One advice I dey give people na say, no go invest money make hunger go kill you oh. As you dey invest, keep the one wey you go chop and if things no work out as you plan am no hesitate to sell but for only important things that need monetary attention. The market no dey stay up forever opportunity to buy again go come. Apart from emergency, sell when you dun reach the target wey u been set from the very beginning of your investment to avoid regrets. Shey e get reason why you Invest in Bitcoin (fit be to get money to pay for school fees or house rent etc) when you each that target just sell and take profits so you no go dey regret tomorrow if the bear market come. When you sell you fit buy again and our mind go strong because funds dey account to use hold body.
Di boss, I thank you for making dis clarification, because I know understand why people de complain so much if person sell im bitcoin take solve important financial needs way arise or if di person sell am when im if feel say enof profit don accrue for im investment. One of di essence of investing na to fall back on am wen you see something of value wey you wan aquire. Aldo e de good to get target or goal of wetin you wan use di invested bitcoin to do in di future, no be to just leave am there de look as price de pump and dump without any plan. Dem say if you see wetin pass yam you go sell di barn, sodiafo, if you see something wey worth say make you sell your bitcoin, dat na better investment decision. Di person fit still start again, because bitcoin investment na continuous thing.
Where e bad be say if person no plan well, go sell di bitcoin wey im don suffer de invest, go put am for something wey no get head, na dat one regret dey de.