Author

Topic: Reason why some pipo run do fraud. (Read 154 times)

sr. member
Activity: 350
Merit: 335
April 22, 2024, 04:32:29 PM
#18
My question be say, How you go feel to dey teach people wey you know say really dey interested to learn technical things? Even if say the person no get money to learn you go still teach am?
I don try many times to teach people somethings free of charge but at the end, i end up regretting because they will never take it serious as them no commit their money for the thing. No be one no be two and it keeps happening. On the other hand, people wey I collect small money from put their mind take learn plenty things and are happy today for the knowledge. Wetin I dey do be say, if you wan learn something from me, I must make you commit small money so that you go take the knowledge serious. No be say I no fit teach for free but teaching free no dey give me the result wey I want. E fit work for other people but e no dey work for me.

I done see am say youths dey run go do fraud because them get hope say if them go there then go see ways to feed and get data subscriptions wey them go take do fraud and many of them dey go there without any kobo for their pockets and the person wey dey in charge of the place dey accommodate them but if any money come out them go split the money equal or 10 to 20 percentage.
There is no justification for fraud and anybody wey dey deceive himself dey find reason to go do fraud is being unfortunate. My believe be say anybody wey chose fraud is either lazy or wicked. Even as Nija hard so, there must be genuine way of earning a living, one must not do fraud to make it. E dey pain me the way society dey normalize crime now unlike before wey people dey detest anyone involved in crime. Now they even dey give thieves chieftaincy with two feathers.
hero member
Activity: 574
Merit: 627
April 22, 2024, 04:32:18 PM
#17
In this life today many have tried all their best to make sure that they make it in life yet,they still remain what they are ,in this case what many people always think is for them to do bad things inorder to make money their by involving in stealing and kidnapping,in many cases it favour some people,why many are bing hold and face the law
Some people always just want to look for what they can use as an excuse to make their crime life look pitiful in the eyes of others, but deep down, one thing I always believe is that we always have a choice to make, and they just chose to go that way.
 
You can't tell me that they have tried all things, and yet nothing is working in a society where there are also people who have made it in life through the same things that they said they have tried. 
 
There are just a set of people who don't want to stress themselves over anything; they just want a means to make quick money. They are influenced by friends, and things they can't afford are what they desire, which creates room for them to start getting involved in all manner of illegal activities just to make it in life, as they believe doing things illegal will fetch them the bread faster than any legal job will.
member
Activity: 105
Merit: 9
Eloncoin.org - Mars, here we come!
April 22, 2024, 04:30:38 PM
#16
Op I gat ur points sha but dis mata na individually.No be only because say person wey no dey to teach pipo internet skills nai make scam full everywhere oh see one thing I believe say na our mindset dey control our being so person wey wan fraud pipo go fraud because em don build em mindset to scam pipo.Wetin make me say I gat your point be say many people dey discouraged because say dem deny dem access to learn internet skills to do freelance so with that depression dem fit just feel say "Fraud na the last hope of a man to make huge amount of moni".
newbie
Activity: 56
Merit: 0
April 22, 2024, 04:20:06 PM
#15
In this life today many have tried all their best to make sure that they make it in life yet,they still remain what they are ,in this case what many people always think is for them to do bad things inorder to make money their by involving in stealing and kidnapping,in many cases it favour some people,why many are bing hold and face the law
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
April 22, 2024, 04:08:21 PM
#14

One thing wey dey make a lot of pipo dey do fraud nah say them no get person wey go teach them internet skill to do freelance job and other jobs too (and this done make scam full everywhere

No be true say one thing wey make pipo dey go do fraud or 419 be say dem no get person wey go teach dem internet skills, my brother no be so oo. E get one proverb wey dem dey say "the thing wey make asirin or nkapi (na those kind rat wey get long mouth) dey smell dey for inside the body " This one mean say those people wey dey go do fraud decide to dey do am and no be say dem no see who go teach dem. Their nature na to cheat people so even if you teach dem, dem go still want to defraud people. Me I know of somebody wey people wey dey around him dey do well from yahoo but him decide not to join dem. So you see na choice and no be say dem no get person to teach dem. People no want go through process but dem want fast lane and that be the main thing wey make people dey join fraud.
I agree say them done decide to do am nai make, but e get one saying wey say "nah condition nai make Crayfish bend" if you reason say A no go work for you abi no be to do the B?
Everybody no be the same nai make we still get other people wey no go eventually try to do fraud. Just this afternoon I dey on social media so that I go just while away time as e be say I dey less busy today nai I come across one post for Instagram. The guy dey talk say, if person scam am em no go dey happy nai make em no won scam people too, and say if person scam em mama em no go like am, so instead em go do person watin them no go like make person no also do the same to ram. We still get good youths, no be lie but nah just few my guy. Just like person wey show you road to this place but e get people wey no go fit show them fellow Ge this place (na so e just dey).

Fraud na fraud and some people dey see am as the easy way out and nothing like say person no dey to teach dem internet skills, some person sef dey use their internet skills for negative reason because e get person wey sabi every thing for internet but still prefer to use those skills for evil things rather than making use of it the right way. And also the society today na fraud don dey active pass so everyone just wan get involved.
Well you self done talk your own and I done see am say you just talk am based on your own assumptions, but you no lie sha. IMO anybody wey dey see say fraud nah the easiest way to make money that person reason no understand watin em dey do, fraud nah something wey be say you sef no dey sure say e go favour you just like how gamble dey so. You fit join do am but nothing to come out for your side because your grace and others grace no be the same, for me, I take am say that fraud stuff nah something wey person dey call am try your luck.

I really get the points wey you dey try to talk sha, but from my own opinion I think am say e get people wey still dey believe say fraud nah the quickest way to make money. Like yesterday I hear somebody dey tell somebody say fraud done hard say nah before nai e dey easy. But still I dey feel am say people still dey do am and as dey dey go e dey multiply by 2.
I nearly learn website designing from somebody wey dey close to me but the person no gree teach me because say I been never get the money to pay for the skill wey I won learn. So e dey bad sha. If to say I be the type of person wey like bad things, as the guy no gree teach me because of say I no get money nah so I for done run go do fraud.These days people dey reason am say the legit things hard to pay and them also dey reason am say nah fraud nai pay pass.
Thank God say you sef get my points, like I done talk am earlier, say fraud just dey like try your luck something, e fit favor you and e fit still ko favour you at all. Person wey no dey carry pipo along nah bad ones dem dey call am, but for me I see am say those pipo wey dey do those things them get good mind for each other's sha.

~snip~
I totally understand your point but it's quite true and also not true to some extent.

Do you realise that fraud is a lazy man's job? Yeah, it's true that a lot of people doing fraud right now are either lazy to pick up a skill to do or they are fascinated by the wealth that they see from others too.
Nah you talk that one. Person wey dey do fraud no go agree with you if you try to debate am for were them dey.
To carry people along for internet skill dey important and E dey reduce internet fraud or scam. But the Koko be say some people never dey interested to learn a genuine internet skill. Teaching person online job sometimes can be risky to you depending on the person you wan teach. Some people dey always look for internet work wey dem go carry blow one time. Some dey only come say dem wan learn wetting you dey do because them think say Na short cut to make money. Some no even  dey serious, dem just come know wetting you dey do to use am against you by reavieling your financial worth to outsiders wey no dey inline with wetting you dey do. Sometimes when them come see how far you don go, instead of them to be happy for you, dem go become jealous of you and want your down fall. No be say I dey kick against teaching person online skills, but when you dey teach the person internet skill, totally avoid telling the person wetting you don achieve so far or wettin you intend doing the next minutes. just teach them the work and show him the way and do your normal thing because human being will always be human being. Going futher to explain yourself as a form of self appraisal will put you into more trouble.

Some people wey come to learn the work and dem head no fit carry am, na abuse and corse dem go dey corse you instead of working on their incompitency. In summary to help people for this life dey difficult but if you help the right person you no go regret.
Although you get points, but to add small join for watin you talk, some people dey ready to join the genuine updates but them self folle dey lazy. No be say them dey lazy totally o but them no just dey ready to do am. From my other reason, anything wey involve money for this life, 95% of youths no go see money thing then leave am. Make we no shork say one say fraud go hard and lot of them we no get any online skill go run to learn them.
I do much enjoy this talk way you talk for the end, "In summary to help people for this life dey difficult but if you help the right person you no go regret. This na better talk .

People no de teach odas wetin dem know na im make we Africans no de move forward, our forefathers dem wey sabi better medicine to take cure many sicknesses and to perform wonders, some of dem de so selfish wey dem go die with all dos powers and skills without teaching anybody. E de good to teach people wey get genuine interest to learn, even if dem no get money to pay to learn, because you don reduce poverty as you help di person, tomorrow, himself fit to help anoda person and poverty and dependants go de reduce.
Well-done mate, some pipo just kick bucket and them relatives no sabi say em get money, na so some still kick bucket for life with all the wisdom wey them get. E dey very bad say you go Sabi something then keep am all to yourself, to carry person along no be bad things, even if say you no carry others along e better to carry your own relatives along.
Those that run to do fraud, never have interest on genuine Internet that pay very well because they have concluded in their mind that they can't make it in life, and the best way to make it is  through fraud.
I totally disagree. Because person fit fine apply em no see then chose to lick mango. This talk mean say person wey do fraud fit no see way to do the genuine ones nai make em do chose to do fraud, nai make them say this life nah all about choices and every choice wey somebody dey make dey always come with consequences.
My question be say, How you go feel to dey teach people wey you know say really dey interested to learn technical things? Even if say the person no get money to learn you go still teach am?
I done see am say youths dey run go do fraud because them get hope say if them go there then go see ways to feed and get data subscriptions wey them go take do fraud and many of them dey go there without any kobo for their pockets and the person wey dey in charge of the place dey accommodate them but if any money come out them go split the money equal or 10 to 20 percentage.
I don’t understand Wetin you mean by technical things, but Most of our youth wey Dey do yahoo, even if dem they run things online and the money wey dem Dey get no really plenty, dem go still do yahoo. I no go lie you most of them na big money dem Dey look for, Dey wan drive big cars, make dem go club, follow girls with big yansh, and na big money go fit do all those once, if the technical wey u wan teach them no go fit fetch them that kin money, Dey will still run yahoo.

I know say if some of them Dey get small money for any online work, Dey no go do yahoo, but plenty of them go still Dey run am. But seriously no matter how you are suffering, that doesn’t mean you should do fraud, there is no excuse for doing fraud.
One thing dey are supposed to know is that every investment or business one is doing determines the level at which he/she wants to go in life. One who's is planning to buy cars and own a house at early age should plan properly. So watin I dey mean be say person wey won achieve big for early age go supposed to find better skills wey fit give am that money if em start to get jobs. If person learn coding and start to work with better clients, 6 months letter em go get watin em dey find.

I have no doubt on what you have said about our youths and their fraudulent activities on social media, many of them have painted the country black and most white people are scared to run their business with Nigerians online because there is no more truth. IMO it's always good to carry others along because like you said "your boy today fit he your oga tomorrow because internet nah big place, em fit get client wey get money and em go dey work for am". Internet is a very interesting place because we have vad and good inside it. The rate people are involving in fraud is much, if a boy sees his friends doing fraud he will also like to join and the friends will feel free to teach him because they love each other's but I have not seen a person who's doing a legitimate data entry job teach his fellow neighbor. The more we learn to teach people about legit online jobs the more people will quickly get involved in it instead of doing fraud and it will also help the many of the youths and the country.
Yes mate. If I go fit even remember, somebody been talk say if no be fraud for this country many people including him for carry gun. So for me I no support am because you ko go fit they gain then another person dey loose. And any money wey because you dey get dey happy the other person dey cry, that kind of money no be better one and e fit still land you for gbase.

Fraud na fraud and some people dey see am as the easy way out and nothing like say person no dey to teach dem internet skills, some person sef dey use their internet skills for negative reason because e get person wey sabi every thing for internet but still prefer to use those skills for evil things rather than making use of it the right way. And also the society today na fraud don dey active pass so everyone just wan get involved.

The main reason nah due to lifestyle because you no get but you too want to live the life wey you see your mate they live, so even if you sabi other internet skills so far as you no they get that enough money wey you go dey live that life wey many of your mate they live, you go just switch join fraud because them too go like to be feel among. And this kind thing don carry many youth and even teenager to the wrong path which at the end they will come and be regretting their action, because if they see their mate they spray money for club and they come get some things like cars, them too go think say they wan spray money for club, they wan buy benz, and many others, and as the country they go if no be fraud you no go fit get that kind money oo nah watin just dey affect them be that lack of consistency.
That one sef follow brother. But from the look of things, before when e start, no be because of life style oo and no be because of hunger, na now when I con dey see am am say before pipo wey dey eat 4 square mean a day dey do fraud (why i kno be say then money get value and phones no dey rampade the way e dey now but them dey buy am. Now people wey no get anything go leave to learn better skills then chose to do fraud. IMO, I conclude say nah them make things cost sef.

You say make them try dey carry people along, but the problem be say, people wey dey wan carry along shey dem fit do am? Because every skills wey dey internet no be by cho cho cho man must show working. You fit show some people way now but their greedy no go allow them hustle, even person wey join Hk today go dey in hurry say him want to be like him boss, even the bosses know the kind of steps wey him follow to reach the kind of level wey dem dey today. Youth of now a days our own dey different, many of us no get patient and how person wey no get patient go better pass him oga one day? Abi the boi will go thief ni?

Normally as this country take dey so, youths no fit survive am without any online skills, how we go take survive as the same hand work don full everywhere before you get work to do sef e dey hard. I believe say if no be this forum wey help some of us, we go dey among the youths wey dey do fraud now.  Grin
Lol no be lie, I no actually mean say you go see person dey just choose to help am teach am skills oo. E get some pipo, dem go just dey observe you and them go like make you show them road, those people nothing come out because them just like your packaging nai make them want make you carry them along, but e get people wey be say them no dey after your profits but them won just learn skills wey them go use support them self, those ones nai be people wey dey always dey serious for something.

E de easy to teach person yahoo pass any freelance job online and the reasons plenty. Yahoo no really require and technical skills, na to jus follow white man chat and most of the chat na still format e be, so na to just de do copy and paste, while person whey Dey freelance work online Need use him head, need read and make plenty research. Another reason wey de be say person wey de into yahoo or any other fraud online fit decide to plus (go Babalawo place) but you wey de do freelance work online na still research you go still make to see money collect. These days sef plenty boys wey no even go school go tell you say them de do yahoo and dem go still see money collect but for freelance work online him no fit.
Grin na you talk that one, Oga abi na person/people nai write the format? So why they no put all those knowledge to take scam pipo together use am do the legit things? The way scammers them take dey committed to those fraudulent activities if them use am do the legit things them go also get am right. That's another reason why fraud is not good because one day when you are no longer getting money you can decide to do the otherwise, recently dey just used one girl for my area go plus up naw the girl done dey mad.
Quote
And again another tin wey de cause all these tins again na the lifestyle wey dem de imitate, like all these our musicians these days, then de practically promote yahoo, through their slangs or even their music as a whole. So all these thing Dey practically contribute. And again he if you de start yahoo today you believe say na big money u go collect. So that thing de follow contribute, then de get the mindset say as dem de start dem go just blow so na why most of dem de run go yahoo.
Many of them don't know were they should put their head, so anything they see them just do am because say others dey do am too.
Quote
And again if you de involve for freelance work I doubt am say you go fit live lavishly, like maybe make you go Club go de spend lavishly, and most of our youth these days wan spend lavishly dem wan live lavish lifestyle. Them wan make every hypeman sabi dem, them wan lodge girl for 200k or even 350k hotel. Besides most of them believe say na yahoo to bet be the fastest way to make for this our frustrating country.

Why because money wey you hustle to get you go hardly spend am lavishly unless say you be that kind of person wey get spending fever.
member
Activity: 102
Merit: 21
April 21, 2024, 06:04:59 PM
#13
E de easy to teach person yahoo pass any freelance job online and the reasons plenty. Yahoo no really require and technical skills, na to jus follow white man chat and most of the chat na still format e be, so na to just de do copy and paste, while person whey Dey freelance work online Need use him head, need read and make plenty research. Another reason wey de be say person wey de into yahoo or any other fraud online fit decide to plus (go Babalawo place) but you wey de do freelance work online na still research you go still make to see money collect. These days sef plenty boys wey no even go school go tell you say them de do yahoo and dem go still see money collect but for freelance work online him no fit.

And again another tin wey de cause all these tins again na the lifestyle wey dem de imitate, like all these our musicians these days, then de practically promote yahoo, through their slangs or even their music as a whole. So all these thing Dey practically contribute. And again he if you de start yahoo today you believe say na big money u go collect. So that thing de follow contribute, then de get the mindset say as dem de start dem go just blow so na why most of dem de run go yahoo.

And again if you de involve for freelance work I doubt am say you go fit live lavishly, like maybe make you go Club go de spend lavishly, and most of our youth these days wan spend lavishly dem wan live lavish lifestyle. Them wan make every hypeman sabi dem, them wan lodge girl for 200k or even 350k hotel. Besides most of them believe say na yahoo to bet be the fastest way to make for this our frustrating country.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
April 21, 2024, 04:54:38 PM
#12
You say make them try dey carry people along, but the problem be say, people wey dey wan carry along shey dem fit do am? Because every skills wey dey internet no be by cho cho cho man must show working. You fit show some people way now but their greedy no go allow them hustle, even person wey join Hk today go dey in hurry say him want to be like him boss, even the bosses know the kind of steps wey him follow to reach the kind of level wey dem dey today. Youth of now a days our own dey different, many of us no get patient and how person wey no get patient go better pass him oga one day? Abi the boi will go thief ni?

Normally as this country take dey so, youths no fit survive am without any online skills, how we go take survive as the same hand work don full everywhere before you get work to do sef e dey hard. I believe say if no be this forum wey help some of us, we go dey among the youths wey dey do fraud now.  Grin
full member
Activity: 280
Merit: 159
April 21, 2024, 04:43:13 PM
#11
Fraud na fraud and some people dey see am as the easy way out and nothing like say person no dey to teach dem internet skills, some person sef dey use their internet skills for negative reason because e get person wey sabi every thing for internet but still prefer to use those skills for evil things rather than making use of it the right way. And also the society today na fraud don dey active pass so everyone just wan get involved.

The main reason nah due to lifestyle because you no get but you too want to live the life wey you see your mate they live, so even if you sabi other internet skills so far as you no they get that enough money wey you go dey live that life wey many of your mate they live, you go just switch join fraud because them too go like to be feel among. And this kind thing don carry many youth and even teenager to the wrong path which at the end they will come and be regretting their action, because if they see their mate they spray money for club and they come get some things like cars, them too go think say they wan spray money for club, they wan buy benz, and many others, and as the country they go if no be fraud you no go fit get that kind money oo nah watin just dey affect them be that lack of consistency.
full member
Activity: 182
Merit: 152
Never give up
April 21, 2024, 03:54:03 PM
#10
I have no doubt on what you have said about our youths and their fraudulent activities on social media, many of them have painted the country black and most white people are scared to run their business with Nigerians online because there is no more truth. IMO it's always good to carry others along because like you said "your boy today fit he your oga tomorrow because internet nah big place, em fit get client wey get money and em go dey work for am". Internet is a very interesting place because we have vad and good inside it. The rate people are involving in fraud is much, if a boy sees his friends doing fraud he will also like to join and the friends will feel free to teach him because they love each other's but I have not seen a person who's doing a legitimate data entry job teach his fellow neighbor. The more we learn to teach people about legit online jobs the more people will quickly get involved in it instead of doing fraud and it will also help the many of the youths and the country.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
April 21, 2024, 01:59:49 PM
#9
My question be say, How you go feel to dey teach people wey you know say really dey interested to learn technical things? Even if say the person no get money to learn you go still teach am?
I done see am say youths dey run go do fraud because them get hope say if them go there then go see ways to feed and get data subscriptions wey them go take do fraud and many of them dey go there without any kobo for their pockets and the person wey dey in charge of the place dey accommodate them but if any money come out them go split the money equal or 10 to 20 percentage.
I don’t understand Wetin you mean by technical things, but Most of our youth wey Dey do yahoo, even if dem they run things online and the money wey dem Dey get no really plenty, dem go still do yahoo. I no go lie you most of them na big money dem Dey look for, Dey wan drive big cars, make dem go club, follow girls with big yansh, and na big money go fit do all those once, if the technical wey u wan teach them no go fit fetch them that kin money, Dey will still run yahoo.

I know say if some of them Dey get small money for any online work, Dey no go do yahoo, but plenty of them go still Dey run am. But seriously no matter how you are suffering, that doesn’t mean you should do fraud, there is no excuse for doing fraud.
full member
Activity: 1190
Merit: 124
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
April 21, 2024, 12:13:48 PM
#8
Those that run to do fraud, never have interest on genuine Internet that pay very well because they have concluded in their mind that they can't make it in life, and the best way to make it is  through fraud.

Even though you want to help such people, not to go into fraud in the environment by teaching them how to grow account in the bitcoin.org to start using it to apply for signature campaign or bounty to start making money from it, but they will never pay attention to you because they will feel is a long journey to get money.

Some of them believe, that the easiest way to make this money is through fraud, not knowing that fraud can lead them to prison that will make them not to live long to fulfill their destiny.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
April 21, 2024, 11:52:06 AM
#7
People no de teach odas wetin dem know na im make we Africans no de move forward, our forefathers dem wey sabi better medicine to take cure many sicknesses and to perform wonders, some of dem de so selfish wey dem go die with all dos powers and skills without teaching anybody. E de good to teach people wey get genuine interest to learn, even if dem no get money to pay to learn, because you don reduce poverty as you help di person, tomorrow, himself fit to help anoda person and poverty and dependants go de reduce.

Anybody wey enter yahoo or arm robbery because of poverty or im no get helper, make you know say criminality don de for im blood before, e get people wey de for di same situation but criminality no be option for dem. I don see youths from rich homes wey de into yahoo scams, abi na poverty cause dem own? Life na choice, so we de responsible for all of our actions.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
April 21, 2024, 11:07:21 AM
#6
To carry people along for internet skill dey important and E dey reduce internet fraud or scam. But the Koko be say some people never dey interested to learn a genuine internet skill. Teaching person online job sometimes can be risky to you depending on the person you wan teach. Some people dey always look for internet work wey dem go carry blow one time. Some dey only come say dem wan learn wetting you dey do because them think say Na short cut to make money. Some no even  dey serious, dem just come know wetting you dey do to use am against you by reavieling your financial worth to outsiders wey no dey inline with wetting you dey do. Sometimes when them come see how far you don go, instead of them to be happy for you, dem go become jealous of you and want your down fall. No be say I dey kick against teaching person online skills, but when you dey teach the person internet skill, totally avoid telling the person wetting you don achieve so far or wettin you intend doing the next minutes. just teach them the work and show him the way and do your normal thing because human being will always be human being. Going futher to explain yourself as a form of self appraisal will put you into more trouble.

Some people wey come to learn the work and dem head no fit carry am, na abuse and corse dem go dey corse you instead of working on their incompitency. In summary to help people for this life dey difficult but if you help the right person you no go regret.
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
April 21, 2024, 06:50:35 AM
#5
~snip~
I totally understand your point but it's quite true and also not true to some extent.

Do you realise that fraud is a lazy man's job? Yeah, it's true that a lot of people doing fraud right now are either lazy to pick up a skill to do or they are fascinated by the wealth that they see from others too.

It's also true that fraud requires a lot of skill, in the high fraud tendance but for the popular and local fraud it's a skill free source of income for them. All you just have to do is lie to the next person and promise them what you don't have boom you already convinced them and you're on cash-out already. It's that simple.

And also it's true that the internet skill that we see today are mostly handled by strict people who can not share their source of income with anyone except you're to be fully trusted to some extent. Hence they require you to pay some kind of money to be acquainted with the said knowledge whereas in the internet fraud anyone can teach you without any pay for a start but at the end you still have to pay the difference is just you pay before for a response job and you pay after for an irresponsible job.

The only thing there is we have to try as much as possible to convince a lot of people to remove there minds from what they see as fulfillment and focus on learning new things that can be very productive.

But anyways the country follows trends and soon the trend for fraud will be over especially the ponzi scheme scam in the country because almost everyone is beginning to be aware of it. Then another trend will come up for them to follow again.
hero member
Activity: 616
Merit: 509
Top Crypto Casino
April 20, 2024, 05:23:15 PM
#4
I really get the points wey you dey try to talk sha, but from my own opinion I think am say e get people wey still dey believe say fraud nah the quickest way to make money. Like yesterday I hear somebody dey tell somebody say fraud done hard say nah before nai e dey easy. But still I dey feel am say people still dey do am and as dey dey go e dey multiply by 2.
I nearly learn website designing from somebody wey dey close to me but the person no gree teach me because say I been never get the money to pay for the skill wey I won learn. So e dey bad sha. If to say I be the type of person wey like bad things, as the guy no gree teach me because of say I no get money nah so I for done run go do fraud.These days people dey reason am say the legit things hard to pay and them also dey reason am say nah fraud nai pay pass.
full member
Activity: 280
Merit: 151
God is All
April 20, 2024, 04:31:13 PM
#3
Fraud na fraud and some people dey see am as the easy way out and nothing like say person no dey to teach dem internet skills, some person sef dey use their internet skills for negative reason because e get person wey sabi every thing for internet but still prefer to use those skills for evil things rather than making use of it the right way. And also the society today na fraud don dey active pass so everyone just wan get involved.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 20, 2024, 04:26:15 PM
#2

One thing wey dey make a lot of pipo dey do fraud nah say them no get person wey go teach them internet skill to do freelance job and other jobs too (and this done make scam full everywhere

No be true say one thing wey make pipo dey go do fraud or 419 be say dem no get person wey go teach dem internet skills, my brother no be so oo. E get one proverb wey dem dey say "the thing wey make asirin or nkapi (na those kind rat wey get long mouth) dey smell dey for inside the body " This one mean say those people wey dey go do fraud decide to dey do am and no be say dem no see who go teach dem. Their nature na to cheat people so even if you teach dem, dem go still want to defraud people. Me I know of somebody wey people wey dey around him dey do well from yahoo but him decide not to join dem. So you see na choice and no be say dem no get person to teach dem. People no want go through process but dem want fast lane and that be the main thing wey make people dey join fraud.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
April 20, 2024, 03:32:32 PM
#1
Good day my country pipo, I carry one better talk and idea come this place. I dey sure say if we go manage to think this kind of thing, e go help us and others too. Watin I won talk nah very common thing wey dey happen for around us.
My question be say, How you go feel to dey teach people wey you know say really dey interested to learn technical things? Even if say the person no get money to learn you go still teach am?
I done see am say youths dey run go do fraud because them get hope say if them go there then go see ways to feed and get data subscriptions wey them go take do fraud and many of them dey go there without any kobo for their pockets and the person wey dey in charge of the place dey accommodate them but if any money come out them go split the money equal or 10 to 20 percentage.
One thing wey dey make a lot of pipo dey do fraud nah say them no get person wey go teach them internet skill to do freelance job and other jobs too (and this done make scam full everywhere ). And speaking from experience, even if say them teach you finish them no go also carry you along as person wey just lean dey find jobs (after you done even pay huge money to learn).
Some of use dey so greedy sotay we no go teach person something if em no pay money, e dey very bad because as internet dey so, your boy today fit he your oga tomorrow because internet nah big place, em fit get client wey get money and em go dey work for am.
So my main point be say make we always dey carry ppl along when it comes to Internet skills.
Jump to: