Author

Topic: New scam alert BEWARE!! (Read 131 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
April 22, 2024, 04:38:52 AM
#12
Just the way I dey hear of am for the first time, e fit be say person sef never hear of am, and that na because of the circulation of this scam for people ear no dey sufficient enough. Abeg make una still try dey update this scam matter for this board so that those wey never get the latest update fit identify one wen e see am. Them say one of the way to solve some problems na when you know the basic or don get experience before. Infact knowing the problem alon don give you hint on how to avoid am in the first place, so make we try update each other.
sr. member
Activity: 434
Merit: 265
Sibi Dabo,,,,,,, Teme Ini Na Sime
April 18, 2024, 04:06:12 PM
#11
This scam is very common. The main cause of it is when the buyer see the product very cheap on the fake site or the scam seller telling him low price. He will be attracted to it and not knowing it is just a scam.

I prefer to use sites like Jumia, Konga or official site like Oraimo for buying something  online. And some of them have pay on delivery which I prefer.
Yesa brother, this scam is very common and people fall in these cams because of how cheap these products are. The internet is full of legit and scams so if we want to buy or make a deal of any kind through internet we show be careful so we don't fall into these scammers hand's. It will not be good if we lose our money into the hands of scammers. Honestly I have placed an order from JUMIA site and they are reliable but most times my problem with them some times is that what one orders is not what one receives. In any thing I do, I don't feel comfortable when it's has something to do with pay before delivery, it's make no sense because the internet is full of scammers, so the best pattern is to pay on delivery right after you have seen what you ordered.
member
Activity: 364
Merit: 44
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
April 18, 2024, 12:34:58 PM
#10
It good as you still remind people on the scam matter shall now old something, but we are living in a world way many sort of things happen person need be smart and apply wisdom mostly business on the social media space make one mo come give am 75%percent trust, the best on this online is paying on delivery if the company allow booking, alternatively certain things need one to devote it's time and avoid online purchase by going directly to the office to avoid most of this cheap scam.

Since is your new to this nation, is like you never see something for this world allot is happening this one now cheap scam.
sr. member
Activity: 714
Merit: 347
April 18, 2024, 10:46:56 AM
#9
Na god save you ooh if not the scammers go Dey use your money Dey shutdown club now  Grin, I just Dey wonder why some people too like online order, my brother if I wan buy anything I will make sure say I see am with my two naked eyes before I buy am, this news wey you just share no be today e start because many people wey Dey order things online don start to Dey regret now no be today, even the Jumia and other online things wey Dey legit I can not order anything from them, this your story Dey remember me when I want to buy the present phone I’m using now , someone told me that he have people who are selling phone and if I just send money they will bring it for me in the next, my mind is not set and I ask that I want to see the people face to face and he said no problem, the matter never reach 1 weeks na him my guy tell me say those people na scam.

I don’t trust online orders and I like it like that , because it is good to be scared than allow you to be scammed and you see this scammer Ehn, them no get joy this days as Nigeria Dey hot them no go even leave anything, even a cobo they won’t live it in your account.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
April 18, 2024, 02:25:53 AM
#8
First and foremost if you wan buy phone you go to phone vendor to buy either new carton phone or you buy London used with receipt and warranty.

Oga no dey do like say you no dey this Nigerian. All us know how things dey be especially for gadgets matter, and mind you, London use no get warranty. I don see vendor wey buy phone from person 2nd hand still put the phone for London used category to sell am again and e come sell am cost. Actually that Facebook marketplace na scams naim full there na why I no dey like to go there say I dey even go observe phone sef and one thing na their price, things for there dey always dey very cheap pass normal market, anything concern me and online buying sef, I commot body because all those things no dey move me. E better make we see do the business commot for ground than make you dey far business deals
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 17, 2024, 06:58:10 PM
#7
This scam is very common. The main cause of it is when the buyer see the product very cheap on the fake site or the scam seller telling him low price. He will be attracted to it and not knowing it is just a scam.

I prefer to use sites like Jumia, Konga or official site like Oraimo for buying something  online. And some of them have pay on delivery which I prefer.
E dey very common no be lie and the reason why I also avoid places like the Facebook marketplace especially when the person say na pay half first and complete on delivery even that one sef me I no dey do because with the way things don be for the country everyone dey find watin dem go use outwit person and if you no dey on guard you go fall mugu for them, so times na the buyers ability to be deceived dey cause all this because the moment the scammer tell am the price, he get indulge feeling he has hit jackpot not knowing he is the jackpot himself.
full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
April 17, 2024, 06:50:18 PM
#6
This scam is very common. The main cause of it is when the buyer see the product very cheap on the fake site or the scam seller telling him low price. He will be attracted to it and not knowing it is just a scam.

Scammer just full every corners this days. Trying to buy things even at a price you know it can be available in the market will either make you buy a fake product or get scammed. Scammers are always there looking for tricks to use on people. They know we are greedy, lazy, want to make money without working, love awuf and that is where they always used to get our attention into their scam. Awuf sometimes dey run belle. We should try to avoid some awuf if we don't want to get scam.

I prefer to use sites like Jumia, Konga or official site like Oraimo for buying something  online. And some of them have pay on delivery which I prefer.

This is what I do as well. Although there goods may be expensive but I'm sure I'm going to get my right goods since I pay mostly on delivery. In addition to the site mentioned, I still use aliexpress as well. Although they don't have pay on delivery but they have a good esrowed service.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 17, 2024, 02:48:15 AM
#5
This scam is very common. The main cause of it is when the buyer see the product very cheap on the fake site or the scam seller telling him low price. He will be attracted to it and not knowing it is just a scam.

I prefer to use sites like Jumia, Konga or official site like Oraimo for buying something  online. And some of them have pay on delivery which I prefer.
full member
Activity: 462
Merit: 196
April 17, 2024, 12:57:03 AM
#4


Abeg make una dey careful out there oo.
normally, if you're dealing with Facebook marketplace vendors, you've got to be as careful as anything if not you risk losing your money in a way you least expect.

I've heard similar experience last month when  my phone spoilt and I needed replacement asap just so I could finish my work for the week. I went to normally phone mall to see that most phones have become too expensive and the only thing that came to my mind was to use marketplace vendors and upon chatting a vendor up, he offered to sell a phone that's 190k for just 80k even though he claimed to have used it for one week. That sent the first r d flag but because I was desperate to get a new phone that day, we scheduled a meeting and upon reaching there, I brought out thier phone and the phone was as dead as hell. Dude no know wetin to talk again oh! Come say make we find place power am say him never on am for like one week forgetting he had earlier told me he only used it for one week. To cut the long story short I have him my power bank and de phone no still on the guy man begin change mouth say him wan go house go collect another one come oh.

One thing about buying phones from vendors that aren't from trusted source like jumia or good phone malls is that you risk buying either copy phones, stolen phone or they kuku scam you run away with your money.
sr. member
Activity: 462
Merit: 355
The great city of God 🔥
April 17, 2024, 12:37:37 AM
#3
Just as cryptoprinces said na old scam be that maybe you no get the update, acording to your explanation you been wan buy him phone being his old phone then him go buy new phone Abi? If I tell you now say you don make mistake how you go feel because right now you don fuck up. First and foremost if you wan buy phone you go to phone vendor to buy either new carton phone or you buy London used with receipt and warranty. For business dem no dey do base on friendship. Sometimes people go even see weting no good just because say na dear friend or neighbour dem go sell am to them and their neighbour go buy am unknowingly,  dem go come dey complain later. You do business to favour you not to favour others. Now that guy been wan use your brain make you give am money make him use am complete the money him hold to buy new phone, an him no no say na scam dem wan scam am . Like this him for leure you to the scam. So always avoid hand to hand business go to the shop and buy or you order phone from a trusted vendor like jumia wey be say na pay after delivery. Any business wey involve payment before delivery just totally avoid am because na scam attempt. All their strategy I know except say na new one wey dem never bring.
full member
Activity: 266
Merit: 120
April 16, 2024, 09:57:31 PM
#2
No be today wey we start to dey advice ourselves on the latest scamming strategy wey Dem dey use now, naim be why e no dey good to dey buy some things online for vendors wey no dey verified or wey no dey offer pay-on-delivery service because buying things online is risky so if you want to promote your business as well den you will take risks and offer pay-on-delivery because dat is the only way people can give you the benefit of doubt.

E even good say make you no even give Dem attention at all because I don't know the kind JuJu wey Dem dey do wey be say as you just give Dem your attention, you are likely to fall victim and later realize yourself so it is better not to even enter into any form of negotiation or conversation at all.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
April 16, 2024, 09:38:52 PM
#1
My people today I carry one update about scam wey sup for my eye come board today, and na new scam wey I just dey hear of for the first time, though the scammer was not successful but I still feel like to share so that we go dey very careful.

Some days ago I been wan buy phone from one of my neighbor, but e come tell me say make I wait make em new phone come before e release em old one,  naim I go back house with my money, after some days e come call me say make I go meet am for car park say the person wey dey bring em new phone dey come. Naim I go reach there as my neighbor come, e come tell me to transfer the money for am, without  delay naim I run am, thinking the em own selling dey the park there with us. Just for my guy to start to make call make the buyer send am the waybill code. Na this guy been wan send the em seller money for the guy to release the code. I come tell am to wait first, come ask am weda e trust the guy, e say e no even know am, I come suggest say make we ask the girls wey dey work there weda any phone delivery arrive so that we go dey sure say e don really come. Omor naim them tell us say dem scam person like that last week. Na there my body take weak, because that my guy for send my money join and e for come dey give me excuse.

One thing wey make this scam look real na the fact say the scammer send this guy message say na the waybill code message from the company but e come remove the actual code say unless the guy make payments before e go give am In full. Anyway my guy send me back my money after everything. But those wey like to cart phone or things online wey no be trusted platforms like jumia make una dey very careful, because this my guy, na for Facebook e take jam this seller and them talk for phone well but the guy intent na to scam am. So abeg if possible conduct physical business, so that if problem sup you know the person office already.

Abeg make una dey careful out there oo.
Jump to: