Author

Topic: Naija and power (Read 64 times)

full member
Activity: 238
Merit: 151
October 03, 2023, 04:07:44 PM
#7
My country people I dy hail una inside this hurt afternoon, e get one habit wey we for we country dy do wey I no like at all,
na wetin I wan talk about today.

We for we country we too dy wicked our self, yes we, we too misused  power, we go dy complain say jagabam do dis and dat, but give us small power first, most of us worst pass am.
How person go enter market to go buy something wey him dy buy steady on a daily basis, but because say na only one person get the goods or services that day, him go just skyrocket the price as if him no wan sell, base on say na only him or she get the tin, you go later buy am since you need am desperately.

Ok make we take naira scarcity for example, during dat time Pos people dy behave as if dem be king, dy wicked people anyhow, if y wan collect 10k, dem go tell you 50-50 for your hard earn money, some people for we country no dy try, we worst pass our politicians.
Any small power wey enter our hand, we go wan use am anyhow, my country people how una see dis gbege?

Well in as much as life is concerned, the quest for power cannot be overemphasized. It is very bad how people beg you to help them be at the top but immediately the reach the top they begin to treat those that aided them as trash.

They will look for any avenue to make you believe in them but afterwards to turn to wolves in sheep clothings. Well, which ever way it is no one can be in power for a life time so one day when dey loose power they will be judged based on how the use or misuse the power given to them.

Life is a boomerang as one good turn deserves another and whatever one sows is what they would reap, they may not reap it directly but through their loved ones and relatives they will still reap it.

Power ought not to be mismanaged as your actions can also affect you in time coming so we should be cautious of how we use power when given the opportunity.
full member
Activity: 448
Merit: 117
October 03, 2023, 03:51:21 PM
#6
OP, you no lie at all. Wetin you cap na the reality of we country now. As you see so, na we Dy do ourselves all this things no be our leaders. All these things wey we dey do ourselves naim dey make our leaders Dem too dey do us anyhow.

I don come to realize say most of all these hike in price of a thing na intentional act from vendors. Dem too dey take advantage of situations at the detriment of fellow Nigerians without having any conscience or second thought of the outcome of their actions. Lets take the fuel scarcity for example. I remember that very day Mr. President may his acceptance speech and told the whole Nigerians the truth behind the fuel subsidy what happened that day, just some minutes after that filling stations and depot started closing down. Marketers were threatening strike at was a shot down virtually across Nigeria. Why did they do that. Other aspect of the economy joined Dem and started to increase price on everything causing untold hardship on Nigerians.

So I will not argue or doubt with your case here. Your observations are all correct. Na we dey do ourselves for this country.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 03, 2023, 02:24:31 PM
#5

@Majestic-milf, you talk well, but make you not 4get say everybody no be the same ooo, some people no go take more than or near half of the power way dem get to use do evil thing, like to use am take upress others way dey below them.
Abi you never see some good pipo for this we country or you still think say good pipo no dey 9ja? Abi them done finish Grin? No bro, good pipo dey nah just because say the influence of the corrupt 9jas cover the good ones nai make e be like say good pipo no dey we country again.
Although, we get bad pipo and good pipo too but the thing be say bad pipo nai plenty pass the good ones.
Greediness nah one of the major problem way we dey face almost everyday and I really believe say nah this same greediness nai make we country still dey like this, if to say we fit dey help each other's at least this country 4 better small.
Op fit dey right 4 one side and at the same time still dey wrong again, but if at all some of this things way the OP talk nah true.
No get me wrong. I no dey talk say good pipo no dey this life but the way op align the talk e come look like say to get power nah bad tin and not to side those misusing it but if we were opportuned to get it, we fit no take am do good.
Like I talk earlier, good people dey this world and make we use this forum as instance, person nai bring us into this place so we for fit dey financially independent. And some dey too wey get this kind update and power to help the next person but them dey go keep am in, or fes settle their family(which is not a bad tin) but thing I dey try yan nah say power dey sweet but e dey purge too.

sr. member
Activity: 266
Merit: 217
October 03, 2023, 11:40:21 AM
#4
Your topic make sense and you no lie for wetin you tok but I for like ask you one thing.. make we assume say you dey in power for one day? You no go like one use am to your advantage? Sometimes we dey rush call out some peeps for their greedy behavior but the truth be say we fit do the same tin if we enter dey in their shoes. See, those individuals wey bin dey complain say doz in power no good, Sha dey don enter seat, what change are dey bringing?
 Man is innately greedy and self centered but as you come limit am to naija e come look like say nah naija own bad pass. See eh, power can be intoxicating and it takes self control for a good person to not to be ruled by it.
@Majestic-milf, you talk well, but make you not 4get say everybody no be the same ooo, some people no go take more than or near half of the power way dem get to use do evil thing, like to use am take upress others way dey below them.
Abi you never see some good pipo for this we country or you still think say good pipo no dey 9ja? Abi them done finish Grin? No bro, good pipo dey nah just because say the influence of the corrupt 9jas cover the good ones nai make e be like say good pipo no dey we country again.
Although, we get bad pipo and good pipo too but the thing be say bad pipo nai plenty pass the good ones.
Greediness nah one of the major problem way we dey face almost everyday and I really believe say nah this same greediness nai make we country still dey like this, if to say we fit dey help each other's at least this country 4 better small.
Op fit dey right 4 one side and at the same time still dey wrong again, but if at all some of this things way the OP talk nah true.
member
Activity: 96
Merit: 13
October 03, 2023, 11:08:49 AM
#3
Your topic make sense and you no lie for wetin you tok but I for like ask you one thing.. make we assume say you dey in power for one day? You no go like one use am to your advantage? Sometimes we dey rush call out some peeps for their greedy behavior but the truth be say we fit do the same tin if we enter dey in their shoes. See, those individuals wey bin dey complain say doz in power no good, Sha dey don enter seat, what change are dey bringing?
 Man is innately greedy and self centered but as you come limit am to naija e come look like say nah naija own bad pass. See eh, power can be intoxicating and it takes self control for a good person to not to be ruled by it.

Bro I understand wetin you dy talk wela, I know say me I no good, even Jesus say make no body call am good master, say na only God the father nai good,  bro, anywhere way bad people plenty, good ones still dy inside, even though dem dy few, e no just make sense if we wey be bloodlines dy wicked our self, if na the politicians or foreigner we dy do dis tins, dat one na different issues, bro love sopos spread like butter fly among us, problem no dy finish, no be all this tins go solve all our problem, we sopos normalize showing love to our bloodline even though we all know say some people na ingrate, anyhow e be, make love stay for front.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 03, 2023, 10:04:18 AM
#2
 Your topic make sense and you no lie for wetin you tok but I for like ask you one thing.. make we assume say you dey in power for one day? You no go like one use am to your advantage? Sometimes we dey rush call out some peeps for their greedy behavior but the truth be say we fit do the same tin if we enter dey in their shoes. See, those individuals wey bin dey complain say doz in power no good, Sha dey don enter seat, what change are dey bringing?
 Man is innately greedy and self centered but as you come limit am to naija e come look like say nah naija own bad pass. See eh, power can be intoxicating and it takes self control for a good person to not to be ruled by it.
member
Activity: 96
Merit: 13
October 03, 2023, 09:16:49 AM
#1

Jump to: