E goo make naira self high because the cost of living depends on how much we dey ain as salary per daily, weekly and even monthly, at least, if naira dey at the normal rage way e been dey before, the cost of living go reduce small.
If naira gain more value pass like this the economy go truly balance pass the way e dey now, but that one no mean say everything go dey alright because majority of our problems na from leaders, because even when our economy be beta pass like this, one of dem just go intentionally close border say make we farm, but the thread no be to talk about dem so I go end there. Marketers sef get thier own wickedness for body, when price and economy sef dey try to balance dem sef nor dey gree bring price of things down. Dem go dey act like say dem be God especially when u no get another option. Provided say we dey get something for this forum and dem dey pay in doss, I know say this news nor dey too sweet our belle, but if we talk wattin dey for our mind as e be, e go com be like say we be selfish prick, but na the truth be that, anybody wey dey earn in BTC or currency wey high pass our own go dey pepe like this.
Just as Charles_Tim talk, this new nor go too last because, wattin dey drag our economy backward big pass watin dem just do so, until dem fulfill plenty back draw the country go dey the way e dey. Though this current CBN governor dey try, e don first remove FX restriction for some items before e dey do this one so, if e keep the good work up e go come dey left for the leaders to do their part.
I understand say one thing way make our country they like this nah because of say our leaders no dey try in some ways and this one way naira currency no con get value nah still because of how the government no still dey do well.
True true, if naira regain em straight back, many things no go change back to the way e been dey be for, but at least some things go reduce price.
Yesterday night nah me I start to dey witness am say dollars dey go down and naira done dey take advantage of am, omor no be small thing oh, e dey good sha and as e dey bad for some pipo side nah so e still dey good for other people side too.
E goo make naira self high because the cost of living depends on how much we dey ain as salary per daily, weekly and even monthly, at least, if naira dey at the normal rage way e been dey before, the cost of living go reduce small.
But the truth of the matter be say even if as naira dey gain value the price of things no go come down instead it will still keep on going highwhich is very bad.
No man, things some price if things go come down back to normal but e go take some time.
People are really suffering because of the price of things that is very costly. The government for look into this matter not to allow traders to use this dollar rise as an advantage to make money and when naira com get get value the price will still be high. People who dey earn in dollars na this thing go pain pass because as naira Don gain strength the price of things for market no go still change.
Some business men and women way dey buy things from outside countries come dey sell for Nigeria, if the government no want make business people no sell their good in dollar rate that one mean say them go run at loss, the better things for them to do nah to fine way make naira self increase like $.