Pages:
Author

Topic: Info-thread: Translation of Useful English topics to Pidgin {mix images} (Read 1762 times)

legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
Thank you dear Sokani as you translate one more of my topic! Great job! Dis way more and more pipo go dey aware of de struggles of de poor Julian Assange.

Dis theme na dedication to Cypherpunk, to freedom of journalism, and at de same time, de material try to bring out de unjust justice wey Asange bin face. And all dis because he want talk de truth, de whole truth and nothing but de truth.

Similar to Ross Ulbricht, US government bin hold Asange as an example. At de same time, none of de oda journalist wey cooperate with am face similar allegations. No New York Times journalist wey secret agencies don ever persecute. No Der Spiegel journalist wey US don accuse of spying. No Guardian journalist wey dem don hunt. And all dis na de biggest names for de press wey collaborate with Asange. Instead dem bin hold am as role model.

We go only fit hope say him go dey finally free again...
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Translated Topic in Pidgin Language: De call for Julian Assange || De WikiLeaks Manifesto - Make all of us read am
Original Topic: The call for Julian Assange || The WikiLeaks Manifesto - We all should read it
Author: GazetaBitcoin




Maybe plenti pipo don hear about de name Julian Assange, but na only few persons know who him be, wetin him do and wetin him dey do now. From dis, na only few person who know why him be emblematic figure for de crypto space.

Dis topic na call for help, na him make I post am for the beginners and Help board. Na call to help Julian!

I bin don plan to write about dis topic for sometime, but for some reasons (de most important be say I no get time) delay am. However, another recent discrediting of de press (in one way or de other) come make me to write dis thread. Though de reason behind dis dey less important. Wetin dey important be say Julian need help!



De last sentence for dis topic na cautionary tale: "Make all of us continue Cypherpunks' work and dey fight for freedom!"

De Cypherpunks group bin emerge initially for 1992 from Eric Hughes, de author of "The Cypherpunk Manifesto", John Gilmore and Timothy May, de author of "The Crypto Anarchist Manifesto". From one former meeting for Gilmore office, dem come create one mailing list, under de name of Cypherpunks mailing list.

During dat time, odas join Cypherpunks fight against de state as dem dey surveil de citizen. De number persons bin reach more dan 1000 contributors.

Julian Assange bin dey part of de group between 1995 and 2002. Him get brilliant mind wey odas bin observe. If May, Hughes or Gilmore bin focus more on "algorithms for people", for digital cash and for public access to cryptography (for de era wey NSA bin dey fight wit all their power against dis), Assange bin get different principle: “Freedom of information na respected liberal value."

The WikiLeaks Manifesto, one document less known, unfortunately, e contain oda words of wisdom from Julian: "Only reveal injustice person fit answer; for one man to do anything thing intelligent him suppose know wetin dey go on."

As Gutenberg printing press bin surface for 1448, wey come lead to Printing Revolution, elite power over classified documents come dey reduce constantly. Dis na one of de first form of information decentralization. Julian Assange take am to a whole new level.

And dis one happen after de launch of Wikileaks, in 2006.

"I grow wit de understanding say de world wey I live na one wey people dey enjoy some kind of freedom to communicate wit each oda in privacy, without pipo to dey monitor am, without pipo to dey look into or analyze am or judge by some shadowy figures or systems any time they talk anything wey dey travel through public line." - Edward Snowden

I dey reason de same way as Snowden, and even more: I dey try to help am by recommending where him go fit settle and where him no fit settle for him new life after him betray de govern; Assange published thousands of classified information from all parts of de world.

Him connection to Bitcoin?, Some fit as.

After US govern bin come initiate a financial blockage of WikiLeaks accounts, Julian come realized de potential of Bitcoin and come dey reason to accept de new cryptocurrency as a way for donation. De idea bin put BitcoinTalk on flames dat time:

"Bring am come", as RHorning bin emphasize.

However, Asange continue, ""Satoshi Nakamoto", de pseudonymous inventor of Bitcoin, bin respond: "No, no "bring am come." De project need to grow gradually so dat de software fit get strength along de way. I don appeal to WikiLeaks make dem no try to use bitcoin. Bitcoin na small beta community wey dey very young. You no go get any beta thing oda dan pocket change, and de heat wey you go bring go likely destroy us at dis stage."[...] Six days later, for 12 December 2012, Satoshi come famously disappear from de Bitcoin community, after him post dis message: "e for dey nice to get dis kind attention for any oda context, WikiLeaks don kick de hornet net and de swarms dey come towards our direction.""

As a deep sign of respect for Satoshi and for him work, as Asange bin talk (for de previous mentioned link), "WikiLeaks bin read and agree with Satoshi analysis, and come decide to stop de launch of bitcoin donation channel until de currency don dey more established. WikiLeaks later launch their bitcoin donation address after de currency major boom, for 14 June 2011."

A sign for respect wey na rara avis nowadays.

Julian rely on Bitcoin certainly no only help WikiLeaks: e also help make Bitcoin to dey popular; e raise awareness about Satoshi creation; e bring more and more people to de path wey Satoshi open.

Wetin happen next dey well known dan de above mentioned history. US government start to dey hunt Assange for 2011, and in response, Julian come manage to help himself by seeking asylum for de Ecuadorial embassy for London. Dem come grant him request for 2012. However, him stay for de embassy bin no dey easy - among many oda things, him bin no step outside de embassy until 2019(!), him bin dey live almost like an inmate. Between fabricated accusation of sexual harassment, wey dem drop after years by the Swedish govern, and him continue work for WikiLeaks, Asange also try to keep his moral and do him best to avoid extradition to the US, as him dey aware say if dem carry go there na death penalty or at least 175 years behind bars.

Unfortunately, for 2019 Ecuador come end him asylum, for reasons wey dey more or less ridiculous, but e dey almost clear say dem force de decision somehow by oda secret agencies or by oda governs.

As I dey write dis thread, Julian trial for extradition don start. During de trial, him dey stay for prison.

As I bin talk recently, for one of my previous topic,

De fight for freedom of speech, for privacy and to dey render governs irrelevant start long long time ago. Now e dey our hands.

E dey our hands also to help Julian. And to help am mean to help freedom of information!

I no go talk how to offer dis help, I dey sure say everybody know, or atleast, get small intuition about am.

Time dey for debate and time dey for action. Now debating time don pass.



Issues to note:

I also recommend make una read de following:
- Nils Melzer's The Trial of Julian Assange: A Story of Persecution - The shocking story of de legal persecution of Wikileaks founder Julian Assange and The dangerous implications for The whistleblowers of The future
- Robert Manne's piece of art The Cypherpunk Revolutionary Julian Assange
- The Most Dangerous Man In The World: The Inside Story On Julian Assange And WikiLeaks, written by Andrew Fowler
- Cypherpunks: Freedom and the Future of the Internet, by Julian Assange. De book na discussion between Julian, Jacob Appelbaum (Tor developer) and Jérémie Zimmermann (co-founder of La Quadrature du Net)
- Underground, by Suelette Dreyfus & Julian Assange. Na fascinating book about de rise of Australian hackers and phreakers from 1980s, including de early activity of Julian Assange, which by dat time dem bin know am as Mendax.
- When Google Met WikiLeaks, by Julian Assange
- The Unauthorised Autobiography, by Julian Assange.

Besides de following movies dey parts of a most watch category:

Ithaka - na documentary wey show Julian struggle to avoid extradition to de US
Na WikiLeaks very own documentary - full movie
Risks - Na WikiLeaks documentary, directed by Laura Poitras (a friend of Julian Assange) - full movie
The Fifth Estate - Na great movie about WikiLeaks
We Steal Secrets: The Story of WikiLeaks - Na yet another documentary about WikiLeaks
Underground: The Julian Assange Story - Na another movie about Julian, wey describe him early career.
sr. member
Activity: 490
Merit: 311
Play Bitcoin PVP Prediction Game
Translated Topic in Pidgin Language; Bitcoin securiti and safeti
Original Topic: Bitcoin security and safety
Author: Charles-Tim


Bitcoin, na digital currency wey get better value and na also asset wey don dey popular all over di world, na di first currency wey dey fulfill the purpose of money, wey be privacy. Some companies dey, wey dey offer custodial services (controlling services) to dey help you manage or hold your bitcoin,but di company go cor get full control of your bitcoin, while you go fit end di purpose sha. Dem create bitcoin normally, somehow wey go make people wey get bitcoin to hold bitcoin themselves by using noncustodian wallet (wallet wey no body dey control) and dem they use m store di private keys way get access to di bitcoin way dem keep on di blockchain. Bcos of dis, need dey for us to take care of our bitcoin bcos na we dey manage m ourselves without any other person so that we go get full control over m. But, we need to dey careful and protect our bitcoin and bitcoin wallets from thief and also make we nor lack safe means of good protection.


Ways wey bitcoin fit tel lost
Although, to send bitcoin to wrong address, purposely sending bitcoin to scammers before person cor know say na scam, when person use fake custodian exchange (exchange way another person dey control), Although, stealing bitcoin through di virus wey di wallet, fake giveaways, cloud mining services and many other ways way person fit become victim of scammers and for there lost bitcoin, dis na why we need to dey careful of scammers and scam sites and to dey always avoid them. For dis case di bitcoin nor lost in any ways wey go make m dey permanently inaccessible but na ways wey scammers fit tel theft m. Ways dey by which person fit lost bitcoin and the bitcoin nor go cor dey accessible again and na dey discuss below.

Inaccessible lost bitcoin
Some people dey in di past wey might think say bitcoin price dey low at dat time and so nor believe say e go rise or base on some other reasons, so they lost access to their private key, and they nor cor fit access their bitcoin on blockchain, dis go fit be as a result of say them encrypt their bitcoin wallet file and so they nor fit decrypt m again, damaged or inaccessible bitcoin storage devices, corrupt backup files, forgetting seed phrase or private key. Also forgetting passphrase (password) wey go cor make you nor fit spend your bitcoin go fit be di result of lost bitcoin. Another reason way go fit cause inaccessible bitcoin na when person nor fit make payment with bitcoin to another person and none of them cor get access to m ( dat is, e hang for air).

Securiti practices
For you to protect your wallet, many security practices dey wey you must follow, some people go download online/hot wallets for the purpose of using bitcoin, but di private key of online wallets dey connected online, dat na why those custodian exchanges (exchanges wey dey help person hold their bitcoin) and dey use online storage dey often dey hack, dis one go only fit good to dey save small amount of bitcoin. For inside the online wallets, Web wallets na dey most easy to hack follow by mobile wallets while desktop wallets be good sha but na still online wallet and should be used to store small amount of bitcoin.
Cold wallets na di safest, private key dey store offline. Dat na why, they be di most recommended wallet for person, example na di airgapped wallet and di paper wallets, they fit dey hard to use but them dey very safe. Bcos of how e tel hard to use airgapped and paper wallet, especially for everyday bitcoin transaction, some companies cor create hardware wallets wey be cold wallets but cor easy to use for dis purpose. Cold wallets dey recommended for long-term storage and to store large amount of bitcoin bcos na them be the safest to use. Another wallet wey dey worthy to be mentioned na the multisig wallet wey dey safe to use also. Lastly na di noncustodial two factor authentication (2fa) wallets, but the transaction fee for multisig and 2fa wallets dey high but likely fit become low in multisig wallet if taproot dey implemented in which any wallet wey dey support taproot go dey able to carry out transactions with normal fee.

No wallet dey 100% safe, you yourself go make m 100% safe
Normally, no wallet dey 100% safe, for example, some people dey make use of their device tel visit any site wey them like, they fit possibly enter sites wey go install virus on their devices, wey go cor make di virus fit thief information wey them fit use tel access di wallet on di device on another device wey fit lead to bitcoin loss or wallet hijack. Dat na why need dey to visit URL and di URL go be link to a safe and legit website instead of using search engines like google wey go fit bring up phishing ads. Also some people go dey use playstore tel go download fake wallets and they go dey think say na di right wallet, to dey visit di official sites for di wallet is di safe way. Also using di latest anti-virus on your device and to dey use ads blockers if you dey use search engine, and if necessary to use search engine, making use of privacy ones like duckduckgo go be di best, although dis nor go give you best user experience but na dey safe to use than to dey use search engines of giant companies like Google and Microsoft on your wallet devices. Even, using cold wallets still need users protection and online privacy.

Watin you wan protect
Protecting your seed phrase, private key, seed and passphrase dey very important, because if attacker fit know these things, e fit go lead to di wallet being compromised, they should be protected offline, keeping it on devices go be di stupidest means of backup, and online backup dey dangerous. To copy your seed phrase into three place and to save m in a place wey nor dey accessible to attackers and damages na di best way to protect seedphrase. Nor go use complicated or difficult-to-remember passphrase, and nor go backup di passphrase together with di seed phrase and do offline backup too just like seed phrase backup. Lastly, use a backup way you go easily retrieve, not di ones wey go dey difficult to impossible for you to retrieve, some people like to encrypt their seed phrase, e nor bad, but make sure say you use encryption way you go fit easily decrypt.
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
Hey Stable090, thank u say u don help me rewrite dis very important topic of mine! Great job!


Dis topic suppose open d eye of people wey never sabi d danger wey dey whenever de use BTC with centralized exchanges and banks. D topic don try to make all those people make dem change d way dem de reason, so that de go fit use BTC in an anonymous way, e go help dem commot for governs radars, banks and other third parties.

I don too de happy say I see say de don rewrite dis topic for pidgin language, I believe say e go help plenty people for ur local board on how dem go use satoshi’s invention.
sr. member
Activity: 574
Merit: 387
Translated Topic in Pidgin Language: 12 years don pass and people no still sabi how dem go use Bitcoin or waiting e good for
Original Topic: 12 years later and people still don't know to use Bitcoin nor what it's good for
Author: GazetaBitcoin




12 years don pass since bitcoin don de. Till now, plenty people no get idea on how dem de use bitcoin, or Wetin bitcoin de good for. Plenty people de make combination again d nature, dem de use bitcoin together with our bank and centralized exchanges, de no get knowledge about its libertarian and crypto-anarchic grounds. De no sabi say bitcoin de here to help us invade d slavery wey governs and banks de force dem to, people de do everything wey dem fit do to enslaves themselves, de come make am easy for elites wey de oppress dem for thousands of years.

12 years ago Satoshi carry better tool come for humanity, tool wey don set dem free. Make we see how him de describe his invention:

Quote
A purely peer-to-peer version of electronic cash wey go allow make we make payments online wey we go send directly from one party to another and e no go pass through any institution.



Commerce for d internet don come to rely almost exclusively on financial institutions wey de serve as trusted third parties to process electronic payments. D system de work well for most transactions, e still de suffer from d inherent weakness of d trust based model.
If u don make transactions u no fit reverse am, since financial institutions no fit avoid mediating disputes. D amount for mediation de increase d transaction costs, and e de limit d minimum practical transaction size and e de cut off d possibility for small casual transactions, and there is a broader cost in d loss of ability to make non-reversible payments for non-reversible services. With d possibility of reversal, d need for trust spreads.

[…]

Wetin be d things wey we go need for electronic payment system based on cryptographic proof instead of trust, e de allow any two willing parties to de transact directly with each other and de no go need  any trusted third party. Transactions wey don de computationally impractical to reverse e go protect sellers from fraud […]

E don offer us method wey go make people fit transact directly, peer-to-peer, e de avoid any third party, no matter Wetin be d name - govern, bank or other person wey go de middle.

Satoshi carry bitcoin come and him give am out for free, for helping people get financial freedom, but people, in return, invested centralized exchanges, “helping” themselves to remain miserable slaves. Dis one na something wey remind me of other memorable scientific inventions, wey dem do to help people, but as dem create d inventions other showed up de come weaponized dem. Apparently, if any entity no de to harm them, we people de always choose on our own to harm ourselves.



If u don read dis finish, some people fit ask: “Wetin de wrong with using centralized exchanges? Na dem de keep money for me and I fit get my money whenever I like and I fit do anything wey I want with dem!”.

D last sentence na monumental lie. Na oxymoron, e mean say na expression Wey denies itself. E be like say I de talk say “I dey smoke in a healthy manner”.

D wey people de greed never get any limit. Bitcoin appeared for liberating dem, de only understand say bitcoin de there to make dem get money. Na d greed de determined people to invent d centralized exchanges. Instead wey dem go use bitcoin between dem, in peer-to-peer transactions. De get fact wey go render traditional money and governs as irrelevant, people don create an abomination meant to centralize something wey dem born decentralized.

Some people dey sharp pass others, but dem also de greedy, and de take advantage of their knowledge and d others’ greed for creating dis their centralized exchanges, where people de rush to deposit their money - which, since de don deposit am, e don turn exchange’s money. Individuals believe say dem go rich, de know no say dem de lose for all directions. D de very dramatic, as de no lose only money, but way more…

Wetin go de wey pass money? Dem de lose their personal information - that gift wey dem receive at d birth wey remain personal only if individual no want make e de personal again. And if de don reveal d personal information, e no go ever turn personal again. How many don ask themselves “Wetin be personal?”. As greed blinded them, dem de hope say de go get profits and de go become rich over night, people run happily go meet centralized exchanges, sparing no effort for having accepted their requests for opening accounts. E mean say de carry all their personal information give exchanges. Some exchanges de give dem free 5-10-20$ to people wey de create accounts with dem. U don reason before y d exchanges de give dis kin free money? U don tell urself before say “d exchanges de honored to have me as a customer, that’s why”? I no de sure. Dat money wey d exchange give u for free na nothing to dem, as dem go get back plenty money from d clients. Dem de talk say if something na free, na u be d merchandise. Like on Facebook. In d case of exchanges, d situation de worst: if dem de pay u to become a customer, reason d worst thing wey fit happen to u!

Wetin be d highest bad thing wey fit happen?

First of all, exchange no de ever lose money. House de always win. And na customers de Always lose. Users de always de happy if de see say bitcoin de pump, thinking de go earn some profits. Dem de always feel bad if de see say bitcoin price de crash, because dem de lose money. Plenty people sell their bitcoin even if de know say dem de at lose, but dem de sell am so that de no go lose more money. Dey know say as long as de keep their money for BTC their money go remain there de no go lose. And Wetin exchange de even do? De win when bitcoin soars, as de earn fees from d users. Dem de earn if BTC value de go down, as dem de receive fess now also. Anytime wey people commot money from d exchange, dem de lose more money. And we never even talk about d network fees, but d exchange’s fees. In other words, people de always contribute to d benefit of exchanges and also to their very own poverty. Besides, how many of us don notice how d biggest exchanges, like Coinbase or Binance, always encounter "technical outages", shutting down their platforms Since d time wey BTC dey dump reach time wey e de pump? Can it be a coincidence that each substantial price change, an outage shuts down d exchanges till dem see say price don come back to its previous value? D reasons wey d exchanges’ spokepersons de give de very pathetic and ridiculous. E de vivid clear that, since dis shitty moves don de happen for years, d exchanges decide to shut down in that particular moments, thus people no go get profit if BTC soars too much and limiting dem to buy BTC if d price plunges.

Second of all, as I de talk for d post wey de up, people de lose their personal information and na dem de carry themselves pass d dangerous process, wey dem de call KYC. Nothing consign d exchange about their customers or about their customers personal information. All Wetin dem want na more money. De can be hacked by hackers, which besides stealing money, de fit also steal customers personal information, wey de fit even turn to more money, most especially if dem sell d information on Dark Net. A CNBC article describes how those hackers de sell personal information for 1$ a piece (Dis information consisting, among others, de go sell d physical address of where d customer de stay, their credit / debit cards, copies of their IDs etc.): Hackers de sell ur data on d ‘dark web’... for only $1. A notorious similar case from d forum is D case of the Romanian bekli23, which, him de pretend say him de decrypt old BTC wallets, him be de ask people make dem send picture’s wey dem de hold their IDs and other bills for hand. Obviously, him no de decrypt any wallet na lie, him just de use style de collect people personal information, most likely, him de sell am for Dark Net, for as low as 1$ per piece!

For some cases, d exchanges na dem de sell customers’ personal information! And no be say na small, shady exchanges, we de talk about big exchanges. Coinbase na one of d biggest exchanges, and de don catch dem before wey dem de sell customers personal data! A 2019 article, Coinbase Admits Its Former Data Provider Sold Client Data, describes how Christine Sandler, one of d exchange’s executive, e admitted that d company sold d users’ personal information. Him get dis example, you think say other exchanges no de do the same thing? Na just because de never catch dem yet?

Third of all, exchanges offer users’ personal information directly to d authorities. Were u de reason say d govern no go sabi about u and ur finances - at least ur crypto transactions (considering that de know anyway all ur transactions with fiat money)? By using centralized exchanges, e de certain say d govern go put eye for u! Again, example involving Coinbase: a Forbes article, Coinbase Notifies Customers That It Will Turn Over Court-Ordered Data, e shows how exchanges de give people private information to IRS. No reason say na a singular case. Those practices are done by all exchanges, no matter d country.

Fourth of all, a centralized exchange no de give their customers private key, e mean say their customers no get access to d tool wey go allow dem control their own money. Na exchange de hold d private key to d exchanges, thus d users accept dem de cease d right of ownership over their money whenever de deposit to exchanges. Regarding dis situation, d Bitcoin evangelist Andreas Antonopulos used d expression “No be ur keys, No be ur Bitcoin”. Him even make things more clear, in a lawsuit against Coinbase ( dis exchange seems to be d most negative example), D accuser been lose d trial and d judge decided  Not Your Keys, Not Your Bitcoin.

Fifth of all, Hackers fit hack exchanges ( u don lose ur money be that).

Sixth of all, exchanges fit talk say u go against their rules make dem freeze ur accounts any moments (and u go lose all ur money).

Seventh of all, exchanges can exit scam (and u go lose all ur money).

Na d reason y u suppose avoid centralized exchange be that. Na y we no suppose use bitcoin together with such monsters, which dem de only work just to prejudice of d customers! Na how d customers of centralized exchanges de lose money their money no d operation wey dem de plan do. And dis is how, besides money, de also lose their personal information, risking to have it stolen by bad actors, facts wey exposes dem to monumental risks: if all those criminals just get access to person personal details, de fit pay him a “visit”, de fit attack am, de fit enter him house, de fit steal things wey him get and de fit threaten to kill am!



People’s greed no get limit and, although d above examples should suffice and convince anyone make dem run commot for centralized exchanges, e still no de happen. People no just limit am to d abomination of using centralized exchanges; de carry d absurd to d moon, and used Bitcoin in an even more grotesque combination, by involving also d bank for d financial transaction! Meaning dem de involve trusted third parties wey Satoshi wan carry commot by force for d system. D man fight well to damage himself as much as possible, by combining  Bitcoin with d exchanges and also with banks.

Similar as above, after u don read this finish, some go ask: “Wetin de wrong with make we de use bank? De go help me keep my money at my disposal and I go fit do anything wey I want with them!”.

Again, d last sentence na monumental lie.

First of all, banks no de hold ur money for u, dem de use am find more money for themselves. Dem de keep small for reserve but, plenty times, de no de even hold that fraction. Dis details was also observed by Satoshi and e fit represent another reason wey ginger am to create Bitcoin.

Quote
D central bank must be trusted not to debate d currency, but d history of fiat currency don full with breaches of that trust. Banks must be trusted to hold our money and de go help us transfer am electronically, but dem de borrow am out in waves of credit bubbles and de fit no even leave small for reserve. We suppose trust them with our privacy, trust them not to allow thieves wipe all d money wey de our account commot.

Second of all, banks no dey allow their customers use their money d way dem like. If de deposit money Wey plenty (d one wey plenty pass d money wey u de deposit before), d banks fit put leg for ur account dey go freeze am, de go come force d customer make him justify where dem see that kin big money from. D same thing de happen if customers receive big money like that. People wey de believe say de fit use their money anyhow dey very wrong. D same thing with centralized exchanges, if their customer don deposit money to d bank, de don give bank full control over d money be that.

Third of all, banks fit carry their customers give authorities. And again: If transaction wey dem do no de clear for d bank eye, normally na transaction wey involve big money, den banks no go just put leg for d account alone, de go involve authorities also. And, for dis matter, Wetin d customer go face go even worst, de go force am make him justify d money for front of d authorities!

Of course, if d customer no fit defend where him get d money from, then d money don go be that. Banks act like long arms of d govern and de no care about their customers; d only thing wey de care about na how dem go grow their own money, while keeping a good relationship with d govern.

Fourth of all, banks fit reject transactions wey their customers do, as de want, or base on d Terms and Conditions, which go represent a document wey customer sign, but no customer dey read that kin plenty things wey dem de write when customers de open account. And, as plenty banks no too like crypto, crypto users de very exposed.

Fifth of all, some people de use services wey some financial institutions de provide like Revolut, dem go de think say dem de own crypto. For real life, de no own even 1 Satoshi! Na because Revolut no de allow anybody own any crypto, but of CFDs. De sell u d illusion that ur own crypto, but u don’t. Na d same thing de happen to eToro.

Sixth of all, E dey similar to centralized exchanges, bank customers go lose money in all possible ways: de go pay to open account, de go pay money to deposit, de go pay money to commot money, de go pay to transfer money, de go pay money to check d money wey remain for account, de go pay for administration of d accounts, de go pay to collect credit / debit card and other things like that.

Seventh of all, banks fit go bankrupt also, de fit exit scam and de fit loose customers personal information. But all dis cases no be always compare to crypto exchanges, but all those things fit still happen. De don happen before and de go still happen later again.

And, if u de reason say Wetin I de talk since no de right, d picture wey I go provide below show how one of Romania’s biggest bank treats its customers:

Photo source: Facebook

Translated In English, e mean say:

Quote
Within d business relation wey d bank get with his customers, d bank is forced to follow d laws related to knowing their clients wey d purpose na to prevent and fight money laundering, sponsoring terrorism and to follow d General Business Conditions (GBC) for d entire customers portfolio.

According to GBC, to d regulation 2/2019 of National Bank of Romania and d law 129/2019, na d customer responsibility to provide d Bank all d documents wey dem ask for, wey dem need all those documents for verification and clarification of d purpose and d nature of d recorded transactions. Through dis documents, we go allow u know that, as we don analyze d transaction wey happen for ur account, we decided d typology of dis transactions don break art. 23.1 from GBC, which states d following: “in case d bank see some potential risks or some requests coerced by financial institutions implied in banking operations, d bank reserves its right to reject some transactions wey de connected to some services like gambling, acquisition of pornographic services (including to de videochat or similar services), buying of weapons/munition without complying with d conditions stated by d law, transactions wey involve cryptocurrencies.



For below u go fit read  how d customer of d bank wey de up take react. U fit laugh, but de suppose carry d matter serious:

Photo source: Facebook

Translated In English, e mean say:

Quote
Subject: justification signed by […] in order to explain Wetin I de do with my own money

I […] being a customer of d bank, I sign d present document being forced by d Bank, wey invokes some internal regulations wey no dey against me, in order to coerce me to justify in front of d Bank Wetin I de do with my money.

Given d fact say na summer time and na time for vacation, considering say na post-quarantine period, I wan just have plenty fun. For doing so, I wan travel go Holland, where Ashawo business de LEGAL, so that I go fit nack some whores. Most likely, if I dey road de go Holland, I go do the same thing for Austria and Germany.
Then, if I don de Holland, given d fact say drugs de LEGAL, I get am for mind to smoke some weed and hashish, but I go try some shrooms.
I hear say dem get better weed cakes for Holland, and I go recommend am make u try am, maybe u go wake up and u no go force people make dem sign any rubbish papers again, base on stupid procedures, in order to justify to u Wetin dem de do with their own money.
Obviously, if I no go get toilet paper, given d fact say I get plenty money, maybe I’ll fancy and clean my yansh with a few hundreds of euros, like rich people de do.
D money wey remain na to de borrow my friends and making useless expenditures, wey I go regret later.





All d things wey de up suppose make all of us de reason about make we de use Bitcoin together with centralized exchanges and banks. Beware! U go just harm urself maybe u go vex irrecoverable prejudices. Make I also talk about Mt. Gox exchange, wey lost  850.000 BTC Huh Make I also talk about dozen (hundreds?) of exchanges wey de don hack and customers wey don lose money? Make I mention thousands of cases when banks don freeze customers’ accounts? Make I mention how many people de don threaten to kill, how many de don blackmailed, how any were extorted, how many hackers don force to pay them ransom, after hackers don get personal information finish?

Sha u wan live that kin life? If u no want, den stop using bitcoin together with centralized exchanges and banks! Make u de use crypto cash-in / cash-out ATMs, wey go offer u anonymity. Make u use decentralized exchanges, wey no de hold even small customer money and act just to connect d users one with each other. Make u use peer-to-peer transfer. Use crypto wallets which have embedded anonymous exchanges, wey go allow u change cryptocurrency with each other. Make u use any style preserve ur anonymity and financial privacy. Na for ur own good.



Dis essay na part of my educational articles. I recommend all of u make u read d following essays:

- Bitcoin: D dream of Cypherpunks, libertarians and crypto-anarchists
- Governs dey come 4 traders!
- Cryptocurrency nd digital money Palava by di state
- De Crypto Anarchist Manifesto - Make all of us read am
- Govern try to limit de public to access of information and freedom long long time ago
- Wetin Phil Zimmermann's Dey Reason about PGP  - Make all of us read am
- When d govern wants to hold your private keys
- The call for Julian Assange || The WikiLeaks Manifesto - Make we all read am
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
Nheer thank you oo as u don help me translate another one of my topic! You don do another good work!

Dis topic na more of a philosophical debate wey be about the outcome of governments' constant oppression of bitcoiners. How many time go pass before bitcoin users go finally begin de use bitcoin as dem suppose use am? Nobody get dis answer but i believe say, sooner or later, e go happen... Nobody fit do am wey governments wey de against cryptocurrency go de hunt am like criminal wey d person go resist am endlessly.
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
Translated Topic in Pidgin Language: The Oppression wey governs' dey show bitcoiners fit turn against dem
Original Topic: Governs' Oppression of bitcoiners may turn against them
Author: GazetaBitcoin




Governs don de oppress bitcoiners for more than a decade now. As dem take sabi say bitcoiners de earn real moni from deir crypto transactions, governs all over d world con begin de extort bitcoiners, for carrying d moni wey dis piple don earn on deir own without d state helping dem in any way. piple de work, dem de pay dem for deir work, but d state de want him own share.

Oppression begin de grow bigger and bigger as time passed. As dem don sabi how dem go take force piple to pay, governs for d whole world con create laws wey no de exist before, dem con de try centralize wetin suppose de decentralized. And piple, wey de greedy, con de help d state extort dem even more.

Prometheus bin give piple fire, make dem use am warm up deir homes and make dem use am prepare food, but piple use am burn deir neighbors’ houses. Similarly, Satoshi bin give piple bitcoin free of charge, make e help dem get rid of d slavery wey governs and banks impose on dem, make e perform peer-to-peer transactions, make any third party no put hand, but piple, because of greed go de create centralized crypto exchanges.

Some opportunist believe say dem fit become rich if dem operate this kind exchange. One of dem na im be Charlse shrem (yankee (BitInstant)). A young enthusiast, wey adopt bitcoin wen him bin de college. Later him con launch BitInstant, one of d first crypto exchanges and wey, at some point, bin de tun about 30% of all bitcoin transactions. Later na for cell him con end up, say him de aid and abet operations of money transmitting business wey no get license. Him still get another name “Bitcoins first felon”.

Since Shrem’s case, governs con begin de even more strict on bitcoiners. A 2018 article tell us say d “the so-called “Bitcoin Maven, wey bin admit say him de operate an unlicensed bitcoin-for-cash exchange business and laundering bitcoin […] dem bin sentence am today to 12 months and one day in federal prison, three years of supervised release and a fine of $20,000”.



Crypto exchanges bin soar and so did deir users, and dem no understand say dem de act against bitcoin’s principles: peer-to-peer / anonymity / pseudonymity / getting rid of middle man. New laws bin come too together with crypto exchanges, and dem force exchanges say make dem impose KYC on deir customers.

Piples greed na im lead dem to:

- risk deir moni wey dey exchange, as no be for deir hand deir private keys dey
- risk deir moni, as dem bin hack many exchanges
- risk deir personal information, as dem bin hack many exchanges and hackers bin use customers’ personal information, or dem bin even sell am for dark web (wey lead to even more risk for dis piple, as you no go know wen criminals go come your door and robs you after dem don buy all your personal information for $1 for dark web)
- risk deir moni, as many exchanges just simply freeze deir account
- risk deir moni, as many banks just freeze deir account after dem find out say d moni come from crypto transactions
- risk deir moni and also deir freedom in case dem no obey d new laws issued by d govern.

Yet, na only few learn deir lesson. Perhaps d ones wey dey wise and d ones wey live at least one of d situations wey dem mention above.

And, as time de go, “Crypto laws” bin become more harsh and more complex. For many cases, e bin de more ridiculous or to raise more questions wey nobody answer.

In Romania, for example, dem bin issue first crypto law for 2019 but, until den, you bin de face d risk wey dem fit accuse you of tax evasion, or say you get criminal record or jail term sef for not declaring d fiat moni wey you get from crypto transactions, although dem no get any legal framework. Accountants bin no sabi how dem go take declare these incomes of deir customers and authorities bin no sabi how dem go answer piples questions. After dem issue d law, in early 2019, bitcoiners con de pay a 10% tax for d profit dem bin make in the previous year. And if deir profit plenty pass 12 minimum wages, dem still suppose pay 10% of d amount of 12 minimum wages. Dem bin give health system d secondary tax. Piple wey na losses dem get for d previous year no suppose pay anything.

Still, d law no de clear. Wetin miner suppose do? If he make profit in d previous year but d hardware equipment wey him buy still far for him to pay back, shey na profit d miner de get abi loss? And wetin go happen to miners wey no get any more bills / invoices of deir hardware equipment? Nobody knows.

For future, new taxes fit come. More complex, more ridiculous.

In any case, dem no conceive bitcoin for anything like dat dem no create am say make e de give piple more troubles nor make carry dem go jail incase dem no give d states deir own share, share wey state no contribute anything. Everything just de d reverse way dan e suppose dey.

Instead wey we go render governs and banks say dem de irrelevant, instead wey you go comot middle man for d equation, na piples action na im enforce dis entities. And now, dis entities de fight back, dem de oppress piple even more. All exchanges de collect users' data con de prepare am keep for d authorities. Bitcoiners go smiling at crypto exchanges -- nobody knows why -- and dem de offer am for free and at deir own will deir moni and personal information. To make sure say dem go turn slaves again, users' de also associate deir accounts from exchanges to bank accounts, thus e de allow banks too to freeze deir funds at will and also give deir data to authorities.

Then many de see money from deir crypto activities and, dem no sabi d very complex laws, dem con turn sitting ducks for front of authorities.



However, i believe say e go get limit wey all things go end. All dis incorrect uses of bitcoin, all govern and bank extortion, all d abuses of crypto exchanges.

And dem go reach dis limit when enough piple go suffer from deir greed, from deir naïveté, from deir stupidity. When enough of dem go get criminal records and when enough of dem go get jail term wey dem go serve.  Na only sufferness wey strong go fit open piple eyes.

And wen dis thing go happen, bitcoiners go don finally  stop de use exchanges. Dem go stop de put deir fiat incomes wey dem get for crypto activities inside deir bank accounts. Some sef go de avoid to use fiat money. If all dis things go happen den individuals go begin de use bitcoin d way Satoshi bin create am: for deir own benefits, for rendering governs and banks irrelevant, for eliminating middle man, for anonymizing their financial deals, for being deir own bankers, for owning deir private keys instead wey dem go allow exchanges have dem.

And when dis go happen, all d previous oppression wey governs bin de impose go turn against dem. Dem no go fit catch any victim again as deir first victims don sabi how dem go take protect themselves and how dem go use bitcoin properly. when these go happen, d prey go turn hunter.

I no sabi how much time wey go pass wey dis thing go turn real. But i get feeling say, sooner or later, piple go realize say dem don suffer enough and dem go say: "Enough". And dem go open deir eyes and dem go understand how dem go use bitcoin. No be for states benefits, but deir own benefits.
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
Thanks again Sokani as you take translate another of my topic! I appreciate all your efforts!

Dis na very special topic wey mainly dey dedicated to raising awareness about Ross Ulbricht unfair trial. Many people bin accuse am without proper knowledge of de case. E dey easy to talk many things, but as you watch dis amazing documentary, you go understand say things bin no dey dat simple with am. Agencies bin dey fight each other to take over de case, corrupt DEA agent dey steal BTC from Silk Road: Dem no gree make Ross authorized witnesses appear for court, de persecution bring unauthorized evidences to de court and de judge accept am just to make an example of Ross - all dis and many mata you go understand from de topic and from de documentary.

Finally, one man dey serve 2 life sentences for prison + 40 years bonus(how any person fit take fulfill this kind sentence?!?) without parole, because him dey run a website (!!!) and for him first offense, while de administrators of SR 2.0, 3.0 or other dark markets dem bin don caught dem, imprison dem, and already release dem. Fair justice? Yes, sure!!!
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Translated Topic in Pidgin Language: Silk Road Case: De Real, Untold Story. Na Karpelès be Satoshi or DPR?
Original Topic: Silk Road Case: The Real, Untold Story. Is Karpelès Satoshi or DPR?
Author: GazetaBitcoin




E get any person wey don watch de latest documentary about Ross Ulbricht? You fit find am here Youtube (or for dis second link) and na Free Ross organization na im create am.

I dey ask because I notice some interesting allegations, besides all de wuru-wuru wey dem do during de trial. De wuru-wuru wey dem do against Ross Ulbricht (I think) many people sabi well well de details about de case, many of dem xtraelv bin also torchlight am for im very interesting topic.

However, some of de details (atleast I no no) wey de documentary expose. Some dey very unrealistic (like de suspicion say Mark Karpelès be Satoshi, which I no say actually na fake, but no bodi no de truth), but some raise questions though... Besides, de film give de idea say Karpelès fit be DPR, and not just Satoshi.

  • For example, for de beginning of de documentary, (between 0:04 and 09:22), e bin first mention SR for here, by the user silkroad inside de topic Silk Road: anonymous marketplace. Feedback requested Smiley (wey dey correct). Jared Der-Yeghiayan, wey be de first investigator of SR (no talk about how im get to know about SR existence), find out say de site wey dem mention for de topic (silkroadmarket.org) na just a surface web platform wey bin dey inform users on how to use Tor and on how to access de real SR for Deep Web. Der-Yeghiayan find out say dem register silkroadmarket.org with XTA.net, na domain server wey a company Mark Karpelès own wey de name na Mutum Sigillum. As una already know, Karpelès na de ex-owner of de defunct Mt. Gox. From dis point e raise de suspicion say DPR(de new owner of SR, after Ross give am de site) na de same person wey be de owner of Mt. Gox.
  • By dat time, according to Ross statements, him no longer be de owner of SR. Him bin talk say him dey overwhelmed and after him don find a guy wey help am well well wit de site, him agree to pass de ownership to am. De guy nickname na DPR (Dread Pirate Roberts) and dem dey suspect am to be Karpelès.
  • From here, things come even dey interesting: Karpelès buy Mt. Gox. about de same time wey dem launch SR. For de documentary e raise de suspicion say Karpelès fit be Satoshi (wey I doubt) and him for get all de reasons for de world to open SR, to put there de BTC wey him earn from Mt. Gx. and vice-versa. Besides de interesting coincidences, e get one nonsensical accusation - say Karpelès na him be also de owner of BitcoinTalk, na de information wey Der-Yeghiayan receive from one secret informant, wey Karpelès bin previously hire. Dis idea come up after dem note another coincidence for de film, e dey like dis: de SMF platform, use for BitcoinTalk site, dem bin also use am for de discussion forum for SR. Besides, due to say dem dey hardly use SMF for forums, de fact say dem bin use am for both BitcoinTalk and SR bin raise de suspicion of de investigator, wey come make am dey consider say de same owner fit get both platforms, meaning say Karpelès fit be Satoshi.

Examples of de similarities in UI between de sites:

  • Make we come back to Ross and how de investigation start (32:00 - 34:46): dem talk am here say de govern use "parallel construction" in other to frame am and make am look like de real DPR. To be more specific, one IRS agent (Gary Alford) bin find for BitcoinTalk one post wey contain Ross email, wey him write before Der-Yeghiayan create him thread (wey I mention above). Practically, Der-Yeghiayan find de topic Silk Road: anonymous marketplace. Feedback requested Smiley, wey de username silkroad bin post March 1st, 2011, while Alford talk say him find de post wey de user altoid for January 29th, 2011 (without specifying de name of de topic). De documentary talk say Der-Yeghiayan no fit don find dis topic during him investigation because e no exist. Alford claim say him find de respective post wey another forum member quote in one discussion about SR ( I no fit find de post though I don search for am). Afterwards, Alford come mention one real post of altoid from October 11th, 2011 (wey I find to be IT pro needed for venture backed bitcoin startup), where one email bin talk say: "rossulbricht at gmail dot com". And from here de govern come believe to suspect say Ross bin dey behind SR.

However, wetin de documentary yan, Karpelès (de alleged owner of BitcoinTalk) fit don plant this information or by another user wey get high level of access. Besides, de way Alford find de respective email, dem fit compare am wit " finding a needle from a pile wey fit dey like de size of de internet" (which I totally agree). In other words, for all de people wey dey try to find information about de SR owner, Alford only manage to find dis email address. From there de idea con come up say dem fit don plant de information. Because someone wey get high access fit don make de respective post in de name of Ross and hand over de information to Alford, make everything look real.

De entire documentary dey very interesting, but na de first 35 minutes na im dey raise de questions wey dis current topic talk about. Karpelès fit be Satoshi and also DPR? Another aspect wey de documentary no mention but de forum know about am na say Karpelès bin also perform audit for BitcoinTalk, maybe dis aspect for raise more suspicion for de documentary.

I believe say na how de attacker carry out de attack: after de 2011 hack of de forum de attacker bin come put some backdoors. Mark Karpelès bin come remove dem wen him run post-hack code audit, after small time, de attacker come use password hashes wey him obtain from de database in other to take control of an admin account and put back de backdoors.

In de end, I wan mention say I find de entire film very interesting, wey bring new details about Ross case, about de unbelievable way de judge treat am and de sabotages some secret agencies/agents perform towards other agencies/agents. I recommend everybody to watch am, na a must watch documentary!
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
Translated Topic in Pidgin Language: A Declaration of Independence for cyberspace - make we all read am

Thank u Stable090 for spreading my words to ur people! I believe say de go enjoy reading all dis translated topics.

Dis topic na another piece of history and I believe say e worth sharing for d forum. D author, John Perry Barlow, na another iconic figure of cryptography and libertarianism, associated with many rebels of his era, including John Gilmore. And d fact that he co-founded the Electronic Frontier Foundation should everything about him.

Dis one na very interesting material and I de impressed by d author's persistence in keeping governments out of cyberspace. Of course, it never happened, but his ambition and fight for a free Internet de extraordinary!
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
Top Crypto Casino
Translation Topic in pidgin Language:The Lighting network FAQ
Original Topic: The Lightning Network FAQ
Author:  Rath_    


 if you no know anything about d lightning network matter before, try make you read "Basics of The Lightning Network" first

Table of contents

1.Lightning basics
2.wallet
3.Running a node
4.Concerns
5. other questions


Lightning basics

How the coins wey dey lightning network take come different from the onchain one?

The two of them na d same coin. Them dey store Dem for inside wallet, wey dey carry many signatures address and them dey settle this collabo without say them carry am come out for Blockchain (except them dey open and close the channel). Now, anytime wey e be say dem  transfer money, Dem go con confirm one new commitment transactions.this kind transactions dey show d state wey the channel dey.and them fit broadcast am if one of d person wey dey involve com run commot.

How many times Dem fit use one particular payment channel?

That particular payment channel fit still dey I use sofa say the two persons wey dey involve, still be pardy or still dey collabo.
The channel no get use and e no dey expire.

Watin be d size of the lighting network?

The overall number, channels and network capacity den dey go up these days. You fit use 1ml.comto take see the today date table. Make we remember say some channel dey private o. Dem no show dem for network and like this so, Dem no join those table.

Watin be d speed wey lightning network payment take dey run?

Dem normally dey fast oo. But some payment fit take small time
If e be say the wallet wan try use many different ways.

When this payment go fit take fail?

Payment go fit fail, wen the place wey e dey go no get road make e follow reach or if the liquidity for the channel wey Dem select no reach. Problems wey fit come latter fit get solution if Dem go share the payment small small come send Dem follow different road.

How much dem dey take Tay do transaction?

Some channel dey charge one particular fee and dis fee dey d same with the money wey person send.so if the money way you wan pay big, you go pay more. Normally you supposed pay less than 3 Satoshi for transactions <=$10 some time.


Dis lightning network e dey hide identity pass on chain transactions?
 
Yes, the lightning network dey hide identity well. E dey use watin Dem dey call onion routing to break am down, if payment dey routed, the node wey dey involve go only know d node wey dey come next and d one wey dey before. Like this now, e no dey possible to take know the person wey first start dis payment and where the payment dey go.

Wallets

Which wallet go good make I use?

Many  better type dey for different persin

No-coiners:strike

Bitcoin people wey newly start:BlueWallet

Regular users:Phoenix Wallet, Breez Wallet, Blixt Wallet,

People wey don Tay for the matter: run your own node  Grin

Electrum still get properties of lightning network, wey them make for inside. Try make you read am first if you know say you wan try am.

Make I run my own node if I no wan use wallet?

You fit get gain if you run your own node some kind way.
Now make we say you run your node 24/7, you go fit receive you money any time. Node still fit help network say e go carry the payment go front. You go come also fit enjoy some kind things like: opening multiple channels for only one transaction, you fit do two transfer and use key take send payments.

E come dey necessary say I go dey generate invoice, anytime wey I wan receive coins for lightening network?

No, invoiceless(keysend/spontaneous) payments dey supported by LND and c-lightning. Sha some wallet no dey supported this matter.

WHY I NO FIT RECEIVE COIN?
first things first, dem go first decide the time lock, before Dem go create the channel. Normally, some nodes dey force d other peer to dey wait 144blocks(~1day). The value wey Dem dey accept reach na e be the 2016 block(~2 weeks). I don make sure say my node go only fit make channel with their sef delay= 432blocks (3~ days), so if person come wan try close the channel wey my dey open to my node without my knowledge, Dem go come need to wait 432 blocks(after the commitment transactions don dey concluded) before Dem go fit use the output wey them get. The timelock dey connected so e mean say you no go come sign new commitment transactions anytime you mine new block. No need to dey pay 60 sat/vbyte wen Dem dey confirm 1 sat/vbyte transaction under small minutes.

The first transaction na e be the commitment transaction. Make we say we get node A(lice) and nodeB(on), and node A come showcase the commitment transaction. The commitment transaction go come include two outputs:

-output #0: 3 BTC (wey dey spendable by node B's private key)- come dey reflect node B balance
- output #1: 6 BTC (RSMC) - wey dey reflect node A balance

-one more better thing dey, before we go fit continue the matter. Anytime Dem sign new commitment transaction, both pardies them go exchange revocation key wey Dem take do their previous commitment transaction to take make sure say the other pardy no go go showcase the old channel matter.

-RSMC stand for Revocable Sequence Maturing contract. This kind output dey carry one time lock. This one mean say you no go fit spend the output until e get particular block wey you go mine since the transaction wey carry dat output them mine am.
 
Make we say node B no change d original value of 144 blocks and the Dem con confirm the commitment transaction. No only two ways e go fit take sub.
1)Node A come try cheat and showcase the old commitment transaction. Node B get only 144 block to spend the RSMC output say e go use e and node A revocation key wey e carry web Dem dey work for the new commitment transactions.
2) Node A come showcase the lastest commitment transaction. For this kind matter so node B go get node A revocation key for d commitment transaction, so e no go fit spend d RSMS. Node A go fit showcase another transaction so e go come spend the output once e don mine the 144 block


 The lighting network e dey centralized?

The matter now be say people Dem dey normally open big channels instead of small or medium ones. As we dey confirm the matter, make we dey expect say hundreds or even thousands of nodes to focus on end users. The post dey focus on nodes wey fit dey exist. You fit check am out if you dey interested.

The matter fit cause bad things for the first layer?

If den go close plenty channel d same time, the transaction fee fit go up and no go gree come down for some time.


The lighting network fit still solve Bitcoin scalability problem?

Sha e no go finish am. Dem design lightning network Normally for those small small transactions wey no go dey costly for the first layer. Big big payment still dey possible, thank God say we get multipath payments. On chain transaction dey involve, if you wan open channel. So if every person come open one channel, d Blockchain go come full well well. So na e make am we go need other solution for d matter. Again ehh, you fit still add more layers ontop of d lightning network.
 
Watin go happen if node commot online for small time?
If plenty big big nodes commot online at the same time, e fit cause catter catter for payment. If you come get only one channel and your pardy no dey online, then you no go fit transfer or receive any fund

Other questions


Which store go fit allow payments with these lightning network?

here, you go fit find some pardy them wey dey gree carry LN payments.

Any exchange dey gree for lightening network?

Yes o, the exchange wey dey support lightning deposit and withdrawal na e be Bitfinex. Here, you go see today today list wey dey gree for exchange with LN.


Watin be the features, wey we go dey expect?

Channel wey dem fit double fund- the two pardy Dem, go fit add money join d channel. This matter don already dey c-lightning but na test dey Sha.

Splicing -in &out- like this ehh you go fit commot your money from your lightning network channel even if you no close am.

Channel factories- lightning network wey don first dey go fit open new channel even though say e no show am to the Bitcoin network. Normally na only one person dey get access to any channel. For factories wey channel dey, people many. These people them dey try make sure say dem maintain the channel by their sef. As users dey plenty, their savings dey increase. If one of the pardy them no come dey follow up, e no go affect the channel.but them no go fit create another channel.

  
sr. member
Activity: 574
Merit: 387
Translated Topic in Pidgin Language: A Declaration of Independence for cyberspace - make we all read am
Original Topic: A Declaration of the Independence of Cyberspace - We all should read it
Author: GazetaBitcoin




Dis topic na sequel of my earlier topics -- The Crypto Anarchist Manifesto - make we all read am and The call for Julian Assange || The WikiLeaks Manifesto - make we all read am.


Another article wey anybody wey de bitcoin suppose know, libertarian or crypto-anarchist: John Perry Barlow's Declaration of d Independence of Cyberspace. Na for February 1996 dem write d essay by John Perry Barlow, co-founder of Electronic Frontier Foundation, na foundation wey dem build for Internet liberties. Another iconic figure wey de part of EFF na John Gilmore.

Barlow’s declaration come as a reply to telecommunications Act of 1996, wey d US accept for January 1996. All d documents no allow govern’s sovereignty on top cyberspace, dem no allow govern’s de d place and dem denies govern’s to rule people wey de cyber space. D document come de very popular, E don reach like 40.000 websites wey don copy and share d documents.

We fit see all d declaration for d post wey de down (na me get d text formatting):

Quote
Governments wey get d industrial world, you weary giants of flesh and steel, na from cyberspace I come, d new home of mind. I de beg because of d future, I want make u wey de before free us. We no welcome u for were we gather. U no get power for where we de.

We no get government wey we select, and we no fit get any one, I go talk to you with no greater authority than d one wey person Wey fit do anything go talk. I de tell global space wey we dey build to de free from the tyrannies wey dem don put ontop us by force. De no get power wey dem go use rule us and de no get power wey de go use force us we get true reason to fear.

Governments get their powers from consent of d governed. U never ask or received our own. We no talk say make u come. U no sabi us, and you know sabi our world. Cyberspace no de for your boundaries. No de reason say u fit build am, no de reason say na public construction project. You no fit. Dis one na nature and na by itself e de grow with things wey all of us de provide.

U never put mouth for our great and gathering talk, and u no create d money for our marketplaces. You no sabi our culture, our ethics, and d code wey we never write wey don provide our society pass anything wey you go talk say you put on top us wey we no want.

U de talk say wahala de for our middle wey u suppose solve. U use dis one deceive us come invade our precincts. Almost all d wahala wey u talk say e de no de all na lie. Where d real fight de, where things de wrong, we go pick them out and we go find solution to dem ourself. We de arrange our own social contract. Dis governance go rise according to d condition wey we agree on and no be u. Our world de different.

Things wey de cyberspace plenty and I go de list some of them. Transactions de, relationship de, and thought itself, wey de arrayed like a standard wave in the web of our community. Our own na world wey dem carry come from everywhere and nowhere, but no be were bodies dey live.

We de create world wey everyone go enter no be say na special people go de there and no be say na by race, economic power, military force, or were dem born u.

We de create a world where anybody, anywhere go fit talk anything wey de him mind. No matter how singular, and fear no go de say dem go force you make you no talk.

Your legal concept of property, expression, identity, movement, and contex no fit work with us. All na base on matter, and for our own side matter no de.

Our own identities no get any bodies, e no be like your own wey you fit obtain order by force. We believe say some ethics, enlightened self-interest, and d commonweal, our own governance go come together. We fit share our own identities for our own jurisdictions. D only law wey de wey our own people go generally recognize na our own golden rule. We hope say we go fit work on our own solution on that matter. But we no go gree with the solution wey u wan force on us.

For United state, u don create law today, d Telecommunications Reform Act, wey repudiates ur own constitution and e don insult d dreams of Jefferson, Washington, Mill, Madison, DeToqueville, and Brandeis. Dis dream go need start afresh inside us.

All of u de fear ur own pikin, since na native dem be for world wey una go always be immigrants, because u de fear them, you don entrust ur bureaucracies with d parental responsibilities u don too de cowardly to face ourselves. For our own world, all dis ur opinion and expression of humanity, from d debasing to d angelic, de for parts of d seamless whole, d global talk of bits. We no fit separate d air wey de Choke from d air wey wing de beat.

For china, Germany, France, Russia, Singapore, Italy, and for United states, we dey try prevent d virus of liberty and we go need put guard post for front of cyberspace. Dis one go fit keep out contagious for little time, but de no go work for d world wey go soon de blanketed for bit-bearing media.

Ur increasingly obsolete information industries would perpetuate themselves because dem go propose new laws. For America and other places, wey de claim say na dem get speech for d whole world. Dis laws go fit declare new ideas for another industrial product, nothing like noble than pig iron. For our own world, anything wey human mind fit create we go fit produce and share am infinitely and we no go collect any money. D global conveyance of thought no need ur factories to accomplish.

Dis increasingly hostile and colonial measures put us for d same position like those people wey de before wey like freedom and self determination who de always reject d authorities of distant, uninformed powers. We go need declare our virtual selves immune to ur sovereignty, even as we continue to de consent to ur rules over our bodies. We go spread ourselves over d planet so that no one go fit arrest our own thoughts.

We go create civilization of the mind in cyber space. E suppose dey more easy and fair pass d world wey your governments don make for us before."
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
This na de only political article wey I don ever write. Like dis, I write am to try do something to help de oppressed people - de Ukrainian people. I dey completely against war, against oppression, against violence of any kind, and I don try wit dis article to somehow help de Ukrainian people. One great help na 1maiu wey suggest dis to me and I dey happy say I write am for dis very day February 24th, wey de war reach one year.

Thank you for translating dis my topic. All of us, as we dey use Bitcoin, we dey give more power to Bitcoin and so Bitcoin fit help de Ukrainian people even more. Sokani, you don do a great job by translating dis topic and I no get enough words to thank you.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Translated Topic in Pidgin Language: Help Bitcoin help Ukraine!
Original Topic: Help Bitcoin help Ukraine!
Author: GazetaBitcoin




Na exactly one year wey Putin invade Ukraine - on February 24, 2022. Na sad anniversary for de Ukrainian people and humanity.

One article from Bitcoin Magazine, wey 1miau recommend to me, come recently catch my attention. Bitcoin Magazine na one great resource place wey dey write beta informative articles about Bitcoin and also dey torchlight many philosophic and libertarian essays.

De article dey long, maybe na one of de longest article wey I don ever read, e get about 14.000 words. E take me time to read am finish but as I read am reach de end, e come ginger me to support de Ukraine cause. De article yan about de chaotic past of the Ukrainian people, de struggle of de past wey still dey continue today, de things wey dey cause dis struggles dey different, but de pain na de same.

We don also get information about Bitcoin adoption for Ukraine and e tell us about de tori of war heroes or tori of Ukrainian bitcoiners. One tori for dis article dey really touching. E yan about Naumenko, na confirm bitcoiner and a hero:

Quote
In 2018, Naumenko get de opportunity to work wit Bitcoin giants like Greg Maxwell and Pieter Wuille as intern for Blockstream, eventually him follow co-author a paper wit Maxwell and Wuille wey dem propose Bitcoin improvement, Erlay, wey go make de network more efficient and resilient. For 2021 and early 2022, Naumenko work on Bitcoin protocol come reach new milestone.

Just some days before de invasion, Naumenko release “CoinPool,” a new implementation of bitcoin wey go allow may users to share the same "UTXO" or spendable piece of bitcoin. Na complement to de Lightning Network, and something wey go help Bitcoin scale well well and increase privacy. CoinPool na de result of many years of work wit fellow developer Antoine Riard. De release go be better achievement under any circumstance, na surprising scientific breakthrough from a country wey wan go war.

On February 24, Naumenko wake up from sleep as him phone ring. Him friends bin don bombard am with messages: De invasion dey real, for him mind him no think say e go happen. Just 12 hours earlier, him bin cruise him electric scooter go coffee shop go read book. De weather bin no dey bright, no person for street, him bin come dey feel some how. Na wen dem wake am up by 5:00 am e clear for him eyes say war don come. Him carry him backpack quickly rush go metro shop, where him come hide for one Soviet-era bomb shelter, wey dem build to withstand nuclear attacks.

Him spend three days and two nights for de bunker. At first, wen him go de subway station, one old woman wey dey de turnstile tell am make him wear mask. Him look at her come confuse. COVID-19 don finish, war wan start. Many people and families wit children dey come, dey carry pillows and food, dey prepare to live there. Initially, de shock of war bin drive people go underground, but after some days, out of necessity, people come dey return to their normal lives.

Wen Naumenko finally leave de shelter, him bin meet with friends come decide to leave de city in a pink BMW. De car dey too bright but na de only one wey dey available. Dem come dey fear say de car fit bring too much attention but dem decide to use am like dat go west. Russian army bin dey some residential areas outside of Kyiv, dey kill civilians, and dem dey hear de gunshots. Time dey really important.

Naumenko friends japa enter Romania but him tell dem to drop am for one Ukrainian town before dem cross de border. Him bin wan stay and help.

Putin troops bring plenty suffering to Ukraine, where Russian troops bomb and destroy de houses of many Ukrainian civilians. Some Ukrainian cities dem bring am come ground and Mariupol, one city wey bin get population of 500.000 don finish kpa-kpa. Satellites images even show how Russians dig mass graves, to bury Mariupol citizens, wey go be war crime. Putin bring war for everybodi wey dey Ukraine even dose wey dey de western part of Ukraine need to look for shelter wen Russians begin to launch new missile strikes. E dey horrible, because anytime u fit get air raid warning, dey hope say rocket no go hit your house.

Putin also bring suffering for him own country, wen him carry more troops to war front to conquer Ukraine, him bin announced de mobilization of 300.000 young men come send dem unprepared to de front for him own cruel war. Na wetin military strategies dey call "cannon fodder".
Many Russians bin dey try to leave de country but Russian guards bin stop dem for border. Dem don hold dem, force dem go de war front.

Na big shame wetin Putin dey do for deir, him don start de biggest land war since WW2, wen Hitler bin launch attack against Poland, and later many oda countries. E dey completely justifiable to call Putin "Putler" because him dey stand for de tradition of Hitler actions for WW2.
People dey suffer because maniac Putin wan create Soviet Union 2.0 and wan re-establish him communist shit hole.

How bitcoin go fit take help get rid of Putin dictatorship?

As Alex Gladstein take describe am for him article Currency of last resort how Bitcoin dey take help people wey dey suffer from Putin's bloody war, e for make sense to see how Bitcoin go fit help us pursue Putin comot from office or atleast weaken am make him surrender.
Sure, e no dey easy and Bitcoin alone no fit stop Putin from invading Ukraine but Bitcoin fit be part of the solution wey fit send Putin regime to Gulag 😊

How Bitcoin fit contribute:

  • Russians go disapprove Putin war by using Bitcoin. As all of us know, Putin dey fear to lose power. Him be dictator and dem no go fit remove am democratically, so people need to make democratic decisions. Bitcoin na democratic tool and him no fit ban am if the people choose to use am instead of him Ruble.
  • We, as allies of Ukraine, go help undermine Russian Ruble, de national currency of Russia. E go weaken de Russian Ruble, and a fragile Ruble go weak Putin ability to buy or manufacture more weapons = less people go die for Ukraine from Russian missiles and Ukraine go fit push de Russian troops back comot from Ukraine.
  • If Putin still dey rule in an authoritarian way, make Russians refuse to dey pay taxes as to dey pay taxes for de country wey free and fair election never take place for dey optional. By doing so, people fit force a democratic election and vote Putin out of power. Eastern Germany collapse in de same way.
  • Bitcoin fit help us send aid to Ukraine as initiative from icopress or JohnnyUA don show us.



Sometime ago I bin write dis topic Bitcoin can help a bit to reduce spreading of coronavirus, e get small help wey Bitcoin fit bring as e no dey like physical cash, wey fit carry de virus.

E get another aid wey Bitcoin fit bring: help people from Ukraine wey no fit receive fiat donations, bitcoin dey unstoppable. G7 don sanction Russian but e no dey enough to shake de currency too much, bitcoin fit help for here as well. E no dey too much but na something! And, as we dey use bitcoin more, we all dey make am more powerful and de power dey come back to help us. E no dey much but at least, we fit do something to help Ukraine thru bitcoin.

So help Bitcoin help Ukraine!
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
Thank you nheer as you don help me translate dis topic  for me. You don do another good work!

This topic de very special for me, e de touch me well well anytime i think about how Satoshi manage change d whole world and blood no flow from anybody! Dis be more of a philosophical writing, but e de state true fact: all of us bin live (and we still de live) inside bloodless revolution.

Satoshi bin no ever wan blood. Him bin just wan free us. Free us from banks, from government oppression, from any third party wey just wan steal for our hand in any way. Him don carry bitcoin come for us for free and we fit get full control of our moni since d time wey bitcoin come
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
Translated Topic in Pidgin Language: Bitcoin - Revolution wey de bloodless
Original Topic: Bitcoin - a bloodless revolution
Author: GazetaBitcoin




All revolution de imply say blood must flow. Na why revolution flags de always red.

Since spatacus’ rebellion (71 - 71 BC) go American Revolution (1765 - 1783); from French Revolution (1789 - 1799) go Hungarian Revolution from Budapest (1956); from Prague (1968) go Carnation Revolution from Portugal (1974); from Mexican Revolution wey na Emiliano Zapata salazar lead dem (1910 - 1920) go Great Proletarian Cultural Revolution wey Mao Zedong launch (1966) go Nicaraguan Revolution (‘60 and ‘70) and go Romanian Revolution 1989. And d list fit continue sef. All revolution get their bloodbaths. Their leaders bin get purposes wey dem bin de fight for, but none of dem bin succeed bloodless revolution.

Until Satoshi Nakamoto

Satoshi bin no get intention say him wan be revolution leader, buh wetin him bin create -- Bitcoin -- bin revolutionized the whole world. E bin take power from d hands of senior men con carry am give d piple back. Piple con begin de fit control deir own moni and nobody con de force dem make dem involve third parties. Bitcoin con cancel middle men and dem governs and banks con de irrelevant for piple wey de rely on bitcoin. E de disrupt traditional moni and e don implement a new paradigm. A purely peer to peer version of electronic cash wey go allow make we fit send online payment directly from one party to another and e no go pass through any financial institution. Bitcoin na im be d first revolution 4 history wey blood no flow.

Nobody bin die make bitcoin take prevail. For bitcoin revolution dem no scatter anywhere, dem no massacre piple, dem no kill anybody and dem no do any dangerous thing wey de happen for other revolutions. E bin help poor piple and piple wey hunger wan kill to get chance live and fight for their lives. E con help piple connect from all over the world. And no political leader fit shut bitcoin down. D revolution don de continue pass 10 years now.  And everyday, e de get more adept.

Plenty times i don ask myself how bitcoin manage run dis bloodless revolution thing sef. And sometimes i go con de think say, somehow dis bitcoin revolution followed the rules Of Saul Alinsky. Alinsky na American activist, and among others, na him write the rules of successful revolution. As e de easy to see, non of his rules imply any violence

Rule 1: Power no be d only thing wey you get, but na wetin opponent think say you get. -- Since e show, govern’s, banks and other elites con de fear Bitcoin. Dem de feel say dem go loose all the power and authority weg dem get until then dem con begin de see bitcoin as big enemy, although bitcoin bin jus de him first days.

Rule 2: Whenever e possible, go outside d experience of an opponent. For here u go wan cause confusion, fear and retreat and ways wey him no go sabi how he go fight against. -- Elites no de ever fear say dem go loose their pawa over citizen. After all, govern’s and banks don de oppress piple for thousand years sef. Yet wen bitcoin land, together with him new pattern of peer-to-peer financial deals, join with pseudonymity wey dem fit improve well well tru tumblers and coin join, all oppressors con begin de confuse. Next thing wey dem feel na fear. Dem no sabi how dem go take fight bitcoin. And plenty years don pass now wey dem don de try shut down bitcoin but e no work.

Rule 3: Make opponents live up to their own book of rules. -- Bitcoin bin fight against elites with deir own pawa, as elites bin strip piple wey dem no get control of deir money for plenty years, naso bitcoin do too, wey him give piple back d pawa to control deir own moni.

Rule 4: Ridicule na im be man’s most potent weapon. E de hard to counterattack ridicule, and e de vex d opposition, wey go con react to your advantage. -- Governs de always wan sabi d amount of money wey each citizen get and how dem de spend deir money. Satoshi build bitcoin in a way wey e go rubbish d greed wey government get make dem sabi all d transactions wey every citizen make: you fit see all bitcoin transactions for blockchain, wey be public; yet d addresses of persin wey send and persin wey receive na just strings of alphanumeric characters, wey de give out no names, no surnames, no personal information (assume say users no give deir personal information to third parties like dem centralized exchanges). Wetin Satoshi invent don use states eyes see shege and e be like e de say: “shey you wan know how much moni i get? Here you fit see am. Shey you wan see all my transactions? You fit see that one too. I don make am public, for your eyes. But wetin u no sabi na who i be.

Rule 5: Tactics wey dem de use for too long go turn wahala. Commitment fit turn ritualistic as piple de turn to other issues. -- Therefore dem need changing, even na small one. Bitcoin bin pass through changes during last decade. From segwit go bech32 and from taproot go plenty Bips, bitcoin bin change as time bin de go.

Rule 6: Keep the pressure on. Use different tactics and actions and use all events of d period for your purpose. “The major premise for tactics na d development of operations wey go maintain konstant pressure upon d opposition. Na dis thing go make d opposition react go your advantage.” -- Since bitcoin land govern’s and banks begin de feel pressure wey still de continue de grow constantly. Plenty time don pass wey piple get financial problem na bitcoin piple con de use. And d more dis kind terrible problem de happen, d more piple de embrace bitcoin, wey don lead to huge pressure ontop governs shoulder, as dem don de see say d power wey dem take de control piple don de fall comot for deir hand and piple fit organize dem self on deir own without the intervention of State, banks and other third parties.

Rule 7: Pick d target, freeze am, personalize am, den make u polarize am. -- Bitcoin don choose im target even before dem born am: D financial system wey de exist, d middlemen, d govern’s and d bank. Dem bin show deir intentions, in a subtle way, even from em genesis block, wey dey carry d following message: ”Chancellor wey de ontop brink of second bailout for banks".

We fit get many years to live and naso our children and grandchildren fit get. Yet, i no know if we go fit ever see another revolution wey go de bloodless for future…
full member
Activity: 280
Merit: 111
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
u get anoda one wey newbie fit translate bcus de rest wey I don read for ur work get photo for dem

I thank you say u dey interested. Actually eh, e still get oda topics wey dem fit still translate to pidgin and u fit see am here. But d tin be say, I nor dey work with low ranks. Sorry. Abeg no vex.
Okay Boss
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
u get anoda one wey newbie fit translate bcus de rest wey I don read for ur work get photo for dem

I thank you say u dey interested. Actually eh, e still get oda topics wey dem fit still translate to pidgin and u fit see am here. But d tin be say, I nor dey work with low ranks. Sorry. Abeg no vex.
full member
Activity: 280
Merit: 111
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
I throw away salute for u Davidvictorson for d effort wey you put to take translate my tori! Wetin u do mak sense! And e dey sweet me for belle to see say one more of my topic don dey translated for Nigerian Pidgin language  Smiley

u get anoda one wey newbie fit translate bcus de rest wey I don read for ur work get photo for dem
legendary
Activity: 1666
Merit: 6436
Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker
I throw away salute for u Davidvictorson for d effort wey you put to take translate my tori! Wetin u do mak sense! And e dey sweet me for belle to see say one more of my topic don dey translated for Nigerian Pidgin language  Smiley

Dis tori na very important one for history: Phil Zimmermann and him invention wey e call PGP. D creation of PGP dey very important for cryptography sake of say all cryptography dey base on top PGP. Phil na genius and without am, we nor fit tok where cryptography for dey today or how our private communication go fit dey work.

Him na strong man for him time and now all of us dey benefit from wetin him create. Na im make i reason say this tori need for bitcoiners to read am. Make we nor forget those pipo wey first hustle for free cryptography, cryptography wey everybodi fit access and use now!
Pages:
Jump to: