Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 274. (Read 554634 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 30, 2020, 06:36:59 PM
imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,
Good for bringing this up, but for here I no think anyone go fall for scam, btt don teach us how we go dey smart and avoid scammers. But for people wey no dey this forum, ignorance dey their body. I join one group for telegram, for less than 5 minutes, one idiot come add me telling me about trading, the scammers dey tell me say na 24 hours return, that one even dey beyond ignorance if falled for, na greed.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 30, 2020, 03:00:46 AM
As we day reason altcoin matter make we try day very careful, because this Na crytocurrency e fit good today come go somehow the next day. And pls make we advice those way one here, imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,
I dey tell people sey Forsage na ponzi scheme because na pyramid e bi. Any scheme wey get to pay you only wen you bring person enter their cult without a product to sell na ponzi. E nor just be any MLM (Multi Level Marketing), na pure ponzi and e fit collapse at any time. But I sabi one big crypto and Forex trader for PHC wey dem dey call Jesam, (Brainboss fit sabi am as na im area) dey promote this Forsage.

Abeg, make una avoid that Forsage thing.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
July 29, 2020, 05:23:06 PM
As we day reason altcoin matter make we try day very careful, because this Na crytocurrency e fit good today come go somehow the next day. And pls make we advice those way one here, imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,

Those people wey dey carry Foresage matter put for head like gala and lacasera for traffic no too Sabi anything about cryptocurrencies. The only word wey dem dey use deceive dummies like themselves na Smarth contract. I dey laugh Thier mumu anytime I come across them sha. Dem recently introduce another one dey dey call Lionshare.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
July 29, 2020, 04:20:30 PM
As we day reason altcoin matter make we try day very careful, because this Na crytocurrency e fit good today come go somehow the next day. And pls make we advice those way one here, imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 29, 2020, 03:34:30 PM

For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that.

Na how the matter the take play be that. As e fall like this many people go run go sell the small them get make all for no lost. Last last na who get that business oriented mind; patient and believe go laugh last, I see future for that coin too, e go raise as I de take eye see am so...
Na true. Like me now I bin sell that yesterday but I don rebuy am today with extra tokens to show for it. If you see any opening sey any utility coin wey you dey hold wan fall, na to sharperly sell am and then wait for the weak hands to follow dump. Una sabi sey some people go just begin run for streets once dem see other people dey run without knowing wetin dey pursue dem, ba? 😂😂 Then as a guyman wey you be, just smile and then quickly buy am back to add more to your hodlings. Na so the parole dey be oh but you gat to be very careful sha. Otherwise, you fit sell and not be able to buy back and then the cruise go leave you behind.
member
Activity: 127
Merit: 12
July 29, 2020, 03:24:34 PM

For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that.

Na how the matter the take play be that. As e fall like this many people go run go sell the small them get make all for no lost. Last last na who get that business oriented mind; patient and believe go laugh last, I see future for that coin too, e go raise as I de take eye see am so...
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 29, 2020, 12:03:41 PM
Brother, you all dey good and helping, I dey thank for your contribution toward Africa bitcoin ATM I posted few minutes back.

https://bitcointalk.org/index.php?topic=5265432.new#new

Check it out, if deserved corrections, please do.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 28, 2020, 04:59:07 PM
The ATM dey lagos. Na one lounge and bar like that. Them even consider installing more ATMs across the country. But that fit be for 2020.
Guy, you confuse me for here. Shebi na 2020 wey dey already like this na abi na political 2020 you dey refer to here? 😏😏
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 28, 2020, 03:42:50 PM
But where the BTC ATM dey for Naija? Lagos or Abj?
Yes, @nelson4lov dey correct. I got included all details in the thread.

who see wetin that my darling Curio do a few hours ago?
Curio makes sense, since yesterday when he got to $1, the coin dey drop to $0.8 back to $1, that name good profit. But I dey fear because curio drop na big loss but it mainly $1 price.

About the minimum amount to hold to participate for staking, I believe say them go reduce am prior to the release and if them no release am, staking pools were go dey to cater for people wey no get up to the minimum.
I believe that, possibly staking pool go result.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
July 28, 2020, 01:25:18 PM
Although, gain go dey there, many people will buy ether not knowing how the reward thing dey work but this go increase ether price and very possible ether could be driven to $500 in price or more presumably.

About the minimum amount to hold to participate for staking, I believe say them go reduce am prior to the release and if them no release am, staking pools were go dey to cater for people wey no get up to the minimum. ETH 2.0 na the biggest update, yet for their ecosystem. The price fit reach $1000. ETH all time high back in 2017 na $1400. I dey feel say e go reach am.
But where the BTC ATM dey for Naija? Lagos or Abj?

BTW, who see wetin that my darling Curio do a few hours ago? For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi.

Curio never dey my watch list. Na that Cartesi wey I miss yesterday na pain me. The coin no too dump, I hesitate to buy thinking say e go go lower.

But where the BTC ATM dey for Naija? Lagos or Abj?

The ATM dey lagos. Na one lounge and bar like that. Them even consider installing more ATMs across the country. But that fit be for 2020.

Omo, in light of the recent Bitcoin run and price growth. Abeg is it safe to say another bull run don come? Yesterday run mad.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 28, 2020, 10:21:50 AM
@ Josefjix and Gozie51. You talk sense, I have it for mind make I create writeup for Africa ATMs. Only 1 ATM dey Nigeria, so to make it Africa generally na sense. Make I dey wait for other comments but I think all go suggest this too.
You sabi sey dem nor dey use mirror look wristwatch na. E go better to give the thread a wider coverage with the African umbrella to make am attract more posters since na only one ATM dey owa country as e bi na. Na my own contribution be that for this matta. But where the BTC ATM dey for Naija? Lagos or Abj?

BTW, who see wetin that my darling Curio do a few hours ago? For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that. Also, I dey observe that ETN for better buy.  All these coins dem be use-case coins.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 28, 2020, 10:01:09 AM
@ Josefjix and Gozie51. You talk sense, I have it for mind make I create writeup for Africa ATMs. Only 1 ATM dey Nigeria, so to make it Africa generally na sense. Make I dey wait for other comments but I think all go suggest this too.
hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 28, 2020, 09:27:00 AM
@Charles-Tim , I go suggest make you give the thread an African coverage. That will be better. Then you fit make Naija as a case study inside the thread.

Or... You fit just make am Africa now and hope to create a new one for Naija particularly.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
July 28, 2020, 07:23:47 AM
My people, I dey always cool to dey around you, I wan ask your opinions about something.

In the local board, I wan great two similar topics

1. Crypto ATMs in Africa
2. Crypto ATMs in Nigeria

For now, na one dey Nigeria, and seem like not to create a thread of such for Nigeria, but I dey also think, the earlier the better if we dey talk details about it from scratch now. Nigeria support crypto and possible the number of ATMs will increase.

Should I create a thread for only crypto ATMs in Africa, or, creat for Nigeria too. 

@ CryptopreneurBrainboss, Upgrade00, nelson4lov, Mpamaegbu, BIT-BENDER and all of us, I will like your opinions.

Creat am e fit give every African joy as no be only Nigeria the thing dey.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 28, 2020, 07:04:29 AM
My people, I dey always cool to dey around you, I wan ask your opinions about something.

In the local board, I wan great two similar topics

1. Crypto ATMs in Africa
2. Crypto ATMs in Nigeria

For now, na one dey Nigeria, and seem like not to create a thread of such for Nigeria, but I dey also think, the earlier the better if we dey talk details about it from scratch now. Nigeria support crypto and possible the number of ATMs will increase.

Should I create a thread for only crypto ATMs in Africa, or, creat for Nigeria too. 

@ CryptopreneurBrainboss, Upgrade00, nelson4lov, Mpamaegbu, BIT-BENDER and all of us, I will like your opinions.
hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 28, 2020, 06:42:36 AM
If u fit understand this market you no go loss too much, just act smart, play play u go beat d market. Altcoins been dey boom last 2weeks plus so now ethereum and bitcoin don take over. No too panic but if you get vex money na to buy the potential alts wey don crash, return go dey am mad. When bitcoin don mumu finish, profit go back into altcoins and when Alts rise again profit go comot again go back to bitcoin/ethereum, the whole market na cruise.

Nomata within u dey do, always own bitcoin and add am ethereum, those two coin na d backbone of the industry, remember red means opportunity but research properly make u no go buy dead waste. If d thing too much for you just buy ethereum, bitcoin and forget trying to play the market street

Na experience be the teacher. This post na word of wisdom from our eye for this ogboge forum. Baba jus tell us say market na rise and fall, depending wen you buy. Make we research well before we buy. But with the way this our house dey go joli joli, we fit even get better infomate about the market we want buy. If to say I sabi about this house wen I still dey crawl, I sure say I for no waste money for some dead coin. Anyway, na advise for us shaa, to come ask guys for here wetin dem think before we buy at least.
I see say cartesi na better market as @Mpamaegbu talk too

I really dey happy as this house don begin grow and as I dey see some guys wey carry name wey I no even no say na our Naija guys.
@posi , so you be our blood. This your name na wa oo Grin Grin Roll Eyes
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
July 28, 2020, 12:42:36 AM
If u fit understand this market you no go loss too much, just act smart, play play u go beat d market. Altcoins been dey boom last 2weeks plus so now ethereum and bitcoin don take over. No too panic but if you get vex money na to buy the potential alts wey don crash, return go dey am mad. When bitcoin don mumu finish, profit go back into altcoins and when Alts rise again profit go comot again go back to bitcoin/ethereum, the whole market na cruise.

Nomata within u dey do, always own bitcoin and add am ethereum, those two coin na d backbone of the industry, remember red means opportunity but research properly make u no go buy dead waste. If d thing too much for you just buy ethereum, bitcoin and forget trying to play the market street
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 27, 2020, 05:58:33 PM
The biggest update na say ETH go change from POW mining algorithm to staking.
The PoS that will be adopted by ethereum platform dey somehow centralized, people having less than 34 ether only hold, the reward dey for those wey hold 34 ether or more.

Although, gain go dey there, many people will buy ether not knowing how the reward thing dey work but this go increase ether price and very possible ether could be driven to $500 in price or more presumably.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
July 27, 2020, 04:52:41 PM
~
~
Ether, litecoin are still altcoins, ether dey really show good sign to even still rise more if bitcoin is rising. Lately, ether even rose than bitcoin. I don noticed the fact say the two coins (bitcoin and ether) are showing good sign. Like me, I am waiting to see bitcoin brake the $11000 resistance as its price now is over $10700.

Most altcoin are not moving up, and I valid your advice.

Yeah, I noticed Ethereum growth. Hope you know say Ethereum developers go soon release ETH 2.0 next month or so? The update (as per changelog) go fix most of the current issues with Ethereum like speed of transactions with fast confirmation and smooth operation even during heavy traffic/load. The biggest update na say ETH go change from POW mining algorithm to staking. Na why e don rise lately though I miss out on it. Sorry about your loss bro. I experienced something similar. I say make I buy dip but it got deeper.

Some altcoin prices I don see today dey insane. Too low!
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
July 27, 2020, 03:48:54 PM
My people, shey una don see Bitcoin for him true form – A beast. I also hope say una no own altcoins at this time because na bloodbath since yesterday. See ARPA don drop below 200 sats for this first time in the last 2 months. Even Cartesi dey take severe beatings. If una wan buy, abeg just chill small make bitcoin relax small coz like this, e fot reach $12K before e retrace and e no go look funny for altcoins.
You adey right, I bought Zilliqa today and losing $20 already, most altcoin no dey move up but there were some that increase, but dey few.

Curio dey $0.28 some days ago but as at yesterday it was $0.48 but risen to $1 today. It really rose.  But, I think it is now time to only cash out because the coin can later dump.

Jump to: