Author

Topic: Na peaceful Election no go fight kill yourself. There Pikin no go follow fight. (Read 34 times)

sr. member
Activity: 434
Merit: 500
Na true you talk, politicians wet you Wan DE fight for or die for their children sef no de participate for the campaign and even though you go see the kind security wet go de follow them and even if them Wan vote na so so security men go follow them so we tin be the use say you die for them. As you die na for there dem go forget you and na your family ho con de suffer am. Even if we you fight person weh go win go still win so why not make we vote peacefully and make sure say we go home safely.
member
Activity: 308
Merit: 26
For years now election for Nigeria done dey characterized by electoral violence and the rest, you go hardly hear say these politicians their children die on any election Day most of their children no dey participate for the election most of their children dey outside the country they enjoy Better life, so elections here no be do or die, the life of a citizen is bigger than any election do make we watch our back as we dey go vote,

Even if you never vote u come see say the election wan turn violent abeg retire back to your house,  many Election go come and go but na only one life you get to live, so make we dey careful out Der on Saturday

Vote and return home safely.
Jump to: