Author

Topic: NIJA YOUTH AND BETTING: it is draining our productive workforce (Read 127 times)

jr. member
Activity: 67
Merit: 7
This betting of a thing e get as e be, i know of person's way fit stand for visual front from morning till night worst part be say no be him dey play all through him go just dey there dey beg people then e go still use am play again some person's destiny just dey tied to betting many young ones drop out of school, some use their salary sef on top betting my question is how much Dem feel say Dem go win before Dem go leave am
sr. member
Activity: 854
Merit: 451
Apart from churches and POS stand, I doubt say any other thing plenty pass betting shop for this we country.

 Almost all the street for my area get at least one betting shop and I know plenty persons when no de go look for work but de go just baff finish enter the place play vitual from morning till night and them go return back to their house.
Na true you talk ooo, you see pos stand and betting shop, like say na d two business wey people dey divert their money go be that. But e dey surprise me as some people go carry gambling as their main source of income, how u go take bath, dress like say you go enter office, you go come enter gambling shop start to dey gamble from morning till evening, e no really make sense to me ooo. Me I no dey against gambling, but make u no dey addicted to gambling, because people wey dey addicted to gambling dey do crazy things, which some go affect d family members and the entire society.

I understand say e de help boys on a normal oh, but I still feel say e de make most of our youth to be less productive as most of them still de hope say one day them go just hit jackpot like this and their level go just change.
Most of our youths wey dey depend on gambling always are addicted to gambling, if you sabi d amount wey some people dey lose on bet, you go just shake head, money wey dem suppose divert go other things maybe to run business. If you dey gamble and you dey hope to hit jackpot one dey, u fit no even hit d jackpot, you go just dey waste money for gambling, and addicted gamblers dey always deceive themselves say if no give up, you go hit jackpot.

In dis country, me I go talk say gambling do cause more harm to d citizens than good, because I sabi some people wey be say gambling don spoil their life before.
member
Activity: 308
Merit: 32
sports betting get big effect for the field of sports economics. E dey generate plenti money, e dey influence market value, e dey shape the sports media landscape, and e dey affect sports governance and regulation. As sports betting dey change and dey enter more into the sports industry, e dey important for everybody wey dey involved to understand and adapt to wetin e mean. By embracing the opportunities and challenges wey sports betting bring, the sports industry fit continue to dey successful and grow for this ever-changing economic landscape.
sr. member
Activity: 798
Merit: 364
Almost all the street for my area get at least one betting shop and I know plenty persons when no de go look for work but de go just baff finish enter the place play vitual from morning till night and them go return back to their house.

How dem dey take get money to go play virtual if they are not working? Gambling no be bad thing entirely but truly we dey abuse am for Nigeria here. Even oyibo wey introduce and design gambling no put the matter for head like us. The thing na two edge sword and government no fit do anything on it unless you want it affect the operators. This companies dey pay huge tax to government which in turn is use to develop the nation in one way or another. My problem with them is allowing under age children to gamble when there rules clearly says "not allowed for under 18 years". E get one incident wey happen for my side back then involving the bet9ja shop owner and one small boy like that. The matter long but na for police station dem go settle am.

As a grown up man, you are responsible for anything concerning your well-being. You no need wait for government to regulate something before you know wetin no good for you. You fit suggest how government go take regulate am and e go dey effective? Because we Nigerians wey I know, dem go by pass everything continue with their normal things. You remember the time wey FG ban Twitter? You see how we begin dey use VPN to access Twitter? Na the same thing go happen even if government take a measure to regulate gambling. The only thing to do here is to create awareness about gambling effects and to orient people to gamble responsibly.
sr. member
Activity: 182
Merit: 120
Firstly government can't regulate betting because them dey take tax from each win so they can't regulate betting, secondly na people business so e no even sound nice to reduce the population of betting wey those shop owners dey benefit from, na them dey bet wrongly and na them go face the consequences cause this betting of a thing dey drain people when it comes to financial matters.
The example wey you set, hardly you see normal person dey enter betting shop regular likee the person no even get work and the person no ready to find work. All this mistake na some people dey do and them go dey paint gambling black for outside, bet what you can afford to lose and make betting no be your regular work or habit, people like this need advice but them no go learn because them don turn to addict.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
Because of say some of them de win for sometimes, some people no de gree go find work do or look for one skill when dem for learn, everybody wan de bet and some go even get mouth de talk say e better to stay for beating shop from morning till night rather tan doing yahoo. Why you go de compare bad habit with a worse habit no?

I know wan too delve into the so many negative effect it has had on our youth oh!

But How una see this betting matter?   

On the norms everything with advantage still get enough disadvantages and addiction in gambling is one wrong habits which many people not just the youths even elderly men, also not only in this Nigeria alone many other countries are facing same problem.

The government may not be efficient to help reduce the level of addiction, we all can gamble and place bets with our phones while indoors and no possibility of the government interfering but can be worked out individually, when we try knowing the truth, working in the truth and helping others who are victims of this addiction in gambling and betting.
newbie
Activity: 8
Merit: 0
gamble no be better thing to do but na em dey help youth this days na, I don see person before wey use gamble money go and and graduate, he no reply on anybody and he finish with gamble money.
some youth dey live on gamble money, na me them dey chop, buy cloth pay rent and some na luxury live them dey live o.
but some people no dey get luck like that and e dey affect them and as them be part of us na e dey literal affect us too because na them be  thief today.

e go make sense government do something about it na especially the shops on, almost everybody wey dey go there no be good person, them they thief even within themselves, they no dey even look nice always in bad cloth and bad behaviour, na there them go say if u plug your phone and you no look ahm and them thief na u sabi and true true if you plug your and you commot there ahswear before u coke back them go thief ahm

and this kind of shop na me plenty for Nigeria especially trenches places, you go see small place with almost two to three betting shops and it bad like that

But almost people wey dey win  this days dey use their smart phone and them dey make good money
government fit stops those shops and leave online own
e go make sense that

so about being draining or productive, I fit talk say online own dey productive and shops own dey draining

for online u fit dey play some odd and win but shops own e no go make sense to dey play 2 games na
newbie
Activity: 8
Merit: 0
Apart from churches and POS stand, I doubt say any other thing plenty pass betting shop for this we country.

 Almost all the street for my area get at least one betting shop and I know plenty persons when no de go look for work but de go just baff finish enter the place play vitual from morning till night and them go return back to their house.

I understand say e de help boys on a normal oh, but I still feel say e de make most of our youth to be less productive as most of them still de hope say one day them go just hit jackpot like this and their level go just change.

E for no make sense make our government look into this betting stuff and try regulate am in a way when no go make our youths become addicted to it?

Because of say some of them de win for sometimes, some people no de gree go find work do or look for one skill when dem for learn, everybody wan de bet and some go even get mouth de talk say e better to stay for beating shop from morning till night rather tan doing yahoo. Why you go de compare bad habit with a worse habit no?

I know wan too delve into the so many negative effect it has had on our youth oh!

But How una see this betting matter?   

E go better say government interfer oo cause the of rate of gambling in naija now ehn no be for Africa as continent, some youth go go hustle from morning to night and still use that money gamble and losss.
Na em dey make some go do illegal things na cause I can't just be working hard and be losing without not doing anything about it, e no go make sense like that.
But government no fit put mout for this matter remember na the same government put us for this condition make almost all the youth dey  think say the only way out na to hit jack point and it by gambling, despite say people they waste their hard earned money there some still they win and no go like make them alter the thing bad, so I don't see that happening
But e dey possible though make government make things easy for us and make jobs available both educate and non educate na and I sure say government go fit stop.
because na person wey u dey feed you na em go fit talk to na
sr. member
Activity: 504
Merit: 378
The great city of God 🔥
Almost all the street for my area get at least one betting shop and I know plenty persons when no de go look for work but de go just baff finish enter the place play vitual from morning till night and them go return back to their house.
First of all this your thread for good for gambling discussion but nevertheless. You no go blame the youth wey dey comot for house dey go stay for bet office from morning to night before them dey come back. Person wey no get money and Him dey stay for house go receive too much insult, e dey also cause disrespect from family and friends and even your partner. So Naim make some guys dey comot go betting Shop go relax because na only there they give them rest of mind. Going to betting shop self no make them inresponsible, but just that the opportunity never come. Most of those guys you see for betting Shop na graduate wey don find work tire and them no see. and wahala don jam Pak for them head, especially when dem  be the first son, dem go explain tire why dem never get money. so the only thing them dey do na to go try luck for bet wether God fit show them love. Most people wey you see for this forum been dey thesame shoe, but if you check out now wey dem don dey get money for signature campaign there original sense of reasoning don come back to do the needful. So na frustration Naim dey cause most cronic gambling.

I understand say e de help boys on a normal oh, but I still feel say e de make most of our youth to be less productive as most of them still de hope say one day them go just hit jackpot like this and their level go just change.
People wey dey product dey, and e also get those wey no dey productive. No be everybody wey dey bet office Naim come for gambling oo. Most people you see there just come to watch Match, and some to come charge there phones,  while some just come to lap you if you win make dem get small thing play. And others dey only come once but e get some people wey dey very lazy to an extent say early morning dem go enter without even brushing them mouth I believe na those set you dey talk. But believe me no be everybody be like them.

E for no make sense make our government look into this betting stuff and try regulate am in a way when no go make our youths become addicted to it?
Nothing I know government fit do about am. Because person wey don reach 18 years an above no be small Piking wey go misuse him fund come put the blame for government head. Even betting site dey always say play responsibly and also with your spear money. So no be by force na just for the youth to minimiz there expenses on gambling.

I know wan too delve into the so many negative effect it has had on our youth oh!

But How una see this betting matter?  

The matter I don already explain am above. So make the youth creat budget for gambling not by using any amount wey dem get go play gamble, dey think say as you no win yesterday say today fit be your luck. If you don stick to dat mentality money no go stay for your hand. and if you no take time, your second name go be investor. Everytime make i go invest. Untill person go even give you money make you just hold for am, the spirit of investor go push you enter bet office go waist am. So make we play with caution.
sr. member
Activity: 476
Merit: 316
Get $2100 deposit bonuses & 60 FS
E for no make sense make our government look into this betting stuff and try regulate am in a way when no go make our youths become addicted to it?
Op how government go carry regulate betting wey go stop people from betting the way they want?
Op anybody wey they go betting shop from morning till night, na the only update wey that person get to use commot for poverty be that and nothing you go tell that person go make am leave betting. Some na addiction don make them no fit to stay one day without having a bet slip or copy to follow up in "flashscore" with the hope say the slip go enter but at last e go still cut. Betting is supposed to be a way of making extra money and having fun but anytime we are on a losing streak with our predictions we should take a break from gambling not to get addicted to it
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
My brother, no be lie you dy tlk, betting don practically take over the mindset of our youth for we country, which I believe get in own negative effect, but make we check am na, government no go just wake up one morning and put a stop to it because dy themselves never do wetin dem sopos do, which is providing jobs for the youth for we country, and na because of lack of jobs dy make most youth feel say na the best and easiest way to make money, which we, we know say na just fantasies of gamblers.
Wetin government fit do now to withdraw some youth for betting shop na to engage them, by providing jobs for them, because sometimes even the ones wey get mind to still play betting no go get chance to play am due to wrk. So that is the best way to reduce this menace to me.
member
Activity: 117
Merit: 4
Apart from churches and POS stand, I doubt say any other thing plenty pass betting shop for this we country.

 Almost all the street for my area get at least one betting shop and I know plenty persons when no de go look for work but de go just baff finish enter the place play vitual from morning till night and them go return back to their house.

I understand say e de help boys on a normal oh, but I still feel say e de make most of our youth to be less productive as most of them still de hope say one day them go just hit jackpot like this and their level go just change.

E for no make sense make our government look into this betting stuff and try regulate am in a way when no go make our youths become addicted to it?

Because of say some of them de win for sometimes, some people no de gree go find work do or look for one skill when dem for learn, everybody wan de bet and some go even get mouth de talk say e better to stay for beating shop from morning till night rather tan doing yahoo. Why you go de compare bad habit with a worse habit no?

I know wan too delve into the so many negative effect it has had on our youth oh!

But How una see this betting matter?   

Regulate wetin??? Crime rate go just sky rocket... I believe say people need to advice themself...i work for bet shop after secondary small so i understand you...but e get people wey e dn change their life also people wey e damage their life... So my stand be say allow them advice themselves... good things dey always birth from self advice and determination
full member
Activity: 490
Merit: 225

Jump to: