Original Topic: Recent events should make everyone withdraw all their coins to their own walletsAuthor: o_e_l_e_o
MATTER WEY NEWLY DE SUP SUPPOSE MAKE EVERYBODY ALL COMMOT THEIR COINS GO THEIR OWN WALLETEverybody no say u suppose hold ur key and coins by ursef.To de leave your coin make other pipo de control am like Dem centralized exchange, web wallet ,interest account and many many others , mean say no b ur coin at all and Dem fit make am say u no go fit access am any time.Apart from the matter say many of dis service don lock pipo make Dem no fit access their account many times con sti de pressure Dem make Dem do KYC , many many pipo sti de use all dis pipo and service take de hold their coin con sti de put am 4 mind say dat kind matter no fit happen to Dem.
Den to come talk of dem truckers way de canada. Weda you agree wit Dem or not e nor matter. Watin I b de interested in na how government go take answer Dem,way b say Dem go freeze account, reverse transaction and seize money way dis pipo and pipo way de donate give dem get.Nor b only normal bank account oo dem sti do am to their crypto exchange account.dem nor no say their government fit access their moni any time.i nor no d kind matter way Dem de reason. Maybe watin de their mind na (I be better pesin way de obey government so I no go do anything way government nor go like.)
After dat matter come talk of Russian invasion matter.some Countries de seize Russia pipo property, de freeze their accounts, de stop Russian banks, de commot Russia from all d SWIFT system way de, plus many many other tins.Yes na,dis matter go painPutin, but e go sti pain other Russia pipo, plus d ones way no get hand for anytin way no sti want war. How u go feel wen u no say decision way ur government make way u no agree to at all fit make Dem seize or freeze ur moni and asset? Beta thinking matter no de here. U no suppose de reason say (government no go do dat kind tin) wit d way our government de do tins 4 their personal matter at expense of watin go happen to us many times.
D tins way don sup 4 d weeks way we jus de finish so suppose open d eye of pipo way de store their coins wit all dis dem exchange and other service way other pipo de run.U fit no fit access Dem anytime and e no get watin u go fit do about am.