For were I come from like this eh, we get fishing as our local occupation and growing up na through that means man take de survive. We no really reason the fishing like any big deal, all our mind na to enter town, speak good English like those children we de watch for tv, eat like city children and just enjoy the city life. We no really know the value of our resources or make I talk am say we know even know say the fish na our legit resource, all we've really been taught in school about Nigeria natural resource just tilt to oil! oil! oil!.
Dem talk say you no go know the value of wetin you get until you lose am and the same goes for the national resources of the country. Better truth be say we no know the value of wetin we get and the government dun do this one on purpose, dem refuse to invest for this other national resources so everybody no go get food chop. Dem prefer when we dey die for hunger so when them go come back say make we vote dem and dey go eradicate the poverty we go believe them but all na wash. All the different states get wetin dem fit work on and dem go dey take care of demselfs but the government no want any of dem to dey independent but want make dem dey depend on the federal power so dem go get control to push everybody go where dem want dem to go.
The matter long sha but I think our leaders and elits are not doing enough to tap into our numerous local resources because God don too bless Nigeria with mad resources.
Forget oil, see the difference national resources wey the different states dem get but government dun abandon all of dem to chase after oil wey be say we no even dey utilized the oil very well, all the other products wey dey come from oil, we no even dey get self. Wetin we for do as a country, refine am so we go dey get better choppings from am we refuses but prefer to sell am to oyinbo make dem for give us anything wey dem like and settle our ogas at the top wey dey incharge of the exchange and dem go close mouth and sometimes self dey sell the oil to other countries while we dey here dey produce oil still dey get fuel scarcity. Wetin dey there if the government make every state chop from their own national resources and they pay the government commission, e for us to utilized all the national resources wey we get well.