Pages:
Author

Topic: Scarcity of new naira notes.. POS charged me 9k to withdraw 30k... - page 2. (Read 380 times)

member
Activity: 308
Merit: 26
This men no supposed dey office again, everyday na another wahala, Governor of Kano done tell em state people to continue to they use the old naira notes, now self even the 100 and 200 notes we no dey see am, politicians done buy all the money and come dey make people dey suffer unnecessarily, even market women dem confuse as them no know how to sell there market again, now if u carry that old notes buy something no change for you, as them go high the price of the goods as to make one or two extra gain,

Everybody done tire oo, now na survival we dey reason first, POS no dey pay again bcOs of shortage of cash,
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
No be only you the matter don tire, d matter don tire everybody. Every decision wey dem take na we dey suffer am and they don't give a damn. Hunger go dey do you strong tin and your money dey for bank but you no fit collect am buy something to eat. It's really painful. POS too wan use this opportunity cash out with their high charge rate. Yesterday I know wetin I see before I fit get small cash take do one or two things.
hero member
Activity: 784
Merit: 666
This thing done get out of hand , na we dey make this country hard for ourselves small scarcity of naira note we done take advantage they suffer our fellow average citizens, those big men no dey suffer this scarcity we dey suffer but na same us wey supposed help each other dey make life hard for each other, I go say make I withdraw 30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain, things are getting from bad to worse and na the ordinary citizens they suffer am , let's not see every situation as an advantage to make money people dey hungry. You get money u no fit use am...wat a country.

This matter tire me wallahi. How we go dey trade naira against naira again. I’ll pay naira to buy naira. This matter no just favour the less privilege at all rather na the poor masses still dey suffer am. Any policy wey government implement to attack the rich men, last last na the poor masses still dey suffer am. With all these thing wey we don see happen, he mean say we not fit ever defeat all this them big politicians for the country?
hero member
Activity: 798
Merit: 723
This POS charges much for us but to m, it is not their fault, because some of them do buy the money from business men and women, so for their money to come out and they will still make their own gain inside, that is how that one be.
Exactly as u talk am na so e be. I get person wey de do POS business, him self na bribe him they give to get money wey him go they give people, and even with that no be any time him they see the money for the bank self.
Although we they do ourselves too because the charges wey those POS guys they charge too much for an average Nigerian wey they hustle wetting him go chop for house with him family. I de sure say this money issue go reach after election before e go settle because big men wey bank managers go give money go soon comot the money during election.
member
Activity: 308
Merit: 26
Guy u suppose dey happy say na 10% them collect from u wen my area na 50/50 we dey share with pos operators, the situation for the country don reach the stage wey be say even normal provision shops don dey collect transfer for #200 pepper,if u no get new currency. Even POS operator dey form to give u your own money wey u sweat for. And the worst part be say no be even the new note em go give u,na still the same old note wey we dey find way to commot for hand na em dem still dey give u. Now the news today na say make all old note return go bank before tommorow so even shops wey try dey collect old currency dem dey double the price for small thing wey u for buy, some thing wey dem dey sell 200 don turn 500, and e dey very bad.
Guy 50/50 Omo na die o, this POS guys no get chills o, 50/50 for your own money again, Omo the country done cast , today see queue wey line up for 200 naira notes and 100naira notes laugh wan kill me, but the truth of the matter be say hardship dey everywhere because of this naira notes, you go get money you no fit spend, for Benin I hear say CBN enter market they give POS agents money and the rate na 100naira for every 5k. That one goes well and daily everybody get limit for withdrawal,  other governments gats follow waiting Benin government do in other circulate cash everywhere. And Stop this outrageous charges we dey face up and down.
full member
Activity: 840
Merit: 137
Imagine person wey get access bank no fit access him money. No money for bank, no money for ATM, no money for POS, Buhari don give us an unforgettable parting gift.

Op, no vex ooo but I find this hard to believe because me no fit cough out this kind money give POS operator for just 30k transaction because na 10% dem dey charge for almost everywhere for my area wey be PH. Today sef I don perform 2 transactions using POS. I do 5k transaction at N400 and 6.5k at N600 and money wey dem charge me really pain me. The second person used my head, after agreeing that was going to do a transfer to him, las las the guy go call POS girl say make she collect the money, naso I come pay the charge. If to say na something wey I fit return I for just return am cuz the thing pain me.
Guy u suppose dey happy say na 10% them collect from u wen my area na 50/50 we dey share with pos operators, the situation for the country don reach the stage wey be say even normal provision shops don dey collect transfer for #200 pepper,if u no get new currency. Even POS operator dey form to give u your own money wey u sweat for. And the worst part be say no be even the new note em go give u,na still the same old note wey we dey find way to commot for hand na em dem still dey give u. Now the news today na say make all old note return go bank before tommorow so even shops wey try dey collect old currency dem dey double the price for small thing wey u for buy, some thing wey dem dey sell 200 don turn 500, and e dey very bad.
newbie
Activity: 25
Merit: 0
This POS charges much for us but to m, it is not their fault, because some of them do buy the money from business men and women, so for their money to come out and they will still make their own gain inside, that is how that one be.
member
Activity: 308
Merit: 26
Dem talk say na who wear the shoe know where e dey pain am. See eh, to be honest I nor blame these POS merchants wey dey add charges. For some of them na their only hustle be this dem nor get any other option, some of them nor get who to depend on, for some of the POS business na where dem dey see their daily bread. Since the whole thing start, some of them dey risk their lives every day dey comot for house by 3am, 4am just to go bank to ensure say dem dey front queue to see money collect. When dem reach there, e go take them almost 8hrs before them fit collect money. Now sef na only 5k people fit collect from ATM for my side. How these POS merchants go take see money chop? I just hope say e go better one day all these nonsense go stop.
I swear bro, the shoe they pain us wella but the issue be say we no go fit commot the shoe, the government no dey even talk anything concerning the recent happenings, their own na just to win the election, them no get the interest of the poor masses at heart, Omo every day things dey become worse as the days they pass, but we naija we strong o, we dey survive any situation, even it's gets worse we still survive, we no dey carry last and na waiting they really help us, because no matter how the situation harsh we go still scale through.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
This thing done get out of hand , na we dey make this country hard for ourselves small scarcity of naira note we done take advantage they suffer our fellow average citizens, those big men no dey suffer this scarcity we dey suffer but na same us wey supposed help each other dey make life hard for each other, I go say make I withdraw 30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain, things are getting from bad to worse and na the ordinary citizens they suffer am , let's not see every situation as an advantage to make money people dey hungry. You get money u no fit use am...wat a country.
Dem talk say na who wear the shoe know where e dey pain am. See eh, to be honest I nor blame these POS merchants wey dey add charges. For some of them na their only hustle be this dem nor get any other option, some of them nor get who to depend on, for some of the POS business na where dem dey see their daily bread. Since the whole thing start, some of them dey risk their lives every day dey comot for house by 3am, 4am just to go bank to ensure say dem dey front queue to see money collect. When dem reach there, e go take them almost 8hrs before them fit collect money. Now sef na only 5k people fit collect from ATM for my side. How these POS merchants go take see money chop? I just hope say e go better one day all these nonsense go stop.
sr. member
Activity: 714
Merit: 421
This is not different from the truth. The outrageous charges from POS SERVICE is something too worrisome. They charge. #100 like as if that is their last transaction they would do on earth. They rare really taking advantage of the current situation of Naija bank since their is a shortage in the new note, and bank knows this. I am a witness the experience
Is not what one would go through without undergoing stress and pressure. But how ever the payment transaction fee still goes not until the CBN and federal government make available through the bank enough naira notes in circulation for the citizens
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
You see this our country people wey d do one business or the other, Call it transportation, marketers, traders, government officials etc dem d wicked. Dem d take advantage of any small thing wey happen for the country as an advantage to siphon the general public. How can peso open em God given mouth to charge peso 9k out of the 30k wey em wan withdraw from POS. No be wickedness be that? You expect peso to give you such huge amount wey you no work for just like that.

Na this kind thing wey I d tell people sae, as we all be Nigerians our ways no pure wen given an opportunity to serve the public. Every small little na thing na money. Peso no fit help you for ordinary for the country without demanding for something in return.

This was country don turn her citizens to have a corruptable mindset to take an given opportunities brought to them as an advantage to enrich themselves. What a country we live so. Everybody d find ways to siphon others
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
This thing done get out of hand , na we dey make this country hard for ourselves small scarcity of naira note we done take advantage they suffer our fellow average citizens, those big men no dey suffer this scarcity we dey suffer but na same us wey supposed help each other dey make life hard for each other, I go say make I withdraw 30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain, things are getting from bad to worse and na the ordinary citizens they suffer am , let's not see every situation as an advantage to make money people dey hungry. You get money u no fit use am...wat a country.
I no really blame this POS agents because most times I dey see the kind shit tem dey go through just to make small money dey available for us to use and for that alone Dem dey try aswear and some of them dey even sleep for ATM just to meet up with cash but Abeh make them also reduce the price Abeg no be we do am.

I think the government should be the right ones we should declare war on and I think this is another great farewell message to is by the presidency.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
Guy everything for these country now na wuta wuta lol.
Buh that POS wey charge you for 9K because you wan 30K e too much na.
Sorry to say but most of POS people they among  people wey make these worst because.
Now for my side some POS they even charge normal price  as them they do before  before the scarcity of these note but we pray everything should come in order because these country don hard for people.
Person with him money e no fit withdraw the thing they surprise me uptill now
member
Activity: 308
Merit: 26
30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain,
The POS attendance wan carry you build house ?? Lol.
The charge really high pass normal, for our end here the highest them they charge nah 2h for each 1k which no be everybody self they charge so, if u Waka for like 1-3 people you fit see who go take the least 150 for each 1k which that you 30k for be like 4.5k for the fee .
But this 9k way them wan charge you nah 3h per 1k..
Sometimes I no they too blame this POS people because nah Buy most of them they buy money to carry do business.
Omo me I done stop to do POS, na transfer I dey run now, I go just go the shop if you get waitin I wan buy I go ask you if you dey do transfer of you say no I goy way if you say yes I do the transfer, if waitin I buy na like 4300 I go transfer you 5k then you go give me the remaining 700 naira for hand make I carry see front I no fit shout o, this POS and there charges wan kill person come belike say na only charges person the withdraw.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
This na real matter o, serious one way dey worry the whole nation as e be now and some Nigerians dey react crazily about the whole thing. E con be like say, na the first time way dem dey change money for this nation. The last time dem change money no get the kind effect way we dey get now and I wonder watin change.

The only thing way dey play for my head be say, people don become too business minded and the corruption way dey for we country do make people to appreciate and use there office to dey take advantage of the masses. I hear for news yesterday say Efcc don go carry one bank manager with over #22m in raw cash of the new notes. Money way never go round, person don dey hoard am and the pos people cef, you no just know where them dey bring out the money from but, I no go surprise if na buy them dey buy way don make the charges dey very high.

Only charge cef dey finish money when person never even use am do watin e for like use am do... d matter cast like that.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
This thing done get out of hand , na we dey make this country hard for ourselves small scarcity of naira note we done take advantage they suffer our fellow average citizens, those big men no dey suffer this scarcity we dey suffer but na same us wey supposed help each other dey make life hard for each other, I go say make I withdraw 30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain, things are getting from bad to worse and na the ordinary citizens they suffer am , let's not see every situation as an advantage to make money people dey hungry. You get money u no fit use am...wat a country.
Bros the thing  done tire everybody with time the charges go come down and the problem now be say pos people self they suffer to collect money now bank apps too they misbehave, I buy something yesterday I run transfer I no see my package carry till the next day because the guy no see alert, na zenith bank people see shege pass today, I know even know waiting to talk again for this cash matter.
hero member
Activity: 532
Merit: 618
30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain,
The POS attendance wan carry you build house ?? Lol.
The charge really high pass normal, for our end here the highest them they charge nah 2h for each 1k which no be everybody self they charge so, if u Waka for like 1-3 people you fit see who go take the least 150 for each 1k which that you 30k for be like 4.5k for the fee .
But this 9k way them wan charge you nah 3h per 1k..
Sometimes I no they too blame this POS people because nah Buy most of them they buy money to carry do business.
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Top Crypto Casino
This matter don serious pass wetin I expect oh, where I start to see reality na yesterday night when I transfer small 1k to lose #200 as charge nai them debt me go show declined for the POS paper up till now I never see my moni wey come back.
[~snipped~]

I experienced the same thing the last time I went back home from school. I go POS make I withdraw small cash make I for hold make eh nor be like say I nor just get anything for hand at all at all nai I enter POS shop. After she press wetin she wan press finish for her machine I input my pin only for the machine to show declined and still yet I receive debit alert for my phone. The lady say even if heaven come down she nor dey give me shishi until I go bank go print statement of account come show her. And even the bank queue when dey too long nai make me just die the matter like that.
But for my school environment we still dey manage for there Sha at least those ones the accept transfer for anything when you purchase so the issue of no cash nor really they affect us there. Nah only if we wan buy things when the price nor too high nai we dey use cash for.
sr. member
Activity: 644
Merit: 384
Play Bitcoin PVP Prediction Game
Since dis craziness started I never withdraw from any POS, I just dey lucky to have buy plenty food for house wey fit carry me reach 6 months, if this nonsense reach 6 months I don enter am be that.
member
Activity: 308
Merit: 26
This matter don serious pass wetin I expect oh, where I start to see reality na yesterday night when I transfer small 1k to lose #200 as charge nai them debt me go show declined for the POS paper up till now I never see my moni wey come back. That same night we find where to even do 5k but my contri piple, we no see, no moni to take buy kerosine or any soup things even to refill gas self na war while the POS person say moni wey dy nai wetin him wan take survive say moni no dy. My God, I no believe say I chop food wey no done well cos no moni and night don cover to even take credit something, see as to even sleep well dy hard cos of say I chop food wey no boil well...
I dey tell you this POS guys no get chills, just to withdraw money you go end up spending almost half the money you wan withdraw, and all of them enter agreement as the same dey applicable everywhere, now for my area ATM machines no dey dispense money, bank sell money to this pos guys , I been wan do POS some days ago the woman was so in  a hurry just because they call am say where she dey buy money the cash done dey available say make she come collect she was so rude about it, and I was like who are those selling this Money, now to withdraw na man know man, it's frustrating man.
Pages:
Jump to: