Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 262. (Read 554593 times)

legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
December 30, 2020, 06:54:22 AM
@brainboss baba as u talk na so e be i don hear i go use am motivate mysef for de hurdles ahead eno easy but i know say mama dey wit her ancesstors now dey faji and she go like see me dey faji too, my people say na person wey dey alive dey wear condom.. dis local board thing na good tori o but our people say na cooperation make rice and beans full pot make i burst ur brain 87% of our naija brodas wey dey dis forum no dey gree show face 4 here i don see like 10 legendary members wey be naija but dey never near here before and secondly too dis place dey like fat woman nyash if u no bend well u no go see toto  Grin ... make we try dey make dis link accesable e too dey hidden..... our brodas full 4 bounty markets den dey contest with d philipines  Grin make una reach dem dere too... d local board we go get am 2021 i had  a DREAM.



legendary
Activity: 2226
Merit: 4126
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
December 30, 2020, 03:50:17 AM
Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Baba life be like wheelbarrow eno balance mama sacrifice for me well well pure water she never drink all d cars I wan buy no way baba I no get joy as I dey so but baba God dey our mata any how ebe

No reason am 2much if not e go wey you. Life no easy that I know and sometimes say person no dey tell e story no mean say e own life better. We all dey passthrough life but d prayer be say baba God go see us through. The feeling you dey get now I understand am. E no easy say your mama go surfer finish and just go like that. Tins like dis go dey make you question God.

But no allow the tin put you down. I remember when I small I tell myself if my mama no chop my money nobody go chop am but as I grow older I come dey small pikin talk inside am. The reason we dey alive na to help people, the moment we don help finish we go go visit our marker.

Hope say una Xmas dey go well. Merry Xmas and happy new year to all man for here for advancementation. Una tight no be beans. Make una no forget oh our 2021 goal na to get local board anything wey you fit contribute like idea to make an a success bring am come.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 29, 2020, 05:25:21 AM
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).
Dis guy don comot from dis place as police 4 here report am say him do plagiarism, d thin just vex me plenty when him don gada small merits. Even wen you draw deir ear say dat kind tin no follow for here, dem no wan hear sometin.
I just go through the stuff now, and truly him copy the write up, way be say him Don gather small merit him for try calm down,I believe say maybe them don ban him account cause him account they inactive since 23rd,na to start all over again I just hope him no go make the same mistake him make this time.
My dear, you dey mind dem. Pepper body too much for those guys side. Dem nor wan make anything Africa shine. E even worse once dem know sey na Naija.
Haha, ur pidgin dey sweet me 4 belle aswear, you tight.
D tin just taya me for all this oyibo pipo, dem no wan make persin follow dem enjoy, all our yan and mata just dey 4 deir room dey mormor con dey yab us like say we no be human being, anywhere e pain dem, make dem scratch am, bad belle pipo. Abeg my men dem, make una no 4kup as dem dey find small mistake wey we go do. Shine ur eye and dey on clear road.
Mona fagi dis Xmas.
Na so e be right from time them no dey ever take Africans serious, them dey feel like say na only them deserve the good life, but las las no be so, anyhow e be make we just dey push dey go, "na just time e go take stamerer go call him papa name".
Merry Christmas my people, make una stay safe oh, this one I dey hear say another lockdown wan happen from January, na true?
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
December 27, 2020, 06:08:08 PM
Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Baba life be like wheelbarrow eno balance mama sacrifice for me well well pure water she never drink all d cars I wan buy no way baba I no get joy as I dey so but baba God dey our mata any how ebe
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
December 27, 2020, 05:25:43 PM

Dis guy don comot from dis place as police 4 here report am say him do plagiarism, d thin just vex me plenty when him don gada small merits. Even wen you draw deir ear say dat kind tin no follow for here, dem no wan hear sometin.

Omo. Plagiarism bad Oo and them dey take am very seriously in the forum. Na why I no fit advise anybody to go down that path. Sorry to Nelkel sha. Na my fellow PH guy.

(...)
As 4 me I no celebrate dis year as my Mama kpai 4weeks ago our house no get joy. Una wey get reason to celebrate make una enjoy.

Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.


Compliment of the season my people. I dey wish everybody happy holiday celebrations with family and friends.

Abeg no forget to enjoy life. When we die, we go leave this world behind so make we just live and enjoy life wey we go remember.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
December 26, 2020, 08:52:11 AM
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).
Dis guy don comot from dis place as police 4 here report am say him do plagiarism, d thin just vex me plenty when him don gada small merits. Even wen you draw deir ear say dat kind tin no follow for here, dem no wan hear sometin.
My dear, you dey mind dem. Pepper body too much for those guys side. Dem nor wan make anything Africa shine. E even worse once dem know sey na Naija.
Haha, ur pidgin dey sweet me 4 belle aswear, you tight.
D tin just taya me for all this oyibo pipo, dem no wan make persin follow dem enjoy, all our yan and mata just dey 4 deir room dey mormor con dey yab us like say we no be human being, anywhere e pain dem, make dem scratch am, bad belle pipo. Abeg my men dem, make una no 4kup as dem dey find small mistake wey we go do. Shine ur eye and dey on clear road.
Mona fagi dis Xmas.
full member
Activity: 756
Merit: 231
December 26, 2020, 07:24:12 AM
Hope sey na im "pearls" still giv am dis award ni?, bad peps evarywher. I don come 2 undastad sey him wey God bless no body wey go fit cause am, nor itimidate am, my sincere greeting sir, we all tap into dis ur success dat b4 2020 end we go all colet our own blessings accordingly, once again a big Congratulations Boss, more go cum(**) 2021.
Make I take this opportunity beg all man here sey make dem dey very careful with anything dem dey do here as many of those peeps eyes dey for owa parole now. E go give dem excess joy to see sey dem tarnish owa imagine with red as I dey see dem. Make una shine eyes like pussycat oh and reason the matta wella wey I just throwey for ground now.

One love my people! Feliz navidad...(Felix Na dibia 🤣)
I belive sey plenty peopu don read dis ur advise, de tin go giv dem joy if dey succeed but God gat our back 4 sure. We neva 4get dat one wey happen to our broda posi, so, make we dey very careful bikonu.

Happy Christmas 🎄my pipo abeg if u get two plates of rice abeg dash ur neighbour one plate because e get as thins be dis year for some pipo. We get plenty challenge for dis country but no reason we go settle dat one next year.
Dat one na 4 sure becus dia's love in sharing, tank u.

Quote
As 4 me I no celebrate dis year as my Mama kpai 4weeks ago our house no get joy. Una wey get reason to celebrate make una enjoy.

Our oga dem make una do xmas awoof na  Grin
We all get reason to be joyful becus our eyes don see anoda 25th again, but am sorry 4 ur mama matter, please tak heart ehh, na so life be, may our God keep mama till we meet again.
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
December 25, 2020, 11:05:54 AM
Happy Christmas 🎄my pipo abeg if u get two plates of rice abeg dash ur neighbour one plate because e get as thins be dis year for some pipo. We get plenty challenge for dis country but no reason we go settle dat one next year.

As 4 me I no celebrate dis year as my Mama kpai 4weeks ago our house no get joy. Una wey get reason to celebrate make una enjoy.

Our oga dem make una do xmas awoof na  Grin
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 24, 2020, 10:01:55 AM
Hope sey na im "pearls" still giv am dis award ni?, bad peps evarywher. I don come 2 undastad sey him wey God bless no body wey go fit cause am, nor itimidate am, my sincere greeting sir, we all tap into dis ur success dat b4 2020 end we go all colet our own blessings accordingly, once again a big Congratulations Boss, more go cum(**) 2021.
My dear, you dey mind dem. Pepper body too much for those guys side. Dem nor wan make anything Africa shine. E even worse once dem know sey na Naija. As owa bad leaders dem don paint us bad for dem eyes any good thing wey we do nor dey sweet dem for belle again. But the truth be sey when Baba God blow your whistle, my broda whether you wear Jersey or tie wrapper you go play for the game. Na so the matta be. Make I take this opportunity beg all man here sey make dem dey very careful with anything dem dey do here as many of those peeps eyes dey for owa parole now. E go give dem excess joy to see sey dem tarnish owa imagine with red as I dey see dem. Make una shine eyes like pussycat oh and reason the matta wella wey I just throwey for ground now.

One love my people! Feliz navidad...(Felix Na dibia 🤣)
full member
Activity: 756
Merit: 231
December 24, 2020, 09:32:18 AM
My people! Na back to back for owa main man, CryptopreneurBrainboss! The bobo join another feather to im cap as im win Golden Feather Award join the "Interview" award wey im win cash price last week.
Brainboss still make top nominations for other categories too. Well done, bro! You deserve am.
Hope sey na im "pearls" still giv am dis award ni?, bad peps evarywher. I don come 2 undastad sey him wey God bless no body wey go fit cause am, nor itimidate am, my sincere greeting sir, we all tap into dis ur success dat b4 2020 end we go all colet our own blessings accordingly, once again a big Congratulations Boss, more go cum(**) 2021.
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
December 24, 2020, 03:59:20 AM

I salute una oo my pitakwa brodas how we go tak sidon enjoy oursef even na d least fowl feather we chop and to tell baba God thank u 4 dis Xmas? Oga brainboss baba God dey shame ur village pipo small small 4 here congratulobia broda ur face show. Grin

Anybody wey get awoof mak u try dash ur broda una grab wetin I mean na. Una too dey belleful oyibo ooo
Pitakwa people, e bi like sey na una go rock this December. Suya or chicken barbeque nor go dey bad to handle with all the big boys here. Make una sha remember to share pictures later with us oh. Persin wey nor chop can still watch pishures na 😁. I know very soon most of the polithieftians for PH go begin enrol for this forum to equip themselves with Bitcoin knowledge.

About the awoof wey you talk, I understand you. Just continue with your work, e go come when you least expect am.
We dey wait our oga brainboss me I don shine my shoe keep any day wey him set date shap shap I don knack my coat burst out with my shenke  Grin

Our Gov Wike head no correct again make una help us we don tire for flyovers for PH no joy Grin

We 4 get telegram group wey we 4 tak dey yen as edey hot here be like borokiri prison oyibo eyes no comot
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 23, 2020, 06:15:02 PM
My people! Na back to back for owa main man, CryptopreneurBrainboss! The bobo join another feather to im cap as im win Golden Feather Award join the "Interview" award wey im win cash price last week. BB, abeg you need kill goat for us abi na catfish you go do? That cash na something oh 😏. Abeg, I nor wan bore una now with too much talk talk. Make una just see the pishure below or check the result sheet here Spreadsheet


Brainboss still make top nominations for other categories too. Well done, bro! You deserve am.
Wow, another achievement for own boss man @CryptopreneurBrainboss,congrats boss, I believe say more go come na the starting be this, them go hear am for this forum Cheesy, naija all the way Cool.
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).

Omo my guys, I dey new here,I dey post nice tinz but I no dey get merits.
Then secondly them never update my activity to ryhme with my post.
I need help jare!!
Welcome to the forum paddy, just follow the rules and you go dey okay.
And the reason why your activity no dey match with your posts count na because them dey delete your posts them,try make unique and creative posts them, no reason the starting continue to dey push.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 23, 2020, 03:19:02 PM
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).

Omo my guys, I dey new here,I dey post nice tinz but I no dey get merits.
Then secondly them never update my activity to ryhme with my post.
I need help jare!!
Welcome bro. Sorry sey I skipped your post the other time as I dey hurry out when I put that comment on congratulobia to Brainboss.

I salute una oo my pitakwa brodas how we go tak sidon enjoy oursef even na d least fowl feather we chop and to tell baba God thank u 4 dis Xmas? Oga brainboss baba God dey shame ur village pipo small small 4 here congratulobia broda ur face show. Grin

Anybody wey get awoof mak u try dash ur broda una grab wetin I mean na. Una too dey belleful oyibo ooo
Pitakwa people, e bi like sey na una go rock this December. Suya or chicken barbeque nor go dey bad to handle with all the big boys here. Make una sha remember to share pictures later with us oh. Persin wey nor chop can still watch pishures na 😁. I know very soon most of the polithieftians for PH go begin enrol for this forum to equip themselves with Bitcoin knowledge.

About the awoof wey you talk, I understand you. Just continue with your work, e go come when you least expect am.
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
December 23, 2020, 11:11:03 AM
I salute una oo my pitakwa brodas how we go tak sidon enjoy oursef even na d least fowl feather we chop and to tell baba God thank u 4 dis Xmas? Oga brainboss baba God dey shame ur village pipo small small 4 here congratulobia broda ur face show. Grin

Anybody wey get awoof mak u try dash ur broda una grab wetin I mean na. Una too dey belleful oyibo ooo
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
December 23, 2020, 05:33:12 AM
Fly high big man Brainboss, you don too do am for people so, we gat do am for you kwa. E no easy to see road con show people and even carry them along. Na so e suppose be but some kind people no understand the matter. you be real 9ja guy, i salute you and your progress dey sweet me for body.

My people way dey here, una well done o as una carry show capability. This small thing way una just display for this parrol eh, e show say na we dey here, na we get am. Anyhow e be, make we still use our head o, oyibo na oyibo o, e dey there body too.

Make una take time jolly the season, una too much.
member
Activity: 504
Merit: 57
December 21, 2020, 05:49:23 PM
My people! Na back to back for owa main man, CryptopreneurBrainboss! The bobo join another feather to im cap as im win Golden Feather Award join the "Interview" award wey im win cash price last week. BB, abeg you need kill goat for us abi na catfish you go do? That cash na something oh 😏. Abeg, I nor wan bore una now with too much talk talk. Make una just see the pishure below or check the result sheet here Spreadsheet


Brainboss still make top nominations for other categories too. Well done, bro! You deserve am.
Brainboss done turn to something else for bitcointalk lately ooo and him try to win so many awards inside this arena, me self day wish to be like the guy when I grow. Baba crypto for 9ja.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 21, 2020, 12:32:05 PM
My people! Na back to back for owa main man, CryptopreneurBrainboss! The bobo join another feather to im cap as im win Golden Feather Award join the "Interview" award wey im win cash price last week. BB, abeg you need kill goat for us abi na catfish you go do? That cash na something oh 😏. Abeg, I nor wan bore una now with too much talk talk. Make una just see the pishure below or check the result sheet here Spreadsheet


Brainboss still make top nominations for other categories too. Well done, bro! You deserve am.
newbie
Activity: 28
Merit: 4
December 21, 2020, 12:25:39 PM
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).

Omo my guys, I dey new here,I dey post nice tinz but I no dey get merits.
Then secondly them never update my activity to ryhme with my post.
I need help jare!!
hero member
Activity: 2240
Merit: 579
Degens.bet - On-chain 1000x Futures
December 17, 2020, 03:14:46 PM
To God be all the glory. If 2 say wi no do ham God do ham for it is written.
legendary
Activity: 2226
Merit: 4126
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
December 17, 2020, 09:53:25 AM
Ma people I hail oh una to much I throwaway salute for all of una main main as without una support, I no for fit get dis free oyinbo dollars I go soon received like dis, una well don. At least now I no get any reason to say I no benefit from knowing all of una for dis forum, una welldon again. My broda Mpamaegbu, I undastand ur yanings, no reason am. I get reason besides the reason say dat guys interview go well die. See eh dem been don dey attack ma people badly and nothing worth una to surfer just because of me.

If u observe well afta my public declaration of dat guy post, d attack reduced, u fit see say I try withdraw so the matta go end but no work. Just see as our broda posi account don get red trust just because e been wan help e follow broda. All of una account been dey under serious observation and I try to water the issue down na e make I do wetin I do, I beg for ur forgiveness if I fall ur hands but I do am for my people. Becky666 u too much, in fact all of una much and I see una handwork and I appreciate una badly.

Just know say we no lose instead we live to fight another day. Sometimes e good to lose the fight in order to win the battle. The battle now na our local board. We go win dat battle surely. I dey prepare the thread, we go run dat matta January when every where don cool from all dis contest and we go use the whole of next year demand for am if na wetin e go take. Una thank you again, una do well.
Jump to: