Author

Topic: My advice concerning the new trend (No gree for anybody) (Read 233 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
Every slang when burst out for we country de always push us to be better. E get one when make me like this no free for anyone slang and na when this our condoan, Mc Monica been visit bovi for him house and bovi grit everybody come to leave de guy and him grit am, the guy man call am back tell am plain say him de hear oh and from their then come even exchange pleasantries.

The main koko be say make we no play oh, no gree for village people, no gree for yourself, no gree for sleep and no gree for any setback.

This na the right mentality when we need use start the year and e go better prepare us for whatever lies ahead of us. We mauve.

I totally gree wetin u talk, every slang wey dey come out for our country dey ginger us or dey make us discover our potential powers or abilities wey dey inside us and e dey comot laziness from us self. So this no gree for anybody wey come out like this, dey really sweet me for body o, because I dey see plenty people wey dey hustle hard, dem dey very handworking now, just to make a living and to make sure say dem no fit beg again or depend on anybody again, everybody won become boss man and boss woman and nobody won become a slave again, plenty people eye don open finish, nobody dey depend on government, even if dem no get plenty but at least, dey won dey comfortable with their life and na wetin dem dey try do to maintain than standard, infact I'm in love with this slang.
member
Activity: 364
Merit: 44
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
 Op now true you dey yan for the matter this advice kajad many only they look something for one side leaving the other side not know the other side too matter pass. You fit no gree for any body even the result may not add value for yourself but now when you know gree for yourself that is when the result go show full. just like person fit call you mad man you may not gree with am but the results show when you know gree for yourself by doing those things that is free from being seen as mad man.

Many may see the slogan as cruise for the year but it's already a motivational word for many who know the value as our people always dey talk am say kola nut last long for the mouth of person wey know the value, personalizing the slogan bring it more reality than directing focus on your opponent.
full member
Activity: 350
Merit: 128

First first,  no gree for anybody!

The trend sweet die because eh as e dey go,  e done reach the level were we go begin dey question some kind things for our life and this kind of trend dey come along as a wake up call from the street say make you no allow any body have any negative final say for your life,  because eh for naija the bad one plenty pass the good ones even for inside your family sef e dey happen.

So the slogan eh e mean different thing for different people but for me and people is my cycle I believe the trend na to stand up against oppression and falsehood both external and internal.

Men need be on guide 100%!

Precisely the trends is a motivational insightment to face your fears and do your unusual in other to be victorious.
The essence of that slogan is to energize your weaknesses so you can stand the chances of your flops with the tendencies to uncover all those unrealistic agendas and individuals whom had been so responsible of bridging our glories.
It's absolutely a trend tending to say enough is enough for those impossible achievements we've always been chasing after to be achievable at the period of our readiness to stand up and proclaim our possessions.
jr. member
Activity: 151
Merit: 4
When this trend comes in many people started using it small thing no gree for anyone oo
And this trend has course alot of problem to the society,so the police officer pass a serious warning about this trend that they don't want to see anyone use the trend again, people started shouting that does it means that people are not longer have freedom of speech anymore,yes their is freedom of speech but the trend has been coursing a lot of harvock that's the main reason why police put it as a law of not using the trend anymore,me since the trend comes in I haven't used it because it course a lot of problem in the society,so many people started saying if they dont longer have freedom of speech, their is freedom of speech but if you make the wrong one you will be corrected,now police has sets in about this particular trend,to me since police is against it nobody should use it ,they know how many case they are handling due to the trend
hero member
Activity: 700
Merit: 577
To some extent I like the slogan because it looks like a revolutionary movement which the rulling class will also know that the citizens are not happy with the happenings again. I have seen the slogan every corner in the internet and in most cases in social media. But the one that funny me the most is the one, two guys were carrying a corps and one of them asked "what really killed him" then the other answered, "him say him no go gree for anyone". Lolz. Really funny but there is a very big lesson inside. Because this slogan brought back the ancient saying, " I no go gree, I no go gree nai dey tear pants". And that one na di true. Because wen a man huge to have sex and his wife go say no then he go drag her pants and it will tear. And dis thing mean be say, I no gree I no gree, one person must go down. So be careful when you dey say I no gree for anyone this year.

Na very big moral lesson nai e dey this slogan matter. Dis slogan na revolutionary one so the law enforcement agencies e dey aware, so if you just drag with them small sef dem go say, "so you no go gree for anybody in dis year". Use wisdom for your dealings. This is a nice slogan of the year.
sr. member
Activity: 546
Merit: 265
Slogans usually have influential impacts on those that are fond of using it with a mean mode.
Time after times there reveals trends of slogans which might be meaningful with the tunes of fun and likely to be possessive whereas, individuals tends to work their goals with the mental terminologies of adopting the slogans while it bootens the capacities of their endivoirs.
I dearly fears that people shouldn't abuse or be negatively insighted by these slogans with the concepts of corruptive  morales else such slogans should serve a an energymatic encouragements to achieve great things.
member
Activity: 364
Merit: 89
Reward: 10M Shen (Approx. 5000 BNB) Bounty
Well, I must say this your post is a commendable one indeed and you must be a very creative person for coming up with this slogan "no gree for yourself " and if i get it correctly you are saying no one should allow him/herself to go back or derail from the path that leads to success.
This your slogan is carried and again thanks for the words of advice and encouragement.
Moreover, this no gree for anybody have been the everyday slogan in this our country (Nigeria).
full member
Activity: 980
Merit: 237
I seem to see this statement everywhere, 'no gree for anybody,' and as our OP has advised, what I would like to add is that, let those with low understanding not think that the statement refers to fighting or war among fellow humans.
It is more a statement to motivate everyone to do better, be better and achieve results that were basically impossible or thought impossible all through last year.
full member
Activity: 434
Merit: 216
To me that slang means a lot to me o because I don't know how other people will interpret it to also soot their selves but for me I believe say this no gree for anybody means that enough is enough as one should not keep silent and watch evil happen and don't be intimidated by anyone as we all are all equal even though say we no dey the same level but no matter who you be everybody dey equal and last last na ground wey all of us go enter one day so no allow anybody to oppress you for this life base on say him get money pass you, him build houses pass you, him get investments pass you, him get achievements pass you or him get children pass you.

Any body wey do you bad thing without feeling remorse of wetin him don do you make you do am back, if person bites you for nose make you too bite am for nyash no go gree for anybody at all o, if person want peace give am peace, if him want violence give am violence o this year na eye for eye, tooth for tooth o. Any body wey recognize you make you too recognize am if him no recognize you make him fuck off. Enough is enough!
full member
Activity: 560
Merit: 161
The new trend it something that has so many meme that are funny,  it seems people are doing it just to catch cruise buy my advice is that this new trend should not exceed beyond fun because in life we achieve things from people which respect and humility must be in the picture. Let us not follow the trend and miss opportunity from people who are supposed to be blessing,  the new trend should just only be for fun and people don't need to take it serious as a way of life.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
This follow for wetin make me so much like this country, every year we dey always bring out one new slang to use begin our journey for the year and this one so na better one wey go really help for so many aspects despite say most times we dey take am as cruise.
Omor... no just gree for anybody you get to raise am oh, make dey confirm well so person no go just waka come put sand for your garri you dey drink.

Me i don also make up my mind oh, I no dey gree for my self aswell as i no go like carry last for anything wey i dey partake, i want am ahead ahead no dulling i want dey see progress for anything i put my hand na why i dey always involve God for the matter.
sr. member
Activity: 700
Merit: 270
This our country is a very funny one, we're starting our year with a slogan "No gree for anybody" and it trending everywhere on social media, it always cracks me up whenever I see a post or contents concerning it on the media, the one that amazes me most is someone's post on twitter saying " in 2024 if a job rejects your application, reject their rejection. Hold them for neck, No gree for anybody." And another person replied saying, "Dear Hr, thank you for the response, I could sense the empathy in the previous email. However I regret to inform you that I have reject your rejection. I will be present on the premises on the 9th of January to acquaint myself with the team. Best wishes, Adaeze" Lol. To be honest the fact that we picked this "No gree for anybody" and we're acting upon it gives me joy, the thing is "No gree for your self too" eh no get anything wey you no fit do so far life dey. Avoid procrastination, challenge yourself to do new things cause there's no limit to wetin you fit achieve.

 As the journey for the new year begins, never stop building towards your dream, try to set up goals for yourself and work hard enough to achieve them. Should there be any disappointments along the way, use them for a sturdier foundation. You are the only one who has to live your life, give yourself permission to live it for yourself and for the purpose God created for you, it would make you live a happy and fulfilled life, focus on your goals and try to ignore the rest, no gree make anybody distract you from your goals. The results you want dey the other side of your excuses, and I think the best way to create better future na to do your best for this very moment you dey alive and healthy. Don't forget, as you no gree for anybody, no gree for yourself too, challenge yourself to do better this year and things go fall in place.
Omo I feel say that slogan na just for grouse as I cannot find much meaning to it,  it's one of those social media trends that Nigerians always want to live up to, what's the content of no gree for anybody, trust me between now till the end of February, this slogan will just die a natural death as everybody will forget that it ever existed, because we will be too busy with our daily activities and personal challenges we will all face. Some of us no be Gen Z, way dey leave for the moment, as anything way dey trend them dey carry am for head.
sr. member
Activity: 490
Merit: 346
Let love lead
I just love the way you personalized that adage 'no gree for yourself'. its something to write on our walls and read it everyday morning and night and remind ourselves to be dedicated and determined, no matter the obstacles and perceived setbacks. We ought to learn how to motivate ourselves thoroughly this year and shun unnecessary excuses that supports our laziness and prevents us from achieving our goals. If it is only this adage that people can adhere to this year, everybody will be better off and end the year with several testimonies and positive results to be really proud of, I'll put it into some action statements as wisdom permits me,

  • 'no gree for yourself' until you've finished that important task
  • 'no gree for yourself' until you've planned yourself properly before taking up a challenge
  • 'no gree for yourself' until you're following your year, month, day plan squarely to maximize success
  • 'no gree for yourself' until you've shunned procrastination
  • 'no gree for yourself' until you've taken that bold step you're afraid of
  • 'no gree for yourself' until you've dropped your addiction in gambling
  • 'no gree for yourself' until you start standing up for yourself
  • 'no gree for yourself' until you stop being overly critical of yourself and start showing optimism in yourself and your activities
  • 'no gree for yourself' until you've socialized with the necessary people
  • 'no gree for yourself' until you're agreeable
  • 'no gree for yourself' until you're open to trying out new ideas
  • 'no gree for yourself' until you go for your medical checkups accordingly
  • 'no gree for yourself' until you've invested in your own personal development
  • 'no gree for yourself' until you love yourself unconditionally
  • 'no gree for yourself' until you're investing and holding bitcoin in preparation for the next halving

there are many of them, I can only mention but a few, this is to be taken more seriously than just a random topic on the forum, but a survival and success tactics for this new year.
sr. member
Activity: 182
Merit: 120
To be sincere the trend funny because seeing some funny images on Twitter go just make you laugh and the logo this year make sense, some will love to joke over this trend but I know say the talk get meaning and message wey dey pass, no gree for anybody now let's take out the anybody and direct the quote to our self, no gree for laziness or negative vibes even negative mindset, make we use this motto motivate our self to work hard, take responsibility for our actions, no dey procrastinate, I take this trend for myself personal cause sometimes wey I feel like to do something it's either I will postpone the work and this motto go too good for people wey dey procrastinate to work no gree o, cause this year everybody go collect hot hot if only you put mind do am. Normally una know how this country dey na everything go turn to cruise and now now wey trend start I don dey see no gree for anybody until you don slap army lol, the thing dey funny but some people fit do am ohh, abeg make we dey careful for this trend make e no cause wahala cause anything wey go cause fight abeg gree ohh.
hero member
Activity: 1260
Merit: 765
Top Crypto Casino

First first,  no gree for anybody!

The trend sweet die because eh as e dey go,  e done reach the level were we go begin dey question some kind things for our life and this kind of trend dey come along as a wake up call from the street say make you no allow any body have any negative final say for your life,  because eh for naija the bad one plenty pass the good ones even for inside your family sef e dey happen.

So the slogan eh e mean different thing for different people but for me and people is my cycle I believe the trend na to stand up against oppression and falsehood both external and internal.

Men need be on guide 100%!
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Lol, Tru Tru make we no gree for anybody oo, because life don pass that talk wey Dem say the patient dog eat the fattest bone. For this country now, if you say you wan dey do seme seme , you go just suffer Tay, except say you already get money. And just as the op talk, before you no gree for anybody make you sef no gree for yourself, because you self be be the reason why you never reach where you dey plan to  reach. Sometimes na our own lazy decision naim make us dey were we dey now. So make we shine our eyes, and sa no to some kinds of urge.
sr. member
Activity: 728
Merit: 271
For me this slanguage "no gree for anybody" na motivation for me oh no be just on anybody but also for anything wey the make me dull both for inside the forum and for our everyday real life mattas. But hin get some people wey the interpret this slang in another form entirely oh, like in a trouble way of no gree for anybody, so to me this slangs works for you in the way you choose to interpret am. And sometin wey the marvel me about this "no gree for anybody" na how Nigerians unanimously agree to use this as the theme of the new year all over the country. Grin
sr. member
Activity: 588
Merit: 338
E be like say I de live under the rock for sometime because I just de hear dis "no gree" slang for di first time, anyway di phrase carry strong message say make we no gree for anything wey go set us back from achieving our dreams. Aldo e de important to gree for every positive things wey go come our way for this new year of 2024, because e go de good to de specify di things wey we no wan gree for. I no go fit to blame di originators of dis slang because last year wey be 2023, na very difficult year for naija, new government , fuel hike wey snowball into increments of goods and services, dollar pairing with naira reach im ATH, and di more wey naira de devalue na so di dollar ATH go de reach new heights. Inshort we no suppose gree for dis kind things. Di bitter truth be say make we de double our hustle so if fuel price reach 1k, make we follow afford am,  our government no send.
hero member
Activity: 672
Merit: 546
the one that amazes me most is someone's post on twitter saying " in 2024 if a job rejects your application, reject their rejection. Hold them for neck, No gree for anybody." And another person replied saying, "Dear Hr, thank you for the response, I could sense the empathy in the previous email. However I regret to inform you that I have reject your rejection. I will be present on the premises on the 9th of January to acquaint myself with the team. Best wishes, Adaeze" Lol. To be honest the fact that we picked this "No gree for anybody" and we're acting upon it gives me joy, the thing is "No gree for your self too" eh no get anything wey you no fit do so far life dey. Avoid procrastination, challenge yourself to do new things cause there's no limit to wetin you fit achieve.

So funny

Na so i see even one like that yesterday wey d guy pick money for ground for person na so him comot him percentage oo (30%) say him no de gree for anybody this year

This country ehn na just cruise full am now as work no gree dey again but i like am ehn because sometimes when you are going through alot and you enter social media you will nearly forget about your sorrow because of the kind funny content wey people de create nowadays.

Wetin start all these things na im be say As we don de 2024 now and with how 2023 take hard no body wan just gree again, the kind vex wey de body reach not to gree for anyone again and anyhow anyhow man must survive. Na how everything take start and d mentality no bad like that, no gree for anybody no gree for anything this 2024 make your life no remain the same as last year.
full member
Activity: 490
Merit: 225
Every slang when burst out for we country de always push us to be better. E get one when make me like this no free for anyone slang and na when this our condoan, Mc Monica been visit bovi for him house and bovi grit everybody come to leave de guy and him grit am, the guy man call am back tell am plain say him de hear oh and from their then come even exchange pleasantries.

The main koko be say make we no play oh, no gree for village people, no gree for yourself, no gree for sleep and no gree for any setback.

This na the right mentality when we need use start the year and e go better prepare us for whatever lies ahead of us. We mauve.
full member
Activity: 322
Merit: 211
This our country is a very funny one, we're starting our year with a slogan "No gree for anybody" and it trending everywhere on social media, it always cracks me up whenever I see a post or contents concerning it on the media, the one that amazes me most is someone's post on twitter saying " in 2024 if a job rejects your application, reject their rejection. Hold them for neck, No gree for anybody." And another person replied saying, "Dear Hr, thank you for the response, I could sense the empathy in the previous email. However I regret to inform you that I have reject your rejection. I will be present on the premises on the 9th of January to acquaint myself with the team. Best wishes, Adaeze" Lol. To be honest the fact that we picked this "No gree for anybody" and we're acting upon it gives me joy, the thing is "No gree for your self too" eh no get anything wey you no fit do so far life dey. Avoid procrastination, challenge yourself to do new things cause there's no limit to wetin you fit achieve.
 As the journey for the new year begins, never stop building towards your dream, try to set up goals for yourself and work hard enough to achieve them. Should there be any disappointments along the way, use them for a sturdier foundation. You are the only one who has to live your life, give yourself permission to live it for yourself and for the purpose God created for you, it would make you live a happy and fulfilled life, focus on your goals and try to ignore the rest, no gree make anybody distract you from your goals. The results you want dey the other side of your excuses, and I think the best way to create better future na to do your best for this very moment you dey alive and healthy. Don't forget, as you no gree for anybody, no gree for yourself too, challenge yourself to do better this year and things go fall in place.
Jump to: