The thread been wan confuse me but I later understand say you change the concept of the thread from wetin e be before to wetin e be now. Make we talk about the money laundry wahala. Money laundry dey happen but e no mean say just because say na cryptocurrency say person no fit trace the money. Blockchain dey open to every body to access and unless you dey use privacy focus coins to hide traces for money wey you dey try do money laundry for, no no dey dey hide anything. Bitcoin own na mixer, mixers go help hide the money when you wan run the money laundry.
Fiats (that's paper money) na still the best way to launder money, cash dey very untraceable but people no know. All those wire transfer and online ways of sending money wey we dey use do money laundry dey very traceable. Ask yourself why politicians dey like share money for cash and not online and na cash dem dey get full their hideout spots, na because cash dey very easy to launder and untraceable.
Cryptocurrency is the least of our worries when it comes to money laundry, Bitcoin promotes anonymity no be like e dey encourage money laundry. As for the other discussion of Bitcoin and poverty, just know say Bitcoin na just a currency. Like other currency it can be used to elevate your current condition when you make investment with them but Bitcoin own na say if you buy am you dun already make investment so e fit help your conditions only when you get money to invest in am and hodl.