Author

Topic: Make we try dey cautious online (Read 121 times)

sr. member
Activity: 658
Merit: 441
January 26, 2024, 02:11:37 PM
#14
Thank God say you no send the money. One of my guy get same experience aby a month ago. I no know wetin really happen, wether dem steal him phone or hack am but one of him contact pasted the message on owa departmental whatsapp group, na there many persons come confirm say them receive same message from the unauthorized user wey gain access to the phone.

Wetin I know be say most of this whatsapp hack dey happen through phishing links mostly on Facebook, make we know how you dey click links wey go redirect us to WhatsApp. Also whenever person get message like this, always call your friend first to confirm before making the transfer.
full member
Activity: 448
Merit: 163
January 26, 2024, 01:28:06 PM
#13
Honestly scammers are so common these days, it is crucial that we set up two-factor authentication or solid security for our data. You never know when they will gain access to your phone or personal data. Facebook users frequently have hacked accounts; some may simply inform you that your account requires maintenance while conversing. Make you give the information so they can assist you. Never respond to someone who behaves in such a manner; instead, ignore them. Think about how much has already been rescued.

I'm not even sure what they're up to, so tey they're fine a technique way to hack WhatsApp. As things stand, we should avoid collecting any unneeded links that some of our friends have sent to us via WhatsApp, because some will undoubtedly direct you to places you did not intend to visit.
full member
Activity: 560
Merit: 161
January 26, 2024, 08:59:51 AM
#12
This na something wey don dey happen before now wey hackers don use scam friends and love ones, when we get message like this from people asking for money for help even if we dey willing to give make we try make sure say before we proceed it is important to  contact the person which we recieve message from to be sure that if it is the real owner of the contact . Many people have fall victim of the incident like this.
full member
Activity: 476
Merit: 230
God is All
January 26, 2024, 08:18:30 AM
#11
Thank you for sharing this information here because me as I dey like this I never see am before say scammers dey hack people account dey request for something for people who dey closer with the person wey get WhatsApp, Omo no be small thing person dey see for naija this days ooh, every day for naija you must hear some news and those news no go be good news, E don even reach the stage wey be say them they hack people account, na waw oh, for me sha even before na 2 step verification I dey put for my things because even people wey dey closer to me I no trust them talkless of another person.

This advice wey you give, you do well and he go make some people wey never put 2 step verification for their important apps go put am because as this one dey like this now even if you dey serious and want to borrow money with your people or person want to borrow money with you, you will not trust anyone again, you will want to see the person face to face and maybe the person dey where E no go fit call you, you will not know, na waw for naija, just fear naija in anything you are doing.
My brother the matter tire everybody for the country, like this the way the thing don be eh na to dey very careful with your mobile because this matter of Facebook and account hack is too serious. There is this one way dem go even call you about your siblings or someone related to you being very sick and the person dey hospital and needs emergency deposit which dem go impersonate a doctor and the person follow you talk and if you are naive enough to fall before you go know you don send money give the person.
full member
Activity: 1358
Merit: 207
Catalog Websites
January 26, 2024, 08:10:16 AM
#10
Na God really save u from dat scammer hand because, assume money dey your hand at dat moment, I no say u for send d money to save your friend life but God com do am in a way u no com get dat kind amount of money for hand.

 I don see things like dis from my friends wen I was in school those days, and someone hack my friend Whatsapp number and started sending messages to his Whatsapp contact and d message got to me and my friend that own the WhatsApp number were there with me to see d message and he was shocked with d kind message d hacker send which anybody dat see dat message must respond unless d person no get d money, Dat is why if I wan send money to anybody dat ask me money online, I will make sure I call d person to hear his or her voice before sending d money.
sr. member
Activity: 700
Merit: 470
Hope Jeremiah 17vs7
January 26, 2024, 02:42:20 AM
#9
This na common thing way been don Dey happen for a long time on Facebook only say, e just Dey reach WhatsApp. Still, one means to verify this kind matter when e sup like this na to carry your phone and call your friend number. Make you for heat from en mouth say, na him Dey ask you question. Things just Dey happen these days and you just gats Dey very careful and get a skeptic mind about just anything.
Person fit still call you, tell you to carry phone give another person (business person) and authorize a transaction and na you them go hold.
You just gats Dey cautious about everything. People eye Dey red and people way no fit handle am Dey sell there integrity for small change.
Try Dey verify anything, especially when e no be the person nature to Dey ask or behave in a way you Dey observe.
Yes the thing dey common na make me surprised my friend never set up  2 step verification for he whatsapp, I nor first believe say people or youth still dey like that and that reason make me bring am here so that people for here wey neva do their own, go quickly go set up now
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
January 25, 2024, 06:21:04 PM
#8
This na common thing way been don Dey happen for a long time on Facebook only say, e just Dey reach WhatsApp. Still, one means to verify this kind matter when e sup like this na to carry your phone and call your friend number. Make you for heat from en mouth say, na him Dey ask you question. Things just Dey happen these days and you just gats Dey very careful and get a skeptic mind about just anything.
Person fit still call you, tell you to carry phone give another person (business person) and authorize a transaction and na you them go hold.
You just gats Dey cautious about everything. People eye Dey red and people way no fit handle am Dey sell there integrity for small change.
Try Dey verify anything, especially when e no be the person nature to Dey ask or behave in a way you Dey observe.
sr. member
Activity: 574
Merit: 290
Bitcoin in Niger State💯
January 25, 2024, 05:14:10 PM
#7
The security of our data, information and device is very important and that's usually from the angle I do examine it from in the first place. Then, Secondly, is that you need to protect your WhatsApp by all means and avoid engaging in unsolicited links in the name of looking for opportunities in the internet.

The way and the manner at which people try to hack other people's accounts on WhatsApp and spam their accounts with the ulterior motive of stealing their information or using the account to extort money from the family and friends. It's unfortunate really to get people who are always after taking resources meant for others which is a very wrong thing to do to manipulate people is as well as stealing from them.
sr. member
Activity: 476
Merit: 316
Get $2100 deposit bonuses & 60 FS
January 25, 2024, 12:01:11 PM
#6
Before you go send person money for Naija, even though unah don talk for online about the money, and in send you account details where you go send the money for am, make you try to call am for phone make you dey very sure say na the real person you talk with for online. Make we try to commote our phones for fingerprint security so that if we dey asleep, our brothers, sisters, and friends no go use our fingers to open our phones to collect our important information wey we no know. 
The 2-step verification wey op mentioned na good thing to use guide our account because if someone knows your account login details, he or she must provide the code in the 2-step verification authentication before he or she can log in or move an asset.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
January 25, 2024, 11:25:28 AM
#5
Omo i nor know if anybody for here don first experience or get person way don experience this matter way be whatsapp hack. One of my guy message me for whatsapp on monday say make i help m transfer money go one account way he go send me bcos he don reach he transfer limit but I thank God say the money way he be dey ask for nor dey my account at that time bcos I go for send m fast for am, since I know say he dey highly capable to pay back.

But yesterday my guy cor post for whatsapp status say make everybody way receive that message nor vest, say person be hack he account and he just recently get am back. The thing suprise me and i cor ask am say why he nor vest set 2 step verification for he whatsapp, he say he never first reason that side.

I bring this thing come here say make we dey cautious online, even if we know person well well, nor mean say hackers nor fit get the person account and so anytime person way dey close to us ask us for money (including bitcoin) or any sensitive information from us, make we dey careful and try to see the person first physically or at least call the person to verify bcos things dey happen online, infact even for our bitcointalk forum so, account hack don dey common, we dey see as some of our members of this forum way don come out, cor talk say nor be them borrow money with their own account and come out with proof and now since person way be wan help person now cor dey get their money back, to borrow for here nor cor easy as bfor.

My other advice na be say make anybody way never set 2 step verification for Whatsapp or any other social media account way he/she go set am. 2 step verification get different ones, just observe m and check the one way dey well and secure for, Nor go use over protectivenes tel lock account.
See YouTube video on how to set 2 step verification on WhatsApp and Facebook
Facebook and WhatsApp

Also you fit check this site for ways to set up 2 step verification for other social media and platforms.
How to set up two-factor authentication on your online services
OP na God been get your back that on Monday ohh if not you for explain trie but Wetin I never understand na how the guy scammer tak get  link to him what app OP this should explain to us that this person must have been close to him or most have some little information about him  if it is truthful
This must have teach us how we should not trust people you never can tell who is your enemy.

Back to the topic about the two ways or two steps verification so you mean person no fit enta ur whatapp without ur permission?? If u don verify am.
But OP @Amphenomenon come to think of it does this has to do wit email verification too and adding some password too because without this two some scammer are very smart and they can just use any little information to get inside ur phone.
All of us wey dy for this crypto space and those using the internet need to know that scammers are getting sophisticated everyday, them no need too much information from you for them to hack your account, some of this online scammers na wizard in computer and even coding, so for we to survive here without falling into there hand, we need to get sophisticated also with our security by paying close attention to the smallest details, no allow even the smallest details go out, if not you go pay dearly if e enter the wrong hand, and another thing wey dy really important na that 2factor verification wey the op don already talk about, people no know how important this tin be due to ignorance or lack of knowledge but anybody wey take security serious for this life no sopos carry am play.
sr. member
Activity: 714
Merit: 347
January 25, 2024, 10:45:36 AM
#4
Thank you for sharing this information here because me as I dey like this I never see am before say scammers dey hack people account dey request for something for people who dey closer with the person wey get WhatsApp, Omo no be small thing person dey see for naija this days ooh, every day for naija you must hear some news and those news no go be good news, E don even reach the stage wey be say them they hack people account, na waw oh, for me sha even before na 2 step verification I dey put for my things because even people wey dey closer to me I no trust them talkless of another person.

This advice wey you give, you do well and he go make some people wey never put 2 step verification for their important apps go put am because as this one dey like this now even if you dey serious and want to borrow money with your people or person want to borrow money with you, you will not trust anyone again, you will want to see the person face to face and maybe the person dey where E no go fit call you, you will not know, na waw for naija, just fear naija in anything you are doing.
jr. member
Activity: 79
Merit: 1
January 25, 2024, 04:30:05 AM
#3
Omo i nor know if anybody for here don first experience or get person way don experience this matter way be whatsapp hack. One of my guy message me for whatsapp on monday say make i help m transfer money go one account way he go send me bcos he don reach he transfer limit but I thank God say the money way he be dey ask for nor dey my account at that time bcos I go for send m fast for am, since I know say he dey highly capable to pay back.

But yesterday my guy cor post for whatsapp status say make everybody way receive that message nor vest, say person be hack he account and he just recently get am back. The thing suprise me and i cor ask am say why he nor vest set 2 step verification for he whatsapp, he say he never first reason that side.

I bring this thing come here say make we dey cautious online, even if we know person well well, nor mean say hackers nor fit get the person account and so anytime person way dey close to us ask us for money (including bitcoin) or any sensitive information from us, make we dey careful and try to see the person first physically or at least call the person to verify bcos things dey happen online, infact even for our bitcointalk forum so, account hack don dey common, we dey see as some of our members of this forum way don come out, cor talk say nor be them borrow money with their own account and come out with proof and now since person way be wan help person now cor dey get their money back, to borrow for here nor cor easy as bfor.

My other advice na be say make anybody way never set 2 step verification for Whatsapp or any other social media account way he/she go set am. 2 step verification get different ones, just observe m and check the one way dey well and secure for, Nor go use over protectivenes tel lock account.
See YouTube video on how to set 2 step verification on WhatsApp and Facebook
Facebook and WhatsApp

Also you fit check this site for ways to set up 2 step verification for other social media and platforms.
How to set up two-factor authentication on your online services
OP na God been get your back that on Monday ohh if not you for explain trie but Wetin I never understand na how the guy scammer tak get  link to him what app OP this should explain to us that this person must have been close to him or most have some little information about him  if it is truthful
This must have teach us how we should not trust people you never can tell who is your enemy.

Back to the topic about the two ways or two steps verification so you mean person no fit enta ur whatapp without ur permission?? If u don verify am.
But OP @Amphenomenon come to think of it does this has to do wit email verification too and adding some password too because without this two some scammer are very smart and they can just use any little information to get inside ur phone.
sr. member
Activity: 350
Merit: 254
Enjoy 500% bonus + 70 FS
January 25, 2024, 03:49:20 AM
#2
I don get similar issues like this before but no be for WhatsApp but Facebook. Where them hacks my guy Facebook and the person come dey tell me to invest and get double of wetting I invest, and my guy wey I know no ft do that kind thing which I know. So I come call my guy directly for phone say which kind investment him dey talk about for Facebook na. Him reply say make I no mind that fool wey hack him ACC say make I no answer am say no be him be that. So if I no dey smart enough I for think say na my friend not knowing say na scammer.

We need to dey careful when we receive that kind of message. just like the way I do if you notice any suspicious attempt make you just call the person directly before conclusions because if them hacks social media accounts dem no fit hack your voice or hack you call.

These thread na A very helpful thread, thanks for bringing this to the board sothat people go also learn about 2 step security verification.
sr. member
Activity: 700
Merit: 470
Hope Jeremiah 17vs7
January 25, 2024, 03:15:59 AM
#1

Jump to: