Author

Topic: Nigerian parents and spirituality. (Read 209 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
April 17, 2024, 09:45:03 PM
#17
No be lie na you really talk true here in fact if person get accident now they go say na there grandmother for village lol very funny people no they ever reason say things for just happen like that and need medical attention you just talk about your guy way run mental bro if na for village that guy go done start dey Waka for street that’s because they go still they hammer on spiritual things and things different sacrifice and at the end no result.

This our country really funny no be lie, the way we dey act self dey even dey mk we wonder how God carry create us we be Nigerians, everything wey dey happen na village people, na spiritual something etc. dem no believe say some things na natural occurrence, wey need to just happened like for example if ant bite person, dem don see am as spiritual something, dem don dey banned and dey rebuke am and our Nigeria parents dey very very funny to the extent u go come dey hide to dey tell dem some kind things self but nevertheless na their attitude dey mk us dey live long o with the help of God if not normally e for no easy for us o.
full member
Activity: 160
Merit: 84
November 05, 2023, 01:23:05 PM
#16
The way people dey use God name dey play is very disturbing. The thing be say, many people lack wisdom that's why they always deceive them. People are too  gullible, they call themselves Christian but don't know God for themselves.  Imagine a self acclaimed man of God go boldly call out your own mama say na witch wey won kill you and you believe. This same person no kill you when she carry you for her womb and train you for school till you finish, na now she won kill you?
In all you do in life, please always seek wisdom

sr. member
Activity: 476
Merit: 307
November 05, 2023, 04:39:49 AM
#15
Omo spiritual matter for Naija na major problem o. Na for Naija you go see say severytjing get spiritual interpretation.  Black cat, rabbit, owl, and other natural creatures na them dey collect pass for this we country. E dey hard make you see a Niaja house where spirituality no dominate. Now we even have this concept of "village people", a way we take dey blame other people for our misfortunes.  At some point e, this spiritual things don dey tire person. No be everything be spiritual matter.
full member
Activity: 322
Merit: 211
November 01, 2023, 04:54:58 PM
#14
Spirituality Mata too serious for our obodo 9ja ooh, but although I no go blame most people sha because the rate at which people they envy each other, and e get some part way be say you go hardly see people they prosper because anytime way them see person way they try meet up some evil men go find one way or another to destroy the person destiny.

So we no go blame people way they do prayer prayer because waiting they happen for some places for this our obodo 9ja spiritually no be small thing ooh so na only prayer go fit help us ooh.

But the only one way I no too like be say our churches too plenty, for one street you go see more than five churches with different doctrine, at least as na one God way we they worship we supposed to have a limited churches instead all this plenty churches way full everywhere.
  Na for niaja wey be say pastor go tell you make you come church for Monday morning make you come do counseling, Monday way be money day !!  Some go even tell you make you pray pray when clearly your problem na to just go outside make moves. I no talk say to pray no good ooo but then even the Bible talk say “heaven help those who help themselves”. Religion don make us feel say na prayer we go use solve all our problems whereas some of our problems na we cause am to ourselves or maybe we just need put in work. But no pastor go talk say make them pray your way out.  We go miss our parents them cause na them pray pass this our  generation now the almighty gen Z way still day shake yansh for internet.
  Spirituality good oo but the way we day take carry am at times day sometimes spoil am, plenty of us don even turn hypocrite for this matter, they go day preach watin they no day practice. If na by prayers and kabashing our country for don good by now, the country situation come even make us to day pray harder. Na so the condition don be, they don brainswashed most of us thinking say everything fit day solve by praying when clearly person fit just make good decisions way go favor everybody. But no base on greed and corruption way full them go day thief us come still day tell us to pray. Make God hear our cry one day touch the heart of this people way day rule us. Nothing is impossible for God to handle.
sr. member
Activity: 546
Merit: 265
October 31, 2023, 06:18:54 PM
#13
You are right but these set of people are not to be blamed. If you check the margin of such people you will see it is mostly poor people that lives to such mentality because spiritual consultations is affordable to them than that of the science and technologies.
This basically is inspired as a lineage characteristics inheritance from foreparents because they lived lives without the introductions or invention of the sciences of today's.

However, they could be right too. Most spiritualist are not only based on spiritual awakening but are also dependent on herbs which also termed to  serve solutions to such sceneros even if it was a non spiritual being.

I can also tell you that I have withness an African citizen but a USA base who suddenly seized to walk and can't even stand despites the technological and developed country he was and yet could not be offered solution after undergoing one scientific and technological treatments in one way and the others.
But someone recommended a prophet who based her win Nigeria and then the victim (sick man) was eager to do whatever it takes just for him to be fitted again then he came down Naija and told you prophet that " Many had tried in many ways but can't make me walk but if you can do this, then it is like I owe you my life". Then the prophet embarked on his spirituality assignment and was able to make the man walk at last.

Never underestimate the potentials of spirituality anyways but the mentality of every negative occurances being spiritual is an awkward state of being.
full member
Activity: 980
Merit: 237
October 31, 2023, 03:49:24 PM
#12
It is a normal phenomenon for African parents to be so spiritual these days. Most times I wonder if spirituality is only for Africans. The truth is that, spirituality has done more to inculcate good morals and beliefs into the younglings than the internet has done and I think no matter the family one is born into, what makes a  lasting impression is that of morals and spiritual beliefs.
sr. member
Activity: 476
Merit: 276
October 31, 2023, 03:09:02 PM
#11
Spirituality Mata too serious for our obodo 9ja ooh, but although I no go blame most people sha because the rate at which people they envy each other, and e get some part way be say you go hardly see people they prosper because anytime way them see person way they try meet up some evil men go find one way or another to destroy the person destiny.

So we no go blame people way they do prayer prayer because waiting they happen for some places for this our obodo 9ja spiritually no be small thing ooh so na only prayer go fit help us ooh.

But the only one way I no too like be say our churches too plenty, for one street you go see more than five churches with different doctrine, at least as na one God way we they worship we supposed to have a limited churches instead all this plenty churches way full everywhere.
jr. member
Activity: 44
Merit: 1
October 31, 2023, 04:38:22 AM
#10
No be lie na you really talk true here in fact if person get accident now they go say na there grandmother for village lol very funny people no they ever reason say things for just happen like that and need medical attention you just talk about your guy way run mental bro if na for village that guy go done start dey Waka for street that’s because they go still they hammer on spiritual things and things different sacrifice and at the end no result.
sr. member
Activity: 182
Merit: 120
October 30, 2023, 04:47:29 PM
#9
You try to bring this kind matter come here because me sef don dey reason this matter, I pick out two things wey you talk for here concerning the spiritual matter wey people go dey waste their money for prophetic homes and the mental problem concerning your friend, thank God he's fine now.
This spirituality of a thing I no go talk say e no dey oh, the thing dey but no be so we suppose do for this kind matter. Like case wey be spiritual person suppose know and case wey need medical care person suppose know but wetin dey pain me people don decide to die in slient for all this prophetic homes I no know if na ignorance or wetin but the thing dey pain me, the worst part be say fake prophets don open church and na their church full everywhere who no know no know and just like wetin you talk them dey milk people dry when it comes to money aspect, where in the Bible did Jesus heal and cast out demons for money but still yet people no go know oh.
Secondly this mental issue, in a situation where the case is not a spiritual case and the case needs medical attention, but the cause of this mental issue is coming from smoking of weed and hard drugs, after treatment we all know if the person goes back to smoking that mental issue will still rise in this situation what should the person family do.
full member
Activity: 490
Merit: 225
October 30, 2023, 12:02:07 PM
#8
The reason why most people attribute their challenge to being spiritual rather than a medical abnormality Is because of the kind of society we find ourselves in. There are so many cases of individuals who suddenly develop mental disorders with no clue about the cause and that will normally warrant the guardian of the person to term it spiritual.

What I normally advise people in a situation like a sudden mental shift is that they admit the victim in a health facility while praying or believing for healing from whatever God they believe in.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
October 30, 2023, 10:55:35 AM
#7
 E dey wonder you why pipo carry spirituality for head pass any other thing? Well, there's the saying that before something work for physical, e don already happen for spiritual. Yes, nah true about the saying but e come be like say pipo don too put mind for that belief and forget say no be only one way them dey take solve problem. This issue Op bring up nah exactly how some people don believe say tins must be becos of you look am, the guy just suddenly start to misbehave and what other way to follow am other than spiritual? Who knows how many enemies him get? Roll Eyes
 Just like @Fiveststar note, nah lack of knowledge dey kill some people.
I no dey dispute say spiritual forces no dey o, but we too dey soaked in am sotey when other solutions are proffered, e go be like the person wey suggest am no believe in God or something. These things nai dey make so many fake churches dey spread because them dey regard am as business and when you see say gain dey, you go wan put head na.
sr. member
Activity: 434
Merit: 254
DAKE.GG - CASINO AND SLOTS | UP TO 230% BONUS
October 30, 2023, 09:42:19 AM
#6
It is normal for parents to have their beliefs in anything, we should also know that there are different culture and beliefs not only in Nigeria but in different countries of this world, not only that too, our religion has changed the mindset of many parents today, recently I discovered that there is a church named faith tabernacle, the members of this church don't normally take medication when they are sick, this got my attention, I asked the members of the church why such act, they said that the God heals, that it will be so unbelieving for anyone to take medication when he or she is sick because it will look as if you are tempting God or you don't have faith that God heals, they said that instead of seeing medication as an option you have to fast and pray that God will heal you, just imagine how a sick person will fast and pray without medication, religious confusion everywhere.
hero member
Activity: 546
Merit: 516
October 29, 2023, 07:40:15 AM
#5
This matter tie wrapper my brother. The thing be say, religion don do a lot of damage in our psyche here. We tend to be more religious than even God that is why we put everything intop spirituality. See as the country keep face, God give us everything as a country yet we allow the worst people to rule us while we pray to God to come down from heaven and help us. It is a thing of religious colonialism.

No blame our parents, their own parents also pass the same thing to them... na chain reaction. Wetin you dey even expect from a people wey think say the poorer you are, the more righteous you become just because Bible talk say "it is easier for a camel to pass through the eye of a niddle than for a rich man to enter into the Kingdom of God"

The one wey dey pain me be say no how you go to any spiritual house that they will not tell you there is a problem. It must be either your forefathers, your village people, your mama, uncles etc, there must be somebody after you. They will see all these problems yet they cannot offer solution.

The earlier we focus on God a lone and forget about all these plenty fakes around, the better for us.
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
October 29, 2023, 07:23:06 AM
#4
For this country spiritual attack dey but we just have believes than each other, some problems dey wey be say na spiritual go take solve am, some people they that do not have any little believe on all this spiritual things, even though they tell them say na spiritual they won't consider it. But me i have ever see a person that try scientist but they see say that is the solutions to their problems, they no have choice than to come to the spiritual own. Is just that the problem we have in this country they believe spiritually than scientist, if you are sick before some naija parents go take you to the hospital, until they see that it's not for the spiritual situation.

Our naija parents believe in all this juju stuffs, any small sickness that children will be taken to the hospital to prescribe drugs for, they will first do their own first, all this believes don make some people lose their children thinking that is the only way, that thing they pain me seriously even all this herbalist na fake full everywhere they won't have solutions to your problems and they go just dey make you spend anyhow to the extent they won't pursue you but you go quit by yourself, even a little bit i no dey believe them nowadays, because we of nowadays don't have much believe in all that. If you did not talked about your friend condition and about the hospital, only God knows the condition he will be right now.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
October 29, 2023, 06:36:10 AM
#3
Well, this na true talk which ever way we try to look at it, even bible talk am say "my people perish because they lack knowledge", na God  create spirituality and still create science, and Him come give us brains so that we go fit discern when something is related to spirituality, and when something is related to science, but unfortunately, due to the several fake pastors we have all over the country, that will never teach their congregation about the scientific part of life, but always preaching spirituality all the time, many people come believe say science no dey exist again, every thing in life don be spiritually related, even person wey poor, probably out of laziness or maybe he never do the right thing wey go make am become rich, such a person go dey, and still believe say na spiritual powers hold him or her down succeeding.

This na the situation we find ourselves in this country in this generation, all we can do is to always try and educate as many as we can educate, not everything is inclined to spirituality, in as much as it is and still an important part of life abs human existence.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
October 29, 2023, 06:16:47 AM
#2
Anyway sha you done try to talk your own, well me ai go like say most pipo way dey always think say the cause of their problem nah spiritual something I believe say those pipo nah based on their own believe nai them take they conclude their matter, some nah based on the kind of conditions way them dey recently but all this things many pipo know know say such is life, if somethings bad no happen then life no go dey interesting the way e dey so, although bible done talk am for the ending part say many things go happen I me I believe say all this things way they happen so nah just because of the word of God to come to pass.
No body like suffer but still life no predict everybody to come enjoy at ones, some pipo them enjoy their life's for their early age and when dem done dey old suffer go come start while some suffer when dem they young come enjoy their life as them dey old but finally finally e still get many way their parents burn them with Silver spoon and this pipo nah the ones way enjoy life from small till them grow old and even death, although sha no conditions is permanent but we have to live life in a positive ways so that even God can help us.
sr. member
Activity: 448
Merit: 351
October 29, 2023, 05:28:38 AM
#1
E get something wey dey bother me like this for some time and this this thing don too much and I don decide to bring am out make other country people put their mouth for this matter. Why be say we Naija people believe say anything wey we dey suffer na spiritual attack, without seeking for scientific explanations. Even the evidence dey show say the thing get scientific solution most Naija people go still believe say na spiritual problem. We don give room to this spiritual houses to exploit and milk us dry and many of them they lavida from our ignorance. I get one friend wey been no well, the guy start to dey misbehave and e dey show say na mental condition but the parents and other close relatives come dey think say na juju dey hold the boy. The guy been dey act normal but suddenly him come dey act like say him dey run mad, if you and am dey talk him go dey talk off point. You go tell am something and him go relpy you with another thing come dey laugh join. The people come they go prayer houses and herbalists them place dem spend money on goats and fowls for sacrifices. After many months the boy situation come dey worst more than before. I been don suggest for them make them carry the boy go Psychiatrist hospital, but them no agree them say na juju wey dey family house dey do the boy. After some time when dem don do everything and nothing happen na there them come approach me say that hospital wey I been talk say make we go there. Na so I carry them go the hospital for rumigbo inside Port Harcourt. After the doctor attend to the boy and test was conducted, dem come discover say na one condition wey dem dey call dementia dey worry the boy. Na so them recommend drugs and injections wey the boy go dey take every month. Today the boy don dey normal and don get him life back. The thing come be say him dey on drugs monthly and the doctor say thank God say we come the time wey we do, say if to say we waisted more time say the boy for don mad finish. Something wey I want make we know be say no be everything wey dey do us be spiritual. Most people wey dey mad for street today no smoking or durgs make them mad and no be even people wey be their enemy make them mad. Some na cases wey be like this my friend own but people over look am say na drugs, smoke, or spiritual attack. To know more about this condition you can read more here. https://celebrateseniorliving.org/2023/04/19/different-types-of-dementia/ Knowledge is power. Before we conclude say something na spiritual make we make sure we don try and there is no medical or scientific explanation to the problem. Many people they they suffer today because people around they are ignorant. I believe we can still do more to save people that have this similar cases from running mad totally and other people passing through other conditions by always suggesting science first before spirituality.   
Jump to: