
Activity: 840
Merit: 137
February 08, 2023, 06:36:07 PM
#17
Omoh,,Op this particular topic sweet me I swear,because as I dey tell you,e dey like say anytime I see Ekelebe my heart dey beat for no reason.The rate at which those people dey do no dey sweet me at all.Just say you been look good,dem dey tag every fine boy wey dress well now a yahoo boy.
I know say e dey pain dem say young young boys dey drive  at an early age,when dem been no fit drivam untill dem reach the age wey dem don reach now.Anytime I see them,I dey always dolge or make attempts to, because I no wan pay careless money for bail.
full member
Activity: 560
Merit: 100
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 06, 2023, 03:28:03 AM
#16
This ekelebe matter sef don tire person, this men Dem are arm rubbers in uniforms, people dey live with fear now, mostly young guys, and e dey really pain me say Dem dey assume say every young looking fresh nigga na fraudster (Yahoo boy)

Na this same matter wey make Dem arrest me in year 2021, no allegation those men no put for my head that day, i try to explain my self Dem no hear oo, Dem say make we reach station before I go explain, I want try make calls Dem no gree, Dem drag phone from my hand, like play like play, na I reach station,I sleep there for three days until my people come bail me with 80k..

Nothing like how person dey take Dodge ekelebe and efcc oo, make we just dey pray say make God help us, because I know of many people wey go dey their house (vicinity), ekelebe go find Dem come arrest Dem for nothing, all just because Dem want money

legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
February 05, 2023, 08:29:41 AM
#15
2. Limit the way you move around
In addition to limiting the way you move around, you fit limit the way you dey waka still dey waka enter problem. As you limit your moving around, move around at reasonable hours. If you work remotely, and you stay in an environment where people leave their house to the office everyday except on weekends, it will be wise for you to avoid walking around or being seen on the streets during those regular office working hours to avoid been harrased by police men who are dubious and position themselves during those times to stop and harrass any young fellow that they see is looking okay.

Very accurate, also try dey commot eye for your body, dress in a way wey suit the environment you dey. If you dey stay where na mostly married people dey atleast get some decent senators wey you fit dey rock and e go bring some kind respect to your side. Personally I dun benefit from this and that's why I dey try get the least new wears anytime I get some extra funds wey just no dey useful. Your hairstyle na another thing to look at, believe me say nothing come out to dey dress over roughly.

As a young guy nothing bad to dress youthfully at some people but majority dey very responsible. We know say even though you do all this things  e no guarantee say dem no go worry you but atleast you go bypass some kind profiling and snitches wey dey around dey find who dem go put for trouble. Most of this bursting wey this guys dey go na information dey carry dem waka so if you wan avoid falling a victim, you gas use your sense for your environment.
sr. member
Activity: 392
Merit: 262
Lohamor Family
February 04, 2023, 04:00:28 PM
#14
Ekelebe don turn street hustlers,so tey den turn boys to their hustle. This na e make u need to use your head avoid everything wey go draw attention come your side. The truth be say yahoo boiz don cast everywhere,this na e make Ekelebe dey use that orientation dey give you charge say you be yahoo boy so that make them fit extort you. Sometimes you need to know your right and get back up just like as @Brainboss talk. I no dey fear Ekelebe because of wetin dem don do me,because of that I dey cain my lane and stay clean so that me and them no go cross part.
legendary
Activity: 1498
Merit: 1116
Top-tier crypto casino and sportsbook
February 04, 2023, 11:27:04 AM
#13
2. Limit the way you move around
In addition to limiting the way you move around, you fit limit the way you dey waka still dey waka enter problem. As you limit your moving around, move around at reasonable hours. If you work remotely, and you stay in an environment where people leave their house to the office everyday except on weekends, it will be wise for you to avoid walking around or being seen on the streets during those regular office working hours to avoid been harrased by police men who are dubious and position themselves during those times to stop and harrass any young fellow that they see is looking okay.

My approach, work around when people are moving and try not to dey waka when road dey empty and not busy, which includes avoid walking around during working hours if you work remotely and avoid night movements, because the Ekelebe wey jam you for night dey act differently from the one wey go jam you for day.
member
Activity: 308
Merit: 32
February 03, 2023, 05:39:21 AM
#12
This our country Ekelebe and Efcc wey Don turn to business man since, I swear their matter Don tire young boys oo, because how person go hustle to find waiting him go chop and still chance the person again? , and at last if they arrest you na billing they will give you say make you give them their own share, and na the first thing wey dey spoil Nigeria name be that(corruption), Nigerian forces go dey do any how maybe government no dey pay them salaries I don't know for them.
Brother no be small, them go just want make money out of every arrest so them go they waka dey find innocent person them go arrest,  last month them arrest one of my friend wey dey go em project defense, Omo dem carry am oo, say him na G-boy abeg abeg na 50k em pay that morning before dem release am say make em go do the project defense by then the project defense done end, so this men na brain you we gats carry dodge dem bcOs them see every good looking boy like say em dey do illegals and once dem arrest you na better money dem go out for ur head.
hero member
Activity: 1162
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
February 01, 2023, 05:54:49 PM
#11
Our country done hard sotey people wey suppose protect life and property done turn wahala give boys wey dey do their legit hustle through Tech and Crypto. Now for we country any young boy wey just day alright done turn Yahoo boy. Even those wey get their money through day to day hustle. E be like say this force men no wan use eye see young boy wey get money. For their mind young guys no fit get money the legal way.

I been day with my guys recently for the PH City where we say make we just connect after we done miss ourselves for a very long time na em we see Sienna bus wey just park. Next thing na em some men come dey harass us ooo. If no be say one person wey we follow make that waka him papa join the force, we for pay for wetting we no know. Na him day guy put call across before them shift commit for our side. This men done turn demon in human form for we country

No matter how careful you dey, those men go find you werin no good but e better say make you still dey careful. My suggestions to avoid these men harassment na as follows;
1. Avoid some late night movements (especially in group)
2. Limit the way you move around
3. No too show up for exorbitant lifestyle
4. If possible get physical business or job wey you go fit tell them say you dey do.
5. No associate too much with street people if you no follow
6. Importantly make you first dey innocent.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
January 29, 2023, 08:08:22 PM
#10
Our country done hard sotey people wey suppose protect life and property done turn wahala give boys wey dey do their legit hustle through Tech and Crypto. Now for we country any young boy wey just day alright done turn Yahoo boy. Even those wey get their money through day to day hustle. E be like say this force men no wan use eye see young boy wey get money. For their mind young guys no fit get money the legal way.

I been day with my guys recently for the PH City where we say make we just connect after we done miss ourselves for a very long time na em we see Sienna bus wey just park. Next thing na em some men come dey harass us ooo. If no be say one person wey we follow make that waka him papa join the force, we for pay for wetting we no know. Na him day guy put call across before them shift commit for our side. This men done turn demon in human form for we country

Bro... Everybody dey hustle ooo including our law enforcement agents, they just want to get money at all cost and dem no care weda you commit or not, as far u just look suspicious dem don pick you up. In my own opinion the ways we fit take avoid these bad eggs na: (1) Make we dey pray to God Almighty to order our steps and to protect us from this evil men. (2) Dress properly. There's a saying that the way you are dressed, so shall you be addressed. If you dress well and look sharp as e dey help promote your image say you dey responsible, no be to dey sag anyhow. (3) Avoid flamboyant lifestyle. Man gats enjoy himself, eat your money wey u hustle for but you no go dey spend anyhow because if this men see you dem go feel say na gee u dey do even if you your hustle dey legit. Because na gee boiz dey spend anyhow because dem no suffer to get their money. (4) Always be conscious of your environment.

First go get one lawyer number wey go fit help you if you into this people their mata then try know force person too. Fit be you ur friends people but atleast get one person wey you fit call and you on your own try coordinate yourself well wey he say this people no go fit just harass you anyhow.

Well said boss. E good to get good contacts wey fit come through for you when situation like this arises. I remember when I been get one issue like that sometime ago. I had to call someone who intervened for me and naso the mata end.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
January 29, 2023, 02:25:24 PM
#9
Our country done hard sotey people wey suppose protect life and property done turn wahala give boys wey dey do their legit hustle through Tech and Crypto. Now for we country any young boy wey just day alright done turn Yahoo boy. Even those wey get their money through day to day hustle. E be like say this force men no wan use eye see young boy wey get money. For their mind young guys no fit get money the legal way.

They aren't wrong for thinking that way because that's how the country was programmed. This old fools make am wey be say, before you fit stand as a young guy you supposed dey 30+ years. And by then your youthful years dun finish and na settle down you done dey reason so. If no be Internet, I no know where we for dey for this country. Others dey make am possible wey be say as a young guy before you even reach 20 you suppose dun d h get bread for yourself but our own no be so.

The only thing we fit do na to try dey equip ourselves with the necessary resources to help us in situations like this. First go get one lawyer number wey go fit help you if you into this people their mata then try know force person too. Fit be you ur friends people but atleast get one person wey you fit call and you on your own try coordinate yourself well wey he say this people no go fit just harass you anyhow.
member
Activity: 308
Merit: 32
January 29, 2023, 12:22:52 PM
#8
Omo na based on serious disguise, no too much show up, just dey normal dem no go reason your Mata, I dey keep my working phone for inside house , carry small phone go outside when I come back I continue anything I wan do , becos if you no do so them go carry you shine o, in other to dey on a safer side just disguise no show up,  but if you dey drive just carry drivers license with your complete papers that way dem no go too disturb you,  police once you just find them something them done free you be that , if you  dey drive make sure u carry small money follow body too.
sr. member
Activity: 742
Merit: 349
January 27, 2023, 03:55:59 PM
#7
This our country Ekelebe and Efcc wey Don turn to business man since, I swear their matter Don tire young boys oo, because how person go hustle to find waiting him go chop and still chance the person again? , and at last if they arrest you na billing they will give you say make you give them their own share, and na the first thing wey dey spoil Nigeria name be that(corruption), Nigerian forces go dey do any how maybe government no dey pay them salaries I don't know for them.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
January 27, 2023, 12:37:16 PM
#6
Do you need to dodge or hide from force men them?
I understand say, these men them get the kind wahala way follow them for body via say, them fit haras you at anytime and over anything but, I no see any reason why we need to dey dodge them. If your not a criminal, why you go dey hide yourself or live with fear of the force. Maybe na because I never get one on one encounter with them via crypto matter but, you should live your life just the way you want am and if your lifestyle attract wahala, you explain yourself the way you see fi out of the wahala or solve am. Every wahala is solvable. That no mean say make you carry yourself go fine wahala shah but, no point to hide when you never do anything wrong.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
January 26, 2023, 10:14:23 PM
#5
 This one nah serious issue to for this contri because the way we youth don make things be for this force men them eyes you go begin wonda if you suppose go out go hustle as a guy, ok imagine say everybody broke and we no con sabi operate any tech nah still them go dy yab us say make we the youth go find work do oh, but go somewhere like bank nah them go still say my Pikin help me with this thing abeg ma withdraw, that kind thing.

 Wetin I dy yan be say some of this force men no wan hear say you dy sell bread before you fit afford things wey you get, na we dy take our hand spoil things for us. Some of this force men no mind collect from us take survive that's after them arrest any youth oh, yahoo guys nah make us dy double check wetin we wear before we comot. E easy for girls Sha, to me oh.
hero member
Activity: 1176
Merit: 785
January 26, 2023, 05:28:50 PM
#4
My brother, this matter na one very big matter wey if we start to discuss, we no go comot here today oh, because on the general sense, the entire society don get this stupid ideology say if you be young guy, you try dey live well, get clean car say automatically you be yahoo boy. And if you come to run statistics, you go get to understand say majority of people wey dey always get that stupid ideology na people wey get zero knowledge about online opportunities. And all these police/Sars people all fall into that very category of persons.

So my advice to all of una my Naija brothers/sisters (most especially my P.H people) be say..
1. Make una try dey dress responsibly, because there is a popular saying that the way you dress is the way you shall be address.

2. Make una try to avoid clubs or bar for night, because even if you go go, abeg make eh no be always

3. Make you no too dey let people know say you get money, because even if you get, abeg no let your next door neighbour know oh, because at times na them go fit even set you up using those nonsense Sars/police men
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
January 26, 2023, 05:20:02 PM
#3
Everytime I read these kind stories my heart dey break because if you never experience am you nor go fit understand by just imagining it. Dem talk say dem don disband all these guys but that one na big lie. One suggestion be say, just avoid any kind thing we go draw unnecessary attention to you when you dey public place. E good to vibe and the rest of them but nor go overdo because even some of all these EFCC and Ekelebe na some of your guys wey dey work with them dey call them. After dem don extort money finish, dem go give them their cut.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
January 26, 2023, 04:03:35 PM
#2
My brother, na de matter new dey see so. These men Dem don turn into something else na God go help us for this country. Any young bobos wey just blo now don turn Yahoo boy so tey de harassment don dey become something wey we no fit control again. As e be say Dem no get orientation naim make Dem dey mumu like this. Dem no dey exposed to modern innovation at all even tech sef na war. School dem.no go so how Dem want to take get sense na. Wetin me I fit talk be say make the youth Dem dey careful these days because these guys Dem no get chills at all. Them fit frame you up for wetin  you no do say na wetin you nobody go unless you get strong hands for government. Na so e be now for Naija o.
sr. member
Activity: 1036
Merit: 311
January 26, 2023, 02:48:12 PM
#1

Jump to: