This na really beta thread you just bring up my Oga, because for me, I don dey use Remitano for more than 3yrs now and since then I can proudly say I never get any issue with them, but no be say I no dey use Binance oh, but i don dey use to Remitano & na him I dey use the most, bcos one good thing about Remitano be say if for instance you try to withdraw Naira now, in less than 5 minutes you go don see alert for your phone, very fast and convenient.
The steps just dey very simple & here is how to go about it
Step 1: While using Remitano, the first thing you go need to do na to just log in the app, then click on the down side wey they write "wallet" and after that you select the coin you intend to deposit (i.e BTC)
Step 2: After you don click on the deposit button, eh go carry you come this side wey you shown below and all you need to do na to just copy the wallet address wey you go send the coin to and make sure say you deposit more that 0.0001 BTC, if not your fund no go deposit inside your wallet and you no go see am again.
Step 3: So after the BTC don land for your wallet, the next tin to do go be to go swap your BTC into NGN as you dey see below. All you go need to do na to just input the amount wey you go wan swap into NGN, and this process dey always dey instantly.
Step 4: So after you don swap your BTC into NGNR, the next step go be to click the withdraw button as you fit see below, and eh go take you go the next step
Step 5: So after you don click step 4, eh go carry you come this side all you need to do na to just select your bank, input your acct number & in few minutes you go see alert for your phone. Very simple