As una don see am for the title,
"SATOSHI" wey dem name after the original creator of Bitcoin
SATOSHI NAKOMOTO. how many of us really know say 0.00041 na Satoshi, no be Bitcoin them dey call am? I know say our senior members then go know this one as no be new thing to them again.
Just as naira get Kobo, dollar get cent na same thing with Bitcoin but dem con call am Satoshi. Satoshi na the smaller units wey person fit take address Bitcoin wey dey less than 1 btc. the whole fraction 1 go up, na e Dem dey call Bitcoin. although some people fit still call 0.11111111 bitcoin, but the right name for am na Satoshi. these small fractions of Bitcoin don help many of us Wella to be Bitcoin investors as e for no dey possible to dey start investment with a whole 1 btc (currently $28355.13) as a common person unlike all those big men them.
so to make am easy for every one, bitcoin come dey divided into smaller units. 1 btc dey equals to 100million Satoshi. but Satoshi no be the only smaller unit of Bitcoin, as we still get fractions like.
- centiBitcoin (cBTC): 0.01 BTC
- milliBitcoin (mBTC): 0.001 BTC
- microBitcoin (uBTC): 0.000001 BTC
- Satoshi: 0.00000001 BTC
of all these smaller fractions, na just the Satoshi and the milibitcoin na e dey more often recognized for most wallets. 1 Satoshi (0.00000001 BTC) no carry better weight that wan be say 1 (sat) Satoshi dey equals to $0.000262 currently and dis one na very small value.
why Satoshi, smaller unit if Bitcoin dey important?1.as we don first talk am, Satoshi, wey na e be d smaller unit, e supposed get why e dey exist. just take for Instance say you wan buy bread now, and you only get coin for wallet and you wan buy this bread wey sweet die. you no need to stress your self because Bitcoin get smaller unit u fit run your transaction Wella.
2.for many people them, wey still dey fear to invest put for Bitcoin the matter be say Dem they think say if you no invest big money put for Bitcoin then you never start investment. this one no be true. the smaller versions of Bitcoin, don make am dey easy for everyone to invest small small even reach 1 dollar self, some exchange fit run am for you.unlike other investment, you no fit start with small money, but Bitcoin no be like that, e dey run am on a steady, na you come know how much and when you wan take buy.
3.satoshi, na also the original unit, wey Dem take dey calculate Bitcoin for Blockchain.d Blockchain dey designed, to run transaction,show balance and all data for this Satoshi unit. d Blockchain na e dey run the whole conversion matter come display am for us, we no need to stress our self.
4. e still dey very important for d source code we Dem take run Bitcoin, and e dey help specify the total number of btc we dey. as we know say d total amount of Bitcoin wey fit exist na 21million. and since each Bitcoin get 100million Satoshi, that one mean say Bitcoin get total of 21 quadrillion (2,100,000,000,000,000) units. if you dey see tiny rewards or fees for Bitcoin transaction, Dem fit show am for Satoshi, so e dey easier to use for small small tins dem.
well, I hope say I don fit explain give my people Satoshi, and why e dey important for Bitcoin.the Bitcoin technology dey grow very fast, and e no go good make you dey left behind as this one na opportunity for you to take dey among the people we wan dey dance very soon. so buy Bitcoin today make u dey on the safer side.
Source links crypto new, satoshiunderstanding-the-smallest-unit-of-bitcoin/what-is-a-satoshi