I haven't been on here due to some circumstances.
I left home since morning before my family were up and I just had to talk to my mum that I went out so earlier for something very important to me on the phonem. Then everyone has believed it was ought to be something productive just as I hoped it was going to yield incomes but here @ 10:20 PM I struggles to even secure transportation back home to my family.... May the creature of all provisions provide for all hustlers.
The way this country take they so, person go dey think say na him own take spoil pass, but if you hear another person side story you go go realize say you never see anything for this country, if you even decide that make you comot for house go find something to do wey go add something value to your life, where you go take see any work to get paid on a daily, for this country the work wey u go see if you also do am finish, the money wey dey go pay you will not even enough for only you to chop for one day, not to talk about the family sitting at home expecting you to come back with a good news, everybody just dey face am differently, we have no choice than to face whatever that come.
We need to keep hustling because na person wey work dey chop, we should not get tire of whatever we are doing, given up is not an option, let keep pushing, let be patient one day we go succeed.