You no dey alone OP all this things hard me too when I first come btt, na the mind way I get to really sabi this bitcoin na keep me here if not I for nor fit stay. Them no dey know something finish when people correct you, take am. I tell one person yesterday or so say I nor understand his writing cause of the way he word am, after he edit the topic to something better, baba come my dm dey curse me lol. I come check him profile see say na our person sef. I just laugh because I know my people.
Wait, you mean this thing wey you talk now happen for this forum or outside the forum? If na this forum Omo the person don throwaway the opportunity to learn and become good. In short, even if na outside forum, him still lose guard because anybody wey mind to correct you na person wey like you and want to see you prosper. Na opportunity wey some people dey look for na that person just use him own hand spoil like that. And I dey sure say na newbie profile go do that kind thing. Anytime wey yup see such person dey enter push with his post, just throwaway your face and allow him to face the consequences. If na ban, make him chop because anyone who no like correction never ready to learn.
Omo,I used to struggle back days to write extensively on topics in school,I might have the idea thou but the writen interpretation used to be a lot,then I was introduced to the forum,I swear Initially i struggle to put any thing down.. gradually I see what people put down and am inspired,I started having the desire to learn this art of writing,I spend most times on post of others to learn one or two from them,and I can tell you Nigerians here are doing exceptionally well in terms of contribution to this forum and bitcoin at large
Over time I found out I could write with less stress than before,and my desire to also do research on random topics increased by some margin,which helped me alot in my closing phase in school and my work on my project topic.We have a great community in our hand in this forum and am glad to be part of it at this time.
It's all determination bro. Human mind is always open to new things unless you no want put body if not anything you can take your time to learn, you go definitely sabi am. Me sef and I believe majority of us here suffer from the same thing when we first come here but with dedication and determination, we dey move up gradually. The forum dey contribute to our intellectual growth on a daily basis as we educate and learn from each other here.