Author

Topic: Increase in inflation (Read 95 times)

sr. member
Activity: 602
Merit: 291
Bitcoin in Niger State💯
May 31, 2024, 04:40:14 PM
#8
I never see a government that preparing a country economy to be good without a good plan so lay down the plan. Nigerian economy now is hopeless. For now we go suffer until this Tinubu government go pass because they can't do anything to make the economy good. If the policies were good by now the inflation would have come down but the policies are not good so everything just dey rise. Garri wey we think say e no go go up because na local product but nai come worst pass.

We no wan accept reality for Nigeria and as much as we no wan gree accept say the economy of the country or the situation wey d country they pass Tinubu or Tinubu administration, na something wey don rotten for too long and we sef get hand inside the reason why E rot reach so. But wetin I go talk be say, na we go still correct am. From our own behavior and our own actions.

We no they happy as things they go like this because e no really go well, and even d democracy wey we they try emulate no they really help our matter. Left to me o. Make them forget about this democracy make them go back to Monarch.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
May 24, 2024, 11:16:31 PM
#7
What I don't really get is that after all this their vindictive  acts against cryptos, let's  assume they eventually get rid of crypto (on a scale of 75% which is perfect) in Nija (just assuption) will everything comeback to normal or we will open another phase with new episodes?? because  I know things cannot go back to the way they used to be , which Is why it's  better to focus on not getting it worsen...
The honest truth be say, things nor go fit go back to normal at all. As a tin of peak milk now be N700, e nor go fit go back to N200 wey I ben dey buy am before. Or even small bread wey be N150 before and now come be N400. Satchet water nko? I no think say water go fit go back N10 from the N50 wey e be now. For our country, what goes up doesn't not come down. Na to climb up go meet wetin don go up.

Shall in economic terms, things go fit go down once our fuel price reduce and them fix roads and security. Once them fit do this one, shikena, we don solve 95% of our own problem. Even if them still dey tiff-tiff our money.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
May 24, 2024, 10:47:15 PM
#6
I never see a government that preparing a country economy to be good without a good plan so lay down the plan. Nigerian economy now is hopeless. For now we go suffer until this Tinubu government go pass because they can't do anything to make the economy good. If the policies were good by now the inflation would have come down but the policies are not good so everything just dey rise. Garri wey we think say e no go go up because na local product but nai come worst pass.

Me I know say the government dey do things to favour the businessmen and not to the citizens so inflation will not reduce because the businessmen only make profit very well when there is an inflation. I just pray dat make Tinubu no win did next election.

I agree with totally but you see this country, for me I no really blame our president o, for me, I don see say e dey really try e best but the problem na we wey the individuals na e dey mostly cause this thing o, before they been dey talk say na dollar na e be the cause but now dollar wey dollar don come down, price of things still dey high.

You no dey wonder why some people dey sell things lesser price while some dey sell costly wey be say na still the product wey them dey buy, well our president get e own part to play but make we also play our own part too, make we try dey in unity and dey help each other too, make e remain say our president no play e part.
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
May 24, 2024, 06:51:55 AM
#5
E really dey important for these our governments and their official, both those wey them employ fully and those wey dey work with them per time to know say crypto currency (Bitcoin) done really help this our country well well, because many Nigerians done use this crypto currency tin take achieve many things for life (house, cars and some important things). Some persons for this country nah crypto trader, some nah marchant for exchanges, and some nah crypto investors. No matter any coin wey dey inside the crypto space all of them dey very important because if 1 no work out well for John, e go workout well for James. This our governments suppose to get this one straight, if to say Bitcoin dey centralize, watin dey happen for most exchanges for still dey happen to Bitcoin because as many pipo dey use am, the government go condition everybody say them go start to dey pay tax for every profits wey person make from crypto (this our governments funny sha).
IMO, the inflation go continue to dey increase if better government no take over, and for us to see better person wey go fit do well like the ones wey been manage better as of then, then the country go better small. But make we no also doubt am say the naija done almost spoil finish sha.

If no be cryptocurrency waiting some of us go dey chop by now? If no be crypto I believe say naija go even worst than this. I believe say if no be cryptocurrency a lot of scammers go full this country because nobody go sit down say him mate dey make money to dey survive and be claiming holy for house with hunger. How I wish say our governments go realize say na because of crypto some bad bad things take reduced for this country. Na through this crypto trading some of our youths take dey feed their families and our governments always shout up and down just to end everything related to crypto trading in the country. They just want to put sand for our garri and I believe say them no fit succeed for this one.

You forgot say na naija you dey? I no believe say we go get another better government for this country again. Even though we get better government where the person go take start from? After all the damages wey this bad governments don cause. Make we no expect say the country go better in this Tinubu regime, even the person after him nothing go still change because they are all the same to me. Even the current president we don't know if na better person we choose so because over one year now inflation just dey increase, but the reason why me I no fit blame am be say the country don already spoiled in the hand of our former president.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
May 24, 2024, 05:44:46 AM
#4
I never see a government that preparing a country economy to be good without a good plan so lay down the plan. Nigerian economy now is hopeless. For now we go suffer until this Tinubu government go pass because they can't do anything to make the economy good. If the policies were good by now the inflation would have come down but the policies are not good so everything just dey rise. Garri wey we think say e no go go up because na local product but nai come worst pass.

Me I know say the government dey do things to favour the businessmen and not to the citizens so inflation will not reduce because the businessmen only make profit very well when there is an inflation. I just pray dat make Tinubu no win did next election.
full member
Activity: 182
Merit: 131
RATING:⭐⭐⭐⭐⭐
May 23, 2024, 12:53:33 PM
#3
[Out]
E really dey important for these our governments and their official, both those wey them employ fully and those wey dey work with them per time to know say crypto currency (Bitcoin) done really help this our country well well, because many Nigerians done use this crypto currency tin take achieve many things for life (house, cars and some important things). Some persons for this country nah crypto trader, some nah marchant for exchanges, and some nah crypto investors. No matter any coin wey dey inside the crypto space all of them dey very important because if 1 no work out well for John, e go workout well for James. This our governments suppose to get this one straight, if to say Bitcoin dey centralize, watin dey happen for most exchanges for still dey happen to Bitcoin because as many pipo dey use am, the government go condition everybody say them go start to dey pay tax for every profits wey person make from crypto (this our governments funny sha).
IMO, the inflation go continue to dey increase if better government no take over, and for us to see better person wey go fit do well like the ones wey been manage better as of then, then the country go better small. But make we no also doubt am say the naija done almost spoil finish sha.
You supposed know by now say our government no really carry our betterment for mind as them dey claim, you never notice say anything wey citizens dey put hand wey dey work out for them, they bring them money, and e reach government ear, instead of to support the thing make e for help even more people to alleviate poverty for the country, them go start to investigate the thing, dey find one way or the other to carry accuse or do things wey go make am crash.

The reason government and CBN dey really dey attack bitcoin and crypto at large no be say na for our own interest, if you look their approach alone, you go observe say na their own personal selfish interest.
Just take for instance as government dey ask binance to release the list of Nigerians wey dey trade via binance, wetin you feel say them wan use the list do if no be to use am attack them? If no be to pour sand sand for their garri?

The government already know say, if all the citizens gain financial freedom, e go hard before them go fit control us again, because na money be right, when you get money you go know your right, so the more poor person dey, the more easier e dey for them to fit put the person for pocket, government and politicians them dey wicked and devilish, that's why when good thing dey reach us like this, them don fyn ways to spoil am, if not, wetin exactly crypto do them, wey them wan spoil am? Wey be say if them even embrace am, the thing fit even helps to solve plenty problems we get for. We country today.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
May 22, 2024, 05:51:18 PM
#2
[Out]
E really dey important for these our governments and their official, both those wey them employ fully and those wey dey work with them per time to know say crypto currency (Bitcoin) done really help this our country well well, because many Nigerians done use this crypto currency tin take achieve many things for life (house, cars and some important things). Some persons for this country nah crypto trader, some nah marchant for exchanges, and some nah crypto investors. No matter any coin wey dey inside the crypto space all of them dey very important because if 1 no work out well for John, e go workout well for James. This our governments suppose to get this one straight, if to say Bitcoin dey centralize, watin dey happen for most exchanges for still dey happen to Bitcoin because as many pipo dey use am, the government go condition everybody say them go start to dey pay tax for every profits wey person make from crypto (this our governments funny sha).
IMO, the inflation go continue to dey increase if better government no take over, and for us to see better person wey go fit do well like the ones wey been manage better as of then, then the country go better small. But make we no also doubt am say the naija done almost spoil finish sha.
sr. member
Activity: 476
Merit: 299
Learning never stops!
May 22, 2024, 05:23:11 PM
#1
Inflation  has been gaining upper hand recently in the country's economy with no measures to counter it .
Following the increase in price of good and service from 2023, 2024 seem to be more worsen than the previous leaving  Inflation at its peak while our government continues  playing an enemy role in the world of crypto and blindly going after exchanges  Tongue..
Here's a recent chart of inflation rate directly from CBN website

refs

Source
Food Year on Change recently hit 40 maybe more now...

Jump to: