When I been dey school dat year, e get one lecturer wey dey always dey busy but him no dey achieve anything. Like as him dey from my year one na so him still dey until I graduate. I no know him life outside the university walls if e dey okay but his appearance no change like person wey dey touch money. People like dat plenty for this country, you go see dem busy for nothing and yet dem no dey go far.l for life.
I wan take this discussion out of the office to our normal life as we Nigerians we sabi busy for nothing as we no dey give ourselves breaks that's why you no fit see the average Nigerian's dey chill out or take vacations. Na always work, work work, no be say the money no dey but we believe in been busy always. Make we dey value productivity ahead of been busy the meaning of productivity dey the name so make we dey do things wey go make us dey productivity and not just busy.
If we just dey do busy all the time, at the end of the year we go see say nothing come out. In any activities wey we dey do, look for things that can make you productive and not just busy. We need to change the mindset that being busy is equivalent to being productive. Also make we dey more selective of the kind business or job wey we dey do because there are some jobs that just keep you busy without making you productivity. Been productive affect your general life so the more productive you get in your job or business, you go begin see other differences for your life.
But you know wetting i understand nah miscommunication cause that thing. E they very bad wey be say we wan do something and we no get the right information or direction we fit end u doing wetting they no go accept. This topic done bring us up to the matter of being inquisitive and making more findings on whatever we want to do so that we will do the right thing at the end. Because i know say if we achieve only one thing correctly e better pass 5 things wey no they in line with weting we suppose do. Having the right information's is necessary for being productive.