Author

Topic: Scam and hack 4 9ja (Read 208 times)

hero member
Activity: 812
Merit: 560
January 11, 2024, 05:17:28 PM
#17
Scam happens and are real,if we are never been misfortune for any doesn't mean they don't exist, we should always make sure that we don't get hunted by one out of our careless mistake, also we have to monitor well things we do online, some of us have made ourselves more vulnerable to these scams through various dealings we go through online even without our conscious effort about knowing them to be scam.
full member
Activity: 182
Merit: 120
Cashback 15%
January 11, 2024, 04:24:34 PM
#16
Just like wetin the op talk, if you observe the kind of people wey dey fall victim them too get big eye and them think say free offer still dey again, there's nothing like free money or free juicy offer and my issue is, if this offers dey really work them for no share the update, some people wey don fall victim go still fall victim if them no change that impression of free money and those scammers no dey ever rest every time na new method and strategy to take scam, who believe say them go fit hack WhatsApp but now na wetin dey reign.
Sometimes no be who smart pass dey escape scammers and na to  pray make them no see us cause scammers can call as a friend or relative to trick and people dey always send money before asking them questions to confirm, I read one topic on this local board and the op discussed about the new method wey scammers dey use and the person call as a friend, the funny part na how them dey take get people numbers anyhow and your point make sense because some groups for whatsapp no get any value but scammers dey hide inside the group.Op thanks for your reminder concerning the scammers cause as them no dey rest e good to dey remind ourselves about them.
full member
Activity: 238
Merit: 151
January 11, 2024, 01:49:02 PM
#15
My contri pipo I greet una oo
Many many times I don see pipo way lose dem funds to scammers and hackers dem.so dis matter way I wan Yan so go fit help us.
To de take start watin b d difference between hacker and scammer?  Now many many times pipo de mistake hack and scams matter but true true Dem no b d same.

Although hack and scam are different but in some cases they are interrelated in the sense that someone can scam you in other to hack your accounts for example those scammers wey dey call person for phone say their ATM get issues say make them send some details wey dey contained in the ATM card so as e be say them they tell their victims say them they call from their bank, person wey no no go just give them your details they use am gain access to your account so that's how I see it as interrelated.

Now, it's very unfortunate that scams and hack have been so rampard within our environment because always on daily basis people dey fall for these scammers and hackers and the strategy wey these scammers are hackers dey use no dey easy o, me on how I wise reach I no believe say person go fit scam me but las las them scam me wey be say I look myself for mirror come dey imagine weda na me be dis so make every body dey careful abeg the rate of scamming and hacking people's accounts too much now.  What of the current one wey we hear say them hack United States SEC account for Twitter, so dis people no get joy at all.

Some of the reasons wey me I found out say na him dey make people fall for scammers and hackers na desperation like something wey person tell you, you no go calm down verify the information for another source you don rush go do am quick quick thinking say you dey wise but las las you go come see say na you mumu pass.
It is very important to digest any information you hear be it on phone, newspaper, radio, television and the Internet like just calm down small check well before you enter.

Another thing wey dey cause scams and hacks more especially hacks now a days is logging in your details in some devices that reveals your details to malwares and these malwares fit expose your details to hackers like e get some site wey you go wan log in them go say make you use your email address or Facebook account details take log in, I've been a victim of these Facebook own if no be say I dey fast enough na so I for take lose my Facebook account so make we disregard sites wey dey ask us to use our Facebook, Instagram, twitter, email addresses to take log in their own websites, by so doing we go they escape all these misfortune hackers and scammers Dem small small.

Now, in conclusion, scam simply refers to an illegal or fraudulent business aimed at collecting money or other valuable from someone convincingly without the actual knowledge of the victim while hack means a way of gaining access to people's privacy forcefully by malicious means without the prior knowledge of the owner.
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
January 10, 2024, 09:54:49 AM
#14
Hackers and scammers they everywhere for Naija they find whom they go collect in money or details to use do their bad dealings, and then they improve to come out with the best strategies wey people never know so that their work go they easy for them. Make we they put our accounts them for an extra layer of security like the 2FA authentication so that hackers will find it hard to access our accounts, and make we stop to they use one password anytime we create an account, and make we no they save password automatically for google account so that if they hack our email, the hacker no see our password to use login for the places wey we used that email create accounts, so that they no go move our assets. If person tells you say make you invest 10k to get 40k in the next 2 hours, just no say na scam be that, if na true na in families in go first introduced for the business. Make we they on high alert for online not lose our money to one nonsense scammer.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
January 10, 2024, 05:37:29 AM
#13
My county pple this one them they call scam weak me self, because wetin don xup for where this country dea via hacking and scamming don much.

So many investment app, platform, link dea really make people to fall victim and also dea take people life's,dea put some people for jail and other people no fit learn leasons for there such experience... Abeg make we dea careful for anything wey cause us harms, things like
Fake link
Platform
Investment testimonies
And so on
Because scam and hack too much for 9ja and make we dea careful too.l
full member
Activity: 140
Merit: 63
December 24, 2023, 05:56:01 AM
#12

  • Avoid spam emails; many hack way Dem de run na through phishing link and Dem Dem mostly de send am go pipo email, text or even deir social media accounts. So de check if any link na phishing link b4 u click or open am.
This matte you talk nason e be. But the problem wey dey there na those phising link sometime dey hard to detect and if you no no am you ft just make mistake by clicking on it.

  • de use official tools ; many times pipo de like install mod app or software enter Dem device and dis matter no clear bcos dis apps fit get back door from dis hackers Dem to take tiff ur data.
Not only that, sometimes the app wey we dey download for phone dey also require permission or asses to login using facebook or gmail to sign-up and when we do am to the wrong link with facebook you go just see say after sometime you go see say dem Don hack person facebook.  Me an tipical example, because mason them carry hacky facebook account.  Na later I remember say na wetting I register using facebook sign-up why make them hack my facebook account and this thing Don happen to my first facebook before I open another one.  The second one also thesame thing now na my old facebook I been set use wey I go restore. And the reason na because I back am up with Gmail that's why them no fit termper am.  And I Don also know the cause of the other ones wey them hack.

  • de careful of permssion ; many time if we de install apps we go just de press yes yes de go we no de read d kind permission way d app de ask sometimes b4 we grant am.And no b so e suppose b. So make we try de read all dis permission and de cancel d ones way no pure.
This one main be the worst of all. And almost everybody dey fall victim of this one, reading dry always be Africa man problem to dey read before accepting terms and conditions set always hard us. And scanners no say people no dey too like reading and na there them use enter people. Na even this forum they even make me to read well well If not reading dey always hard o. [/list]
full member
Activity: 504
Merit: 198
My privacy, my right.
December 24, 2023, 03:22:33 AM
#11
Me go like talk on the area of the scammers cos that one nah wetin we did experience regularly than the hackers incidents dem. We the young pipol don alredi get akwanuche about all these tins, in fact sef our eyes don see plenti tins for the online wey done open our awareness so we he young go hardly fall for all dis scammers like dat, but wat about older pipol like our mama and papa dem wey no get idea about how dis scammers did take operate naim mk e go gud make we take time did educate our papa and mama dem about dis tins cos nah dem dis scammers the use cash out wen dem go tok tins of fear put for dia head our mama and papa mind go just fly at dat moment did scammers go take di opportunity colet dem wetin no gud na later Dem go realize say na scam hand dem go enta. So e go gud we for our individual familis we dey teach our parents about dis tins too so dat dem fit dey informed as we too don dey informed about all dis tins.
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
December 24, 2023, 02:03:08 AM
#10
OP, this topic na discussion wey I they always pick interest on top. Plenty of us still they fall into petty scam activities in this era of today. Up till now formats like that of WhatsApp hacks, phishing sites still they exist. For Naija now the one wey they trend pass others now na e-mail spamming. Na wetin we dey hear for street say boys they use scam people be that and the process have been upgraded over time in the sense that if they cast them for one format, they will swiftly work towards transforming to another format.

Wetin i go advise us be say make we no they ignore discussions like this for this forum and make we try they put eye read wetin them they discuss about security as that will always add to the protection of your self against malicious attacks.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
December 23, 2023, 10:44:27 AM
#9
Omo I dey gbadun this your update ah swear, this one go give person Better thing to learn from those hackers, but for me i Don Sabi them very because I know how them they do and I even Sabi person wey dey do that kind thing, and na thing make us scatter up to today wey we never settle because i don't want make him come later do me waiting him dey do people, in fact I hate people wey dey scammed people because that act na the same thing with thief and me and thief na cat and dog, hackers and scammers are very wicked and the one wicked pass na hackers because If hacker get time to hack your system nothing them go leave inside, the best way hackers they see person hack na e be through link, hacker go send you unnecessary link wey be say if you mistakenly press am na access to your system him get be that.

And for scammer matter anybody wey talk say scammer scam am through saying make him send 5k and get 20k in a day that person na comfirm mumu, in fact na greedy person him be because how can person tell me that make I send 5k and 20k in a day and I no do any work, you Don see where you no go work for this life and you go get money before? No way to make money without not working for it my brother, but some scammers na bastard because some of them they use charm, if some talk to you like this you will not say a word and you will do whatever they want, sometimes we need to dey prayerful and wiser with this people if not they no go let us get peace of mind.
member
Activity: 77
Merit: 10
December 22, 2023, 05:09:18 AM
#8
My contri pipo I greet una oo
Many many times I don see pipo way lose dem funds to scammers and hackers dem.so dis matter way I wan Yan so go fit help us.
To de take start watin b d difference between hacker and scammer?  Now many many times pipo de mistake hack and scams matter but true true Dem no b d same.
This one na clear update normally,the rate of scamming now don

Abeg my pipo make we de careful oo bcos e no de sweet at all if pesin lose e moni.

Thanks to Charles-Tim and a other thread way de help us catch scam and hack b4 Dem catch us.
This mata of scam na serious matters at the moment,e get recent survey wey show say d3m dey use people name open opay and palmpay account now..then come dey use am bill people..and them dey fit archive this one when them get hold of your sim(like in a case of stolen phone)or get your actuall account number for regular bank,then use the name open am..so abeg mind where you drop your bank details,especially those places wey give away dey happen..takwuu
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
December 22, 2023, 04:30:43 AM
#7
Well op, you don try for dis update wey u carry drop for we localboard.as e dey be so, I sure say many of us, wey be Nigerians supposed know of how no 2 take day because most of us downfall victims or see people wey Dem don scam around us. D truth be say dis scam of a thing no b only greed dey make person fall, but also lack of reasoning. How person go tell you say bring 5kto get 20k an you no ft reason say na scam. Sha greediness Join because money wey person no get E no supposed dey wish for am. na so de take dey catch people. D best tin na to stay at away from anything wey sounds too good to e true. Free money no de again and no be for social media u gofit see am. Hustle, make e pay u.

For hacking. We just have  to stay away from malicious links wey full internet. And yes, person go say how we go take no say link dey malicious. Dat wan na true because some time e dey hard to detect this kind link sef but we have to be smart. Any link wey dey tell you to click something and accept you gats dey careful make u no go give wrong permission to hackers enter ur device. Also any link wey u received say issue dey any of your online accounts say make u quick do one or two put ur password to retrieve am, no rush. First go the original website, then try log in for your self, make u first dey sure. Most website dey get data leak and na through this link name scammers take dey collect our data come send message give us. In all, we need to be careful when using the Internet as na bad people na many pass.
jr. member
Activity: 44
Merit: 1
December 21, 2023, 08:17:24 PM
#6
Omo my guy this thing way you talk na true scammers way full ground no be here na so they send me message say I won 64k I call the number na different people I just they follow talk and they later tell me say make I send my account number and my account card ahhh I was like why? And for what reason they try wan convince me I was like oga no I don’t want so omo the scammers they come in many ways and if we are not careful many will fall for this.
full member
Activity: 560
Merit: 161
December 21, 2023, 03:11:38 PM
#5
Thank you so much op, mos of the times the reason why people are being scammed is because they lack knowledge on how scammers works , but it is very important for people to educate themselves to understand how scams works, Ignorance has been the major reason why people have always fall for scams.  I could remember the first time I came across scam I was convince by the scammer but I was so lucky that I was not in rush by the time I think about it I was able to understand that it was a scam.
jr. member
Activity: 76
Merit: 3
December 21, 2023, 07:36:28 AM
#4
My contri pipo I greet una oo
Many many times I don see pipo way lose dem funds to scammers and hackers dem.so dis matter way I wan Yan so go fit help us.
To de take start watin b d difference between hacker and scammer?  Now many many times pipo de mistake hack and scams matter but true true Dem no b d same.

HACKERS
Now hackers dem de tif pipo data like card detail, Dem logins, location and many many other tins.now how many of dem take de work? Dis hackers Dem don upgrade well well as time de go .most of dis hack way Dem de do na phishing. Now 4 pipo way nova Fe hear of phishing make I explain am .dis phishing na method way Dem tay de tiff pipo details. 4 dis phishing matter hackers go create fake of beta company way ge level come use am as link take tiff ur data.4 example wit dis phishing  hackers go fit create fake Facebook page com send link give u and wen u click am come fill in ur data press login, all dose detail go send give Dem. Some of Dem sef de use some software take de monitor ur fone once u click dose link .with am dem Go fit get beta information from your fone take tif you. To take avoid hack some of d tins we fit do na ;

  • Avoid spam emails; many hack way Dem de run na through phishing link and Dem Dem mostly de send am go pipo email, text or even deir social media accounts. So de check if any link na phishing link b4 u click or open am.
  • de use official tools ; many times pipo de like install mod app or software enter Dem device and dis matter no clear bcos dis apps fit get back door from dis hackers Dem to take tiff ur data.
  • mind d kind site u de visit; dis one de very Important. Many pipo de visit different sites way no clear even wen deir device de warn Dem. Many of dis site de carry malware way fit infect ur device.
  • de careful of permssion ; many time if we de install apps we go just de press yes yes de go we no de read d kind permission way d app de ask sometimes b4 we grant am.And no b so e suppose b. So make we try de read all dis permission and de cancel d ones way no pure.
  • de use spam protection; many devices now get software way go fit help u no if most message na spam. But some devices no de on automatically so u go need set am by ur sef especially 4 ur fone message setting. If u set am e go help u de filter all does message way ressemble scam.
  • de read article; dis part don help me well well personally. Make we de read scam and hacking tactics from time to time as e go help us no how to take notice am quick b4 e de too late.

SCAMMERS
D scammers Dem de different one kind . Now scammers na pipo way go come meet u with beta offers to take cover ur eye tiff u .e no b like hackers way de tiff ur data but u no go no scammers De juns u collect ur data. many of us sef go don experience dis pipo 4 social medias .some go bring offers like say Dem wan help you, some go even call u de claim say Dem b bank pipo and many many others. But d big question b say hw we fit avoid all dis pipo.

  • De contented ; d reason y dis scammers de catch most pipo na bcos Dem get open eye. Most of Dem de fine quick moni way go de easy.
  • mind hw u de share ur contact ; I don notice say many of dis scammers Dem de get ur contact from groups  especially 4 WhatsApp. So try de avoid contact gain matter way most pipo de like do 4 WhatsApp
  • de updated ; always de try get info of new new scam matter bcos many of dis scammers de bring New format day by day ,bcos sometimes we need understand dis Dem tactics make we 4 fit avoid am. Remember say information na power
  • no de rush! ; many times if dis scammers wan trick u tiff ur data Dem go make am  b like say na urgent matter make u 4 lose guard give dem ur info. So make we de take time check for scam if we de deal with pipo especially online.
  • de careful ; to take avoid scam everytime we need de careful on how we de share our data especially 4 social media.
  • de report scam ; sometimes if we notice scam we go jus ignore but nor b so e suppose b. So make we try to de report Dem as e go help cast their format and the social media fit block Dem I'd many pipo don 2 report dem.

Abeg my pipo make we de careful oo bcos e no de sweet at all if pesin lose e moni.

Thanks to Charles-Tim and a other thread way de help us catch scam and hack b4 Dem catch us.

Op thanks for the update this one don highlight many of us because this scamming and hacking of a thing don become viral na something wey be say man gaz they wise enough, you go see say people dea lose money by people wey be say dey too selfish of their own only themselves dey know.
 why be say you as a human you know go they think twice that person wey you pack him money go chop, you know say abi na hin last change be that or na wetin him they take guide hin family be that ahh let be sincere, since is getting worse make we just dey careful, sometimes you go see say person just jump into your DM introducing himself as so so person, no gree oo for real no be him be that. Even sharing your bank details with any site that they will pay you big amount of money just ly dat, let be very extra careful with all those tins they are many legit way you can make moni, not all are legit because many are there to scam or hack your account and remove all your savings.
Thank you all
full member
Activity: 266
Merit: 113
December 21, 2023, 06:54:36 AM
#3
Scammers full ground wetin no nice and we need de very careful not to be a victim of there dubious means.

Their is one I encountered on my WhatsApp last week and when I looked at his approach towards me, I just laugh because him no know who him de deal with.

The guy man de tell me say him go introduce me to bitcoin reading not k owing say my eye don clear for that side, come say if I send am 20k say him go send me 40k after trading in the next 2hrs come de full my phone with already written messages when we very easy to dictate, I just de laugh am from my end.

The funny thing be say him to use pastor register that WhatsApp come use picture when person wear suit as the dp just so I can believe him easily.

The thing is that as long as you are dealing with a stranger in the online space, no matter how legit they present themselves eh, don't believe them first, if they are trying to persuade you for no just reason, just block them and move on if not you will cry and shy your harsh story in the forum and the only thing we will jointly say will be sorry
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 21, 2023, 05:27:49 AM
#2
Op you don really try to update us for scam and hack matter, all this kind of thread na wattin dey very necessary for reminder, because as we dey wise dey go, na so scammers and hackers Dem sef sti dey improv on dia skills and knowledge, I don tell people tire make Dem nor dey fill all those federal government palliative links but Dem nor dey gree, to me that na one of the most obvious way to take identify hacker.
And to add to wattin you don talk about hacker and scammers, hacker dey more of people wey dey do programming and Dem sabi write code, the ones wey we dey hear for all this crypto side, na the hand work of hackers, the part wey scammer come in na the trading of your coin through p2p. Person wey go scam go tell you to send you coin come make Dem for credit you, but if you go loose guide Dem go just use your coin take jolof.
But most of this yahoo boys wey dey we contri na scam Dem dey scam, so make we shine our eyes oo, make we for not go fall victim. This bpip site wey dey connected to this forum, I nor dey like to enter there reach 5min because  your connect most times nor dey secure with site. If you see that red sign just no say you dey exposed to hackers
sr. member
Activity: 336
Merit: 495
Math + Code = Blockchain 😁
December 21, 2023, 04:27:16 AM
#1

Jump to: