I been dey try to sell bitcoin in Binance just now and I see say di naira side e no dey work and I come tried USD di thing work and I come still try naira again na di same thing.
As I open binance the other time wey I wan check the price wey dollar dey, I see say the thing no show, but MTN network have been misbehaving since morning, so I was thinking it’s network problem so I just closed my binance app, until now wey I dey see this thread na him my brain dey tell me say no be network, we no fit make use of p2p again be that, but this one really weak my body ooo, plenty people don dey use to binance p2p.
If you dey use Binance dey receive payment make una go change am now and move all the coin you get in Binance to another exchange before the story change.
E no dey necessary make dem change wallet now, if they receive money for binance, they fit just send am go another exchange like KuCoin, then they will make use of p2p on the exchange, d only place Wey problem go dey na if government decide to ban binance in Nigeria completely. So the best thing na to dey use non custodial wallet dey receive your money, but if you get mind, then you still fit dey use your binance receive, then they use KuCoin convert your money to naira, I just hope the government won’t come for KuCoin one day also.