Author

Topic: I don reach the final decision (Read 185 times)

legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
July 13, 2023, 04:16:54 PM
#15
Na better decision you don take so oh, if you go do am as you don talk am, e go help you wella and you self go fit help other users too with wetin you don learn. As you don make this post so, many users go dey look your post history to see if you don change true true and if them go fit send you some merits, so no disappoint. Enter sections wey make sense for this forum, nothing good dey for bounties section, but no forget say you gats get patience oh, no rush am and in the end you go dey happy with the decision wey you don take.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
July 13, 2023, 04:08:57 PM
#14
Snip

So you could realized that posting on bounties has nothing to help one to develop from than bounties report, trolls and shitpostings that may be reagarded under the category of spam post also, the earlier the better, i want to congratulate you for such discovery and also wish other bounty hunters will learn to know what they are missing out from what they are doing, you could also discover maybe that's one of the reasons why you could found many spammers on the bounties section because they know nothing about bitcoin or even the bounties they are hunting around after.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
July 13, 2023, 03:46:07 PM
#13
OP you don really talk well but one thing na to talk and another na to act.  This talk wey you talk like this go need you to summon courage act accordingly because I believe say e get some bounty wey you dey do now wey don go far and as e be you go want to leave am and your mind go dey do you double double to continue but no relent on your decision.

Just like our senior man cryptopreneurbrainboss don talk, I for advice to follow am because him dey talk from him experience as e be say him don dey for the forum years before now and na man wey Sabi as things dey go on here. Just follow up and tidy your profile as him talk. I believe say you go do well
hero member
Activity: 1666
Merit: 709
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
July 13, 2023, 02:18:28 PM
#12
Good decision my brother it's better late than never, well to encourage you there have been members like you who had once been a bounty, hunter, spammer and something no one with positive mindset for the forum would be proud of, but guess what they succeeded in turning their story around and changing their ways, a good example is Ddmr Ddmr, according to him he used to be a bounty spammer but now he is amongst the top members of the forum.

I believe it's a good step for you and even though it takes time for you to actually see the results it would definitely show up.
hero member
Activity: 1036
Merit: 675
July 13, 2023, 02:04:09 PM
#11
No b small decision u dey try tak lik dis o nd I sure say, u go don see reason why u need quite dat part way b bounty nd focus on watin go mak d forum worth d time way u dey spend here.
Watin I go lik tell u b say, dat tin way b say don mak u decide say u go drop bounty 4 one side, mak u no 4get am last last. Try 2 dey luk watin dey ur front nd push on.

Abeg as bounties stuff full my activities, wetin I go do, make I leave am and carry on abi wetin una suggest.
I on try run tru 4 pages frm ur post history, ur bounty posts them no be watin to dry alarmed over as e dey shah. U ft leave am lik dat if u wnt or after dem doncoubt am finish, u giv am small time nd delete. Dat 1 stil sure too.
E no easy bt, u go try shah nd u go stil dey used 2 d settings.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
July 13, 2023, 10:47:51 AM
#10
Many of us started on a bounty way, like sae bounty na main thing for the board. Na with time when we come realize sae nothing wey d for bounty, make peso channel em energy to build em account than wasting em time in promoting project wey no go pay am or end up becoming a failed project.

See where most of us the today(hero, senior, and full member rank). That's the decision we made few months back and we are enjoying the fruit of our labor today. That's the power of decision and passion to be a good poster.

Em d okay as you come remove your mind and attention from where bounty d, to focus to build your account to be engaging in standard and helpful discussion for the forum. That one dey sha because no time wey peso wake up for the forum d too late for am. Where Mr. A reach, you go reach am someday with time. That's it, Trust the process and believe sae you go reach your desired rank.
member
Activity: 200
Merit: 27
July 12, 2023, 09:59:09 PM
#9
As of today, as I run through every reply on my post on my experience, a lesson to others (https://bitcointalksearch.org/topic/m.62309929) , I con realize say, true true I need build my profile to standard. So today, I don agree to focus on other boards and leaving bounties. As part of my decision, for naija board, I go be major player with standard and helpful discussion/posts. Na time to learn , grow and help others most especially our country people.

I also believe say, we fit grow this board to the point wey even people wey no be naija fit con see am as one of the best board for increasing their knowledge. The journey don start oooo,

Abeg as bounties stuff full my activities, wetin I go do, make I leave am and carry on abi wetin una suggest.
I greet you my brother,me I just dey come so I no too know how this bounties dey work but wetin I go advise be say do whatever you feel is right and whatever you think would make this our naija board grow don am.And remember say your knowledge no go fit waste as long as you dey use am education people for this board.
sr. member
Activity: 728
Merit: 354
July 12, 2023, 04:41:39 PM
#8
As of today, as I run through every reply on my post on my experience, a lesson to others (https://bitcointalksearch.org/topic/m.62309929) , I con realize say, true true I need build my profile to standard. So today, I don agree to focus on other boards and leaving bounties. As part of my decision, for naija board, I go be major player with standard and helpful discussion/posts. Na time to learn , grow and help others most especially our country people.

E good, as you don later decide to focus on your account  and learn alot of things, and e go better if you focus on that your decisions because me I don Sabi this your username tey tey, I dey surprised as I see am here. Ah been they think say you know be naija guy they I dey see your thread for the forum. So I as I see am here e clear for you, However seriously if you live bounty e go better because me I don see am say people they wey hunt bounty more than you do and Las Las nothing come out. Some of them activity full there profile without merits and some even get the merits but because na bounty they there front they didn't focus on building the account Las Las they con live bounty con focus and now they don they where them they flexing there life.

Quote
I also believe say, we fit grow this board to the point wey even people wey no be naija fit con see am as one of the best board for increasing their knowledge. The journey don start oooo,

Yes oh, the way our board they go now. E make sense there is not much something that is not meaningful all I'm seeing in the board na bitcoin and other cryptocurrencies related discussions and I believe na wetin go make our board among the best boards in the forum bedat, I go like am make we no dey full the board with naija news, because the people wey we dey bring there matter con discuss for here don make. So for that make we live there matter and focus on wetin carry us come here so that we go learn much and other people go come learn from our board top.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
July 11, 2023, 05:06:24 PM
#7
I also believe say, we fit grow this board to the point wey even people wey no be naija fit con see am as one of the best board for increasing their knowledge. The journey don start oooo,

Abeg as bounties stuff full my activities, wetin I go do, make I leave am and carry on abi wetin una suggest.

I just look through your profile e belike some bounties related things still dey, make e no surprise you but I was once a bounty hunter. Infact I been dey promote airdrops dem for the forum as post, the first first time wey I begin write here. Na advice wey people give me wey make me focus attention on growing my account and today I dey where i dey so and to grown am self dun tayah me so I just relax small. I sabi your profile since and I like am as you dun leave bounty to focus on where better choppings fit come out. Bounty no bad entirely but make I give you wan secret always delete your reports and application after stakes are updated for that week or campaign has ended.

Always keep your profile clean, plenty merit wey I get wen I just dey start to dey grow my account come from reviews and I no request for am self because back then request for review wasn't a thing. As people see me say I dey try dem go look my profile and na so I use dey get merits wey I no plan for self. Keep your posting record clean and change your boards of writing. E get some boards wey be say na waste of time to write because merits no dey flow there or better merits fit no come out like Altcoins and gambling board. Put your work for everybody face as person wey face hide here no dey get any reward.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 11, 2023, 02:22:59 PM
#6
Well thank God say you don come to yours normal senses onto say you don decide to leave bounty and focused to be more fruitful to the community than putting efforts on the bounty hunting.

Actually nothing is wrong enrolling urself with bounties but it doesn't pay that much anymore unlike before back then 2017 I believe and is been a long time I focused on partaking in such activities anymore.

Then back to your post history, I don't think you should delete them because I believe they are there for a reason because you would also likely to share your experience in time to come with other beginners while giving them advise just as we have been doing so far. If there are reflection you would tell them to take a look at your profile maybe they would learn new things from your profile. However those people who started before now some of them where bounty hunters then upgraded themselves to be more productive and useful to the forum.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
July 11, 2023, 02:56:13 AM
#5
OP, I am very happy on this decision of yours to put a stop on bounty and face the important purpose why the forum was created. Bounty is like you are chasing peanuts when you can just be patient to build up your account and yourself in the forum. From my own view,I can see that you only have ten merits...if you can abandon your account and register a new one to start learning with. This will be better because I guess that your account has been noticed by reputable and generous merit givers in the forum,this might slow your quick growth in the forum. Like you said,you have been here for a while a would be able to earn for merit easily if you register a new account. Just my own suggestion.

E no even matter say OP dey run bounty package, if him still dey put eyes for the main thing which for bitcoin yarns and make good contributions to the forum, him go still collect but if him no still feel comfortable as those bounty stuff dey him account, make him delete them but no be to go open new account because of that.

You fit delete those bounty stuff if bounty no dey help you. I know say for now nothing dey inside doing bounty now except those wey dey pay with usdt or listed coins wey dey come once in a while. However, e go pay you more if you leave bounty area.
hero member
Activity: 658
Merit: 562
July 11, 2023, 01:32:40 AM
#4
OP, I am very happy on this decision of yours to put a stop on bounty and face the important purpose why the forum was created. Bounty is like you are chasing peanuts when you can just be patient to build up your account and yourself in the forum. From my own view,I can see that you only have ten merits...if you can abandon your account and register a new one to start learning with. This will be better because I guess that your account has been noticed by reputable and generous merit givers in the forum,this might slow your quick growth in the forum. Like you said,you have been here for a while a would be able to earn for merit easily if you register a new account. Just my own suggestion.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 10, 2023, 05:44:56 PM
#3
Action speaks better than voice/talking.

You can delete some of your bounty threads if you are uncomfortable with them now that you have entirely turned your attention away from bounty.
If you start to have good posts that are worth to be given merits, your past posts will not be a reason you will not be given the merit. But as Hyphen(-) posted already, if you feel uncomfortable with it, you can delete the useless ones.
hero member
Activity: 1022
Merit: 744
July 10, 2023, 05:31:55 PM
#2
I'm happy for you because I see you becoming a serious and active user on other boards, especially the Naija local board, since you realize that bounties are a waste of time.

First and foremost, I'd want to congratulate you on achieving member rank in this fantastic forum. I hope this serves as encouragement for you to continue improving yourself as well as learning and contributing to the forum as a whole.

You can delete some of your bounty threads if you are uncomfortable with them now that you have entirely turned your attention away from bounty.
member
Activity: 388
Merit: 30
Reward: 10M Sheen (Approx. 5000 BNB) Bounty
July 10, 2023, 05:15:02 PM
#1

Jump to: