This your request no go possible as we no get the authority to pinned post for the local board. The board just dey start and na small small we go get everything wey other boards dem get. This your thread no bad and if we dey get them once once for the board to remind people of the disadvantage of KYC e no go bad. KYC na one issue wey the forum dey speak against on a steady and e no good since you're basically selling your identity whenever you do such. KYC get more disadvantages than advantage but platforms wey dey request for this sensitive information go tell you that one.
The platforms go dey tell you say your information dey safe with them but na scope as dey just wan make you trust them to give them those information. After you dun give them, so many things can be done with that information. Them fit sell am themselves or claim their platforms was hacked so you no go hold dem responsible when you see your details dey sell for black market. Many cryptocurency platform today needs KYC to access their service but they're not the only platforms you can use as we get better alternative platforms wey plenty for the internet.
Also I fit dey post about Kyc every 2-3 months by this way people go still see why they nor suppose dey do kyc for every platform