Author

Topic: I'm I supposed to pay? (Read 147 times)

sr. member
Activity: 644
Merit: 262
January 28, 2024, 05:38:02 PM
#6
so my question is this, I'm  I supposed to pay such debt?
Simple answer; Yes. You supposed to pay the loan as nah your name dey and profile dey for the loan way your scammers/theif collect so on an interpersonal business level in no concern Opay whether nah you personally take the laon or not. My advice be say just find ways take pay the loan and try dey careful next time not to repeat your mistake.

Another matta, nah how you just the nack poats wey concern we country and nah the bad side you just the throw inside the house, this community no be only we Naija dey here, so try school yourself with crypto resource way go fit help you the engage mostly in the real matters wey bring us com inside this forum which is bitcoin. This pattern you the use no go grow you for this forum oh. Na just advise I dey cap you.
sr. member
Activity: 770
Merit: 445
January 28, 2024, 03:50:55 PM
#5
Dis forum no be only naija people dey here, and other people from other local boards dey monitor our activities for here, plenty people wey come from other countries go dey monitor our post for here, e no go come make sense say Wetin dem dey see wey we dey post no really make sense, make we try dey post about bitcoin or cryptocurrency generally, if you dey seek for opinion about things wey no dey related to bitcoin or cryptocurrency, then make u no carry am come forum here.

E go make sense make u just go back person wey carry u come dis forum make him explain how things dey work for here, if you wan rank up, make u take ur time learn about bitcoin, all dis posts wey u dey create no go really give u merit.

I'm  I supposed to pay such debt?
Make I Answer d question wey u ask for here. Am really sorry for ur loss, but u no get choice ooo, u go pay that money, how Opay go take know say no be u request for d loan? na u make mistake, as dem steal your phone and ur pos terminal, d first thing wey u go do na to block ur account, if to say u don do that, u for no create this thread because dey no go fit access your account.
member
Activity: 116
Merit: 11
January 28, 2024, 02:54:13 PM
#4
Hey buddy!

I'm supposed to read this thread and see the content of your post but I will not because you're spamming the local board with lots of off topics/ threads.
I'm supposed to send you a PM on behave of the forum [senior colleagues] to correct you but on how to post but I will have to copy and paste this message to all the threads which you just created today for you to understand the gravity of your spam.

Here is a link https://bitcointalksearch.org/topic/newbies-read-before-posting-1689727 to a thread you must read before posting and I suppose say person wey carry you come this forum no tell you about the thread make you read and understand am first before you make post.

Another link dey here [ https://learnmeabitcoin.com/ ] for you to go to that website and learn about Bitcoin because na the original thing wey carry everybody come here no be country matter as you dey post Everytime.
Correction noted
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
January 28, 2024, 10:10:52 AM
#3
Hey buddy!

I'm supposed to read this thread and see the content of your post but I will not because you're spamming the local board with lots of off topics/ threads.
I'm supposed to send you a PM on behave of the forum [senior colleagues] to correct you but on how to post but I will have to copy and paste this message to all the threads which you just created today for you to understand the gravity of your spam.

Here is a link https://bitcointalksearch.org/topic/newbies-read-before-posting-1689727 to a thread you must read before posting and I suppose say person wey carry you come this forum no tell you about the thread make you read and understand am first before you make post.

Another link dey here [ https://learnmeabitcoin.com/ ] for you to go to that website and learn about Bitcoin because na the original thing wey carry everybody come here no be country matter as you dey post Everytime.

Thank you very much bro, because wattin the op do no make sense at all. We support active posters for this local board oo, but make the thread creation no be the way you make these ones now. How only you go drop 4 thread within 2 to 3 minutes difference e no make sense na. Abeg make you reduce you pressure and save it for another time. And the worse part na be say the threads them wey you create all of them na off topic, try make you because quality thing about Bitcoin, and from there merit go come. Merit dey hardly come all these kind of off topic Dem. Nangiconference Abeg make you help secure the reputation of the board by avoiding off topics abeg.
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 28, 2024, 09:51:29 AM
#2
Hey buddy!

I'm supposed to read this thread and see the content of your post but I will not because you're spamming the local board with lots of off topics/ threads.
I'm supposed to send you a PM on behave of the forum [senior colleagues] to correct you but on how to post but I will have to copy and paste this message to all the threads which you just created today for you to understand the gravity of your spam.

Here is a link https://bitcointalksearch.org/topic/newbies-read-before-posting-1689727 to a thread you must read before posting and I suppose say person wey carry you come this forum no tell you about the thread make you read and understand am first before you make post.

Another link dey here [ https://learnmeabitcoin.com/ ] for you to go to that website and learn about Bitcoin because na the original thing wey carry everybody come here no be country matter as you dey post Everytime.
member
Activity: 116
Merit: 11
January 28, 2024, 09:37:00 AM
#1
As the cases of fraud are on the increase in Nigeria I am not left at as a victim. Sometime ago my phone was stolen with my opay  POS terminal and out of ignorance I couldn't help myself in blocking their account therefore my account was compromised my funds wiped off and moreso a loan was processed on the account which was approved to them and immediately withdrawn before I could block the account when I contacted opay I was made to understand the activities on my account.
some requirements were to be presented which warranted me to go and get a police report, a court affidavit and other documents to support my claim hoping that the loan will be cancelled and offset from my account and  may be I might be awarded a new pos  terminal for a subsidize price to my greatest  surprise, I was asked to pay a huge amount of money I didn't eat or enjoy having loosed my property like laptop, phone and POS terminal including my own personal funds was compelled to pay a loan I did not take who asked them to provide loan quickly? after my own property and money was missing. Mind you. I am an agent who has been working for opay, for every transaction I run, there is a percentage that opay charge.
so my question is this, I'm  I supposed to pay such debt?
Jump to: