https://twitter.com/benliquidkenya/status/1768254440300069172?t=mSkxwMVfIQiqLUNxniCQDw&s=19
The few days wey I experienced bad network for we country I been still get access to run my p2p transactions because the bad network been no totally affect all the telecommunication networks like Airtel, I been still dey run my transactions smoothly because I swapped my sim since Mtn and Glo network was down. If to say I not get other alternatives I no really know how I for do even with the posting cause using mtn to access the Internet wasn't working that day too even doing bank transactions was also affected cause mobile banking apps was not accessible as people were totally stranded.
Op, abeg if you get other method wey we fit take bypass this kind of situation especially the p2p transactions in this type of situation feel free to notify us because this thing fit happen again in a bigger way we don't expect this one na warning sign.
Yeah, when this bad network issue been dey disturb well well for all network, Airtel been still dey manageable. I for I dey na only Airtel been dey work well, and I thank God say I get Airtel sim, if not I for no fit do anything. Because of this network issue, some persons at first come dey put the blame for opay head say na Dem naim no get network, untill e come dey clear say na the sim Dem na get the issue. With that bad network, I been still get access to somethings like transfer and using P2P. Anyway Sha the network issue don better pass before and now you fit get good access to the internet only the first day wey e start.