Author

Topic: Prick don become issue for naija these days (Read 184 times)

full member
Activity: 560
Merit: 161
October 18, 2023, 06:44:55 AM
#14
We naija people we no dey even help ourselves, the government no dey do us well and we common Nigerians still dey make things difficult for ourselves.  I still dey wonder how this country won take better and we put all the blame on government but we common citizens we no dey play that good role wey suppose benefit us, how the country won take better if the common people no fit do the right things,  that is why sometimes I feel if it is possible if things can get better. The reason why the government they get mind to dey do things wey dem like is because we the common citizens never get ready for change.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
My brother's and sister's, I be wan share this Matta with una, the matter fit be laughing matter but I gast to talk am, I don't know maybe the Matta go Don reach una side, I be Don dey see many videos since last two months now wey be the video of stealing someone prick, I Don watch like 5 videos now wey concern the video, some na from Abuja state, Kaduna state, Niger state and some states like like this, I be dey wonder say why we wan dey use each other part of the body do ritual?, after yahoo boy's they do their own on a lucky dey use people part of body plus their yahoo now people no dey even fear again, them just they carry am come outside now do am, even to take hand shake with person now don become fear.

I be wan ask is this that na hard economy they cause am, because people wey them they catch with stealing person prick na poor people, them no get money, that is why I dey ask say make be na hard economy, although I dey hear say them dey steal person prick but I swear this year of 2023 too much, this thing's wey just dey happen like this, I be dey wonder is the fault of government wey make people dey steal prick abi na waiting just some people mind them dey do?
Op, me never hear this kind tin for long, where you watch the videos them? I know say this prick collecting dey happen for our Naija but e dey dey minimal. The video way you see fit be a prank because skit makers fit use anytin way go drag people's attention carry do skit just to get traffic. For instance, e get the time way skit makers dey release video say, spiritual husband dey sleep with women for their skit. Nevertheless, make we dy careful of how we go dey waka, and also avoid late travel for Naija because we done dey enter December, and boys fit do anytin to get money to use flex for the December.
Ah they suprise say you dey talk asay you never hear this kind thing. Even yesterday i watch one wey for my freind phone yesterday. For my imo state this thing be done happen wey one man give begger money before you know e prick miss. As the man notice him prick no they the begger wan run unitll the man shout they catch the begger. The only annoying part be say the prick no come back but how people they even use this thing i still they wonder.
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
E get where this matter no reach? I don see videos tire online of how the same thing de happen for othere states, the way dem de steal pricks now ehn e just de suprise me seriously and e con be like say na new update we dey pay an why plenty people con de involve for the thing and wetin con de fear me pass be say all the states wey you mention so na places wey i de involve every now and then.

Abuja own sef worse pass, as i see the number of reported cases of stolen prick for abuja police station i shock, it was almost about 60+ cases. With all this things happening in the country they now want us to still believe that Nigeria will become a better country. Because to even shake and answer greetings sef don turn wahala naso so for keke na pep i go jus de inside sit down quietly like person wey no get papa and mama.

This is getting out of hand and all this things na the hardship of the country na im de follow cause all these things because na true all the people wey dem de catch so far na poor people but I doubt if na dem de use am do ritual dem selves, e fit be say dem just be errand boys wey de supply these parts give people wey need am dem go come pay dem one small amount like dat and highest i know say e no go pass 1 million wey dem go give dem.

I like am as na kill dem de kill dem so that others go learn because if dem no do am like that dem no go stop dem go still continue de do am. All this rubbish must stop abeg.
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
E don tey wey this matter dey surprise me. How dem go take shift person prick go and carry am go. Wetin dem wan use am do in the first place. Like believing this narrative to start with, is a funny thoughts then talk more of it turning to a news.

I no believe in the stuff from the beginning but due to how frequently different videos are shared over the internet, you are meant to believe in the scenarios and story as a whole. Scientifically, I don't think there's anything like stealing another person's manhood because I don't understand the chemistry put together to achieve that.

But again, why me self no go believe am small, na because say na for Naija I dey. This is Nigeria and there's literally nothing that doesn't happen here in Nigeria. All sort of mind blowing incidents have happened hence my believe system has been shifted tomorrow believing the stories. Another rumored incident was the report that a prick was stolen in government house but the governor of Niger state refuted.
member
Activity: 784
Merit: 34
👉bit.ly/3QXp3oh | 🔥 Ultimate Launc
My brother's and sister's, I be wan share this Matta with una, the matter fit be laughing matter but I gast to talk am, I don't know maybe the Matta go Don reach una side, I be Don dey see many videos since last two months now wey be the video of stealing someone prick, I Don watch like 5 videos now wey concern the video, some na from Abuja state, Kaduna state, Niger state and some states like like this, I be dey wonder say why we wan dey use each other part of the body do ritual?, after yahoo boy's they do their own on a lucky dey use people part of body plus their yahoo now people no dey even fear again, them just they carry am come outside now do am, even to take hand shake with person now don become fear.

I be wan ask is this that na hard economy they cause am, because people wey them they catch with stealing person prick na poor people, them no get money, that is why I dey ask say make be na hard economy, although I dey hear say them dey steal person prick but I swear this year of 2023 too much, this thing's wey just dey happen like this, I be dey wonder is the fault of government wey make people dey steal prick abi na waiting just some people mind them dey do?

On the other hand my brother no be today things like this don dey happen ever since wey I dey small I dey hear plenty story of how man go loss him manhood, e even get some story you go hear say person turn to goat 🐐🐐🐐, all this thing's e dey always happen for MHBA MONTH time, as in when the year don dey come to and end, like this we Gaz be careful when e dey reach time like this.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
October 14, 2023, 12:29:41 PM
#9
My brother's and sister's, I be wan share this Matta with una, the matter fit be laughing matter but I gast to talk am, I don't know maybe the Matta go Don reach una side, I be Don dey see many videos since last two months now wey be the video of stealing someone prick, I Don watch like 5 videos now wey concern the video, some na from Abuja state, Kaduna state, Niger state and some states like like this, I be dey wonder say why we wan dey use each other part of the body do ritual?, after yahoo boy's they do their own on a lucky dey use people part of body plus their yahoo now people no dey even fear again, them just they carry am come outside now do am, even to take hand shake with person now don become fear.

I be wan ask is this that na hard economy they cause am, because people wey them they catch with stealing person prick na poor people, them no get money, that is why I dey ask say make be na hard economy, although I dey hear say them dey steal person prick but I swear this year of 2023 too much, this thing's wey just dey happen like this, I be dey wonder is the fault of government wey make people dey steal prick abi na waiting just some people mind them dey do?
Op, me never hear this kind tin for long, where you watch the videos them? I know say this prick collecting dey happen for our Naija but e dey dey minimal. The video way you see fit be a prank because skit makers fit use anytin way go drag people's attention carry do skit just to get traffic. For instance, e get the time way skit makers dey release video say, spiritual husband dey sleep with women for their skit. Nevertheless, make we dy careful of how we go dey waka, and also avoid late travel for Naija because we done dey enter December, and boys fit do anytin to get money to use flex for the December.
No be prank o. Na the thing wey dey trend this days expecialy for ABJ. Many issues concerning this prick dismisal don full everywhere for social media. But no solution yet.

No matter how person dey careful, person ft dey at risk for the society. Person need get preventive messures to avoid am totally because they way this thing dey carry mis, you no go ft know. You go just later confirm say your John Thomas no dey the way e dey before you comot. So any body wey get info in prevention make e drop am here.
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
October 13, 2023, 05:09:24 PM
#8
My brother's and sister's, I be wan share this Matta with una, the matter fit be laughing matter but I gast to talk am, I don't know maybe the Matta go Don reach una side, I be Don dey see many videos since last two months now wey be the video of stealing someone prick, I Don watch like 5 videos now wey concern the video, some na from Abuja state, Kaduna state, Niger state and some states like like this, I be dey wonder say why we wan dey use each other part of the body do ritual?, after yahoo boy's they do their own on a lucky dey use people part of body plus their yahoo now people no dey even fear again, them just they carry am come outside now do am, even to take hand shake with person now don become fear.

I be wan ask is this that na hard economy they cause am, because people wey them they catch with stealing person prick na poor people, them no get money, that is why I dey ask say make be na hard economy, although I dey hear say them dey steal person prick but I swear this year of 2023 too much, this thing's wey just dey happen like this, I be dey wonder is the fault of government wey make people dey steal prick abi na waiting just some people mind them dey do?
Op, me never hear this kind tin for long, where you watch the videos them? I know say this prick collecting dey happen for our Naija but e dey dey minimal. The video way you see fit be a prank because skit makers fit use anytin way go drag people's attention carry do skit just to get traffic. For instance, e get the time way skit makers dey release video say, spiritual husband dey sleep with women for their skit. Nevertheless, make we dy careful of how we go dey waka, and also avoid late travel for Naija because we done dey enter December, and boys fit do anytin to get money to use flex for the December.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
October 13, 2023, 08:01:32 AM
#7
My brother's and sister's, I be wan share this Matta with una, the matter fit be laughing matter but I gast to talk am, I don't know maybe the Matta go Don reach una side, I be Don dey see many videos since last two months now wey be the video of stealing someone prick, I Don watch like 5 videos now wey concern the video, some na from Abuja state, Kaduna state, Niger state and some states like like this, I be dey wonder say why we wan dey use each other part of the body do ritual?, after yahoo boy's they do their own on a lucky dey use people part of body plus their yahoo now people no dey even fear again, them just they carry am come outside now do am, even to take hand shake with person now don become fear.

I be wan ask is this that na hard economy they cause am, because people wey them they catch with stealing person prick na poor people, them no get money, that is why I dey ask say make be na hard economy, although I dey hear say them dey steal person prick but I swear this year of 2023 too much, this thing's wey just dey happen like this, I be dey wonder is the fault of government wey make people dey steal prick abi na waiting just some people mind them dey do?

Things are really getting out of hand, we be dey talk say e no get how e go be wey e never be before but this matter is getting too much we need to be careful, before for me to hear say dem collect person prick e no dey pass like one times in a year, some sef i no dey hear anything but this year we just dey hear many things dey sup from different angles, una sure say better naija dey front so? If na hard economy governments no send anybody to still anything or person prick, i believe say work dey to give them daily bread.

Which fear we go even face for God sake now they say manhood no dey safe again waiting dem dey use identify person na man be this no dey save again. Person no go even think of another way to make money is to collect his fellow men life, because without it man life no get uses again, this country na sense person go dey use Waka because all this shit dey happen a lot in my state if i see anybody holding black nylon walking towards me na to change way o, make person no come dey face a lot still come lose manhood again. Even though governments provide job for the youths i believe say some people go still do waiting dey like.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
October 12, 2023, 05:04:13 PM
#6
I be wan ask is this that na hard economy they cause am, because people wey them they catch with stealing person prick na poor people, them no get money, that is why I dey ask say make be na hard economy, although I dey hear say them dey steal person prick but I swear this year of 2023 too much, this thing's wey just dey happen like this, I be dey wonder is the fault of government wey make people dey steal prick abi na waiting just some people mind them dey do?

Toh, even though I not fit talk exactly wetin they course this matter if stealing people prick man wicked wetin go make man steal another man manhood, na something wey we need to consider and think about. Me I they always here about this thing since they start am and e don happen for my side I know they where the thing happen but I don see person wey they still him prick. And the guy wey steal am they ask am why he Dey do am, him say him they find money to chop say if they still am e get where them they carry am go to sell. Them they pay them, although this thing na funny thing at the same time na sad issue be dis. Because e no go make sense they steal person prick carry am go. The matter long na.
full member
Activity: 280
Merit: 172
October 12, 2023, 02:38:54 PM
#5
I don hear but I never see out of curiosity waiting man do man to the extent na person prick them one they collect waiting them they use am do and the worst part be say people wey they collect this prick them they always catch them so waiting come be the use say them collect this kind job I never understand because some of this people self na women they collect am. Prick wey people they enjoy they wan collect am. God forbid it happens oh but how person go feel if them no catch the person the thing done go be that. They suppose they burn anybody wey do that kind thing because make the thing be has lesson to others, if police arrest them police still they leave them waiting come be the use say them they arrest them if they no go charge them. And na why you go see say them no go change and the thing come they happen everywhere.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
October 12, 2023, 12:48:45 PM
#4
Cha omor you try, you try well well to bring this matter come board, I done withness this kin thing before when I been never grow reach like this, for one local government wey dem dey call am ABUA ODUAL for Rivers Starte, one guy buy neck chain (aka necklace) from one aboki man way dey pass, so as the guy and the aboki man price finish nai the guy wear the necklace, so e no take UpTo 3 minutes omor the next thing be say the guy start to touch in between em legs and e con dey shout my prick, my prick, omor nah so area boys chase this aboki man and finally dem con catch am, this aboki man start to dey lie say em no do anything and dem still ask am say then why em come dey run if em no do anything.
To cut long story short, after boys beat this aboki man finis, nah him start to dey confess, so finally, finally, the aboki man tell dem watin to bring and dem bring am, then em do the guy prick come back, omor nah dem call one ashawo babe give the guy for em to tast whether em prick done dey work well   Grin  Grin.
The story fit dey funny but e no dey funny, this nah another matter way dey on board now, I know know why them way get am, no won use the won way dem get take do watin dem won use am do, nah to dey collect pipo own dwm want.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
October 12, 2023, 12:00:00 PM
#3
OP I never really hear this thing happen for my state were I dey now but I no doubt wetin you talk because  the ones them wey big pass this one done happen before and still yet, more dey happen but the truth be say as mainibem don talk na  so e dey be here. One needs be prayerful always to be safe and as you go about your activities, you will have to be very much sensitive when engaging with people. Know the limit to which you would allow people touch you.

Christmas don dey reach both the good and bad don begin double their hustle to make sure say their bank account  go clear their worries this season and too make shame no for dey their eyes say from January reach December say nothing come out.  Na wetin make we dey hear and see all these wahala for the society say person prick dey loss, pikin, girl wey go boyfriend house don go Carry wetin big pass am. Many many funny things though but all these can be averted.

Last last for this matter wey I chook mouth, e good make person pray o. Pray in the morning before you leave your house for God to protect and guide you through the day activities so that nothing evil go come near you because nobody can tell the next thing that could happen to them.
Stay safe mate and be careful.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
October 12, 2023, 08:31:38 AM
#2
First I go like to appreciate you to raising this matta up and again i go also like to address something very important wey be say we as citizens we no dey try at all, why we go dey carry our hands go put for bad thing dey call government say na because of hard economy or things no go well with us. Sometimes wetin i noticed dey always cause this problems na impatient and tolerance onto say we dey see our junior brodas them dey do well we go think say na yahoo dem go do without knowing e get some people wey their hustle legit and for that we no supposed envy at any cost without us knowing their source of income.

Then lastly, i go talk say ritual don dey for long and pipo dey do am coded without the next ear hearing it how knowing what is going on but we go see person don lose and dem go begin dey find am we no go see the person for long, then this prick wey people dey steal me never still get the update although we know say nothing dey hidden and for that we too make we try apply cautiousness because anytime or any day e fit happened to anybody. Na wetin make e no too good make we walka for night especially those in ph, ABJ, Asaba and Owerri because those cities na hot cities wey be say if you lose guard you go collect.

Nothing we no go see for this country and also know say we dey endtime, at this point you would see many things and many stories of what you can neva believe of happening so the best na to exercise patient make our God blessed us then we go enjoy an unending wealth and Riches. Bicus dis mata don tie rappa and we no supos dey look like that rather na to join hands take stops some things onto say when you see where things no good you play your sincerity and correct things that are not going well. We know say country hard but we ourselves can make things better than our government, to shock you na me and you be the government oo incase you dey think say e get special people wey be the government we only get people we are follow while they are the leaders.

sr. member
Activity: 504
Merit: 302
October 12, 2023, 07:39:01 AM
#1

Jump to: