Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 273. (Read 554634 times)

hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
August 06, 2020, 07:25:01 AM
Make una calm down for alts for now, and stack bitcoin and ethereum plus some other big altcoins, like ripple them because dat's where the energy dey flow go.
Brainboss, make I nor lie you XRP na the last coin wey I dey even look im side. I nor get a single Ripple as I dey type this thing. The big supply wey enter billions dey discourage me from buying it. Although the news wey dey come out from the coin head dey great and e suppose make the coin rise well but nor be wetin we dey see. If half of the news for Ripple concerning the collabo wey im dey do with other multinationals happen with ETH, my broda Ethereum go hit the roof one time, even pass Bitcoin. Anyway, I go chook eye for that Ripple now for this weekend make I see whether I go fit buy one.

For ripple I believe e go fly again for im level. E get when e reach like $3 wey baffle many people. The ish about the coin be say many people see am as a coin wey dem dey pump and manipulate wella because of the centralized nature.
But anyhow, is still cheap now and no how wey e no go follow the bull ride wen e come full as a top 3 coin. I guess na the angle wey @boss dey also look at. If I go buy the coin, no be to hodl for too long.

Curio makes sense, since yesterday when he got to $1, the coin dey drop to $0.8 back to $1, that name good profit. But I dey fear because curio drop na big loss but it mainly $1 price.

Guy curio go fly no doubt. The supply is very low, 2million. And the team is very active, they deal on exotic cars. In its early days, just few months , is like it got around 0.10, I can see from my search in mar 24/25/2020 it low was 0.11 and you can see the progress so far. Is not up to a year, I think is good project from Asia region.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 06, 2020, 03:02:02 AM
Make una calm down for alts for now, and stack bitcoin and ethereum plus some other big altcoins, like ripple them because dat's where the energy dey flow go.
Brainboss, make I nor lie you XRP na the last coin wey I dey even look im side. I nor get a single Ripple as I dey type this thing. The big supply wey enter billions dey discourage me from buying it. Although the news wey dey come out from the coin head dey great and e suppose make the coin rise well but nor be wetin we dey see. If half of the news for Ripple concerning the collabo wey im dey do with other multinationals happen with ETH, my broda Ethereum go hit the roof one time, even pass Bitcoin. Anyway, I go chook eye for that Ripple now for this weekend make I see whether I go fit buy one.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
August 06, 2020, 02:36:27 AM
If anyone get free cash or fit sacrifice dem lunch, make una go buy ESH sharp sharp o. E get something wey oga dem dey cook for the coin head. Current price be around $0.08 and supply dey less than 14m. Gbanga!
The coin na switch, I just go analyze ham small and see no prospect for the coin for now but I can dey wrong. But na so one coin wey I think no go get prospect increase this year pass the price I could not think of. I believe you brother, but you fit give us more info wey go dey convincing.

Sure sometimes e dey happen like dat, u go see coin u talk say na trash but in the next coming weeks e dun rise die. The truth be say most time those projects na actually trashed but big boys dun pump am to decieve gullible users so dey fit cashout for their head. Just use ur number six, if you miss anycoin wey u been believe say na trash just lock up go research on anoda coins as they plenty for d market.

Make una calm down for alts for now, and stack bitcoin and ethereum plus some other big altcoins, like ripple them because dat's where the energy dey flow go. The market na stage by stage and the best well to follow am na understand wetin dey sup for the market for e every movement. Una well-done oh and good morning.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 06, 2020, 02:32:38 AM
If anyone get free cash or fit sacrifice dem lunch, make una go buy ESH sharp sharp o. E get something wey oga dem dey cook for the coin head. Current price be around $0.08 and supply dey less than 14m. Gbanga!
The coin na switch, I just go analyze ham small and see no prospect for the coin for now but I can dey wrong. But na so one coin wey I think no go get prospect increase this year pass the price I could not think of. I believe you brother, but you fit give us more info wey go dey convincing.
ESH na project wey I bin dey follow right from 2018 till date. Dat na to show us sey crypto nor be get rich quick syndrome per sey as many noobs dey think. Waiting na the true colour of dis game oh. Almost two years for cooler, until dem fork McAfee GHOST in May and price come get big dada o from less than 2cents to $2.4+. Price come crash after that. Now, the koko be sey the ESH team dey try wan decrease total supply by burning the ones not in supply yet. Una sabi sey burning dey increase scarcity and price, abi? Na dat angle me I dey take look am from but I hope the thing go wait enter next week sha so I can pack more. Anybody wey im lever nor too carry am fit wait till dem announce burning proper. I go come here still tell una and den una fit buy.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
August 05, 2020, 05:40:35 PM
If anyone get free cash or fit sacrifice dem lunch, make una go buy ESH sharp sharp o. E get something wey oga dem dey cook for the coin head. Current price be around $0.08 and supply dey less than 14m. Gbanga!
The coin na switch, I just go analyze ham small and see no prospect for the coin for now but I can dey wrong. But na so one coin wey I think no go get prospect increase this year pass the price I could not think of. I believe you brother, but you fit give us more info wey go dey convincing.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 05, 2020, 12:23:21 PM
If anyone get free cash or fit sacrifice dem lunch, make una go buy ESH sharp sharp o. E get something wey oga dem dey cook for the coin head. Current price be around $0.08 and supply dey less than 14m. Gbanga!
hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
August 05, 2020, 08:45:39 AM
The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am. If any coin fit reach bitcoin (four/five digit price) while bitcoin increase more na ethereum especially as this der upgrade dey come

The very day BrainBoss talk this thing I been no get much money to buy Ethereum, but I try my best convinced my friend with tangible reason why Ethereum go fit increase price soon, him see my reason legit come drop money take buy 1 eth, now him the smile with the price.
Na why I wan thank am personally and to every other person for una contribution and suggestions, our growth for this forum na the love we get for each other be the fertilizer. I throw Salute for all of una

Na im be say I go just try hodl my very small fraction of etheruem wey I get from bounty tight just like monkey hold the branch of tree tight  Grin Etheruem dey really tell us say na im be numba 2 for the crypto parole.
I remember litecoin too back then wey dey follow etheruem bumpa to bumpa. Litecoin dey $58 as I dey write, e be like say im own time dey come just say na bitcoin dey overshadow am big time
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
August 05, 2020, 07:55:58 AM
Na cooperation dey make rice boil full pot, na so owa old people for village dey talk.
This your adage eh, meaning full am I swear. E goes well broda.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 04, 2020, 12:53:20 AM
Me I go like make we loosen up for here. I no say everybody no dey here pigin for here but, the plenty people way hear and understand am, make we promote am, pigin na our culture and that's what Africa is mostly about.
I sabi sey all man wey dey hear dey knack pidgin here. Na the parole for this owa local board be dat, except sey fit to yarn sey wen we started. But now, all man na official pidgin 🤡

The more we dey post the more the merit, the more the rank, make we Naija dey strong to the extent we go get our btt official local board.
Na cooperation dey make rice boil full pot, na so owa old people for village dey talk.
hero member
Activity: 1400
Merit: 655
Bitcoin is achievement
August 03, 2020, 07:05:00 AM
Una thank you ooh for una support and advice for my new level wey i celebrate,are thank everybody wey encourage me and those wey no encourage me very well because is not easy oooh.
My brothers una do well very much, I don't really know how are go thank una again, but na God wey dey heaven go bless una very well to achieve una dreams.

I say God make bless everybody for me.

member
Activity: 127
Merit: 12
August 03, 2020, 05:27:21 AM
The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am. If any coin fit reach bitcoin (four/five digit price) while bitcoin increase more na ethereum especially as this der upgrade dey come

The very day BrainBoss talk this thing I been no get much money to buy Ethereum, but I try my best convinced my friend with tangible reason why Ethereum go fit increase price soon, him see my reason legit come drop money take buy 1 eth, now him the smile with the price.
Na why I wan thank am personally and to every other person for una contribution and suggestions, our growth for this forum na the love we get for each other be the fertilizer. I throw Salute for all of una
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
August 03, 2020, 04:57:49 AM
Make I no lie you, you be my brother, you go need to make the English boards no tire you. The progress wey dey here na the results of our works for the English boards as we never get local board. The more we dey post the more the merit, the more the rank, make we Naija dey strong to the extent we go get our btt official local board.
My hands dey up for you Charli-boy. E be like you na guy man way know what's sup. E goes well. E dey give me joy say men like this dey the forum. Tuale for BrainBoss, at least, small-small we don dey know ourselve and e go surely help us see road wella.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
August 02, 2020, 06:41:45 PM
to keep up with English for the whole section of the forum no easy.
Make I no lie you, you be my brother, you go need to make the English boards no tire you. The progress wey dey here na the results of our works for the English boards as we never get local board. The more we dey post the more the merit, the more the rank, make we Naija dey strong to the extent we go get our btt official local board.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
August 02, 2020, 05:46:15 PM

Came down, you meet us for this thread. We dey holam tight. Nothing mege. Onwe hu Ihe mega ayin. Nothing dey bite where you sleep.
[/quote]

Na the matter o, you na correct guy. You know how e dey be na
hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
August 02, 2020, 11:59:19 AM
Abeg, do-do men and women way group up for here I dey hail una o. Happy new  month and Sunday to all of una. How e dey be for una side na? Hope say everything dey go jejely. No wayo shah! Abeg, to keep up with English for the whole section of the forum no easy. Me I go like make we loosen up for here. I no say everybody no dey here pigin for here but, the plenty people way hear and understand am, make we promote am, pigin na our culture and that's what Africa is mostly about. Plus, promoting our unique African culture go bring us closer as per the unity. African culture way sweet wella!
Na our own small community be this o, na we dey here, so make we dey like say na our land be this. No plenty big big grammar for here. Loosen up, give me correct pigin way go make me laff. No be say, you no go make your point o, or pass message with better English for the rest way no understand pigin to follow up but, you go use your head and promote the vernacular abi mother tongue once-once. Abeg, if you sabi the pigin wella, make una follow me yan for here abeg, pigin-english sweet o. Abi the plenty comedy for we country no be when them use pigin direct am na em you dey enjoy am. Ah-ah! Too much English wan kill person for this forum. I dey see say some people dey run am already and I dey enjoy una, I no go lie. Na for people way still dey hide am to burst out o. Give me the wazobia, na so I like am, raw and original. Make we level up for here abeg.
I Preach One Africa,
I Rep Africa,
Ur Official 9Ja Guy.

Lol... Guy, you self ehn.
All these your epistle never pass those englishians own  Huh

Came down, you meet us for this thread. We dey holam tight. Nothing mege. Onwe hu Ihe mega ayin. Nothing dey bite where you sleep.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
August 02, 2020, 04:11:18 AM
Abeg, do-do men and women way group up for here I dey hail una o. Happy new  month and Sunday to all of una. How e dey be for una side na? Hope say everything dey go jejely. No wayo shah! Abeg, to keep up with English for the whole section of the forum no easy. Me I go like make we loosen up for here. I no say everybody no dey here pigin for here but, the plenty people way hear and understand am, make we promote am, pigin na our culture and that's what Africa is mostly about. Plus, promoting our unique African culture go bring us closer as per the unity. African culture way sweet wella!
Na our own small community be this o, na we dey here, so make we dey like say na our land be this. No plenty big big grammar for here. Loosen up, give me correct pigin way go make me laff. No be say, you no go make your point o, or pass message with better English for the rest way no understand pigin to follow up but, you go use your head and promote the vernacular abi mother tongue once-once. Abeg, if you sabi the pigin wella, make una follow me yan for here abeg, pigin-english sweet o. Abi the plenty comedy for we country no be when them use pigin direct am na em you dey enjoy am. Ah-ah! Too much English wan kill person for this forum. I dey see say some people dey run am already and I dey enjoy una, I no go lie. Na for people way still dey hide am to burst out o. Give me the wazobia, na so I like am, raw and original. Make we level up for here abeg.
I Preach One Africa,
I Rep Africa,
Ur Official 9Ja Guy.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
August 01, 2020, 02:09:27 PM
You dey right, but the thing dey under condition, some people for other countries dey even sell merit, I met a guy on cryptotalk wey tell me this. We Naija no dey like that, and the condition be say you go post quality and authentic posts, your brother go see the posts. But, if someone no post good, that na sorry o, no merit for such people, even if the person na from my state person, I no care.

Make we post good and make others know how important Naija dey for this forum and we go dey rank up step by step.
@Charles-Tim I swear down, this thing wey you talk even make sense pass, I don enter other board see how them play with merit like water. Wetin fear me be say post wey no reach 8 words get 4 merits, e con be say the racism too happen for here, na waya for Oyibo oh. Make we try sabi ourself at least I sabi every naija wey don show head for here.
@GeorgeJohn, the only condition na to make quality posts, as Charles Tim talk am. Congratulations on your new rank, e goes well as you celebrate with cartel roots. Keep it up.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 01, 2020, 12:53:34 PM
Please everybody join me am celebrate my membership in the forum because I never believe that I will become a member in bitcointalk community.
The thing sweet your belle come make you compose poem on top the matta sef 🤗. E reach, nor be small thing. Shebi I tell you sey na small small. Before you know wetin dey happen, you too don knack am enter the next one. Make you jollificate and continue to dey post well.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
August 01, 2020, 09:17:43 AM
@GeorgeJohn, I dey happy say you rank up, more power to your elbow.

My people make una dey help oooh make
Our brothers them dey grow well for here
Were we dey together.
Biko make una follow dey celebrate my
New rank today.
Omoh I salute everybody again.
You dey right, but the thing dey under condition, some people for other countries dey even sell merit, I met a guy on cryptotalk wey tell me this. We Naija no dey like that, and the condition be say you go post quality and authentic posts, your brother go see the posts. But, if someone no post good, that na sorry o, no merit for such people, even if the person na from my state person, I no care.

Make we post good and make others know how important Naija dey for this forum and we go dey rank up step by step.
hero member
Activity: 1400
Merit: 655
Bitcoin is achievement
July 31, 2020, 03:41:16 PM
Please everybody join me am celebrate my membership in the forum because I never believe that I will become a member in bitcointalk community.
Today I'm member and is a remarkable thing to me because I fined it difficult to get a membership merit that lead as a member.
Is now I realized the proverbs that says "a journey of thousands miles started with a step"
so therefore I need everyone support because  I'm proud of myself as a son of Africa

Una greetings ooh
Are dey celebrate today ooh
Because are done become member
For our forum wey everybody wey dey inside
Dey talkf for the betterment of bitcoin.

Jump to: