"The Nigerian government has shown interest in blockchain technology, the technology underlying Bitcoin, and recognizes its potential benefits in various sectors such as finance, supply chain management, and more. So, while they may not have accepted Bitcoin as a local currency, they are still exploring how to leverage blockchain technology in their country."
To start with, this part of your post wey you put for quote, if e no be your own original sentence or phrase then make you try add the link from where you from lift am but na your own, no wahala.
So regarding your post about adoption of bitcoin, we know say naija no fit stand on their own, so dem no fit join El Salvador for now. Naija government go want make at least countries wey matter begin adopt am and like we dey see say some don begin talk about blockchain and to use am for election like US, that na im make dem even dey consider blockchain. But make we forget about adoption of bitcoin from countries oo because the government go want to have control over currency and that one follow for one factor wey make them be government and again bitcoin dey volatile. So dem go just support their CBDC and take blockchain support the system.