Author

Topic: No be everytin dem dey talk for outside. (Read 17 times)

hero member
Activity: 798
Merit: 702
No be the first time this kind thread they pop up the op of that thread no even be the first person, and this kind matter no be something of to give who you carry come better orientation nah matter of common sense, no country way no get bad people but you no go see people they talk about am everywhere, but that one aside nah digital world we they so even outside this forum new broadcasters don already paint the country red but even as that our country still they below countries like Russia, Indian, Pakistan, for the last data way dem publish about internet scammer. 
data 1
data 2

Mind you pidgin no they hard to understand who bring head and mind down fit read am well incase you feel say nah only you and people way from here fit understand your write up..
full member
Activity: 560
Merit: 161
Ma contri pipe e get post wey I see for a section of the community wey me i no gbadu at all. I dey try tu make dis post make e b only us wey b naija wey go fit understand wetin I dey talk.

Dis person wey I dey talk about talks something wey no dey good at all about our own country people. No contri dey good but other people wey from another country dey cover their own bad side.

Some of the tins wey wi dey talk about our own no even dey necessary for other pipo to know about it, instead e fit be somtin wey dem go still use against us and dem go see all of us as the same thing.

I no wan post d link of the post here, but d person make post say our country people na only online 419 dem dey do as work now.

I know say many of us here na person bring us come here and as we dey bring other new members make we try give dem better orientation make dem know wetin dem go dey post wey go make other people respect us for here.

Even if we wan talk things wey dey sup for our contri, we fit talk ahm with our pidgin wey others no go fit understand.
Jump to: