Author

Topic: Possible scam attempt message for newbies. (Read 128 times)

member
Activity: 132
Merit: 14
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
October 20, 2023, 03:39:04 PM
#11
As naija come be like this we suppose dey Galant and on the look at for possible scam, illegal hustling here and there.

I believe say many of us don receive texts and calls from possible scammers, how person go send me message say Dem don give me stay-at-home job and the pay is 65,000 per day that I should just click the link below to claim it. Lol, I would literally tell my family members about this job if I were the person, but yeah it isn't legit and that's why they look for victims that aren't their family members.

Like 65,000 pay per day isn't that a scam staring at me in the face 😂 as Nigerians we suppose know wetin dey legit and wetin be scam, I believe say Nigerians get Sense so make we apply our sense here too, make a guy no go guy a guyyo.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
October 05, 2023, 05:03:47 PM
#10
This matter really tire person because when them send me that kind messages to my number, them come call my line say make I send them my bank details say them dey detect issues from my bank. At first then call my name come asked whether na me be so so and so person, I come say yes then say they have been trying my number say e no dey reachable make whether I fit get chance call my card details for them say emergency dey for my bank account. Before I know them say go inside pick your atm card make we secure your account say them detect say scammer dey try withdraw money from my account say them block am but I go need to change my ATM pin immediately to avoid further damage say make i call the previous pin so that them go generate new pin for me to secure my card.

My people this story became more interesting because me self don already get the code say na scammer dey do but on the hand I wan waste their airtime to dey keep them on work, so them say are ready to call your card details and I say yes.. Na so them say oya start, I called many random numbers unstoppably till them say repeat, I still repeat another separate random numbers my people the matta became more interested them tell me saying give us the pin, I call another for random number and them say repeat I still a separate numbers till there airtime exhausted na so I say thunder fire them there.

See the thing is, we need to be smart to outsmart those scammer, infact e get one self wey send me card one time like that wey them call me, I tell am say the room where my card dey inside my people sister pikin lock am comot say I need airtime to call her to bring key so that I go send them my card details, na so de scam say how much card I need. I as good woman I tell am any amount them send is good for me, na so them send me 500 Naira card to buy my heart so that I fit happy send them my card details but immediately them send me card na so my zoom of my line go sleep first 🤣.

Those guys dem no get joy at all. Every body dey vex for this country as things don be like this wey make men don begin run things street way.  Na to open eye for them if them come your way collect them go your way like nothing happen. Dem no go think to near you again for their life because dem don learn lesson say no be everybody dem go just wake up in the morning begin call like that. E good as you teach them lesson.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
October 05, 2023, 03:38:57 AM
#9
Big companies  still de spend plenty money de advertise dem products, evendo say dem products de very popular and everybody know dem, so dis information no be for newbies alone, na for everybody. Evendo say every member here suppose know wetin de about di activities of scammers, weda for fiat or cryptocurrency. Because faith comes by hearing , no matter how many times wey we don hear or even experience am, we suppose to constantly de remind ourselves, no matter how many times.

For dis technological age, person suppose de very careful about enticing links and calls wey de promise  rewards, weda na financial, gifting or even help, because of di activities of dis scammers. Infact na to treat certain calls and links wey enter your phone as suspects. Some go even call you as your friend or relation and de tell you one story of how dem take de stranded or inside hospital, if you panic go ask weda na certain person be dat? Dem go say yes, claim to be dat person and send you pos account number to transfer money, later your eyes go come clear say na scam.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
October 04, 2023, 05:27:26 PM
#8
Scammers get difference scope to Carry enter people.person just need to be smart otherwise Dem go enter you unknowingly. No be only for crypto Dem dey use o. no be every link you see wey go tell you to sign in without your Facebook or Gmail wey you go use otherwise Dem go aslo hack you're Facebook account.
full member
Activity: 252
Merit: 157
October 04, 2023, 05:08:04 PM
#7
The matter tire me oh, I no no why people go just they reason how them go take scam people there money finish, without any consideration say people they suffer before them go get money them come they won scam the person, na so one guy call me come they tell me say him they work with p.square and that say them they do giveaway for people way go fit answer some question correct, so him come ask me about p square song I come answer all of them correctly so him come tell me say I done win 80 inches plasma TV, four apple laptop and three iPhone say but before I go collect am I go pay 50k before them go bring am for me so I come tell them say I no want am.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
October 04, 2023, 05:06:40 PM
#6
See the thing is, we need to be smart to outsmart those scammer, infact e get one self wey send me card one time like that wey them call me, I tell am say the room where my card dey inside my people sister pikin lock am comot say I need airtime to call her to bring key so that I go send them my card details, na so de scam say how much card I need. I as good woman I tell am any amount them send is good for me, na so them send me 500 Naira card to buy my heart so that I fit happy send them my card details but immediately them send me card na so my zoom of my line go sleep first 🤣.
Omo 🤣, I need to cor learn from you sha, they deserve it the highest I have to them is burn their airtime. All these scams nor dey funny especially all these ATM scam because this one nor be cause of greed but ignorance many people don fall for am and many go still fall put, sometimes I dey wonder these scammers tel dey know say person get ATM because I remember say na wen I tel request for ATM na I tel first recieve their call. This na one reason way bitcoin tel better bcos bitcoin dey anonymous and nor go fit fall for this kind scam say person call/text you say person wan hack your wallet if you dey use non custodian wallet.

Those people too get mind to do person something but las las me self feel bad too to also put them for my pocket, one thing we go always understand about this people be say them dey get mind to do person without even know weda you get the money or weda you be poor or rich their own be say make you bring your card so that them go scam person.

But any person wey dey vigilant no fit fall victim to all these small small scammer them because some kind things na ignorance, but I know say plenty people go still read through this my post here so that them go learn something wey dey very important so that them no go fall laxy for those scammers. Naturally me na one kind person no like to dey click any link or visit any site because I dey very security conscious for any hack, and some kind thread i dey always visit here too dey give me clues on how those criminals behave most times.

Only thing be say nothing much to learn rather shine your eyes know wen something wan become scam, sometimes those people dey always use charm to call person and you go recollect when them don already scam you before person eyes go open to know say that person just scam person.
sr. member
Activity: 490
Merit: 311
Play Bitcoin PVP Prediction Game
October 04, 2023, 12:26:35 PM
#5
See the thing is, we need to be smart to outsmart those scammer, infact e get one self wey send me card one time like that wey them call me, I tell am say the room where my card dey inside my people sister pikin lock am comot say I need airtime to call her to bring key so that I go send them my card details, na so de scam say how much card I need. I as good woman I tell am any amount them send is good for me, na so them send me 500 Naira card to buy my heart so that I fit happy send them my card details but immediately them send me card na so my zoom of my line go sleep first 🤣.
Omo 🤣, I need to cor learn from you sha, they deserve it the highest I have to them is burn their airtime. All these scams nor dey funny especially all these ATM scam because this one nor be cause of greed but ignorance many people don fall for am and many go still fall put, sometimes I dey wonder these scammers tel dey know say person get ATM because I remember say na wen I tel request for ATM na I tel first recieve their call. This na one reason way bitcoin tel better bcos bitcoin dey anonymous and nor go fit fall for this kind scam say person call/text you say person wan hack your wallet if you dey use non custodian wallet.

Na so I receive this message directly to my phone today. I come dey wonder why the scammer no use him number send me the link.  I come begin dey reason am say make I try see wetin dem send. I copy the link to another Separate browser wey no dey signed into my account come use incognito mode open am Na telegram community pop up wey dem say make I join in but something fishy happen as I clicked the link and another one open. Dem send a prompt  for me to allow external access to my applications wey no dey normal. Na there I just delete everything from my phone immediately so that I no go mistakenly go click the link unknown to me.
Op, watin you do good but next time once you see any message like this way dey obvious say na scam, just better leave am instead to click am and one thing way you need to know na be say incognito mode nor dey protect against hack or malware to avoid every issues e dey advisable not to click any link way person from random person or even person way them know especially wen the link cor dey suspicious.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
October 04, 2023, 11:42:00 AM
#4
This matter really tire person because when them send me that kind messages to my number, them come call my line say make I send them my bank details say them dey detect issues from my bank. At first then call my name come asked whether na me be so so and so person, I come say yes then say they have been trying my number say e no dey reachable make whether I fit get chance call my card details for them say emergency dey for my bank account. Before I know them say go inside pick your atm card make we secure your account say them detect say scammer dey try withdraw money from my account say them block am but I go need to change my ATM pin immediately to avoid further damage say make i call the previous pin so that them go generate new pin for me to secure my card.

My people this story became more interesting because me self don already get the code say na scammer dey do but on the hand I wan waste their airtime to dey keep them on work, so them say are ready to call your card details and I say yes.. Na so them say oya start, I called many random numbers unstoppably till them say repeat, I still repeat another separate random numbers my people the matta became more interested them tell me saying give us the pin, I call another for random number and them say repeat I still a separate numbers till there airtime exhausted na so I say thunder fire them there.

See the thing is, we need to be smart to outsmart those scammer, infact e get one self wey send me card one time like that wey them call me, I tell am say the room where my card dey inside my people sister pikin lock am comot say I need airtime to call her to bring key so that I go send them my card details, na so de scam say how much card I need. I as good woman I tell am any amount them send is good for me, na so them send me 500 Naira card to buy my heart so that I fit happy send them my card details but immediately them send me card na so my zoom of my line go sleep first 🤣.
full member
Activity: 448
Merit: 117
October 04, 2023, 11:26:34 AM
#3
Thanks for sharing this important and helpful titbit of info but I go still dey emphasis on the need to be careful and wary of these suspicious and phishing links. The stuff you drop sopoz ring alarm bells because person no go just dey throway BTC around and knowing how that value of 0.05 BTC when converted to we naira nah #1.368m, e for just tell you say nah scam.
 Scammers don dey dey desperate and if nah to use this kind thing lure unsuspecting individuals to their trap, them go do am but wetin you sopoz ask yourself nah;
- wetin you do to get such freebie?
- If e legit, why them never give their family members?
The info for the pic reads; "we give 0.05btc. use within 24 hours". Wetin you wan use 1.368m do in that short space?

Senior Man me too come dey reason the matter sef o. How person go just dey like this dey do this kind give away here wey him family dey one corner. Na newbies wey no get knowledge about the scope Naim go fall victim of this act. On a normal person see this thing na to rush am Na but as e be say man eyes don open as a result of experiences and lessons learnt in the course of life's journey. See the way dem package the message sef with upgraded Pattern sef go baffle you. If no be say we know how the system be, person for don fall Mugu be that o.
The desperation of these scammers is something else. One needs be careful because they Improvise every time with new schemes to achieve their goals.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 04, 2023, 10:34:00 AM
#2
 Thanks for sharing this important and helpful titbit of info but I go still dey emphasis on the need to be careful and wary of these suspicious and phishing links. The stuff you drop sopoz ring alarm bells because person no go just dey throway BTC around and knowing how that value of 0.05 BTC when converted to we naira nah #1.368m, e for just tell you say nah scam.
 Scammers don dey dey desperate and if nah to use this kind thing lure unsuspecting individuals to their trap, them go do am but wetin you sopoz ask yourself nah;
- wetin you do to get such freebie?
- If e legit, why them never give their family members?
The info for the pic reads; "we give 0.05btc. use within 24 hours". Wetin you wan use 1.368m do in that short space?
full member
Activity: 448
Merit: 117
October 04, 2023, 10:13:23 AM
#1
My country people. I hail una and I also believe say we dey gidiba. I say make I bring this topic here sake of say e go dey beneficial to our newbies wey just join us here. I know say we don dey hear about scam and how e dey take dey happen wey be say you go just click link wey dem send you for phone as text message before you go know another thing don pop up and you click again another one don come before you know scammers don scam you or to steal your details from your phone or gadgets then come use am steal from your wallet or otherwise.
Make una see;
 

Na so I receive this message directly to my phone today. I come dey wonder why the scammer no use him number send me the link.  I come begin dey reason am say make I try see wetin dem send. I copy the link to another Separate browser wey no dey signed into my account come use incognito mode open am Na telegram community pop up wey dem say make I join in but something fishy happen as I clicked the link and another one open. Dem send a prompt  for me to allow external access to my applications wey no dey normal. Na there I just delete everything from my phone immediately so that I no go mistakenly go click the link unknown to me.

I drop this one here so that our newbies dem go see am as examples of wetin dem dey always hear here say make dem no dey click links wey dem send as text message to their phone. Not only text message to phone also email and chats sent to your social media accounts too. Avoid clicking them to be on the safe side.

The funny thing be say them go just write one better caption for the content of the message wey go entice you to click the link immediately and if you no get intro on their gimmicks, you go just fall mugu for them and dem go use the person shine.

To our newbies here, try avoid such text message if you receive any and you are very much sure you don't know the sender and you are not expecting any message of such nature. Delete it immediately.
Jump to: