Author

Topic: Patient to read post (Read 304 times)

full member
Activity: 1134
Merit: 154
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
April 16, 2024, 02:46:03 PM
#29
My country people una good evening as I carry this one come to ask una here..
I know say many people wey get strength to read lengthy post dey but e get one of my thread wey I create for reputation board wey I see one oga like that come comment for the thread, him make am clear say him no fit devote time to read my post but him just reply my post based on my title. My question be say how this kind people take push for the industry wey be say persin need to read to understand wetin the whole thread dey talk first before persin go comment but this one open my say him no even read but just comment although him comments no too dey bad sha but I see am something we no too organized like say him read the whole post.

Now if na we people post this kind thin shay dem go report am as shitposter or person wey no know wetin dey do abi?

Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.

That one na true sha, e good mk person calm down read post before e go fit reply or quote person self but sometimes the fault dey from the poster hand, wey be say e go talk another thing for topic, come dey write another, wey dey confused person at times, especially for people wey be if dey see some kind topic like this we no go just go read first before we reply, we go just reply one time, later we go go come see say wetin we dey talk and wetin others dey talk no be the same things o, so e go better too mk we calm down dey read post before replying and also mk poster also create context mk e rhyme together with we dey create as topic and at a time some people no dey get dat strength, because one thing or the other so to save person strength and energy.
hero member
Activity: 798
Merit: 669
August 20, 2023, 04:38:06 PM
#28
Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.

Dat your post really lengthy and no be everybody go fit sit down go through am read before dem comment about am. As you talk, d person reply you base on the topic wey your post be and dis na true. Even from looking at your topic title and then scroll down to pictures then d conclusion part, person go don already know wetin you dey get at. I don see some posts wey be say the topic title go dey different from the main topic discussion, wetin you go talk about dat kind matter for people wey dey comment to post only from title wey dey don see? Mostly dis no dey happen to high rank members but newbies, as you be senior member, person no suppose think twice say you go go off topic contrary to wetin the title be. Me I no see any problem with dat as long as the person comment dey in point of wetin the topic of discussion dey talk about.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 17, 2023, 04:18:06 PM
#27
Guys e no easy for Ezekiel o😄 to dey patience to read post na work o expecially the newbies. After person go don read the rules guiding the forum person no go like make mistake.

Sometimes me personally no understand this forum. because the forum no get who dey guide each other. Everybody dey find merit. If many people wey dey here understand how to get merit with short story I think some quantity message for no dey dis forum.

Do not focused your thinking and efforts on how to earn merits rather be creatives in constructing post, and let it be meaningful then merits will flow on you. Like this our locals you can be actives to be giving some latest updates and if any of them gets people attention then I am sure what you want will definitely follow you. There are other people who have been here before you, including I Myself also break out by devoting time to read post and then you can contribute heavily as well; if you don't read post and you always think of merits how would you contributes to fetched you merits and besides meriting shouldn't be your ultimate goal otherwise you won't last longer here as you might be scrapped out quickly.

Na wetin make you go seatdown carry ur phone or lapi read wella if not no joy for you, and you must change your mentality you must not reason like the normal people you know, you have to be abnormal to be normal. In essence what do I mean?
For you to excel in this forum you need to remove haste and rush because we believe we all that gets to this level didn't start a day to start earning merits or to start waxing greatly in the forum. "Our people say na small small dem dey carry lick soup wey dey fire". 
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
August 17, 2023, 01:00:49 PM
#26
Guys e no easy for Ezekiel o😄 to dey patience to read post na work o expecially the newbies. After person go don read the rules guiding the forum person no go like make mistake.

Sometimes me personally no understand this forum. because the forum no get who dey guide each other. Everybody dey find merit. If many people wey dey here understand how to get merit with short story I think some quantity message for no dey dis forum.
No be only you many people e no fit read post mostly di long threads. To read di rule e good because dat one na to direct you weti you go do wey tok about the probs and cons. In the forum we dey guide one another, and weti you go do be say, make you ask questions whenever no something, no just mute like that. And if you dey find Merit, na dat time u supposed ask questions to create quality posts so dat people go give you Merits. Normally forum na personal race.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
August 17, 2023, 12:10:23 PM
#25
Guys e no easy for Ezekiel o😄 to dey patience to read post na work o expecially the newbies. After person go don read the rules guiding the forum person no go like make mistake.

Sometimes me personally no understand this forum. because the forum no get who dey guide each other. Everybody dey find merit. If many people wey dey here understand how to get merit with short story I think some quantity message for no dey dis forum.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
August 17, 2023, 07:28:02 AM
#24
Understanding differs, note your topic, is a succinct explanation of the content of your message or writeup, this is why people don't bother reading the full post, before making their contributions, another fact here is, as we advance in knowledge, we may not necessarily need to read much about stuff before talking about them, may be because of our versed idea on similar subjects discussed earlier, I think it is normal for things like this to happen, every post has its reply with a different opinion and argument, sometimes people find it hard to go through it rather they make their contribution and move on.
jr. member
Activity: 50
Merit: 7
August 14, 2023, 06:59:19 AM
#23
As some people don already comment, from some topic you fit know watin the person wan talk, but if you want comment e go better to read that post well well.
I've actually seen posts where the topic is saying one thing and when you enter to read you see another thing. It could be really bad if one just goes and comment based on topics. A lot of threads are really long and for us to write something really reasonable and good we need to read it and understand what the individual is saying. I believe I can't be the only one who even go as far as reading comments, if I am then maybe it's cause I'm still learning alot about Bitcoin and the Bitcoin forum.
I'm probably not in the position to tell them OG's in the forum to read before they comment, but it'll definitely be profitable to my fellow newbies here that patience to reading, learning, commenting and even writing your own thread is very important.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 12, 2023, 02:14:09 PM
#22
Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.
No be person wey write plenty na him dey make sense, quality isn't judge from quantity. Sometime self wetin me dey use judge quality post na post wey dey bring about quality discussion from all the paragraphs of the thread. Like people fit read your title know wetin you dey write about and give him opinion, him fit still read first paragraph or your conclusion and have something to contribute. When the whole topic is filled up of quality, discussion can be gotten from everywhere. This forum no be lecture room, it's a forum used during leisure hours so no expect anybody to dey wast him precious time to read everything wey you dey write, life hard already no add to am.

Na good thing you talk so but sometimes e still good to read some post even though person no get strength everything but e good make know wetin the thread dey talk, because thin you see so fit affect upcoming people to dey skip post. And one thin wey help me na to dey read post as well if not e for hard me well well here so, and if newbie begin get this kind orientation now e go hard to focused and read important thins no wonder dem dey always report our brothers as people wey dey spam because no strength and energy to read through plenty post. Yes you hit the point say here no be place wey people go dey seat down dey read every every but e good make them develop the heart and passion to read before skipping post or replying post through their titles, at least e get some kind level them go reach here then dem fit skip body of the topic.

I believe say pipo like you fit read through title dem no go fit put much eyes for you but if jjc come onboard do that kind thing people fit sanction onto say them never gain ground. See eh me no argue you for one day oo say wetin you talk no follow but me go like to also encourage our newbie to read no matter how the thread and topic long reach as them read am e go give them better edge to save their heads.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
August 12, 2023, 10:08:14 AM
#21
Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.
No be compulsory to read a post from beginning to di end, sometimes from di title you go easily deduce wetin di topic dey talk about and sometimes wen you read first few lines you go also know wia di poster dey go. Personally, I no dey like lengthy posts except na topic we interest me or na subject wey I wan gain knowledge. Just as Brainboss talk no be quantity na im really mata, na quality. Wia dose lengthy posts dey bad pass na if di person no be native English speaker or di person just put some incoherent thoughts with disjuncted grammar into writing. A well structured, concise and to the point posts or reply go do di work for you instead of all dose talk talk or repetitions wey no really mata.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
August 12, 2023, 04:07:32 AM
#20
You supposed know say some people get plenty experience for this forum so them go just connect the topic to the board where you post am to understand wetin you dey talk even if them no read every every wey you write. Na you call the person Oga, meaning say him get the experience to connect the dots. This may not be easy for person wey never gather that kind of experience. I no dey talk say reading the entire post to get all the details dey bad, but you know say some of those Oga them get plenty things for their hand... them fit no get time read every every before them contribute.

Make we no forget say as our faces different, na so our habits different too. I know plenty people wey no like reading in general;e come be long post, them no follow you for that kind play. I also know people wey dey read very fast and like to read wella... na those people we dey call jacking machine for Uniport those good old days.

Nevertheless, I believe say we too go mature reach that level for this forum. Personally, I no dey too feel bad when them criticize me because I believe say I no dey perfect; so I try to draw the lesson from criticism. Therefore, make we dey push am small small dey learn wetin the forum dey offer and I believe say we go mature with time.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
August 12, 2023, 03:39:39 AM
#19
Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.

Na you go carry forum for head, people get plenty things to do in life and reading through the forum isn't a priority for them. Personally I mostly just skimmed through most thread especially those ones wey dey belike article. The forum was made for discussion and for discussion to flow properly your need to make your point as easy as possible to understand and straight to the point that's why the way you write the topic of  your thread will determine if it'll attract readers or not. We need to forget dat saying wey be say "don't judge a book by its cover" because for here you can easily sight a quality or spam thread from the introduction to the thread which is the topic. Nobody owe you to read through your whole thread as discussion can be gotten from any part of the thread.

No be person wey write plenty na him dey make sense, quality isn't judge from quantity. Sometime self wetin me dey use judge quality post na post wey dey bring about quality discussion from all the paragraphs of the thread. Like people fit read your title know wetin you dey write about and give him opinion, him fit still read first paragraph or your conclusion and have something to contribute. When the whole topic is filled up of quality, discussion can be gotten from everywhere. This forum no be lecture room, it's a forum used during leisure hours so no expect anybody to dey wast him precious time to read everything wey you dey write, life hard already no add to am.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
August 12, 2023, 01:05:54 AM
#18
So from what everybody said here, I have been able to draw to a conclusion that we have got 3 kinds of people here on this forum, that is,
First, those who dislike long post & always try to avoid it.
Second, those who always try to have a glance through a long post to catch up the centre message to see what they can come up with (i.e reply)
Third, those who don't mind reading a long post from A-Z, in as much as it's a thread created by a fellow forum member.

And all three are totally okay, in as much as it's not compulsory to post on long thread, and whichever format gives you the ability to engage in meaningful conversation here on this forum, then you are at liberty to use any, as long as you follow the rules that governs this forum without using hateful words.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
August 11, 2023, 07:36:52 PM
#17
My country people una good evening as I carry this one come to ask una here..
I know say many people wey get strength to read lengthy post dey but e get one of my thread wey I create for reputation board wey I see one oga like that come comment for the thread, him make am clear say him no fit devote time to read my post but him just reply my post based on my title. My question be say how this kind people take push for the industry wey be say persin need to read to understand wetin the whole thread dey talk first before persin go comment but this one open my say him no even read but just comment although him comments no too dey bad sha but I see am something we no too organized like say him read the whole post.

Now if na we people post this kind thin shay dem go report am as shitposter or person wey no know wetin dey do abi?

Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.

Well I even had to quote the entire thread because me self no be fan of reading long stories especially  when the stories no reay dey catchy to me and the truth be say over the time, I don read topics and threads wey I later discover say na total waste of time and most times people dey confuse quality  and quality  and them forget say quality  fit dey for less then 5 line post pass the full Bible story wey person go write.

On the other hand, once I open a thread and the story long, especially  without link, the first thing I dey do na to tap op for inbox irrespective  of the country and try let am know say reference no dey him work just incase he carry anyone from the internet.
I don't reading post  no matter how interest the story might be and it takes serious dedication  to achieve this.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
August 11, 2023, 05:59:59 PM
#16
Make I just put mouth for the matter after I don read almost wetin my people drop here, for my own eeh, I no dey read everything went person post before I respond or comment but once I get the centre message, I don already know wetin I go comment and most times too from the topic person fit know wetin the op dey talk about but for some people wey write plenty plenty story, once I come across that one, na to just cut something wey I wam talk about comment on that one asap.

Sometimes too if you no read post well well before you comment e go make you go off topic atimes na why you gats try read at least the first two or three lines before you begin dey respond e go help you not to go off completely.
member
Activity: 784
Merit: 34
👉bit.ly/3QXp3oh | 🔥 Ultimate Launc
August 10, 2023, 10:14:53 PM
#15
My country people una good evening as I carry this one come to ask una here..
I know say many people wey get strength to read lengthy post dey but e get one of my thread wey I create for reputation board wey I see one oga like that come comment for the thread, him make am clear say him no fit devote time to read my post but him just reply my post based on my title. My question be say how this kind people take push for the industry wey be say persin need to read to understand wetin the whole thread dey talk first before persin go comment but this one open my say him no even read but just comment although him comments no too dey bad sha but I see am something we no too organized like say him read the whole post.

Now if na we people post this kind thin shay dem go report am as shitposter or person wey no know wetin dey do abi?

Na dis make me carry this one come to know how una dey manage for reading aspect for this forum abi una dey do like that person wey I take set example? As for me since I know how I take walker reach here I no carry reading play even though e take me 2hrs to finished a thread me go gredie there to finish reading before I go hit sumbit button. I com say make I asked see how far dey way una dey carry read as well.

E good say you bring this line wey i mark for RED come inside this talk because for sure them go nack am warning message join, my dear even if i know weytin the title don already talk me go still gredie read the post well, with that self i go dey find out small small grammatical error wey dey inside den come point am out for the person to do the needful.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
August 10, 2023, 03:43:47 PM
#14
No be every body wey get that time to dey read long story o. Some people just need short and simple sentence wey them go just read and understand unto say the sentence get full meaning. Some people go just look the topic of your post know wetin the writer dey upto then dem reply am because dem see reading of lengthy posts as a waste of time. While some go just read your topic know the content or body of the post then know wetin to reply.

But I think taking time to go through post would be more better and worth it because you will clearly digest everything to your understanding and knowledge while reading.  You can only get a better understanding of what a poster made only when you read the post. This would guide you through while replying to that post of need be.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
August 10, 2023, 04:39:58 AM
#13
The thing be say e depend on how catchy your topic is and how informative your content are too. We all know that reading is not a lazy man job and na why lazy student dey fail exam for school. When the topic no dey interesting some people no go even open am and if the content con long again without meaningful ingredients inside e go make am worse. The truth be say plenty of post for the forum no dey align with the topic at all or sometimes with little correlation between the topic and the content.

Best thing is to summarize your post to make am look short and informative with attention catching topic if you are making a post. If na comment you want to make, read the topic first and you go derive ideas (assume na you want to write on that topic) read the content for more information and if possible read few comments under the post if there's any and then make your own opinion. E no dey possible to read everything but the little you read should be able to help you add something to the conversation.

And again, Forum na where sentiment and agenda gather dey  Grin you go learn to tolerate and overlook plenty things wey no add value. Some people comment na troll and discouragement full am while some na criticism and of course some na commendation too. You go train yourself to adapt. If you get the energy, you go return any similar things given to you but I go advice you to stay out of troll as someone coming up. Gradually we go all continue to grow.
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
August 10, 2023, 04:00:02 AM
#12
Reading a post completely actually determines how well composed your reply and contribution will be be so Me I de always read a thread from starting to end if na topic wey interest me but some post de wey too long and boring again so if I de read that kind post e no de ginger me to read am finish especially when I de read am go I no con de understand the message wey dem de try pass. But me I like post wey no too long and wey the message de direct and straight forward.

Since it’s not mandatory to reply to all posts on the forum once i see you post is a lengthy one I try to go through it then if along the line I find out it’s boring I immediately close the page and stop reading it. Though sometimes e depends on my mood at that moment, I feel lazy sometimes and other times I feel so active so if at the time of reading i de lazy I just skip past the post.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
August 10, 2023, 02:06:24 AM
#11
Your content dey come from di topic and dat make it article. So a good op draw his conclusion from the topic nor the topical sentence so if di commentators understand di topic then they can also draw a conclusion from the op topic. So their comments sometimes correct with content with di op. Because sometimes to read lengthy text dey tire pesen. But really it is very good to read everything in di op and if possible read some comments before making your reply so dat u will know what to say from di op and other comments.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
August 09, 2023, 03:52:38 PM
#10
The thing be say people no dey too like read posts wey too long, sometimes dem fit just skim through the post to try understand wetin e dey talk about, if you use only post subject take reply to posts, you fit post off-topic posts oh, because e get people wey their post subject no concern wetin dey the content of the post. So even if post long, after reading the subject, na to try skim through the post, and you go definitely get wetin the op dey talk, but if you be person wey fit read posts wey dey very long, you fit read am. Me i no go fit reply to posts wey i no read, so if maybe the post dey too long, e better say i no reply than to reply without reading it.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 09, 2023, 03:14:45 PM
#9
For me, from the title of that thread which you gave above, with the pictures and first paragraph, it has already explained all what a person needed to understand from that thread without reading the entire thread, good enough to give anybody a clue of what to comment about, because if you can observed, you will notice I'm one of those who congratulated you on your achievement of getting a new phone, but I literally read your thread in full from A-Z, as a familiar forum member I have always come across to be active on this local board.
So the fact that that person didn't read your thread in full, it doesn't mean people don't read here. As It's you who summarized your whole thread in first paragraph & pictures.

Well I don't practically mean people don't read but when it comes of a lengthy post or what if person made a mistake with their title to test those who only follows titles to comment don't you think something might happen to them as it is.
Actually I do see everyone's reply to me and I am pleased to see my people where there to cheer with me though despite you all didn't meet one on one but I guess few people are around us came in person. The truth is that it's actually good to read the whole body of the content before using their titles to expressed their entire body of the language.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
August 09, 2023, 03:05:31 PM
#8
For me, from the title of that thread which you gave above, with the pictures and first paragraph, it has already explained all what a person needed to understand from that thread without reading the entire thread, good enough to give anybody a clue of what to comment about, because if you can observed, you will notice I'm one of those who congratulated you on your achievement of getting a new phone, but I literally read your thread in full from A-Z, as a familiar forum member I have always come across to be active on this local board.
So the fact that that person didn't read your thread in full, it doesn't mean people don't read here. As It's you who summarized your whole thread in first paragraph & pictures.
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
August 09, 2023, 02:28:38 PM
#7
Wetin you need to understand sae no be everybody fit get that time to d read lengthy post. Once you make a lengthy post, some people go just read little of the post and dem don grab wetin the post the talk about. Some go just reply to a post based on the title of the post. Whichever way wey that peso chooses, na em own business as long as wetin em wan yarn for the post d align to wetin the post d talk about. I no see any problem for that mata.

Every one of us wey d for the forum, get ways of how em d take read and understand a post. As for my own case, I no get that time to read a lengthy post. Once I don read one or two lines of a post, and read some replies, I don grab wetin the post mean, and I don get my opinion to give for that post. No think sae peso supposed d read a post finish first before em go understand wetin the post the talk about. Our reading approach and mentality differs
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
August 09, 2023, 03:35:48 AM
#6
You know say for this life no be everybody be the same. Some people the moment them see the topic,e fit be something we them din already get idea on,that go make am easy for them to give their own contributions. Some person no like lengthy topics as e dey make them tire to read am so wetin them dey do,na to read people comment on the topic to get idea on wetin the topic dey about. Then some people dey post long post wey no get any good information. Something wey them go fit just summarize and go straight to the point. Imagine say you read long post with no information as expected. This follow for wetin dey discourage people from reading long post. I dey read long post depending on the OP wey create the topic and most times I dey jump and pass long posts based on the topic.
member
Activity: 159
Merit: 39
August 09, 2023, 03:29:04 AM
#5
Sometimes you fit tell wetin the Op dey try talk from the title but at the same time e beta to read so you fit contribute intelligently make you no go talk out of point. Some posters dey feel say nah wen dem make the post long but lack useful info nai go qualify am as quality posts and dis wan dey usually tire some readers.

I believe one of the importance of making good communication nah when you understand wetin the speaker dey talk, that way you fit get one or two knowledge, no be to just rush enter simply because you feel say you get wetin to contribute.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 08, 2023, 07:39:39 PM
#4
eh get people way be say normally dem and post way long no they come in line, me self eh get some kind thread way i they meet for diz place, eh get where i they read am reach, if no be watin they enter my head (I mean topic way be say i they enjoy or i see something to learn inside) Omo i they close am go my way, sometime nah the comment i they read one after the order to come really grab watin the OP they about. from there i fit pick up the line way i fit reply.

As  Charles-Tim talk, sometimes Topic alone they talk everything, so the OP suppose just be detailed explanation, but eh get some thread way be say person fit just read the title carry reply, b4 u know u don fall ur hand, me i don be victim of something like that be, were the title they talk another thing the thread they mean the opposite, nah after one member quote me come call to my attention say assuming say i read the thread well i 4 no ask the kind question way i ask for my comment, nah there i realize say i don mess up. after that day, if i no read the thread finish, i they fine the last line of the thread way some OP they always ask to share opinion or watin person think quote talk my mind on watin i sabi about d topic waka go my way.

Like on a serious note ehh, since I began to change my post quality and also learning from our man JayJuanGee that was how I changed my narratives to start reading because you can't talk with him without you being in line with what his is saying, after I focused to follow him I noticed the secrets of the forum is for one to devote time to read then the rest which we are looking at will quickly follow you, and that was how I took my speed from where I used to be to another better place but I know here isn't the end but I wish to go further than this..
It pays to read, I mean there is benefits when we do read a thread to know what is saying about than just to summarized the whole content with just the title of the message which it doesn't show any acts of seriousness in life.
hero member
Activity: 560
Merit: 624
August 08, 2023, 06:59:36 PM
#3
eh get people way be say normally dem and post way long no they come in line, me self eh get some kind thread way i they meet for diz place, eh get where i they read am reach, if no be watin they enter my head (I mean topic way be say i they enjoy or i see something to learn inside) Omo i they close am go my way, sometime nah the comment i they read one after the order to come really grab watin the OP they about. from there i fit pick up the line way i fit reply.

As  Charles-Tim talk, sometimes Topic alone they talk everything, so the OP suppose just be detailed explanation, but eh get some thread way be say person fit just read the title carry reply, b4 u know u don fall ur hand, me i don be victim of something like that be, were the title they talk another thing the thread they mean the opposite, nah after one member quote me come call to my attention say assuming say i read the thread well i 4 no ask the kind question way i ask for my comment, nah there i realize say i don mess up. after that day, if i no read the thread finish, i they fine the last line of the thread way some OP they always ask to share opinion or watin person think quote talk my mind on watin i sabi about d topic waka go my way.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
August 08, 2023, 06:53:35 PM
#2
From a topic title, sometimes you can predict what the whole topic content would be. But as for me, I still take time to read the whole topic content before I will reply on a thread. If I know that I will not read the topic content, I prefer not to reply.

Sometimes people also easily know what the content would be. I did not read the topic content but in 15 seconds of looking through it, I have concluded that it is about electricity issue in Nigeria and how you will prefer to use a device that will last long after full charge which makes you buy Vivo Y16. But still I prefer to read the whole post to make sure that my post is not off-topic.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 08, 2023, 06:08:06 PM
#1

Jump to: