We have people of wisdom in Nigeria, but why the process to do something correctly is hard in the country. Nigeria need to be fast on regulating cryptocurrencies. The suspended CBN president failed to see how Nigeria government will earn from regulating cryptocurrencies, how cryptocurrencies will increase Nigeria economic growth and development and how it will increase employment. Even without regulation, employment increased and many Nigerians depends on crypto job as of today.
Our problem for this country just circle round the former CBN governor, dat guy was a cancer in our economy. Nothing wey him do wey favor the economy of the country. Na only to dey put laws wey go take us backwards na wetin sabi. What's the need of taxing crypto when it isn't regulated in the county. Na only money mata wey we dey rush sign, we no go do the one wey go make the citizens survive and encourage more business and people to enter the cryptocurency market. E dey do me like say the government rush passed that taxation bills so dem fit dey suck all this crypto companies wey dey country dry.
Dem no go create a conducive environment for business to prosper with regulations yet dem wan dey tax dem. The taxation no be bad thing oh like e good say government dey take tax as na very good way for government to dey gather money way dem go use package the country but what about the regulations of the industry. To do business for this country na big wahala. As of now the taxation wasn't necessary or abi US dun passed their own taxation bill because this country sabi follow follow (maybe na why dem hurry go pass the bill). Anyway sha I just hope say as the taxation bill dey take effect e go make governments to begin reason regulating the industry.
I totally agree say di tax move de premature at this time, especially as dem never regulate cryptocurrency matter for inside Nigeria. Our government suppose to de put first things first, instead of putting di cart before di horse. Otherwise how we want to take make significant progress and compete with countries wey de proactive and de implement laws at di right time wey go de favourable to dem citizens.
The former CBN Governor no try for im tenure, but if our government de serious to right di wrongs of di bad precedent wey di former governor set for crypto matter, dem fit to do am, no be rocket science. But I just de see di lack of willingness to do di needful, make bitcoin Sidon for im rightful place in Nigeria, as a world class decentralized digital currency, wey our people go trust say e de genuine and eventually everybody go adopt am just like fiat.