Author

Topic: Merry Christmas 🎄 but no fail to protect yourself (Read 121 times)

hero member
Activity: 1316
Merit: 379
WOLFBET.COM - Exclusive VIP Rewards
When making Merry celebration like this, we need to exercise caution in most of the things we do during this period, we have to watch what we eat, where we go things we do and so on, but ket me cap them all under the following headlines below:

1. Don't post while amidst celebrating with other people
2. Don't get drunk and cone online to post as well
3. Avoid excessive eating of food or drinks
4. Avoid indescriminate outings or occassions
5. Don't let the celebration period be your own vulneble time to get attacked.

I think dis na de most important part of the forum bicus many of us fit loose guard go cap anyhow onto say dem dey celebration or if dem go drink and e happen dem don over drink you go just see pesin carry him phone come cap nonsense for here de vomit wetin no good for dis side of our hustle na wetin make me no carry highness dey near this section for any dey.. although me like to dey high at times but na coded onto say e no go too affect me here becuse we need to dey carry clear dey follow dis forum otherwise person fit go village him no go return back from dia we go say na village people do you meanwhile na you do urself.
sr. member
Activity: 602
Merit: 260
Merry Xmas you all. Nah true talk b this Una know Shey this kind celebration time many pipo dey lose guard thinking Shey nah every body like dem the way you too like dem no matter how you tey nice you go still get hater for one side. So as we dey celebrate make we jejely stay on our guard nor go too trust who nor deserve am. And mine the things it and where you eat it. So wish you all a peaceful and a safe celebration.
legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
I greet everybody for this our local board and i dey wish all of una merry christmas and better new year in advance, no forget to enjoy yourself well well in this festive season oh, the year has not been easy, but this na time of celebration, so make we forget about our problems and that of our country and share love with our loves ones. No forget to also help the less privilege too abeg, anybody wey you fit buy food for in this festive time, abeg do am. Well done to everybody and take care.
sr. member
Activity: 182
Merit: 120
The best thing is to avoid such place cause now no one is trusted, even your best friend might be the worst enemy, this thing dey happy for everywhere it's best to stay safe this season and some people will refuse to listen all in the name of trust, when I hear stories like this it pissed me off and na season like this things dey happen cause they believe say everybody dey celebrate the season, except from festive season people dey always act like this and any person wey fall mugu will face the consequences.
Now e get one common mistake Nigerians dey make now all in the name of celebration and flexing, nothing bad to flex but if you're a man of high standard or get influence even without influence this season  kidnappers full to kidnap little children so if going out with your kids it's best to stay watchful and protect them at all means.
full member
Activity: 162
Merit: 104
As you see me like this I never even reason to dey moved out every December 25 and December 31 against 1st of January, me dislike this period so bad wey be say people fit poison you because of say you don dey carried away especially for club when you don high with small drink everything go come make you funny and you go feel say every body dey feel dey wey you dey feel without knowing say e get people wey dey watch you to drug you or poison your drink so that person life fit just end.
sr. member
Activity: 854
Merit: 451
2. Don't get drunk and cone online to post as well
Dis one na better talk ooo, make you no go drink come forum come dey post anyhow ooo, people wey dey dis forum no wan hear say you drink na y you make mistake be that ooo. If you wan drink, make sure say you no even on your data not to even talk of say you go even enter forum here. And even if you go drink, Abeg make e no too much, everything wey we dey do, limit suppose dey, no drink in excess just because you dey celebrate Xmas, make we dey drink responsibly and make we stay safe.

3. Avoid excessive eating of food or drinks
Haaa Boss, if food dey make you chop ooo, food na something wey be say if you reach limit, nothing wey u fit do again than make u just leave the remaining one. Na just alcohol I dey against because I know say excess of that one fit cause problem wey go pass your power, so as we dey celebrate dis Xmas, make we drink responsibly.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Na true talk you bring come today wey be say na di day wey we dey celebrate our dear Lord Jesus Christ wey come to the world to save mankind. And since the day is only meant to celebrate Jesus Christ then most of the events and parties are contrary to the purpose of the celebration or the day. Christ would not you to celebrate the day with awkward ways. Drunken should be avoided, going to Beach Parties, Clubs and other social gathering which is not of God should be abandoned and only follow the Biblical way of celebrating.

As op talk am na so many people carry die go because of their carelessness. Though today na di day we shared foods and drinks but you have to know where you drink and eat. Not all the people stay around you are neighbors.
sr. member
Activity: 476
Merit: 316
Get $2100 deposit bonuses & 60 FS
Op this matter don make a lot of people die well well for we country. This season na the time wey friend they use to poison the friends wey they are jealous of. If you they drink with friends for this Xmas and you want to go piss, make sure you carry your drink gum body go piss make your jealous friends no get the opportunity to poison your drink. Secondly, if you know say you go drive car to go flex this Xmas period make sure you no drink alcohol make yourself fit drive your car safely, and go home without getting any problems.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
OP dis matta you drag come here so follow for wetin dy make young ones enter wahala wey them no know, this hold my drink I dy come matta don cast but piple no go still use am learn lesson. No be only that one, even when this festive season don end make we still dy careful, get to gather don turn avenue wey friends go use becos of jealous take spoil things for another person body. As we dy jump dy dance make we no forget say e get person wey don see us as target but Chineke no go gree make evil eyes see us...
full member
Activity: 560
Merit: 161
My country people good morning and Merry Christmas🎄 to you all, as we dy inside the mood of celebration, abeg make we no forget to stay safe, watch my drink make I go piss or watch my drink I dy come don send many people to their grave, abeg as we dy in the mood of celebration make we no lose gaurd for our safety, make we dy very mindful for wetin we consume into our stomach, bcos life no dy two,  Merry Xmas and a prosperous new year in advance.
This season people like  to celebrate too much, e go make sense as we dey celebrate make we dey try our best not to be carried by alcohol. This season many things dry happen. Na the time different organisations,  clubs and families dey come together.  E go dey very important make we dey watchful of the way we go do things because as some people dey celebrate na so terrible things dey happen to people.  Things dey happen, make we just dey sure we dey alright as we dey celebrate.
sr. member
Activity: 434
Merit: 275
Enjoy 500% bonus + 70 FS
My country people good morning and Merry Christmas🎄 to you all, as we dy inside the mood of celebration, abeg make we no forget to stay safe, watch my drink make I go piss or watch my drink I dy come don send many people to their grave, abeg as we dy in the mood of celebration make we no lose gaurd for our safety, make we dy very mindful for wetin we consume into our stomach, bcos life no dy two,  Merry Xmas and a prosperous new year in advance.
This thing wey you talk na true many people don die because of this thing wey you talk. No be only that one woman and money na the thing wey dey kill man faster. If you be the womanizing type abeg reduce am, because nothing dey there. To dey carry woman up and down fit make woman use because of the money wey you get kpai you. mean while your future dey bright. If your enermy find you and them no ft get you, them fit use one fine woman bring you down.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
When making Merry celebration like this, we need to exercise caution in most of the things we do during this period, we have to watch what we eat, where we go things we do and so on, but ket me cap them all under the following headlines below:

1. Don't post while amidst celebrating with other people
2. Don't get drunk and cone online to post as well
3. Avoid excessive eating of food or drinks
4. Avoid indescriminate outings or occassions
5. Don't let the celebration period be your own vulneble time to get attacked.
jr. member
Activity: 73
Merit: 3
My country people good morning and Merry Christmas🎄 to you all, as we dy inside the mood of celebration, abeg make we no forget to stay safe, watch my drink make I go piss or watch my drink I dy come don send many people to their grave, abeg as we dy in the mood of celebration make we no lose gaurd for our safety, make we dy very mindful for wetin we consume into our stomach, bcos life no dy two,  Merry Xmas and a prosperous new year in advance.

Op of course we all have to be vigilant as we dea celebrate this festive for our safety e good that way, thanks for the advice.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
My country people good morning and Merry Christmas🎄 to you all, as we dy inside the mood of celebration, abeg make we no forget to stay safe, watch my drink make I go piss or watch my drink I dy come don send many people to their early grave, abeg as we dy in the mood of celebration make we no lose gaurd for our safety, make we dy very mindful for wetin we consume into our stomach, bcos life no dy two,  Merry Xmas and a prosperous new year in advance.
Jump to: