For example dem go say make you deposit 10k to get 20k.And many pipo don fall as victims some even go further to invest their school fees and house rent on d Moni platform wey go later crash with their cash. Which have lead to alot of frustrations and sometimes losses of lives (suicide). Dem go pay for certain periods of time to ginger pipo to invest more as dey invest dem go just closed the platform.
I think wetting dey cause that thing na greediness or playing smart in the wrong direction. Those platform wey dey do all those things have the motive of defrauding people and Dem get time frame and e no dey pass 1 or 2 months. And if you wan make money from them na just the first time wey them go come wey Dem they find customer wey you go fit chop them, but when e don dey pass one month just comot your money because na go e don dey go. No be say I dey advice people on wetting no nice but I dey talk base on expirence. Because you fit take advantage of any opportunity be it good or bad depending on how smart you are. Those people just be like some memecoin wey Dem launch e go pump for sometimes come dump and na early investors go make money comot hand while late investors go fall victim.
The advice I fit give people be say there is no free money anywhere. Because where and how ona think say them dey make there money wey you go invest 10k get 20k so when you see that kind offer, just run for safety except you wan try luck. One thing wey dey baffle me na how people dey ignorant to the extent of falling victim of ponzy scheme countless time. After mmm don come many other come but people dey always fall victim all because them wan make quick money.
Why don't invest on Bitcoin, normally risk dey too we know! But that Moni platform Naim dey risky pass by far. Just jewelry buy your Btc store am for your paper wallet. Hold am for long because in a long run your profit sure and you'll be in a safer side.
Normally most of them for like to invest on bitcoin but they even think say na Bitcoin naim be the real ponzy scheme. Because them dey hear say naim Yahoo boys dey use cash out due to misinformation.
While some wey Dem don give information about bitcoin think say Bitcoin too slow for the kind money them dey expect due to impatient. The funny part be say some wey get money for bitcoin go sell am go invest for ponzy scheme they think say them go make quick money not ontil there money go dey traped before there eye go open. So make we dey always dey careful for investment we dey do because get rich quick scheme dey be like say na juju them dey use, where as na our greediness naim dey push us enter even say we know say e fit crash.