Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
Make we talk true, people fit dey spend bitcoin for other countries, just the way dem dey spend their normal paper money but I just dey reason how that kind thing fit Happen for Nigeria, because people wey no sabi about bitcoin still plenty ooo, see the high level of illiteracy in this country, na just young guys wey dey come up and dem dey educated sabi bitcoin, and some of them go just tell you say dem dey hear about bitcoin but dey no get interest, but some wey get interest self immediately dey hear say na money you go use start am, they go just free am because person wey never see money chop go invest in bitcoin.
I enter some villages for my side, I fit talk say 99% of people wey dey all those villages wey I go no even sabi wetin bitcoin be, dey no even get stable electricity, very poor internet connection, No education, everything wey dem dey do no pass farming, if you tell those people about bitcoin, they go think say you just wan scam them self. Na why I dey reason say e no go easy make we dey use bitcoin for transactions in Nigeria, e fit even dey happen for urban areas, but u see our rural areas, we get work to do for that side.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?
Seriously e go dey fun ooo, but I know say e fit dey possible to dey pay Nepa bills, House rent with bitcoin, but you see that transport bill, e go hard small make we dey honest. Na Lagos conductor(abero) you wan talk say e go accept bitcoin as payment, those once no go even listen to you, you enter car without change self na problem for u, not to even talk say u wan tell them say na bitcoin u wan pay with.