End!
So how una see my response?
My brother your response good. It is good to see how some Nigerians dey still try to defend our country but I sabi say the defending don still tire some people to dey do because of how the country don take be. Kudos for your analogy on the expatriate and Nigerian story and also as you take let the guy know say guys still dey wey be professionals and experts here but men... Naija government no dey like go right, dem dey do left left things and embezzle money den things go just dey as e be.
For the expatriate wey dey less qualified compared to our Nigerian brother, my brother we no know whether na part of the companies scope say dem go always get oyibo person for the company, and some company dey like follow wetin their competitors for the business dey do. Maybe dem get counterpart wey dey still use expatriate for their company.
So that aspect wey dem carry out naija brother take dey teach who go replace him, that fit still be dat search for cheap labour. E fit be say dem no go fit pay the expert expatriate for that area wey make dem step down to pick someone with little experience to be coached by person he has come to replace.
Quite unfortunate anyway but the bulk of the blame go to the government for not putting plans to grow the economy and stop neocolonialism.