Author

Topic: Kids in Nigeria should be taught financial education and literacy. (Read 60 times)

full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
To help your pikin build financial literacy skills na like to give dem superpower wey go help dem for their whole life. See some of the great things wey fit happen when your pikin learn about money from early stage:

Buddy this is one aspect of the financial life that I feel like we need to give more attention to right now, it is very important for us to give our children the knowledge of what monetary resources are and how they should properly manage their finances from their childhood.

They need to first understand the value of currencies and the benefits of savings and investments and I don't want this to be streamlined to the efforts of the schools alone, but I also want the parents to take that burden onto themselves, to educate their children on what it means to have a prudent financial life because if your kids are properly informed about these financial decisions from beginning, it becomes easier for them to take decisions and manage the resources that are availed to them at a particular point in time.

Many of us today suffer from this issue of financial mismanagement because up till today we are still struggling to learn how to manage our finances. So, just imagine if we've been taught of these things from our early age, it would have become a lot easier for us now to take good care of our finances rather than trying to learn how to do it right now.

Families have been broken down here in Nigeria for lack of financial planning and these things are happening at the parental stage, not even at the stage of the kids. Now, imagine the great impact this is going to have on our next generation, if and only if our parents, who already have the financial discipline, can replicate that to their kids.

The key benefits that comes with acquiring these financial knowledge at one's tender age is that it not only helps the individual to have that financial discipline but it also contributes to the economy of the community, at large.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
To help your pikin build financial literacy skills na like to give dem superpower wey go help dem for their whole life. See some of the great things wey fit happen when your pikin learn about money from early stage:

E go help dem make better choices with their money as dem dey grow. Dem go sabi the importance of how to make money, save am and spend am wisely.
Dem go dey better for making decisions about long-term investments, like buying house or starting business. This one go give dem financial security.
Dem go dey less likely to carry debt, especially debt wey get high interest rates. This one go save dem plenty money for the long run.
Dem go get better credit score, wey go make am easy for dem to borrow money for things like car or mortgage. Plus, e go make am easy for dem to achieve their financial goals.
Studies show say pikin wey learn about money from young age dey more likely to make good financial decisions later for life. So, start to dey talk to your pikin about money today and give dem the tools wey dem need to succeed.

You are right but you think say that one go work easily? Many parents for this life now they train their kids like prince and princess, even the ones wey no get money dey train pikin how to chop life, how pikins go take grow up with good  character wey the parents too na stupid lifestyle them dey live, no any pikin wey you go see for naija now wey go tell you say he or she Sabi manage money, everybody own no pass to chop life and be like the other people's without not knowing where those people are getting money from, my brother na only poor man pikin I know say he or she go talk say them go manage because there parents no get and if poor man pikin catch money like this ehn them Sabi lavish money like say tomorrow no dey.

The only way we go just do be say, try dey make your pikin understand life and even if them grow up you should continue to be advising them because no matter how you take wan control your pikin he or she must wan live expensive life, mostly you go hear our elders are saying the children of nowadays need prayers because no matter how you want to explain things for them they won't understand until they finish what they want, so as this life be now prayers na the big weapons.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
All this your concept for be true but I no see am the way you dey see am. So many children when even sabi money too early self they too much misbehave. Most of the them wey I sabi don dey jail, will some don die. Reason being that too much exposure to money at early age they make many youth misbehave dem go dey put hands for wetting no good by stealing and kidnaping because money don finish and then know no how them wan cope with that condition. So the easy solution na crime to them.

No be say I dey criticize young people wey see money at early age but just to let you know say to succeed for business no be by seeing money for early age. Na just for you to get that ability and market understanding and having that special skill of creativity and devising means and strategies to carry succeed without complain.

Sometimes wetting they make people explore for the market wey dem dey do na  because them discover themselves in where dem belong in term of business. Before you fit succeed you must discover where your talent dey and focus only on am sothat you go do well.
full member
Activity: 280
Merit: 159

~snip~

E day very surprising as you take time create all this things, because dey don dey teach children financially studies tey tey. From primary school day don teach you home economics and in Jnr secondary school day for don teach you economics then why you come create this topic?

I get question for you OP, can you differentiate between financial education and economics for me? Because if you don do that you go know say what you day try talk day don day teach am since unless if dey never teach you before nah why you create this thread be that.

I go advice you to delete this thread or just lock am because this discussion no get use
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Studies show say pikin wey learn about money from young age dey more likely to make good financial decisions later for life. So, start to dey talk to your pikin about money today and give dem the tools wey dem need to succeed.

But I don't really know how this take be realistic. If you begin make money for young age no still be guarantee say you don arrive because something can change anytime. The problem about early wealth na management. To me most people wey make money for young age still find am difficult to grow the money until dem go lose am either by spending the money too much for family and relatives. Again, as a younger person you might be carried away with the influence of peers and women
full member
Activity: 518
Merit: 156
No be bad thing watin you talk, as least to teach our children about financial consciousness and how to control money and let it work for you. But before we embark on this journey, make we take time reflect into our society. We are in a society of where more than half of the population are living in poverty, way be say e no easy for poor man pikin to see money to chop, not to even think of investment or having a good financial plan, see in life, you can only make do with what you have, Baba watin Nigerian children dey face now, na serious financial crisis, don't forget that a sound mind is a fertile ground for learning. Watin Nigeria children need, na how to take commot for poverty way government don put them, after that na we go fit talk about educating them about financial education.
full member
Activity: 196
Merit: 123
Actually financial education is one key a man needs in his daily lives to be successful in this turbulence world, but it's not everyone that have access to it due to the fact that it's not been thought in school, but if as an individual you went extra miles to get knowledge of it, then it's very good if our offspring is being taught about it.

It will be very good if children are being taught financial education because it makes them well equipped for the life ahead of them.
Financial education don't just gives you financial stability, it also makes you make better financial decisions. The Nigerian education system is built and arrange whereby once someone is done with his or her education, he start looking for a job, instead of looking at business opportunities he can explore. The rich dad poor dad by Robert kiyosaki explain better of what financial education entails.
member
Activity: 308
Merit: 26

Jump to: