mr Hewlet, if you consider wattin the op sef dey talk na still true mater, most of our youth of nowadays dey sabi select work wey dem go do, i remember clearly for all those 2015 if you say make you go find work for boutique or sales boy or sale girl work, you go waka tire and the one wey you go com manage see dem go just dey turn turn you around until dem go tell you say dem no fit hire you, the one wey pain me pass naim be filling station work as a pump attendant, but since around 2019 come reach now, na so so sales boys and girls vacancy naim i just dey see for street, no be say boys or girls no dey the street oo, but na because of say many of dem don dey run street(yahoo). both the gils dem now no wan even carry hand touch work again dem dey either do olosho work or dem dey depend on boy friend for basic necessity. if you go warri now you go hardly see young boy wey dey do oghoaja work(aka concri) na people mother them naim dey very serious dey do the work. if you even recommend dem to do some online legit work dem sef dem go tell you say e too hard, forgetting say no good thing comes freely for this our stage.
The pump attendant job nah one of the most active job way many pipo dey won do because that one e dey easy for those way like am and small small things for dey enter your hand because if pipo plenty for filling station most of them dey do ojoro and sometimes your fuel fit no complete but based on say crowd dey you fit no get the opportunity to check the merer before you even pay.
Although most times them dey run at lose but according to watin one of my friends talk, she say the time way you go gain plenty pass the times way you go lose and she say she like the job because pipo dey dash her money most times....
Talking about laziness, for me I go say na naw nah we dey dey lazy to do work, think back those days way we dey work like Jacki
, although things must change for good, as oyibo dem dey lazy and things dey go well for them, so e no mean wether we lazy or not because most times hard works no dey pay if we jo dey apply wisdom.